Mateus 17

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 Afta six days, Jesus take Pita, James and John (wey bi James broda), go on-top one high mountin.
1 Seis dias depois, Jesus tomou consigo Pedro, Tiago e João, seu irmão, e conduziu-os à parte a uma alta montanha.
2 Jesus body kon shange. En face kon dey shine like sun and en dress kon white.
2 Lá se transfigurou na presença deles: seu rosto brilhou como o sol, suas vestes tornaram-se resplandecentes de brancura.
3 At wons Moses and Elijah kon appear dey tok to Jesus.
3 E eis que apareceram Moisés e Elias conversando com ele.
4 So Pita kon tell Jesus, “Oga God, e good make wi stay here. If yu like, I go build three tent: one for yu, one for Moses and one for Elijah.”
4 Pedro tomou então a palavra e disse-lhe: Senhor, é bom estarmos aqui. Se queres, farei aqui três tendas: uma para ti, uma para Moisés e outra para Elias.
5 As e still dey tok, one brite kloud kon kover dem and one vois kon sey, “Dis na my Pikin wey I love. Make una listin to am!”
5 Falava ele ainda, quando veio uma nuvem luminosa e os envolveu. E daquela nuvem fez-se ouvir uma voz que dizia: Eis o meu Filho muito amado, em quem pus toda minha afeição; ouvi-o.
6 Wen di disciples hear di vois, dem fear kon fall face groun.
6 Ouvindo esta voz, os discípulos caíram com a face por terra e tiveram medo.
7 But Jesus tosh dem kon sey, “Stand up! Make una nor fear.”
7 Mas Jesus aproximou-se deles e tocou-os, dizendo: Levantai-vos e não temais.
8 Wen dem look up, di only pesin wey dem si, na Jesus.
8 Eles levantaram os olhos e não viram mais ninguém, senão unicamente Jesus.
9 As dem dey kom down from di mountin, Jesus warn dem sey, “Make una nor tell anybody dis vishon wey una si until God go wake Man Pikin from deat.”
9 E, quando desciam, Jesus lhes fez esta proibição: Não conteis a ninguém o que vistes, até que o Filho do Homem ressuscite dos mortos.
10 Di disciples ask am, “Why di law tishas dey tish sey na Elijah go first kom?”
10 Em seguida, os discípulos o interrogaram: Por que dizem os escribas que Elias deve voltar primeiro?
11 Jesus ansa, “Na true sey Elijah go first kom and e go ripair evritin.
11 Jesus respondeu-lhes: Elias, de fato, deve voltar e restabelecer todas as coisas.
12 And I tell una sey, dat Elijah don kom, but pipol nor know am, instead dem do am as dem like. Na so too, God Pikin go sofa for dia hand.”
12 Mas eu vos digo que Elias já veio, mas não o conheceram; antes, fizeram com ele quanto quiseram. Do mesmo modo farão sofrer o Filho do Homem.
13 Den di disciples kon know sey e dey tell dem about John di Baptist.
13 Os discípulos compreenderam, então, que ele lhes falava de João Batista.
14 Wen Jesus and en disciples meet di pipol, one man kon knee down for Jesus front
14 E, quando eles se reuniram ao povo, um homem aproximou-se deles e prostrou-se diante de Jesus,
15 beg am sey, “Oga God, make yu sorry for my son, bikos e nor well and many times, di sickness dey sofa and trow am inside fire and wota.
15 dizendo: Senhor, tem piedade de meu filho, porque é lunático e sofre muito: ora cai no fogo, ora na água...
16 I bring am kom meet yor disciples, but dem nor fit heal am.”
16 Já o apresentei a teus discípulos, mas eles não o puderam curar.
17 Jesus kon ansa, “Una wey nor get faith and wey nor know wetin to do! How long I go dey with una? How long I go bear with una? Make una bring di boy kom here.”
17 Respondeu Jesus: Raça incrédula e perversa, até quando estarei convosco? Até quando hei de aturar-vos? Trazei-mo.
18 Den Jesus kommand di demon komot from di boy body and at wons, di boy kon well.
18 Jesus ameaçou o demônio e este saiu do menino, que ficou curado na mesma hora.
19 Wen only di disciples dey with Jesus, dem kon ask am, “Why wi nor fit drive di demon komot from di boy body?”
19 Então os discípulos lhe perguntaram em particular: Por que não pudemos nós expulsar este demônio?
20 Jesus ansa dem, “Na bikos una faith too small and I tell una true word, ‘If una get faith wey small like mustard seed, una go tell dis mountin, “Make yu move from here go yonda” and e go move and nor-tin go hard una to do.’
20 Jesus respondeu-lhes: Por causa de vossa falta de fé. Em verdade vos digo: se tiverdes fé, como um grão de mostarda, direis a esta montanha: Transporta-te daqui para lá, e ela irá; e nada vos será impossível.
21 Dis kind demon nor go gri komot from pesin body escept na with fasting and prayer.”
21 Quanto a esta espécie de demônio, só se pode expulsar à força de oração e de jejum.
22 Wen dem enter Galilee, Jesus kon tell dem, “Somebody go sell Man Pikin give wiked pipol.
22 Enquanto caminhava pela Galiléia, Jesus lhes disse: O Filho do Homem deve ser entregue nas mãos dos homens.
23 Dem go kill-am and for di third day, God go wake am up.” But di disciples nor happy, bikos of wetin Jesus tok.
23 Matá-lo-ão, mas ao terceiro dia ressuscitará. E eles ficaram profundamente aflitos.
24 Wen Jesus and en disciples rish Kapanaum, di pipol wey dey kollect tax for di temple kom meet Pita, ask am sey, “Yor oga dey pay Temple tax?”
24 Logo que chegaram a Cafarnaum, aqueles que cobravam o imposto da didracma aproximaram-se de Pedro e lhe perguntaram: Teu mestre não paga a didracma?
25 Pita ansa, “Yes.”
25 Paga sim, respondeu Pedro. Mas quando chegaram à casa, Jesus preveniu-o, dizendo: Que te parece, Simão? Os reis da terra, de quem recebem os tributos ou os impostos? De seus filhos ou dos estrangeiros?
26 Pita ansa, “Na strenjas dey pay tax.”
26 Pedro respondeu: Dos estrangeiros. Jesus replicou: Os filhos, então, estão isentos.
27 but make dem nor for kause trobol, make yu go trow hook for river. Di first fish wey yu go katch, wen yu open en mout, yu go si money for inside, den make yu take di money pay di tax for mi and una.”
27 Mas não convém escandalizá-los. Vai ao mar, lança o anzol, e ao primeiro peixe que pegares abrirás a boca e encontrarás um estatere. Toma-o e dá-o por mim e por ti.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Mateus 17, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.