Mateus 12

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARC

Sair da comparação
ARC Almeida Revista e Corrigida 2009
1 Dat time, Jesus waka pass one korn farm for Sabat Day. En disciples kon dey plok di korn chop, bikos dem dey hongry.
1 Naquele tempo, passou Jesus pelas searas, em um sábado; e os seus discípulos, tendo fome, começaram a colher espigas e a comer.
2 But wen di Farisee pipol si dem, dem kon tell Jesus, “Si, yor disciples dey break di law for Sabat Day.”
2 E os fariseus, vendo isso, disseram-lhe: Eis que os teus discípulos fazem o que não é lícito fazer num sábado.
3 Jesus ansa, “Una neva read wetin David do wen en and en pipol dey hongry,
3 Ele, porém, lhes disse: Não tendes lido o que fez Davi, quando teve fome, ele e os que com ele
4 how dem enter God house kon chop di holy bread wey ordinary pipol nor suppose chop, bikos na only priests suppose to chop am?
4 Como entrou na Casa de Deus e comeu os pães da proposição, que não lhe era lícito comer, nem aos que com ele
5 Or una neva read for Moses Law sey, priests dey work for Sabat Day, but nobody dey sey dem kommit sin?
5 Ou não tendes lido na lei que, aos sábados, os sacerdotes no templo violam o sábado e ficam sem culpa?
6 I tell una, pesin wey big pass di temple dey here with una naw.
6 Pois eu vos digo que está aqui quem é maior do que o templo.
7 If to sey una know wetin dis tin mean: ‘Na mesi I wont, nor bi sakrifice’, una nor for kondemn pesin wey nor kommit sin.
7 Mas, se vós soubésseis o que significa: Misericórdia quero e não sacrifício, não condenaríeis os inocentes.
8 Man Pikin na-im bi Sabat Day Oga God.”
8 Porque o Filho do Homem até do sábado é Senhor.
9 Den Jesus komot der kon enter dia sinagog.
9 E, partindo dali, chegou à sinagoga deles.
10 One man wey en hand die dey der. Some pipol wey dey find as dem go take akuiz Jesus kon ask, “E dey rite to heal for Sabat Day?”
10 E estava ali um homem que tinha uma das mãos mirrada; e eles, para acusarem Jesus, o interrogaram, dizendo: É lícito curar nos sábados?
11 Jesus ansa, “If any of una get sheep wey fall inside pit for Sabat Day, e nor go-go karry am out?
11 E ele lhes disse: Qual dentre vós será o homem que, tendo uma ovelha, se num sábado ela cair numa cova, não lançará mão dela e a levantará?
12 Human being betta pass sheep! So, e dey rite to do good for Sabat Day.”
12 Pois quanto mais vale um homem do que uma ovelha? É, por consequência, lícito fazer bem nos sábados.
13 Den Jesus tell di man, “Stresh yor hand.” So di man stresh en hand and di hand kon strong like di oda one.
13 Então disse àquele homem: Estende a mão. E ele a estendeu, e ficou sã como a outra.
14 But di Farisee pipol kon go plan as dem go take kill Jesus.
14 E os fariseus, tendo saído, formaram conselho contra ele, para o matarem.
15 Wen Jesus hear sey dem dey plan to kill-am, e kon komot from der. Many pipol follow am and e kon heal all of dem wey nor well.
15 Jesus, sabendo isso, retirou-se dali, e acompanhou-o uma grande multidão de gente, e ele curou a todos.
16 But e warn dem sey, make dem nor tell anybody who e bi.
16 E recomendava-lhes rigorosamente que o não descobrissem,
17 Dis make wetin Profet Isaya tok, happen:
17 para que se cumprisse o que fora dito pelo profeta Isaías, que diz:
18 “Na my savant wey I choose bi dis,
18 Eis aqui o meu servo que escolhi, o meu amado, em quem a minha alma se compraz; porei sobre ele o meu Espírito, e anunciará aos gentios o juízo.
19 E nor go kworel or shaut,
19 Não contenderá, nem clamará, nem alguém ouvirá pelas ruas a sua voz;
20 or kwensh di small hope wey pesin get,
20 não esmagará a cana quebrada e não apagará o morrão que fumega, até que faça triunfar o juízo.
21 And en name go give hope to Gentile
21 E, no seu nome, os gentios esperarão.
22 So dem kon bring one blind man wey get demon and nor fit tok, kom meet Jesus. Jesus heal am and di man kon dey si and tok.
22 Trouxeram-lhe, então, um endemoninhado cego e mudo; e, de tal modo o curou, que o cego e mudo falava e via.
23 Di pipol sopraiz well-well kon dey ask, “Dis nor bi David pikin wey wi dey wait for?”
23 E toda a multidão se admirava e dizia: Não é este o Filho de Davi?
24 But wen di Farisee pipol hear wetin dem dey tok, dem kon ansa, “Na Belzibub (wey bi demon oga) pawa e dey use take drive demons komot from pipol body.”
24 Mas os fariseus, ouvindo isso, diziam: Este não expulsa os demônios senão por Belzebu, príncipe dos demônios.
25 Wen Jesus know wetin dem dey tink for dia mind, e kon sey, “Evry kingdom wey dey fight with ensef go skata and know town or family wey dey fight demsef, go fit stand.
25 Jesus, porém, conhecendo os seus pensamentos, disse-lhes: Todo reino dividido contra si mesmo é devastado; e toda cidade ou casa dividida contra si mesma não subsistirá.
26 So if Satan dey drive Satan komot, e don divide ensef bi dat, den how en kingdom go fit stand?
26 E, se Satanás expulsa a Satanás, está dividido contra si mesmo; como subsistirá, pois, o seu reino?
27 And if na Belzibub pawa I take dey drive demons komot, na wish pawa una shidren dey take drive demon too? Bikos of dis, una shidren go judge una.
