Mateus 28
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 Wen day break for Sabat Day, wey bi di first day for di week, Mary Magdalin and di oda Mary kon go look di grave.
1 Depois do sábado, quando amanhecia o primeiro dia da semana, Maria Madalena e a outra Maria foram ver o túmulo.
2 At wons, strong eartkweke happen, bikos God angel kom down from heaven, roll di stone komot kon sidan on-top am.
2 E eis que houve um violento tremor de terra: um anjo do Senhor desceu do céu, rolou a pedra e sentou-se sobre ela.
3 En face bi like tonda lite and en klot white like snow.
3 Resplandecia como relâmpago e suas vestes eram brancas como a neve.
4 Di guards kon dey shake and dem bi like pipol wey won die, bikos fear katch dem well-well.
4 Vendo isto, os guardas pensaram que morreriam de pavor.
5 But di angel tell di wimen, “Make una nor fear, I know sey una dey look for Jesus Christ, wey dem nail for cross.
5 Mas o anjo disse às mulheres: Não temais! Sei que procurais Jesus, que foi crucificado.
6 E nor dey here, bikos God don wake am up, just as God promise. Make una kom si di place where e liedan put before.
6 Não está aqui: ressuscitou como disse. Vinde e vede o lugar em que ele repousou.
7 Den make una kwik-kwik go tell en disciples sey, ‘God don raiz am from deat and e dey go wait for una for Galilee. Una go si am for der.’ Make una remember sey I tell una so!”
7 Ide depressa e dizei aos discípulos que ele ressuscitou dos mortos. Ele vos precede na Galiléia. Lá o haveis de rever, eu vo-lo disse.
8 So dem run komot from di grave with fear and dem kon dey happy as dem dey go tell en disciples.
8 Elas se afastaram prontamente do túmulo com certo receio, mas ao mesmo tempo com alegria, e correram a dar a boa nova aos discípulos.
9 But Jesus Christ meet dem for road kon tell dem, “I greet una o-o!” Dem dress near am, hold en leg kon woship am.
9 Nesse momento, Jesus apresentou-se diante delas e disse-lhes: Salve! Aproximaram-se elas e, prostradas diante dele, beijaram-lhe os pés.
10 Den Jesus Christ tell dem, “Make una nor fear, but tell my brodas make dem go Galilee and dem go si mi for der.”
10 Disse-lhes Jesus: Não temais! Ide dizer aos meus irmãos que se dirijam à Galiléia, pois é lá que eles me verão.
11 As dem dey go, some for di guards go inside di town go tell di priest oga dem evritin wey happen.
11 Enquanto elas voltavam, alguns homens da guarda já estavam na cidade para anunciar o acontecimento aos príncipes dos sacerdotes.
12 Afta dem don gada and plan with di eldas, dem kon give di sojas plenty money,
12 Reuniram-se estes em conselho com os anciãos. Deram aos soldados uma importante soma de dinheiro, ordenando-lhes:
13 kon tell dem sey, “Make una tok sey, ‘Jesus Christ disciples kom tif en body for nite wen wi dey sleep.’
13 Vós direis que seus discípulos vieram retirá-lo à noite, enquanto dormíeis.
14 If di govnor hear about dis matter, wi know wetin to tell am and una nor go enter trobol.”
14 Se o governador vier a sabê-lo, nós o acalmaremos e vos tiraremos de dificuldades.
15 So dem take di money kon do as di eldas tell dem. Pipol still dey tok dis story for evriwhere wey Jew pipol dey, kom rish today.
15 Os soldados receberam o dinheiro e seguiram suas instruções. E esta versão é ainda hoje espalhada entre os judeus.
16 So di eleven disciples kon go Galilee for di mountin wey Jesus Christ tell dem.
16 Os onze discípulos foram para a Galiléia, para a montanha que Jesus lhes tinha designado.
17 Wen dem si am, dem woship am, but some among dem kon dey doubt.
17 Quando o viram, adoraram-no; entretanto, alguns hesitavam ainda.
18 Den Jesus Christ waka near kon tell dem, “God don give mi all di pawa wey dey heaven and eart.
18 Mas Jesus, aproximando-se, lhes disse: Toda autoridade me foi dada no céu e na terra.
19 So make una go make pipol my disciples for di whole world, dey baptize dem with di Papa, di Pikin and di Holy Spirit name,
19 Ide, pois, e ensinai a todas as nações; batizai-as em nome do Pai, do Filho e do Espírito Santo.
20 dey tish dem to do evritin wey I tish una. I go always dey with una until di world go end.”
20 Ensinai-as a observar tudo o que vos prescrevi. Eis que estou convosco todos os dias, até o fim do mundo.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Mateus 28, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.