Mateus 18
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 Dat time, di disciples kon ask Jesus, “Na who big pass for God Kingdom?”
1 Neste momento os discípulos aproximaram-se de Jesus e perguntaram-lhe: Quem é o maior no Reino dos céus?
2 Jesus kon koll one pikin stand for dia front,
2 Jesus chamou uma criancinha, colocou-a no meio deles e disse:
3 den e ansa, “I tell una true word, unless una bi like small pikin, una nor go fit enter God Kingdom!
3 Em verdade vos declaro: se não vos transformardes e vos tornardes como criancinhas, não entrareis no Reino dos céus.
4 Anybody wey bring ensef down like dis small pikin, naim big pass for God Kingdom.
4 Aquele que se fizer humilde como esta criança será maior no Reino dos céus.
5 “Anybody wey welkom one pikin like dis one for my name, welkom mi.
5 E o que recebe em meu nome a um menino como este, é a mim que recebe.
6 But if pesin make one of dis small shidren wey bilive mi kommit sin, e betta make dem tie grindin stone for en neck, make e for sink inside river.
6 Mas, se alguém fizer cair em pecado um destes pequenos que crêem em mim, melhor fora que lhe atassem ao pescoço a mó de um moinho e o lançassem no fundo do mar.
7 “Wahala dey for dis world, bikos of di sin wey pipol dey kommit! Na true sey trobol must kom, but e go bad for di pesin wey go kause di trobol.
7 Ai do mundo por causa dos escândalos! Eles são inevitáveis, mas ai do homem que os causa!
8 If yor hand or leg dey make yu sin, make yu kut am trowey. E betta make yu enter God Kingdom without hand or leg, dan sey God trow yu inside fire wey nor dey kwensh.
8 Por isso, se tua mão ou teu pé te fazem cair em pecado, corta-os e lança-os longe de ti: é melhor para ti entrares na vida coxo ou manco que, tendo dois pés e duas mãos, seres lançado no fogo eterno.
9 If yor eye dey make yu sin, make yu pul am trowey. E betta make yu enter God Kingdom with one eye, down sey God trow yu enter hell-fire with two eyes.”
9 Se teu olho te leva ao pecado, arranca-o e lança-o longe de ti: é melhor para ti entrares na vida cego de um olho que seres jogado com teus dois olhos no fogo da geena.
10 “Make sure sey una nor porshu any of dis small shidren komot. I tell una di trut, dia angels dey my Papa front for heaven evritime.
10 Guardai-vos de menosprezar um só destes pequenos, porque eu vos digo que seus anjos no céu contemplam sem cessar a face de meu Pai que está nos céus.
11 Bikos Man Pikin kon save pipol wey lost.
11 {Porque o Filho do Homem veio salvar o que estava perdido.}
12 “Wetin yu tink? If pesin get hundred sheep and one waka lost, e nor go leave di ninty-nine for di bush go find di one wey lost?
12 Que vos parece? Um homem possui cem ovelhas: uma delas se desgarra. Não deixa ele as noventa e nove na montanha, para ir buscar aquela que se desgarrou?
13 I tell una true word, wen e si am, e go happy for dat one pass di ninty-nine wey nor lost.
13 E se a encontra, sente mais júbilo do que pelas noventa e nove que não se desgarraram.
14 Na like dis too yor Papa for heaven nor wont make any of en shidren lost.”
14 Assim é a vontade de vosso Pai celeste, que não se perca um só destes pequeninos.
15 “If yor broda do yu bad, make yu go tell am wetin e do. If e asept wetin yu tell am, yu don win yor broda back bi dat.
15 Se teu irmão tiver pecado contra ti, vai e repreende-o entre ti e ele somente; se te ouvir, terás ganho teu irmão.
16 But if e nor asept wetin yu tok, take one or two pipol follow body go meet am, bikos matter wey two or three pipol tok put, naim betta pass.
16 Se não te escutar, toma contigo uma ou duas pessoas, a fim de que toda a questão se resolva pela decisão de duas ou três testemunhas.
17 If e nor asept wetin dem tok, make yu tell di church leaders. If e nor gri listin to wetin di church leaders tok, den make una trit am like sina or tax kollector.
17 Se recusa ouvi-los, dize-o à Igreja. E se recusar ouvir também a Igreja, seja ele para ti como um pagão e um publicano.
