Mateus 10

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 Jesus koll en twelf disciples kon give dem pawa to drive demons and heal diziz and pipol wey nor well.
1 Jesus reuniu seus doze discípulos. Conferiu-lhes o poder de expulsar os espíritos imundos e de curar todo mal e toda enfermidade.
2 Dis na di twelf disciples name: Simon (wey dem dey koll Pita); Andru, wey bi Pita broda; James wey bi Zebedee pikin and en broda John,
2 Eis os nomes dos doze apóstolos: o primeiro, Simão, chamado Pedro; depois André, seu irmão. Tiago, filho de Zebedeu, e João, seu irmão.
3 Filip and Bartolomew; Tomas; Matiu, wey bi tax kollector; James, wey bi Afaeus pikin and Taddaeus.
3 Filipe e Bartolomeu. Tomé e Mateus, o publicano. Tiago, filho de Alfeu, e Tadeu.
4 Simon wey bi Zealot (pesin wey dey fight for en kountry) and Judas Iskariot wey sell Jesus Christ.
4 Simão, o cananeu, e Judas Iscariotes, que foi o traidor.
5 Jesus send and tell dem, “Make una nor go Gentile aria go prish and make una nor enter Samaria pipol town,
5 Estes são os Doze que Jesus enviou em missão, após lhes ter dado as seguintes instruções: Não ireis ao meio dos gentios nem entrareis em Samaria;
6 but make una go meet Israel pipol, wey bi God sheep, wey lost.
6 ide antes às ovelhas que se perderam da casa de Israel.
7 As una dey go, make una prish di message sey, ‘God Kingdom don near!’
7 Por onde andardes, anunciai que o Reino dos céus está próximo.
8 Make una heal pipol wey nor well, wake pipol wey don die; cure lepers and drive demons komot from pipol body. Na free God give una dis pawa, so make una gi-am free to oda pipol too.
8 Curai os doentes, ressuscitai os mortos, purificai os leprosos, expulsai os demônios. Recebestes de graça, de graça dai!
9 Make una nor karry any money follow body,
9 Não leveis nem ouro, nem prata, nem dinheiro em vossos cintos,
10 or karry bag or estra dress, sandal or walkin stik, bikos di pipol wey una go meet, go give una evritin wey una wont.
10 nem mochila para a viagem, nem duas túnicas, nem calçados, nem bastão; pois o operário merece o seu sustento.
11 “Wen una enter any town or village, make una look for pesin wey ready to receive una for en house, make una stay with am until una komot from dat town.
11 Nas cidades ou aldeias onde entrardes, informai-vos se há alguém ali digno de vos receber; ficai ali até a vossa partida.
12 Any house wey una enter, make una greet di pipol wey dey inside.
12 Entrando numa casa, saudai-a: Paz a esta casa.
13 And if di pipol inside di house welkom una, make una peace stay with dem, but if dem nor welkom una, una peace go kom back to una.
13 Se aquela casa for digna, descerá sobre ela vossa paz; se, porém, não o for, vosso voto de paz retornará a vós.
14 If di pipol nor welkom or listin to una message, make una shake dia san komot from una leg as una dey leave dat house or town.
14 Se não vos receberem e não ouvirem vossas palavras, quando sairdes daquela casa ou daquela cidade, sacudi até mesmo o pó de vossos pés.
15 I tell una true word, e go betta for Sodom and Gomorrah pipol for judgement day, pass di pipol wey dey for dat town.”
15 Em verdade vos digo: no dia do juízo haverá mais indulgência com Sodoma e Gomorra que com aquela cidade.
16 “Si! I dey send una go like sheep for where plenty wiked animals dey, so make una dey wise like snake and gentol like dove.
16 Eu vos envio como ovelhas no meio de lobos. Sede, pois, prudentes como as serpentes, mas simples como as pombas.
17 “Make una dey ready, bikos pipol go arrest una karry go kourt and flog una for dia sinagog.
17 Cuidai-vos dos homens. Eles vos levarão aos seus tribunais e açoitar-vos-ão com varas nas suas sinagogas.
18 Bikos of mi, dem go drag una go meet rulers and kings, so dat una go tok about mi give dem and Gentile pipol.
18 Sereis por minha causa levados diante dos governadores e dos reis: servireis assim de testemunho para eles e para os pagãos.
19 Make una nor worry about wetin una go tok wen dem drag una go kourt, bikos God go give una wetin to tok wen dat time rish.
19 Quando fordes presos, não vos preocupeis nem pela maneira com que haveis de falar, nem pelo que haveis de dizer: naquele momento ser-vos-á inspirado o que haveis de dizer.
20 Nor bi una go dey tok, but na una Papa Spirit go dey tok thru una.
20 Porque não sereis vós que falareis, mas é o Espírito de vosso Pai que falará em vós.
21 “Broda go sell en own broda give pipol make dem kill-am and na so papa go sell en own pikin too. Shidren go fight and kill dia papa and mama.
