Malaquias 2

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 Oga God tell di priests, “Dis kommand na for una:
1 "E agora esta advertência é para vocês, ó sacerdotes.
2 Una must honor mi with wetin una dey do, but if una nor gri listin to wetin I dey tok, I go curse una. I go bikos of wetin una do, curse evritin wey una get. True-true, I don already curse una, bikos una nor gri honor mi.
2 Se vocês não derem ouvidos e não se dispuserem a honrar o meu nome", diz o Senhor dos Exércitos, "lançarei maldição sobre vocês, e até amaldiçoarei as suas bênçãos. Aliás já as amaldiçoei, porque vocês não me honram de coração.
3 I go ponish una shidren-shidren and di animals wey una dey sakrifice, I go rub una face for dia shit and dem go karry una komot for my present.
3 "Por causa de vocês eu vou destruir a sua descendência; esfregarei na cara de vocês os excrementos dos animais oferecidos em sacrifício em suas festas e lançarei vocês fora, juntamente com os excrementos.
4 Den, una go know sey na mi give una dis kommandment, so dat di kovenant wey I make with Levi shidren wey bi my priests, go kontinue.
4 Então vocês saberão que fui eu que lhes dei esta advertência para que a minha aliança com Levi fosse mantida", diz o Senhor dos Exércitos.
5 Di rizin why I make kovenant with dem, na to give dem life and peace and dat na wetin I give dem, so dat dem go respet mi and dat time, dem really respet and fear mi.
5 "A minha aliança com ele foi uma aliança de vida e de paz, que de fato lhe dei para que me temesse. Ele me temeu, e tremeu diante do meu nome.
6 Instead of dem to dey tink bad tins, dem dey tink about wetin dey good and peace dey between us, bikos dem nor only dey do wetin dey good, but dem help many pipol, stop to sin.
6 A verdadeira lei estava em sua boca e nenhuma falsidade achou-se em seus lábios. Ele andou comigo em paz e retidão, e desviou muitos do pecado.
7 Na priest work to tish di trut about God. So make pipol go meet and learn wetin I wont from dem, bikos na Oga God send dem.
7 "Porque os lábios do sacerdote devem guardar o conhecimento, e da sua boca todos esperam a instrução na lei, porque ele é o mensageiro do Senhor dos Exércitos.
8 But una wey bi priest don turn komot from di korrect road. Wetin una dey tish naw, don make many pipol dey sin. Una don break di kovenant wey I make with una.
8 Mas vocês se desviaram do caminho e pelo seu ensino causaram a queda de muita gente; vocês quebraram a aliança de Levi", diz o Senhor dos Exércitos.
9 So, I go make di pipol hate una well-well, bikos una nor dey do wetin I tell una and wen una dey tish my pipol, una nor dey trit evribody ekwol.”
9 "Por isso eu fiz que fossem desprezados e humilhados diante de todo o povo, porque vocês não seguem os meus caminhos, mas são parciais quando ensinam a lei. "
10 Nor bi di same papa all of us get? Nor bi di same God kreate all of us? Den why wi dey break awa promise wey wi make to each oda kon hate di kovenant wey God make with awa grand-grand papa dem?
10 Não temos todos o mesmo Pai? Não fomos todos criados pelo mesmo Deus? Por que será então que quebramos a aliança dos nossos antepassados sendo infiéis uns com os outros?
11 Judah pipol don break dia promise wey dem make with God kon dey do wiked tins for Jerusalem and evriwhere for di land. Dem don dirty di temple wey God love and dia men marry wimen wey dey serve juju.
11 Judá tem sido infiel. Uma coisa repugnante foi cometida em Israel e em Jerusalém; Judá desonrou o santuário que o Senhor ama; homens casaram-se com mulheres que adoram deuses estrangeiros.
12 Doz wey do dis kind tin, make God wey get pawa remove dem komot from Israel kommunity and make E nor ever let dem join again for di sakrifice wey awa pipol dey bring kom gi-am.
12 Que o Senhor lance fora das tendas de Jacó o homem que faz isso, seja ele quem for, mesmo que esteja trazendo ofertas ao Senhor dos Exércitos.
13 Dis na anoda tin wey una dey do: Una go kry until una tear go full God altar, bikos E nor asept di sakrifice wey una bring kon gi-am.
13 Há outra coisa que vocês fazem: Enchem de lágrimas o altar do Senhor; choram e gemem porque ele já não dá atenção às suas ofertas nem as aceita com prazer.
14 Una dey ask, “Why E nor gri asept awa sakrifice again?” Na bikos E know sey una don break di promise wey una make with di wife wey una marry wen una yong. Na una patina e bi, but naw, una don break di promise, even doh una promise for God present sey una go dey faithful to am.
14 E vocês ainda perguntam: "Por quê? " É porque o Senhor é testemunha entre você e a mulher da sua mocidade, pois você não cumpriu a sua promessa de fidelidade, embora ela fosse a sua companheira, a mulher do seu acordo matrimonial.
15 God nor sey, una and una wife go bi one body and spirit? Wetin make am tok like dat? Na bikos make una for get shidren, wey go bi God pipol. So, make una make sure sey, una nor break di promise wey una make with una wife.
15 Não foi o Senhor que os fez um só? Em corpo e em espírito eles lhe pertencem. E por que um só? Porque ele desejava uma descendência consagrada. Portanto, tenham cuidado: Ninguém seja infiel à mulher da sua mocidade.
16 Oga God sey, “I hate divorce. I hate wen one pesin among una do dat kind wiked tin against en wife. Make una make sure sey, una nor break di promise wey sey una go always dey faithful to una wife.”
16 "Eu odeio o divórcio", diz o Senhor, o Deus de Israel, e "o homem que se cobre de violência como se cobre de roupas", diz o Senhor dos Exércitos. Por isso tenham bom senso; não sejam infiéis.
17 Una don make God taya with una many tok. But una still dey ask, “How wi take make God taya?” Na wen una sey, “Pipol wey dey do bad tins, dey good for Oga God eye and E like dem well-well and wen una still ask sey, ‘Where di God wey dey judge well?’ ”
17 "Vocês têm cansado o Senhor com as suas palavras. ‘Como o temos cansado? ’, vocês ainda perguntam. Quando dizem: ‘Todos os que fazem o mal são bons aos olhos do Senhor, e ele se agrada deles’ e também quando perguntam: ‘Onde está o Deus da justiça? ’ "

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Malaquias 2, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.