18 “I tell una true word, anytin wey una take prayer tie for eart, God go tie am for heaven and anytin wey una take prayer luz for eart, God go luz am for heaven.
18 Em verdade vos digo: tudo o que ligardes sobre a terra será ligado no céu, e tudo o que desligardes sobre a terra será também desligado no céu.
19 “Again, I tell una true word, if two of una for dis world gri and pray for anytin, my Papa for heaven go do am for una.
19 Digo-vos ainda isto: se dois de vós se unirem sobre a terra para pedir, seja o que for, consegui-lo-ão de meu Pai que está nos céus.
20 Anywhere two or three pipol gada for my name, I go dey der with dem.”
20 Porque onde dois ou três estão reunidos em meu nome, aí estou eu no meio deles.
21 Den Pita kon ask Jesus, “Oga God, how many times I go forgive my broda wey do mi bad? Na seven times?”
21 Então Pedro se aproximou dele e disse: Senhor, quantas vezes devo perdoar a meu irmão, quando ele pecar contra mim? Até sete vezes?
22 Jesus ansa am, “Nor bi only seven times I tell yu, but na four hundred and ninty times!”
22 Respondeu Jesus: Não te digo até sete vezes, mas até setenta vezes sete.
23 “God Kingdom bi like wen one king wey won know how en savants dey manage en business.
23 Por isso, o Reino dos céus é comparado a um rei que quis ajustar contas com seus servos.
24 As di king dey shek di akkount, dem kon bring one savant wey dey whole 10,000 koins kom.
24 Quando começou a ajustá-las, trouxeram-lhe um que lhe devia dez mil talentos.
25 Bikos e nor fit pay wetin e whole, di king kon orda make dem sell di man, en wife, en shidren and evritin wey e get, take pay di debt.
25 Como ele não tinha com que pagar, seu senhor ordenou que fosse vendido, ele, sua mulher, seus filhos e todos os seus bens para pagar a dívida.
26 “So, di savant fall for di king front dey beg, ‘Oga God, make yu dey patient with mi, I go pay yu evritin.’
26 Este servo, então, prostrou-se por terra diante dele e suplicava-lhe: Dá-me um prazo, e eu te pagarei tudo!
27 Di king sorry for di savant kon release am sey make e nor pay again.
27 Cheio de compaixão, o senhor o deixou ir embora e perdoou-lhe a dívida.
28 “Afta, di same savant kon si anoda savant wey dey hold am hundred silva koins. E seize am for troat nearly kill-am kon tell am, ‘Make yu pay mi my money.’
28 Apenas saiu dali, encontrou um de seus companheiros de serviço que lhe devia cem denários. Agarrou-o na garganta e quase o estrangulou, dizendo: Paga o que me deves!
29 “Di savant wey e seize for troat kon fall for groun dey beg am, ‘Make yu dey patient with mi, I go pay yu yor money.’
29 O outro caiu-lhe aos pés e pediu-lhe: Dá-me um prazo e eu te pagarei!
30 “But e nor gri. Instead e karry am go put for prison, until e go pay wetin e whole.
30 Mas, sem nada querer ouvir, este homem o fez lançar na prisão, até que tivesse pago sua dívida.
31 Wen di oda savants si wetin happen, dem nor happy at-all, so dem kon go tell di king evritin wey happen.
31 Vendo isto, os outros servos, profundamente tristes, vieram contar a seu senhor o que se tinha passado.
32 “So di king koll di first savant kon tell am, ‘Yu wiked savant! I forgive yu di big debt wey yu whole mi, bikos yu beg!
32 Então o senhor o chamou e lhe disse: Servo mau, eu te perdoei toda a dívida porque me suplicaste.
33 Wetin make yu nor sorry for anoda savant like yu, just as I sorry for yu?’
33 Não devias também tu compadecer-te de teu companheiro de serviço, como eu tive piedade de ti?
34 With vexnashon, di king kon give di savant to soja make dem sofa am well-well, until e pay evritin wey e dey whole.
34 E o senhor, encolerizado, entregou-o aos algozes, até que pagasse toda a sua dívida.
35 “So, na like dis too my Papa for heaven go do una, if una nor forgive una brodas from una heart.”
35 Assim vos tratará meu Pai celeste, se cada um de vós não perdoar a seu irmão, de todo seu coração.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Mateus 18, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.