27 E, se eu expulso os demônios por Belzebu, por quem os expulsam, então, os vossos filhos? Portanto, eles mesmos serão os vossos juízes.
28 But if na God Spirit I take dey drive demons, den God Kingdom don already kom meet una.
28 Mas, se eu expulso os demônios pelo Espírito de Deus, é conseguintemente chegado a vós o Reino de Deus.
29 “How pesin go fit break enter strong man house kon tif en propaty, unless e first tie di strong man? Den, e go get shance tif wetin dey di house.
29 Ou como pode alguém entrar em casa do e furtar os seus bens, se primeiro não manietar o valente, saqueando, então, a sua casa?
30 “Anybody wey nor dey with mi, dey against mi and anybody wey nor join mi, dey skata my work.
30 Quem não é comigo é contra mim; e quem comigo não ajunta espalha.
31 Naim make mi dey tell una sey, ‘God go forgive pipol dia sin and all di bad word wey dem tok, but anybody wey curse or tok bad word against di Holy Spirit, God nor go forgi-am.’
31 Portanto, eu vos digo: todo pecado e blasfêmia se perdoará aos homens, mas a blasfêmia contra o Espírito não será perdoada aos homens.
32 Anybody wey tok bad against Man Pikin, God go forgi-am. But anybody wey tok bad against di Holy Spirit, God nor go ever forgi-am, weda for dis life or di one wey dey kom.”
32 E, se qualquer disser
33 “Good tree dey bear good fruit and bad tree dey bear bad fruit. Na di fruit wey tree bear, naim pipol take dey know di kind tree wey e bi.
33 Ou dizeis que a árvore é boa e o seu fruto, bom, ou dizeis que a árvore é má e o seu fruto, mau; porque pelo fruto se conhece a árvore.
34 Una, snake shidren! How una won take tok good word since una dey wiked? Na wetin full pesin heart, naim en mout dey tok.
34 Raça de víboras, como podeis vós dizer boas
35 As good pesin dey bring good tins from en heart, na so bad pesin dey bring bad tins from en heart too.
35 O homem bom tira boas
36 I tell una true word, for judgement day, pipol go ansa God for all di yeye word wey dem tok.
36 Mas eu vos digo que de toda palavra ociosa que os homens disserem hão de dar conta no Dia do Juízo.
37 Na di word wey yu dey tok, naim go fit free or kondemn yu for God present.”
37 Porque por tuas palavras serás justificado e por tuas palavras serás condenado.
38 Some of dem wey bi law tisha and Farisee pipol kon tell Jesus, “Tisha, wi wont make yu show us sign.”
38 Então, alguns dos escribas e dos fariseus tomaram a palavra, dizendo: Mestre, quiséramos ver da tua parte algum sinal.
39 Jesus ansa, “Si dis bad and wiked pipol for dis time wey dey ask for sign, I nor go show una any sign, escept Profet Jonah own.
39 Mas ele lhes respondeu e disse: Uma geração má e adúltera pede
40 As Jonah dey inside big fish belle for three days and nites, na so Man Pikin go dey for grave for three days and nites too.
40 pois, como Jonas esteve três dias e três noites no ventre da baleia, assim estará o Filho do Homem três dias e três noites no seio da terra.
41 For judgement day, Nineveh pipol go kondemn di pipol for dis time, bikos wen Jonah prish give dem, dem turn from sin kom meet God. And naw, somebody wey big pass Jonah dey here with una!
41 Os ninivitas ressurgirão no Juízo com esta geração e a condenarão, porque se arrependeram com a pregação de Jonas. E eis que
42 For judgement day, Sheba kween go kondemn di pipol for dis time, bikos e travel from far place kom hear Solomon wisdom. And naw, somebody wey big pass Solomon dey here with una!”
42 A Rainha do Sul se levantará no
43 “Wen evil spirit don komot from pesin body, e dey pass where wota nor dey, dey find where e go rest, but if e nor si,
43 E, quando o espírito imundo tem saído do homem, anda por lugares áridos, buscando repouso, e não o encontra.
44 e go tell ensef, ‘I go-go back to di house where I from komot.’ Wen e kom back kon si sey di house empty and dem don swip and arrange am,
44 Então, diz: Voltarei para a minha casa, donde saí. E, voltando, acha-
45 e go-go bring seven spirit wey wiked pass am, kom. Dem go enter di pesin kon sidan for der, so di pesin kondishon go kon bad pass as e bi before. Na like dis e go happen to evil pipol for dis time.”
45 Então, vai e leva consigo outros sete espíritos piores do que ele, e, entrando, habitam ali; e são os últimos
46 As Jesus still dey tok, en mama and brodas kon stand for outside, bikos dem won si am.
46 E, falando ele ainda à multidão, eis que estavam fora sua mãe e seus irmãos, pretendendo falar-lhe.
47 So somebody for der kon tell Jesus, “Si, yor mama and brodas dey outside and dem won tok to yu.”
47 E disse-lhe alguém: Eis que estão ali fora tua mãe e teus irmãos, que querem falar-te.
48 Jesus kon ask di pesin, “Who bi my mama and brodas?”
48 Porém ele, respondendo, disse ao que lhe falara: Quem é minha mãe? E quem são meus irmãos?
49 Den Jesus point to en disciples kon sey, “Na dis pipol bi my mama and brodas.
49 E, estendendo a mão para os seus discípulos, disse: Eis aqui minha mãe e meus irmãos;
50 Pesin wey do wetin my Papa for heaven wont, na dat pesin bi my broda, sista and mama.”
50 porque qualquer que fizer a vontade de meu Pai, que

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Mateus 12, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.