Marcos 2

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARC

Sair da comparação
ARC Almeida Revista e Corrigida 2009
1 Afta some days, wen Jesus go back to Kapanaum, news spread sey e dey house.
1 E, alguns dias depois, entrou outra vez em Cafarnaum, e soube-se que estava em casa.
2 Many pipol kon gada and di house full sotey space nor dey to enter or stand near di door. So Jesus kon bigin prish God word give dem.
2 E logo se ajuntaram tantos, que nem ainda nos lugares junto à porta eles cabiam; e anunciava-lhes a palavra.
3 Some pipol kon karry one man wey paralaiz kom.
3 E vieram ter com ele, conduzindo um paralítico, trazido por quatro.
4 As dem nor si road pass go meet Jesus, bikos pipol plenty der, dem kon remove di zink on-top di house for where Jesus sidan, den dem kon small-small drop di bed wey di man liedan put till e rish groun.
4 E, não podendo aproximar-se dele, por causa da multidão, descobriram o telhado onde estava e, fazendo um buraco, baixaram o leito em que jazia o paralítico.
5 Wen Jesus si as dia faith strong rish, e kon tell di man wey paralaiz, “My pikin, I forgive yu all yor sins.”
5 E Jesus, vendo-lhes a fé, disse ao paralítico: Filho, perdoados estão os teus pecados.
6 So some law tishas wey sidan der kon dey tink wetin Jesus tok for dia mind dey sey,
6 E estavam ali assentados alguns dos escribas, que arrazoavam em seu coração, dizendo:
7 “Why dis man dey tok like dis? E dey shalenge God! Who fit forgive sins escept God?”
7 Por que diz este assim blasfêmias? Quem pode perdoar pecados, senão Deus?
8 At wons, Jesus know wetin dem dey tink for dia mind, so e kon ask dem, “Why una dey tink like dis?
8 E Jesus, conhecendo logo em seu espírito que assim arrazoavam entre si, lhes disse: Por que arrazoais sobre estas
9 Wish one eazy pass to tok? ‘I forgive yu yor sins,’ or ‘Get up, karry yor bed make yu waka?’
9 Qual é mais fácil? Dizer ao paralítico: Estão perdoados os
10 But make dem for know sey Man Pikin get pawa for dis world to forgive sins, Jesus kon tell di man wey nor fit waka,
10 Ora, para que saibais que o Filho do Homem tem na terra poder para perdoar pecados (disse ao paralítico),
11 ‘I tell yu, get up, karry yor bed, make yu go yor house.’ ”
11 a ti te digo: Levanta-te, e toma o teu leito, e vai para tua casa.
12 At wons, di man get up, karry en bed travel for dia front. Dem sopraiz well-well kon dey praiz God dey sey, “Wi neva si dis kind tin before!”
12 E levantou-se e, tomando logo o leito, saiu em presença de todos, de sorte que todos se admiraram e glorificaram a Deus, dizendo: Nunca tal vimos.
13 Jesus kon go di wotaside again and pipol kom meet am for der, so e kon start to tish dem.
13 E tornou a sair para o mar, e toda a multidão ia ter com ele, e ele os ensinava.
14 As e dey waka for road, e si Levi, Afius pikin, sidan for where dem dey kollect tax. E tell am, “Make yu follow mi.” So Levi get up kon follow Jesus.
14 E, passando, viu Levi, filho de Alfeu, sentado na alfândega e disse-lhe: Segue-me. E, levantando-se, o seguiu.
15 As Jesus dey chop for Levi house, many tax kollectors and sinnas dey chop with en and en disciples, bikos di pipol wey follow am, plenty.
15 E aconteceu que, estando sentado à mesa em casa deste, também estavam sentados à mesa com Jesus e com seus discípulos muitos publicanos e pecadores, porque eram muitos e o tinham seguido.
16 Wen di law tishas and di Farisee pipol si sey e dey chop with sinnas and tax kollectors, dem kon ask en disciples, “Why una oga dey chop with tax kollectors and sinnas?”
16 E os escribas e fariseus, vendo-o comer com os publicanos e pecadores, disseram aos seus discípulos: Por que come e bebe ele com os publicanos e pecadores?
17 Wen Jesus hear dis, e tell dem, “Pipol wey well nor nid doctor, but na doz wey nor well nid am. Nor bi good pipol I kom koll, but na sinnas I kom for.”
17 E Jesus, tendo ouvido isso, disse-lhes: Os sãos não necessitam de médico, mas sim os que estão doentes; eu não vim chamar os justos, mas sim os pecadores.
18 Naw, John di Baptist disciples and di Farisee pipol dey fast. So dem kom meet Jesus sey, “Why John disciples and di Farisee pipol dey fast, but yor disciples nor dey fast?”
18 Ora, os discípulos de João e os fariseus jejuavam; e foram e disseram-lhe: Por que jejuam os discípulos de João e os dos fariseus, e não jejuam os teus discípulos?
19 Jesus ansa dem, “Pipol wey kom marriage nor fit fast wen di man wey dey marry dey with dem, abi dem suppose to? So-far di man wey dey marry dey with dem, dem nor nid to fast.
19 E Jesus disse-lhes: Podem, das bodas jejuar, enquanto está com eles o esposo? Enquanto têm consigo o esposo, não podem jejuar.
20 But di time dey kom wen dem go take di man wey dey marry from dem, by dat time, dem go fast.
20 Mas dias virão em que lhes será tirado o esposo, e então jejuarão naqueles dias.
21 “Nobody dey tear new klot take pash old one. If e do like dat, di pash go tear di klot more and di whole go big pass as e bi before.
21 Ninguém costura remendo de pano novo em veste velha; porque o mesmo remendo novo rompe o velho, e a rotura fica maior.
22 Nobody dey pour new wine inside wine bag wey don old; if not, di new wine go tear di bag, di wine go trowey and di bag go spoil. Instead, na inside new wine bag dem dey pour new wine put.”
22 E ninguém põe vinho novo em odres velhos; do contrário, o vinho novo rompe os odres, e entorna-se o vinho, e os odres estragam-se; o vinho novo deve ser posto em odres novos.
23 Jesus kon dey waka pass di farm where dem plant korn put for Sabat Day and en disciples kon plok some korn as dem dey pass.
23 E aconteceu que, passando ele n um sábado pelas searas, os seus discípulos, caminhando, começaram a colher espigas.
24 So di Farisee pipol tell am, “Si, why yor disciples dey break awa law for Sabat Day?”
24 E os fariseus lhe disseram: Vês? Por que fazem no sábado o que não é lícito?
25 Jesus ansa dem, “Una neva read wetin David do wen en and en men nor si food chop?
25 Mas ele disse-lhes: Nunca lestes o que fez Davi, quando estava em necessidade e teve fome, ele e os que com ele
26 How en and en men enter God house wen Abiatar bi High Priest kon chop di holy bread wey only priests suppose chop?”
26 Como entrou na Casa de Deus, no tempo de Abiatar, sumo sacerdote, e comeu os pães da proposição, dos quais não era lícito comer senão aos sacerdotes, dando também aos que com ele estavam?
27 Jesus tell dem, “God make Sabat Day to help pipol, but nor bi sey make Sabat Day kontrol pipol life.
27 E disse-lhes: O sábado foi feito por causa do homem,
28 So, na God Pikin bi Sabat Day Oga God.”
28 Assim, o Filho do Homem até do sábado é senhor.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Marcos 2, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.