Mateus 16

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA

Sair da comparação
ARA Almeida Revista e Atualizada 1993
1 Di Farisee and Sadusi pipol kom test Jesus. Dem ask am make e show dem sign from heaven.
1 Aproximando-se os fariseus e os saduceus, tentando-o, pediram-lhe que lhes mostrasse um sinal vindo do céu.
2 But Jesus tell dem, “Wen evening rish, una go sey, ‘Di weda go good bikos di sky red,’
2 Ele, porém, lhes respondeu: Chegada a tarde, dizeis: Haverá bom tempo, porque o céu está avermelhado;
3 and for morning, una go sey, ‘Rain go fall bikos di sky red and dark.’ Una sabi use di sky know how weda go bi, but una nor fit know di signs about di time wey God tok for en word.
3 e, pela manhã: Hoje, haverá tempestade, porque o céu está de um vermelho sombrio. Sabeis, na verdade, discernir o aspecto do céu e não podeis discernir os sinais dos tempos?
4 Wiked and evil pipol for dis time dey ask for sign, but dem nor go get any one, escept Jonah sign.” Den Jesus kon waka leave dem.
4 Uma geração má e adúltera pede um sinal; e nenhum sinal lhe será dado, senão o de Jonas. E, deixando-os, retirou-se.
5 Wen di disciples cross go di oda side, dem forget to take bread follow body.
5 Ora, tendo os discípulos passado para o outro lado, esqueceram-se de levar pão.
6 Jesus kon tell dem, “Make una guide unasef against di Farisee and Sadusi pipol yist.”
6 E Jesus lhes disse: Vede e acautelai-vos do fermento dos fariseus e dos saduceus.
7 So dem kon dey tok among demsef sey, “Na bikos wi nor bring bread, naim make am dey tok like dis.”
7 Eles, porém, discorriam entre si, dizendo: É porque não trouxemos pão.
8 Wen Jesus know wetin dem dey tok, e kon tell dem, “Una faith small o-o! Wetin make una dey kworel with unasef sey una nor take bread follow body?
8 Percebendo-o Jesus, disse: Por que discorreis entre vós, homens de pequena fé, sobre o não terdes pão?
9 So una neva still undastand? Una nor remember di five bread wey I take feed 5,000 men and how many basket una gada afta dem don chop finish?
9 Não compreendeis ainda, nem vos lembrais dos cinco pães para cinco mil homens e de quantos cestos tomastes?
10 Or di seven bread for di 4,000 men and how many basket una gada afta dem don chop finish too?
10 Nem dos sete pães para os quatro mil e de quantos cestos tomastes?
11 Why una nor undastand sey I nor dey tok to una about bread? But na make una for guide unasef against wetin di Farisee and Sadusi pipol dey tish!”
11 Como não compreendeis que não vos falei a respeito de pães? E sim: acautelai-vos do fermento dos fariseus e dos saduceus.
12 Den di disciples kon know sey nor bi bikos of bread make am dey warn dem, but na bikos of di tins wey di Farisee and Sadusi pipol dey tish.
12 Então, entenderam que não lhes dissera que se acautelassem do fermento de pães, mas da doutrina dos fariseus e dos saduceus.
13 Wen Jesus Christ rish Caesaria for Filippi aria, e kon ask en disciples, “Na who pipol sey Man Pikin bi?”
13 Indo Jesus para os lados de Cesareia de Filipe, perguntou a seus discípulos: Quem diz o povo ser o Filho do Homem?
14 Dem ansa, “Some pipol sey yu bi John di Baptist, odas sey yu bi Elijah and some dey sey na Jeremaya or one oda profet naim yu bi.”
14 E eles responderam: Uns dizem: João Batista; outros: Elias; e outros: Jeremias ou algum dos profetas.
15 Jesus kon ask dem, “Who una sey I bi?”
15 Mas vós, continuou ele, quem dizeis que eu sou?
16 Simon Pita ansa, “Yu bi di Mezaya, God Pikin wey dey alive.”
16 Respondendo Simão Pedro, disse: Tu és o Cristo, o Filho do Deus vivo.
17 Den Jesus tell am, “God go bless yu, Simon, Jonah pikin, bikos na my Papa for heaven show yu dis tin, nor bi human being.
17 Então, Jesus lhe afirmou: Bem-aventurado és, Simão Barjonas, porque não foi carne e sangue que to revelaram, mas meu Pai, que está nos céus.
18 And I tell yu, yu bi Pita, wey mean rock and on-top dis rock, I go build my church and di gate for hell nor go fit skata am.
18 Também eu te digo que tu és Pedro, e sobre esta pedra edificarei a minha igreja, e as portas do inferno não prevalecerão contra ela.
19 I go give yu heaven key, so dat anytin wey yor prayer tie for eart, dem go tie am for heaven and anytin wey yor prayer luz for dis eart, dem go luz am for heaven.”
19 Dar-te-ei as chaves do reino dos céus; o que ligares na terra terá sido ligado nos céus; e o que desligares na terra terá sido desligado nos céus.
20 Den Jesus kommand en disciples make dem nor tell anybody sey, na-im bi di Mezaya.
20 Então, advertiu os discípulos de que a ninguém dissessem ser ele o Cristo.
21 From dat time go, Jesus kon dey tell en disciples sey, e go must enter Jerusalem where di eldas, priest oga dem and di law tishas go sofa and kill-am, but for di third day, e go wake-up.
21 Desde esse tempo, começou Jesus Cristo a mostrar a seus discípulos que lhe era necessário seguir para Jerusalém e sofrer muitas coisas dos anciãos, dos principais sacerdotes e dos escribas, ser morto e ressuscitado no terceiro dia.
22 So Pita take Jesus go one korna kon tell am, “Oga God! God forbid! Dis kind tin nor go ever happen to yu!”
22 E Pedro, chamando-o à parte, começou a reprová-lo, dizendo: Tem compaixão de ti, Senhor; isso de modo algum te acontecerá.
23 But Jesus turn face Pita kon sey, “Satan, komot for my front! Yu bi stone wey block road, bikos yor mind nor dey for wetin God wont, but na wetin man wont.”
23 Mas Jesus, voltando-se, disse a Pedro: Arreda, Satanás! Tu és para mim pedra de tropeço, porque não cogitas das coisas de Deus, e sim das dos homens.
24 Den Jesus tell en disciples, “If anybody won follow mi, e must deny ensef, karry en cross and follow mi.
24 Então, disse Jesus a seus discípulos: Se alguém quer vir após mim, a si mesmo se negue, tome a sua cruz e siga-me.
25 Anybody wey won save en life, go luz am, but anybody wey luz en life bikos of mi, go gain am.
25 Porquanto, quem quiser salvar a sua vida perdê-la-á; e quem perder a vida por minha causa achá-la-á.
26 Wetin pesin go gain, if di whole world bi en own, but e luz en soul? Or wetin pesin go fit give take pay for en soul?
26 Pois que aproveitará o homem se ganhar o mundo inteiro e perder a sua alma? Ou que dará o homem em troca da sua alma?
27 God Pikin and en angels go kom inside en Papa glory, den e go reward evribody akordin to dia work.
27 Porque o Filho do Homem há de vir na glória de seu Pai, com os seus anjos, e, então, retribuirá a cada um conforme as suas obras.
28 I tell una true word, some of una dey here wey nor go die, before God Pikin go kom back with en kingdom.”
28 Em verdade vos digo que alguns há, dos que aqui se encontram, que de maneira nenhuma passarão pela morte até que vejam vir o Filho do Homem no seu reino.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Mateus 16, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.