Marcos 7
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA
1 Di Farisee pipol and some law tishas, wey kom from Jerusalem gada for where Jesus dey.
1 Ora, reuniram-se a Jesus os fariseus e alguns escribas, vindos de Jerusalém.
2 Dem kon si sey Jesus disciples dey chop bread wen dem neva wosh dia hand.
2 E, vendo que alguns dos discípulos dele comiam pão com as mãos impuras, isto é, por lavar
3 (Bikos di Farisee and Jew pipol, nor dey chop unless dem wosh dia hand akordin to dia tradishon.
3 (pois os fariseus e todos os judeus, observando a tradição dos anciãos, não comem sem lavar cuidadosamente as mãos;
4 And wen dem kom back from market, dem nor dey chop unless dem first wosh dia hand. Dem still dey follow many oda tradishons, like to wosh cup, kettol and chair wey dem dey sidan put chop.)
4 quando voltam da praça, não comem sem se aspergirem; e há muitas outras coisas que receberam para observar, como a lavagem de copos, jarros e vasos de metal [e camas]),
5 Di Farisee pipol and di law tishas kon ask Jesus, “Why yor disciples nor dey do akordin to awa tradishon, but instead dem dey chop with dirty hand?”
5 interpelaram-no os fariseus e os escribas: Por que não andam os teus discípulos de conformidade com a tradição dos anciãos, mas comem com as mãos por lavar?
6 Jesus ansa dem, “Di tin wey Profet Isaya profesai about una, na true, bikos una dey pritend, as dem rite for God word,
6 Respondeu-lhes: Bem profetizou Isaías a respeito de vós, hipócritas, como está escrito:
7 Dem dey woship Mi for nor-tin,
7 E em vão me adoram, ensinando doutrinas que são preceitos de homens.
8 Dem nor dey respet God law, but dem dey obey human being law.’ ”
8 Negligenciando o mandamento de Deus, guardais a tradição dos homens.
9 Jesus still tell dem, “Una rijet God kommandment, so dat una go fit keep una own.
9 E disse-lhes ainda: Jeitosamente rejeitais o preceito de Deus para guardardes a vossa própria tradição.
10 Bikos Moses sey, ‘Make yu respet yor papa and mama’ and ‘Anybody wey curse en papa or mama, dem must kill-am.’
10 Pois Moisés disse:
11 But una sey e dey okay for pesin to tell en papa and mama sey, ‘Make yu nor vex, I nor fit help yu, bikos di money wey I suppose give yu, I don gi-am to God.’
11 Vós, porém, dizeis: Se um homem disser a seu pai ou a sua mãe: Aquilo que poderias aproveitar de mim é Corbã, isto é, oferta para o Senhor,
12 So, like dis, una nor go let di pesin do good for en mama or papa.
12 então, o dispensais de fazer qualquer coisa em favor de seu pai ou de sua mãe,
13 Na so una dey use una tradishon wey una dey tish pipol take dey spoil God word. And una still dey do many tins like dis.”
13 invalidando a palavra de Deus pela vossa própria tradição, que vós mesmos transmitistes; e fazeis muitas outras coisas semelhantes.
14 Den Jesus koll di pipol again sey, “Evribody, listin to mi make una for undastand wetin I dey tok.
14 Convocando ele, de novo, a multidão, disse-lhes: Ouvi-me, todos, e entendei.
15 Nor bi wetin enter inside pesin body go make am dirty for God eye, instead na wetin kom out from en mout, dey make am dirty.
15 Nada há fora do homem que, entrando nele, o possa contaminar; mas o que sai do homem é o que o contamina.
16 Anybody wey get ear, make e hear wetin I dey tok.”
16 [Se alguém tem ouvidos para ouvir, ouça.]
17 Wen Jesus leave di pipol enter house, en disciples kon ask am about di parabol.
17 Quando entrou em casa, deixando a multidão, os seus discípulos o interrogaram acerca da parábola.
18 E kon tell dem, “Na so una fool rish? Una nor know sey anytin wey from outside enter pesin belle nor go fit make am dirty for God eye?
18 Então, lhes disse: Assim vós também não entendeis? Não compreendeis que tudo o que de fora entra no homem não o pode contaminar,
19 Bikos nor bi di pesin heart e dey enter, na en belle and e go shit am komot. (Dis one mean sey all food dey klean.)”
19 porque não lhe entra no coração, mas no ventre, e sai para lugar escuso? E, assim, considerou ele puros todos os alimentos.
