Mateus 19

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARC

Sair da comparação
ARC Almeida Revista e Corrigida 2009
1 Wen Jesus tok finish, e kon komot from Galilee go Judea aria for di oda side for Jordan River.
1 E aconteceu que, concluindo Jesus esses discursos, saiu da Galileia e dirigiu-se aos confins da Judeia, além do Jordão.
2 Plenty pipol follow am and e heal all of dem.
2 E seguiram-no muitas gentes e curou-as ali.
3 Some Farisee pipol kom test and ask am sey, “E dey rite for man to drive en wife at-all?”
3 Então, chegaram ao pé dele os fariseus, tentando-o e dizendo-lhe: É lícito ao homem repudiar sua mulher por qualquer motivo?
4 Jesus ansa, “Yu neva read am from di biginnin sey na man and woman God make
4 Ele, porém, respondendo, disse-lhes: Não tendes lido que, no princípio, o Criador os fez macho e fêmea
5 and bikos of dat, ‘Man go leave en papa and mama go join en wife and di two of dem go kon bi one?’
5 e disse: Portanto, deixará o homem pai e mãe e se unirá à sua mulher, e serão dois numa só carne?
6 Dem nor bi two again, but one. So, wetin God don join togeda, make nobody skata am.”
6 Assim não são mais dois, mas uma só carne. Portanto, o que Deus ajuntou não separe o homem.
7 Di Farisee pipol ask am again, “Wetin make Moses sey make wi drive awa wife?”
7 Disseram-lhe eles: Então, por que mandou Moisés dar-lhe carta de divórcio e repudiá-la?
8 Jesus ansa, “Moses sey make una drive una wife, bikos una heart dey wiked, but nor bi so God plan am from biginnin.
8 Disse-lhes ele: Moisés, por causa da dureza do vosso coração, vos permitiu repudiar vossa mulher; mas, ao princípio, não foi assim.
9 Naw I tell una, anybody wey drive en wife, wey nor bi sey e sleep with anoda man, but kon marry anoda woman, don kommit adultery.”
9 Eu vos digo, porém, que qualquer que repudiar sua mulher, não sendo por causa de prostituição, e casar com outra, comete adultério; e o que casar com a repudiada
10 Di disciples kon tell Jesus, “If na so husband and wife matter bi, e betta make pesin nor marry at-all?”
10 Disseram-lhe seus discípulos: Se assim é a condição do homem relativamente à mulher, não convém casar.
11 Jesus ansa dem, “Nor bi evribody go fit asept dis word, but na only di pipol wey God give di pawa.
11 Ele, porém, lhes disse: Nem todos podem receber esta palavra, mas
12 Many men nor fit sleep with woman, bikos na so dem born dem, some na human being do dem like dat, but odas na bikos of God Kingdom. Anybody wey fit asept wetin I tok, make e take am like dat.”
12 Porque há eunucos que assim nasceram do ventre da mãe; e há eunucos que foram castrados pelos homens; e há eunucos que se castraram a si mesmos por causa do Reino dos céus. Quem pode receber isso, que o receba.
13 Some pipol bring shidren kon meet Jesus make e put hand for dia head pray for dem. But di disciples kon bigin kworel with di pipol wey bring di shidren.
13 Trouxeram-lhe, então, algumas crianças, para que lhes impusesse as mãos e orasse; mas os discípulos os repreendiam.
14 But Jesus tell di disciples, “Make una leave di small shidren make dem kom meet mi, nor stop dem, bikos na dem get God Kingdom.”
14 Jesus, porém, disse: Deixai os pequeninos e não os estorveis de vir a mim, porque dos tais é o Reino dos céus.
15 So e put en hand for dia head, bless dem, den e waka komot der.
15 E, tendo-lhes imposto as mãos, partiu dali.
16 One man kom meet Jesus, ask am, “Tisha, wish good tin I go do make I for fit enter God Kingdom?”
16 E eis que, aproximando-se dele um jovem, disse-lhe: Bom Mestre, que bem farei, para conseguir a vida eterna?
17 Jesus ansa am, “Why yu dey ask mi about wetin good? Na only God good. So if yu wont enter heaven, make yu keep God kommandments.”
17 E ele disse-lhe: Por que me chamas bom? Não
18 Di man kon ask, “Wish one for di kommandment?”
18 Disse-lhe ele: Quais? E Jesus disse: Não matarás, não cometerás adultério, não furtarás, não dirás falso testemunho;
19 respet yor papa and mama and make yu love yor neighbour as yu love yorsef.”
19 honra teu pai e tua mãe, e amarás o teu próximo como a ti mesmo.
20 Di yong man ansa, “I dey obey all dis law with my heart. Wetin still remain wey I go do?”
20 Disse-lhe o jovem: Tudo isso tenho guardado desde a minha mocidade; que me falta ainda?
21 Jesus tell am, “If yu won dey pafet, go sell evritin wey yu get, den give di money to poor pipol and yu go get betta tins for heaven. Wen yu don do wetin I tok, den make yu kom follow mi.”
21 Disse-lhe Jesus: Se queres ser perfeito, vai, vende tudo o que tens, dá-o aos pobres e terás
22 Wen di yong man hear wetin Jesus tok, e vex waka komot, bikos e get money well-well.
22 E o jovem, ouvindo essa palavra, retirou-se triste, porque possuía muitas propriedades.
23 Den Jesus tell en disciples, “I tell una true word, e go hard for pesin wey get money well-well to enter God Kingdom!
23 Disse, então, Jesus aos seus discípulos: Em verdade vos digo que é difícil entrar um rico no Reino dos céus.
24 Again, I dey tok sey, e go eazy for kamel to pass thru nidol whole, dan for pesin wey get money well-well to enter God Kingdom.”
24 E outra vez vos digo que é mais fácil passar um camelo pelo fundo de uma agulha do que entrar um rico no Reino de Deus.
25 Di disciples sopraiz wen dem hear dis tins and dem kon ask, “Den who go fit dey save?”
25 Os seus discípulos, ouvindo isso, admiraram-se muito, dizendo: Quem poderá, pois, salvar-se?
26 Jesus look dem kon ansa, “E nor possibol for human being, but evritin dey possibol with God.”
26 E Jesus, olhando para eles, disse-lhes: Aos homens é isso impossível, mas a Deus tudo é possível.
27 Den Pita kon tell Jesus, “Look, wi don leave evritin wey wi get kon follow yu! Wetin dey for us naw?”
27 Então, Pedro, tomando a palavra, disse-lhe: Eis que nós deixamos tudo e te seguimos; que receberemos?
28 Jesus ansa am, “I tell yu true word, for dat time wen evritin go dey new, Man Pikin go sidan for en throne wey get glory and una wey dey follow mi, go sidan for twelf thrones, dey judge di twelf tribes wey dey Israel.
28 E Jesus disse-lhes: Em verdade vos digo que vós, que me seguistes, quando, na regeneração, o Filho do Homem se assentar no trono da sua glória, também vos assentareis sobre doze tronos, para julgar as doze tribos de Israel.
29 And anybody wey leave en house, brodas, sistas, papa or mama and land bikos of mi, go get am back hundred times and e go get life wey nor dey end.
29 E todo aquele que tiver deixado casas, ou irmãos, ou irmãs, ou pai, ou mãe, ou mulher, ou filhos, ou terras, por amor do meu nome, receberá cem vezes tanto e herdará a vida eterna.
30 So many pipol wey bi first naw, go bi last and doz wey bi last, go bi first.”
30 Porém muitos primeiros serão derradeiros, e

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Mateus 19, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.