21 O irmão entregará seu irmão à morte. O pai, seu filho. Os filhos levantar-se-ão contra seus pais e os matarão.
22 Evribody go hate una bikos of mi. But anybody wey fit bear rish di end, God go save am.
22 Sereis odiados de todos por causa de meu nome, mas aquele que perseverar até o fim será salvo.
23 Anytime dem sofa una for one town bikos of mi, make una run go anoda town. I tell una true word, una nor go run pass all di town for Israel, before Man Pikin go kom back.
23 Se vos perseguirem numa cidade, fugi para uma outra. Em verdade vos digo: não acabareis de percorrer as cidades de Israel antes que volte o Filho do Homem.
24 “Nobody big pass en tisha and know savant big pass en oga.
24 O discípulo não é mais que o mestre, o servidor não é mais que o patrão.
25 E good make disciple bi like en tisha and savant bi like en oga. If dem dey koll oga for en house ‘Belzibub (wey mean demon oga),’ wot of di pipol wey dey di house? Dem nor go koll dem bad name too?”
25 Basta ao discípulo ser tratado como seu mestre, e ao servidor como seu patrão. Se chamaram de Beelzebul ao pai de família, quanto mais o farão às pessoas de sua casa!
26 “Make una nor fear man, bikos nor-tin wey hide wey nor go kom out and know sekret wey pipol nor go know.
26 Não os temais, pois; porque nada há de escondido que não venha à luz, nada de secreto que não se venha a saber.
27 Wetin I tell una for darkness, make una tok am for day time and wetin I tok for una ear, make una shaut am make pipol hear.
27 O que vos digo na escuridão, dizei-o às claras. O que vos é dito ao ouvido, publicai-o de cima dos telhados.
28 Make una nor fear who go fit kill di body and nor fit kill di soul. Instead, make una fear God wey fit distroy pesin soul and body for hell-fire.
28 Não temais aqueles que matam o corpo, mas não podem matar a alma; temei antes aquele que pode precipitar a alma e o corpo na geena.
29 Nor bi one penny dem dey sell two sparo bird? But no one go fall rish groun, escept God allow am.
29 Não se vendem dois passarinhos por um asse? No entanto, nenhum cai por terra sem a vontade de vosso Pai.
30 Si! God know how many hair dey for una head.
30 Até os cabelos de vossa cabeça estão todos contados.
31 So, make una nor fear, una betta pass many sparo.
31 Não temais, pois! Bem mais que os pássaros valeis vós.
32 “Anybody wey tok for publik sey en know mi, na so mi too go tok about am give my Papa for heaven.
32 Portanto, quem der testemunho de mim diante dos homens, também eu darei testemunho dele diante de meu Pai que está nos céus.
33 But anybody wey deny mi for publik, misef go deny am for heaven.”
33 Aquele, porém, que me negar diante dos homens, também eu o negarei diante de meu Pai que está nos céus.
34 “Make una nor tink sey, I bring peace kom dis world. No! Na war I bring.
34 Não julgueis que vim trazer a paz à terra. Vim trazer não a paz, mas a espada.
35 I kom make boy pikin nor gri with en papa and make girl pikin nor gri with en mama. Wife nor go gri with en husband mama
35 Eu vim trazer a divisão entre o filho e o pai, entre a filha e a mãe, entre a nora e a sogra,
36 and pesin worse enemy, go bi en own family pipol.
36 e os inimigos do homem serão as pessoas de sua própria casa.
37 “Anybody wey love en papa, mama and pikin pass mi, nor go fit bi my disciple.
37 Quem ama seu pai ou sua mãe mais que a mim, não é digno de mim. Quem ama seu filho mais que a mim, não é digno de mim.
38 Anybody wey nor karry en cross follow mi, nor go fit bi my disciple.
38 Quem não toma a sua cruz e não me segue, não é digno de mim.
39 Pesin wey hold en life tait, go luz am, but anybody wey luz en life bikos of mi, go gain am.”
39 Aquele que tentar salvar a sua vida, perdê-la-á. Aquele que a perder, por minha causa, reencontrá-la-á.
40 “Pesin wey welkom yu, welkom mi too and anybody wey welkom mi, welkom di Pesin wey send mi.
40 Quem vos recebe, a mim recebe. E quem me recebe, recebe aquele que me enviou.
41 Anybody wey receive profet, bikos na profet e bi, go get profet reward. Pesin wey receive good pesin, bikos na good pesin e bi, go get good pesin reward.
41 Aquele que recebe um profeta, na qualidade de profeta, receberá uma recompensa de profeta. Aquele que recebe um justo, na qualidade de justo, receberá uma recompensa de justo.
42 And anybody wey give kold wota to di pesin wey small pass among my disciples, I tell una true word, e nor go ever luz en reward.”
42 Todo aquele que der ainda que seja somente um copo de água fresca a um destes pequeninos, porque é meu discípulo, em verdade eu vos digo: não perderá sua recompensa.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Mateus 10, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.