Mateus 11
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NTLH
1 Wen Jesus don tish en disciples finish, e kon komot from der go tish and prish for difren towns for Galilee.
1 Quando acabou de dar essas ordens aos seus doze discípulos, Jesus saiu daquele lugar e foi ensinar e anunciar a sua mensagem nas cidades que ficavam perto dali.
2 Naw, wen John hear for inside prison about di tins wey Jesus dey do, e kon send en disciples go ask am:
2 João Batista estava na cadeia e, quando ouviu falar do que Cristo fazia, mandou que alguns dos seus discípulos
3 “Na yu bi di Mezaya wey wi dey espect or make wi wait for anoda pesin?”
3 fossem perguntar a ele: — O senhor é aquele que ia chegar ou devemos esperar outro?
4 Jesus kon ansa dem, “Make una go tell John wetin una dey hear and si.
4 Jesus respondeu:
5 Blind pipol dey si, pipol wey nor fit waka dey waka, God dey cure leper, deaf pipol dey hear, pipol wey don die, dey wake-up and poor pipol dey hear di Good News.
5 Digam a ele que os cegos veem, os coxos andam, os leprosos são curados, os surdos ouvem, os mortos são ressuscitados, e os pobres recebem o
6 God go bless di pesin wey nor dey vex for mi.”
6 E felizes são aqueles que não abandonam a sua fé em mim!
7 As John disciples dey go, Jesus kon tell di pipol about John: “Wetin una go desert go si? Na grass wey breeze dey blow?
7 Quando os discípulos de João foram embora, Jesus começou a dizer ao povo o seguinte a respeito de João:
8 Who una go outside go si? Abi na man wey wear fine dress? Pipol wey dey wear fine dress like dat, nor bi king palis dem dey stay?
8 O que foram ver? Um homem bem-vestido? Ora, os que se vestem bem moram nos palácios!
9 Wetin una go si for outside? Na profet? Yes! I tell una, e even big pass profet.
9 Então me digam: o que esperavam ver? Um
10 Na John bi di pesin wey dem rite for God word about sey:
10 Porque João é aquele a respeito de quem as
11 I tell una true word, among all di pipol wey woman born, e nor get anybody wey big rish John di Baptist. But di pesin wey small pass for God Kingdom, big pass am.
11 Eu afirmo a vocês que isto é verdade: de todos os homens que já nasceram, João Batista é o maior. Porém quem é menor no
12 From John di Baptist time kon rish naw, pipol dey struggol to enter God Kingdom, but na only doz wey dey struggol well-well, dey fit enter.
12 Desde os dias em que João anunciava a sua mensagem, até hoje, o Reino do Céu tem sido atacado com violência, e as pessoas violentas tentam conquistá-lo.
13 Before John kom, Moses Law and di profets dey prish about wetin go happen.
13 Até o tempo de João, todos os
14 And if una go gri with wetin I dey tok, John, na-im bi Elijah wey suppose to kom.
14 E, se vocês querem crer na mensagem deles, João é Elias, que estava para vir.
15 Anybody wey get ear, make e hear!
15 Se vocês têm ouvidos para ouvir, então ouçam.
16 “Wetin I go sey dis time pipol bi like? Dem bi like shidren for market wey dey hala for each oda sey,
16 — Mas com quem posso comparar as pessoas de hoje? São como crianças sentadas na praça. Um grupo grita para o outro:
17 “ ‘Wi blow flute for una,
17 “Nós tocamos músicas de casamento,
18 Wen John di Baptist kom, e nor chop, drink or enjoy life but una sey, ‘E get demon!’
18 João Batista jejua e não bebe vinho, e todos dizem: “Ele está dominado por um demônio.”
19 But wen Man Pikin kom, e chop and drink and una sey, ‘Si am, long-trot, drunkaman, tax kollectors and sinnas friend!’ But God wisdom dey show for wetin e dey do.”
19 O
20 Jesus kon dey curse all di town where e for do many mirakles, bikos di pipol nor gri turn from sin kom meet God.
20 Então Jesus começou a acusar as cidades onde tinha feito muitos milagres. Ele fez isso porque os seus moradores não haviam se arrependido dos seus pecados. Jesus disse:
21 “E nor go betta for Korazin and Betsaida pipol! If to sey di mirakles wey dem do among una happen for Tyre and Sidon, dem for don turn from dia sin kom meet God, kon karry ashes put for head and wear tear-tear klot,
21 — Ai de você, cidade de Corazim! Ai de você, cidade de Betsaida! Porque, se os milagres que foram feitos em vocês tivessem sido feitos nas cidades de Tiro e de Sidom, os seus moradores já teriam abandonado os seus pecados há muito tempo. E, para mostrarem que estavam arrependidos, teriam vestido roupa feita de pano grosseiro e teriam jogado cinzas na cabeça!
22 but I tell una true word, e go eazy for Tyre and Sidon for judgement day pass una.
22 Pois eu afirmo a vocês que, no Dia do Juízo, Deus terá mais pena de Tiro e de Sidom do que de vocês, Corazim e Betsaida.
23 Una wey bi Kapanaum pipol, una feel sey una fit karry unasef go heaven? No! God go trow una for hell-fire, bikos if to sey dem do di mirakles wey dem do for una, for inside Sodom, di town for still dey till today.
23 E você, cidade de Cafarnaum, acha que vai subir até o céu? Pois será jogada no
24 But I tell una, God go get mesi for Sodom pass una for judgement day!”
24 Pois eu afirmo a vocês que, no Dia do Juízo, Deus terá mais pena de Sodoma do que de você, Cafarnaum.
25 For dat time, Jesus kon sey, “I praiz yu Papa, Oga God wey get heaven and eart, bikos yu hide dis tins from pipol wey get sense and doz wey know book well-well, but yu show dem to small shidren.
25 Naquela ocasião Jesus disse:
26 Yes! Papa, na so yu wont make e bi.
26 Sim, ó Pai, tu tiveste prazer em fazer isso.
27 “My Papa put evritin for my hand. Nobody know di pikin, but na only en Papa know am. Nobody know di Papa, but na only di pikin and anybody wey di pikin choose to show.
27 — O meu Pai me deu todas as coisas. Ninguém sabe quem é o Filho, a não ser o Pai; e ninguém sabe quem é o Pai, a não ser o Filho e também aqueles a quem o Filho quiser mostrar quem o Pai é.
28 Una wey don taya and karry heavy load, make una kom meet mi and I go give una rest.
28 — Venham a mim, todos vocês que estão cansados de carregar as suas pesadas cargas, e eu lhes darei descanso.
29 Make una follow mi and learn from mi, bikos I gentol, I nor dey karry body up and I go give una peace for una mind.
29 Sejam meus seguidores e aprendam comigo porque sou bondoso e tenho um coração humilde; e vocês encontrarão descanso.
30 My way eazy to follow and my load nor heavy to karry.”
30 Os deveres que eu exijo de vocês são fáceis, e a carga que eu ponho sobre vocês é leve.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Mateus 11, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.