Marcos 9

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA

Sair da comparação
ARA Almeida Revista e Atualizada 1993
1 Jesus kon tell dem, “I tell una true word, some pipol dey here wey nor go die until dem don si God Kingdom and en pawa.”
1 Dizia-lhes ainda: Em verdade vos afirmo que, dos que aqui se encontram, alguns há que, de maneira nenhuma, passarão pela morte até que vejam ter chegado com poder o reino de Deus.
2 Afta six days, Jesus, Pita, James and John kon go one high mountin. E kon shange for dia front,
2 Seis dias depois, tomou Jesus consigo a Pedro, Tiago e João e levou-os sós, à parte, a um alto monte. Foi transfigurado diante deles;
3 en klot kon dey shine well-well and e white pass how any dri-cleaner go fit wosh am.
3 as suas vestes tornaram-se resplandecentes e sobremodo brancas, como nenhum lavandeiro na terra as poderia alvejar.
4 Den Elijah and Moses kon appear for dia front dey tok with Jesus.
4 Apareceu-lhes Elias com Moisés, e estavam falando com Jesus.
5 So, Pita tell Jesus, “Tisha, e good make wi stay here. Make wi build three tent, one for yu, one for Moses and one for Elijah.”
5 Então, Pedro, tomando a palavra, disse: Mestre, bom é estarmos aqui e que façamos três tendas: uma será tua, outra, para Moisés, e outra, para Elias.
6 (Dem dey fear and dem nor know wetin to tok.)
6 Pois não sabia o que dizer, por estarem eles aterrados.
7 Den, kloud kover dem and one vois kon tok from di kloud sey, “Dis na My only pikin wey I love. Make una listin to am!”
7 A seguir, veio uma nuvem que os envolveu; e dela uma voz dizia: Este é o meu Filho amado; a ele ouvi.
8 Wen dem look round, dem nor si anybody escept Jesus.
8 E, de relance, olhando ao redor, a ninguém mais viram com eles, senão Jesus.
9 As dem dey kom down from di mountin, Jesus kon tell dem make dem nor tell anybody wetin dem si, until Man Pikin go don wake-up from deat.
9 Ao descerem do monte, ordenou-lhes Jesus que não divulgassem as coisas que tinham visto, até o dia em que o Filho do Homem ressuscitasse dentre os mortos.
10 Den dem kon dey tok with each oda about wetin dis “Wake-up from deat” mean.
10 Eles guardaram a recomendação, perguntando uns aos outros que seria o ressuscitar dentre os mortos.
11 Dem ask Jesus, “Wetin make di law tishas dey sey Elijah go first kom?”
11 E interrogaram-no, dizendo: Por que dizem os escribas ser necessário que Elias venha primeiro?
12 Jesus ansa dem, “True-true, Elijah go first kom, make e for prepare evritin. Naim make dem rite for God word sey, ‘Man Pikin must sofa many tins and dem must hate am?’
12 Então, ele lhes disse: Elias, vindo primeiro, restaurará todas as coisas; como, pois, está escrito sobre o Filho do Homem que sofrerá muito e será aviltado?
13 But I dey tell una naw sey, Elijah don kom true-true and dem don do am wetin dem like, just as God tok for en word.”
13 Eu, porém, vos digo que Elias já veio, e fizeram com ele tudo o que quiseram, como a seu respeito está escrito.
14 Wen Jesus, Pita, James and John kom meet di oda disciples, dem si many pipol and di law tishas gada, dey argue with dem.
14 Quando eles se aproximaram dos discípulos, viram numerosa multidão ao redor e que os escribas discutiam com eles.
15 Wen di pipol si Jesus, dem sopraiz kon run kwik-kwik go greet am.
15 E logo toda a multidão, ao ver Jesus, tomada de surpresa, correu para ele e o saudava.
16 Jesus ask dem, “Wetin una dey argue about?”
16 Então, ele interpelou os escribas: Que é que discutíeis com eles?
17 One pesin among di pipol kon ansa, “Tisha, I bring my pikin wey get demon wey dey make am nor fit tok, kom meet yu.
17 E um, dentre a multidão, respondeu: Mestre, trouxe-te o meu filho, possesso de um espírito mudo;
18 Anytime di spirit seize am, e go trow am down and e go dey bring foam from en mout, dey grind en tit and en body go kon strait. I tell yor disciples make dem drive di demon komot, but dem nor fit.”
