Marcos 1

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB

Sair da comparação
ARIB Almeida Revisada Imprensa Bíblica
1 Na so di gospel about Jesus Christ, God Pikin take start.
1 Princípio do evangelho de Jesus Cristo, Filho de Deus.
2 As Profet Isaya tok for di book wey e rite,
2 Conforme está escrito no profeta Isaías: Eis que envio ante a tua face o meu mensageiro, que há de preparar o teu caminho;
3 One pesin dey shaut inside wildaness sey,
3 voz do que clama no deserto: Preparai o caminho do Senhor, endireitai as suas veredas;
4 For inside wildaness, John di Baptist kon bigin prish sey, make pipol leave di bad tins wey dem dey do, make e for baptize dem, so dat God go forgive dem dia sins.
4 assim apareceu João, o Batista, no deserto, pregando o batismo de arrependimento para remissão dos pecados.
5 Pipol for Judea and all di aria wey near am and doz wey dey Jerusalem, dey go meet John and e kon baptize dem for Jordan River afta dem konfess dia sins.
5 E saíam a ter com ele toda a terra da Judéia, e todos os moradores de Jerusalém; e eram por ele batizados no rio Jordão, confessando os seus pecados.
6 John wear klot wey dem take kamel hair make, tie leda belt for waist and e dey chop lokust and honey for inside bush.
6 Ora, João usava uma veste de pêlos de camelo, e um cinto de couro em torno de seus lombos, e comia gafanhotos e mel silvestre.
7 E kon sey, “Pesin wey big pass mi dey kom for my back and I nor big rish who go luz di rope wey dey en shoe.
7 E pregava, dizendo: Após mim vem aquele que é mais poderoso do que eu, de quem não sou digno de, inclinando-me, desatar a correia das alparcas.
8 I dey use wota baptize una, but e go baptize una with di Holy Spirit.”
8 Eu vos batizei em água; ele, porém, vos batizará no Espírito Santo.
9 Dat time, Jesus kom from Nazaret wey dey for Galilee and John kon baptize am for Jordan River.
9 E aconteceu naqueles dias que veio Jesus de Nazaré da Galiléia, e foi batizado por João no Jordão.
10 As Jesus dey kom out from di wota, heaven open and God Spirit kom down like dove kon land for en head.
10 E logo, quando saía da água, viu os céus se abrirem, e o Espírito, qual pomba, a descer sobre ele;
11 Den one vois tok from heaven sey, “Yu bi My Pikin wey I love and yu dey make belle sweet Mi well-well.”
11 e ouviu-se dos céus esta voz: Tu és meu Filho amado; em ti me comprazo.
12 At wons, God Spirit kon take am go inside di wildaness.
12 Imediatamente o Espírito o impeliu para o deserto.
13 E stay inside di wildaness where Satan tempt am for forty days. E dey der with wiked animals and God angels kon gi-am evritin wey e wont.
13 E esteve no deserto quarenta dias sentado tentado por Satanás; estava entre as feras, e os anjos o serviam.
14 Afta dem don put John for prison, Jesus kon enter Galilee dey prish di Good News sey,
14 Ora, depois que João foi entregue, veio Jesus para a Galiléia pregando o evangelho de Deus
15 “Di time wey God promise sey en kingdom go kom don rish. So make una leave di sins wey una dey do kon bilive di Good News.”
15 e dizendo: O tempo está cumprido, e é chegado o reino de Deus. Arrependei-vos, e crede no evangelho.
16 As Jesus dey waka for Galilee wotaside, e kon si Simon and en broda Andru wey dey trow net inside river, (bikos dem bi Fisha men.)
16 E, andando junto do mar da Galiléia, viu a Simão, e a André, irmão de Simão, os quais lançavam a rede ao mar, pois eram pescadores.
17 Jesus kon tell dem, “Make una follow mi and I go give una pawa to katch pipol.”
17 Disse-lhes Jesus: Vinde após mim, e eu farei que vos torneis pescadores de homens.
18 At wons, dem leave dia net kon follow Jesus.
18 Então eles, deixando imediatamente as suas redes, o seguiram.
19 As dem waka go front small, dem si James and John, wey bi Zebedee shidren inside boat dey ripair dia net.
19 E ele, passando um pouco adiante, viu Tiago, filho de Zebedeu, e João, seu irmão, que estavam no barco, consertando as redes,
20 At wons, Jesus koll dem, so dem leave dia papa, Zebedee, with di men wey dem hire for inside di boat, kon follow Jesus.
20 e logo os chamou; eles, deixando seu pai Zebedeu no barco com os empregados, o seguiram.
21 Jesus with en disciples kon go Kapanaum. Wen Sabat Day rish, Jesus kon enter di sinagog bigin tish.
21 Entraram em Cafarnaum; e, logo no sábado, indo ele à sinagoga, pôs-se a ensinar.
22 Di pipol sopraiz, bikos e sabi tish pass di law tishas.
22 E maravilhavam-se da sua doutrina, porque os ensinava como tendo autoridade, e não como os escribas.
23 For inside di sinagog, one man wey evil spirit dey inside en body kon shaut dey sey,
23 Ora, estava na sinagoga um homem possesso dum espírito imundo, o qual gritou:
24 “Make yu leave us o-o, Jesus wey kom from Nazaret! Abi, yu don kom distroy us? I know who yu bi. Yu bi God Pikin wey dey holy.”