20 Jesus kon sey, “Wetin kom out from pesin heart, naim dey make am dirty.
20 E dizia: O que sai do homem, isso é o que o contamina.
21 Bikos to sleep with who yu nor marry, to tif, to kill pesin,
21 Porque de dentro, do coração dos homens, é que procedem os maus desígnios, a prostituição, os furtos, os homicídios, os adultérios,
22 to sleep with anoda pesin husband or wife, long-trot, evil tins, to deceive pesin, to dey misbihave, jealousy, to spoil anoda pesin, to karry body up and to do foolish tins, na from inside pesin heart all dis bad-bad tins dey from kom.
22 a avareza, as malícias, o dolo, a lascívia, a inveja, a blasfêmia, a soberba, a loucura.
23 All dis evil tins dey kom from inside pesin and na dem dey make pesin dirty for God eye.”
23 Ora, todos estes males vêm de dentro e contaminam o homem.
24 Afta Jesus komot from der, e kon go di aria wey dem dey koll Tyre. Wen e enter one house, e nor wont make anybody know sey e dey der, but e nor fit hide.
24 Levantando-se, partiu dali para as terras de Tiro [e Sidom]. Tendo entrado numa casa, queria que ninguém o soubesse; no entanto, não pôde ocultar-se,
25 One woman wey evil spirit dey worry en dota kon hear about Jesus and e kom meet am kon fall for en front.
25 porque uma mulher, cuja filhinha estava possessa de espírito imundo, tendo ouvido a respeito dele, veio e prostrou-se-lhe aos pés.
26 Di woman na Greek wey kom from Sirofoenicia. E kon beg Jesus make e drive di demon komot from en pikin body.
26 Esta mulher era grega, de origem siro-fenícia, e rogava-lhe que expelisse de sua filha o demônio.
27 But Jesus tell am, “Make di shidren chop beleful first, bikos e nor good to take shidren food give dog.”
27 Mas Jesus lhe disse: Deixa primeiro que se fartem os filhos, porque não é bom tomar o pão dos filhos e lançá-lo aos cachorrinhos.
28 Di woman ansa, “Yes, Oga God, but even dogs dey chop di small-small food wey dey fall from shidren plate.”
28 Ela, porém, lhe respondeu: Sim, Senhor; mas os cachorrinhos, debaixo da mesa, comem das migalhas das crianças.
29 Jesus kon tell am, “Since yor faith strong rish to tok like dis, make yu dey go. Di demon don komot from yor pikin body.”
29 Então, lhe disse: Por causa desta palavra, podes ir; o demônio já saiu de tua filha.
30 Wen di woman rish house, e kon si en pikin sleep for bed and di demon don leave am.
30 Voltando ela para casa, achou a menina sobre a cama, pois o demônio a deixara.
31 Den Jesus komot from Tyre kon pass Sidon go Galilee Sea for Dekapolis aria.
31 De novo, se retirou das terras de Tiro e foi por Sidom até ao mar da Galileia, através do território de Decápolis.
32 Some pipol karry one man wey nor dey hear or tok kom meet am sey make e tosh di man with en hand.
32 Então, lhe trouxeram um surdo e gago e lhe suplicaram que impusesse as mãos sobre ele.
33 Wen Jesus don take di man go korna for where pipol nor dey, e kon put en two fingers inside di man ear, e spit for en hand kon tosh di man tongue.
33 Jesus, tirando-o da multidão, à parte, pôs-lhe os dedos nos ouvidos e lhe tocou a língua com saliva;
34 Den e look heaven kon sey, “Efratah!” (wey mean, “Make yu open”).
34 depois, erguendo os olhos ao céu, suspirou e disse: Efatá!, que quer dizer: Abre-te!
35 At wons, di man ear open, en tongue luz and e kon start to tok.
35 Abriram-se-lhe os ouvidos, e logo se lhe soltou o empecilho da língua, e falava desembaraçadamente.
36 Jesus kon sey make dem nor tell anybody wetin happen. But dem kon dey tok am for evriwhere.
36 Mas lhes ordenou que a ninguém o dissessem; contudo, quanto mais recomendava, tanto mais eles o divulgavam.
37 Pipol sopraiz well-well dey sey, “Jesus don do evritin well. E even make di pipol wey nor dey hear, hear and pipol wey nor fit tok, e don make dem dey tok.”
37 Maravilhavam-se sobremaneira, dizendo: Tudo ele tem feito esplendidamente bem; não somente faz ouvir os surdos, como falar os mudos.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Marcos 7, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.