18 e este, onde quer que o apanha, lança-o por terra, e ele espuma, rilha os dentes e vai definhando. Roguei a teus discípulos que o expelissem, e eles não puderam.
19 Jesus kon ask en disciples, “Una wey nor bilive! How long I go stay with una? How long I go dey bear with una? Make una bring di boy kom meet mi.”
19 Então, Jesus lhes disse: Ó geração incrédula, até quando estarei convosco? Até quando vos sofrerei? Trazei-mo.
20 So, dem take di boy go meet am. Wen di spirit si Jesus, e kwik-kwik trow di boy for groun kon make am dey shake. Di boy fall for groun, dey roll and foam dey komot from en mout.
20 E trouxeram-lho; quando ele viu a Jesus, o espírito imediatamente o agitou com violência, e, caindo ele por terra, revolvia-se espumando.
21 Jesus ask di boy papa, “Since wen dis tin don dey do am?”
21 Perguntou Jesus ao pai do menino: Há quanto tempo isto lhe sucede? Desde a infância, respondeu;
22 Di spirit dey always trow am inside fire or wota make e for die. But if yu go fit do anytin, make yu sorry for am and help us.”
22 e muitas vezes o tem lançado no fogo e na água, para o matar; mas, se tu podes alguma coisa, tem compaixão de nós e ajuda-nos.
23 Den Jesus ask am, “Yu mean, ‘If I fit?’ Evritin dey possibol for di pesin wey bilive.”
23 Ao que lhe respondeu Jesus: Se podes! Tudo é possível ao que crê.
24 Kwik-kwik di boy papa kon shaut, “I bilive o-o! Help mi make I bilive more-more!”
24 E imediatamente o pai do menino exclamou [com lágrimas]: Eu creio! Ajuda-me na minha falta de fé!
25 Wen Jesus si sey pipol dey gada, e kon tell di evil spirit, “Yu deaf and dumb spirit, I kommand make yu kom out from di boy and nor enter en body again.”
25 Vendo Jesus que a multidão concorria, repreendeu o espírito imundo, dizendo-lhe: Espírito mudo e surdo, eu te ordeno: Sai deste jovem e nunca mais tornes a ele.
26 Di demon shaut, shake di boy well-well kon komot from en body. Di boy sleep for groun sotey many pipol kon dey sey, “E don die!”
26 E ele, clamando e agitando-o muito, saiu, deixando-o como se estivesse morto, a ponto de muitos dizerem: Morreu.
27 But Jesus whole di boy hand small-small, karry am up and di boy kon stand up.
27 Mas Jesus, tomando-o pela mão, o ergueu, e ele se levantou.
28 Wen e enter di house, en disciples kon ask am, “Why wi nor fit drive di demon komot?”
28 Quando entrou em casa, os seus discípulos lhe perguntaram em particular: Por que não pudemos nós expulsá-lo?
29 Jesus ansa dem, “Na only with prayer and fasting dis kind one dey take komot.”
29 Respondeu-lhes: Esta casta não pode sair senão por meio de oração [e jejum].
30 Jesus and en disciples kon komot from der pass Galilee. But Jesus nor wont make anybody know,
30 E, tendo partido dali, passavam pela Galileia, e não queria que ninguém o soubesse;
31 bikos e dey tish and tell en disciples sey, “Dem go sell Man Pikin give human being. Dem go kill-am and afta three days, e go wake-up again.”
31 porque ensinava os seus discípulos e lhes dizia: O Filho do Homem será entregue nas mãos dos homens, e o matarão; mas, três dias depois da sua morte, ressuscitará.
32 But di disciples nor undastand wetin Jesus tok and fear nor let dem ask am wetin e mean.
32 Eles, contudo, não compreendiam isto e temiam interrogá-lo.
33 Dem kon rish Kapanaum. So, wen Jesus don enter house, e kon ask en disciples, “Wetin una dey tok for road?”
33 Tendo eles partido para Cafarnaum, estando ele em casa, interrogou os discípulos: De que é que discorríeis pelo caminho?