24 Que temos nós contigo, Jesus, nazareno? Vieste destruir-nos? Bem sei quem és: o Santo de Deus.
25 But Jesus kommand am, “Shut up and kom out from di man!”
25 Mas Jesus o repreendeu, dizendo: Cala-te, e sai dele.
26 Afta di evil spirit don shake di man well-well, e shaut kon kom out from di man body.
26 Então o espírito imundo, convulsionando-o e clamando com grande voz, saiu dele.
27 Evribody sopraiz dey ask each oda, “Wish one bi dis? Dis new tishing strong o-o! Even wiked spirit dey obey en kommand.”
27 E todos se maravilharam a ponto de perguntarem entre si, dizendo: Que é isto? Uma nova doutrina com autoridade! Pois ele ordena aos espíritos imundos, e eles lhe obedecem!
28 So, di story about wetin Jesus dey do kon spread kwik-kwik for evriwhere for Galilee.
28 E logo correu a sua fama por toda a região da Galiléia.
29 As Jesus, James and John komot from di sinagog, dem kon enter Simon and Andru house.
29 Em seguida, saiu da sinagoga e foi a casa de Simão e André com Tiago e João.
30 Simon wife mama nor well, so dem kon tell Jesus about am.
30 A sogra de Simão estava de cama com febre, e logo lhe falaram a respeito dela.
31 Jesus go meet am, hold en hand and di woman kon stand up. Den di fever komot from en body and e kon dey serve dem.
31 Então Jesus, chegando-se e tomando-a pela mão, a levantou; e a febre a deixou, e ela os servia.
32 Wen sun don dey go down for evening, dem kon bring all di pipol wey nor well and wey get demon kom meet Jesus.
32 Sendo já tarde, tendo-se posto o sol, traziam-lhe todos os enfermos, e os endemoninhados;
33 Di whole town kon gada for di door-mot.
33 e toda a cidade estava reunida à porta;
34 So, Jesus heal many pipol wey nor well with difren-difren diziz and e drive many demon komot from pipol body. But e nor let di demons tok, bikos dem know who e bi.
34 e ele curou muitos doentes atacados de diversas moléstias, e expulsou muitos demônios; mas não permitia que os demônios falassem, porque o conheciam.
35 For early morning wen evriwhere still dark, Jesus leave di house go one kwayet place go pray.
35 De madrugada, ainda bem escuro, levantou-se, saiu e foi a um lugar deserto, e ali orava.
36 Simon and di pipol wey dey with am kon dey find am.
36 Foram, pois, Simão e seus companheiros procurá-lo;
37 Wen dem si am, dem kon sey, “Evribody dey find yu.”
37 quando o encontraram, disseram-lhe: Todos te buscam.
38 Jesus tell dem, “Make wi go anoda village, so dat I go prish for der too. Bikos na wetin I kom do, bi dat.”
38 Respondeu-lhes Jesus: Vamos a outras partes, às povoações vizinhas, para que eu pregue ali também; pois para isso é que vim.
39 So e kon go evriwhere for Galilee dey prish for dia sinagog and dey drive demon komot from pipol body.
39 Foi, então, por toda a Galiléia, pregando nas sinagogas deles e expulsando os demônios.
40 One man wey bi leper kom meet Jesus, knee down for en front dey beg am sey, “If yu wont, yu go fit make mi well.”
40 E veio a ele um leproso que, de joelhos, lhe rogava, dizendo: Se quiseres, bem podes tornar-me limpo.
41 Jesus sorry for di man, so e tosh am kon sey, “I wont, so make yu well!”
41 Jesus, pois, compadecido dele, estendendo a mão, tocou-o e disse-lhe: Quero; sê limpo.
42 At wons, di leprosy komot from di man body and e kon dey okay.
42 Imediatamente desapareceu dele a lepra e ficou limpo.
43 So Jesus warn di man well-well as e dey go sey,
43 E Jesus, advertindo-o secretamente, logo o despediu,
44 “Make yu nor tell anybody about wetin happen so, but go show yorsef to di priest. And make evribody for know sey yu don klean, make yu take di ofrin wey Moses kommand, follow body.”
44 dizendo-lhe: Olha, não digas nada a ninguém; mas vai, mostra-te ao sacerdote e oferece pela tua purificação o que Moisés determinou, para lhes servir de testemunho.
45 But as di man dey go, e kon bigin shaut for evriwhere dey spread di story, sotey Jesus nor fit enter any town again, so e kon dey stay where pipol nor dey. But pipol still dey kom meet am from evriwhere.
45 Ele, porém, saindo dali, começou a publicar o caso por toda parte e a divulgá-lo, de modo que Jesus já não podia entrar abertamente numa cidade, mas conservava-se fora em lugares desertos; e de todos os lados iam ter com ele.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Marcos 1, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.