34 But dem nor ansa, bikos wen dem dey kom for road, na who big pass among dem, dem dey argue about.
34 Mas eles guardaram silêncio; porque, pelo caminho, haviam discutido entre si sobre quem era o maior.
35 Afta Jesus sidan, e koll en twelf disciples kon tell dem, “If anybody among una won bi first, e go bi di last and e go bi evribody savant.”
35 E ele, assentando-se, chamou os doze e lhes disse: Se alguém quer ser o primeiro, será o último e servo de todos.
36 E kon koll one small pikin stand for dia front. Den e whole di pikin hand, kon sey,
36 Trazendo uma criança, colocou-a no meio deles e, tomando-a nos braços, disse-lhes:
37 “Anybody wey welkom one of dis small pikin bikos of mi, na mi e welkom and anybody wey welkom mi, nor bi mi alone e welkom, but na my Papa wey send mi.”
37 Qualquer que receber uma criança, tal como esta, em meu nome, a mim me recebe; e qualquer que a mim me receber, não recebe a mim, mas ao que me enviou.
38 John kon tell am, “Tisha, wi si one man wey use yor name dey drive demon komot from inside pipol body and wi kon try to stop am, bikos e nor dey follow us waka.”
38 Disse-lhe João: Mestre, vimos um homem que, em teu nome, expelia demônios, o qual não nos segue; e nós lho proibimos, porque não seguia conosco.
39 But Jesus tell dem, “Make una nor stop am, bikos nobody wey use my name do mirakle go fit tok bad tin about mi.
39 Mas Jesus respondeu: Não lho proibais; porque ninguém há que faça milagre em meu nome e, logo a seguir, possa falar mal de mim.
40 Bikos anybody wey nor dey against us, dey for awa side.
40 Pois quem não é contra nós é por nós.
41 I tell una true word, anybody wey give yu cup of wota bikos yu dey follow mi, nor go ever luz en reward.
41 Porquanto, aquele que vos der de beber um copo de água, em meu nome, porque sois de Cristo, em verdade vos digo que de modo algum perderá o seu galardão.
42 “If anybody make one among dis small pikin wey bilive mi kommit sin, e go betta make dem tie big stone for en neck kon trow am inside river.
42 E quem fizer tropeçar a um destes pequeninos crentes, melhor lhe fora que se lhe pendurasse ao pescoço uma grande pedra de moinho, e fosse lançado no mar.
43 If yor hand go make yu sin, make yu kut am komot! E betta make yu enter inside God Kingdom with one hand, dan to get two hand kon enter hell-fire wey nor go ever kwensh,
43 E, se tua mão te faz tropeçar, corta-a; pois é melhor entrares maneta na vida do que, tendo as duas mãos, ires para o inferno, para o fogo inextinguível
44 di place wey get worm wey nor dey die and di fire nor dey kwensh.
44 [onde não lhes morre o verme, nem o fogo se apaga].
45 If yor leg go make yu sin, make yu kut am komot. E betta make yu enter God Kingdom with one leg, dan to get two leg kon enter hell-fire wey nor dey ever kwensh,
45 E, se teu pé te faz tropeçar, corta-o; é melhor entrares na vida aleijado do que, tendo os dois pés, seres lançado no inferno
46 di place wey get worm wey nor dey die and di fire nor dey kwensh.
46 [onde não lhes morre o verme, nem o fogo se apaga].
47 If yor eye go make yu sin, make yu pul am komot! E betta make yu enter God Kingdom with one eye, dan to get two eye kon enter hell-fire wey nor dey ever kwensh,
47 E, se um dos teus olhos te faz tropeçar, arranca-o; é melhor entrares no reino de Deus com um só dos teus olhos do que, tendo os dois seres lançado no inferno,
48 “di place wey get worm wey nor dey die
48 onde não lhes morre o verme, nem o fogo se apaga.
49 God go try evribody with fire.
49 Porque cada um será salgado com fogo.
50 “Salt good, but if e nor get taste again, how pesin go fit take make am sweet? Make una get salt inside una and make una dey live for peace with each oda.”
50 Bom é o sal; mas, se o sal vier a tornar-se insípido, como lhe restaurar o sabor? Tende sal em vós mesmos e paz uns com os outros.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Marcos 9, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.