Marcos 16
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 Wen Sabat Day don pass, Mary Magdalin, Mary wey bi James and Salome mama kon buy some tins wey dey send well-well, make dem go rub am for Jesus body, make e nor for smell.
1 Passado o sábado, Maria Madalena, Maria, mãe de Tiago, e Salomé compraram aromas para ungir Jesus.
2 For early morning on Sunday, as sun just dey kom out, dem kon go di place wey dem beri Jesus put.
2 E no primeiro dia da semana, foram muito cedo ao sepulcro, mal o sol havia despontado.
3 Dem kon dey ask each oda as dem dey go sey, “Who go help us roll di stone komot from di grave mout?”
3 E diziam entre si: Quem nos há de remover a pedra da entrada do sepulcro?
4 But wen dem look, dem si sey, dem don already roll di stone komot.
4 Levantando os olhos, elas viram removida a pedra, que era muito grande.
5 As dem enter, dem si one man wey wear white klot sidan for di rite side and fear kon katch dem.
5 Entrando no sepulcro, viram, sentado do lado direito, um jovem, vestido de roupas brancas, e assustaram-se.
6 But e tell dem, “Make una nor fear. Una dey find Jesus wey kom from Nazaret, wey dem kill. God don raiz am from deat! E nor dey here again. Make una look di place wey dem put am before.
6 Ele lhes falou: Não tenhais medo. Buscais Jesus de Nazaré, que foi crucificado. Ele ressuscitou, já não está aqui. Eis o lugar onde o depositaram.
7 Make una go tell en disciples and Pita sey, Jesus don go Galilee go wait for dem. Una go si am for der, as e tell una before.”
7 Mas ide, dizei a seus discípulos e a Pedro que ele vos precede na Galiléia. Lá o vereis como vos disse.
8 Di wimen kom out kon run from di grave side, bikos dem sopraiz and fear dey katch dem. Dem nor fit tell anybody anytin, bikos dem still dey fear.
8 Elas saíram do sepulcro e fugiram trêmulas e amedrontadas. E a ninguém disseram coisa alguma por causa do medo.
9 [For early morning on Sunday, afta Jesus don wake-up, e first appear to Mary Magdalin wey e drive seven demon komot for en body.
9 Tendo Jesus ressuscitado de manhã, no primeiro dia da semana apareceu primeiramente a Maria de Magdala, de quem tinha expulsado sete demônios.
10 For where di pipol wey dey follow Jesus dey mourn and kry dey, Mary Magdalin kon go tell dem wetin happen.
10 Foi ela noticiá-lo aos que estiveram com ele, os quais estavam aflitos e chorosos.
11 Wen dem hear sey Jesus don wake-up from deat and Mary Magdalin don si-am, dem nor bilive.
11 Quando souberam que Jesus vivia e que ela o tinha visto, não quiseram acreditar.
12 Afta, Jesus still appear to two pipol as dem dey waka go town.
12 Mais tarde, ele apareceu sob outra forma a dois entre eles que iam para o campo.
13 Dem go back go tell di rest pipol, but di pipol nor still bilive dem.
13 Eles foram anunciá-lo aos demais. Mas estes tampouco acreditaram.
14 Den Jesus appear to di eleven disciples wen dem dey chop. E shaut give dem since dem nor bilive, bikos of dia strong heart.
14 Por fim apareceu aos Onze, quando estavam sentados à mesa, e censurou-lhes a incredulidade e dureza de coração, por não acreditarem nos que o tinham visto ressuscitado.
15 Jesus kommand dem sey, “Make una enter evriwhere for di world go prish di gospel give evribody.
15 E disse-lhes: Ide por todo o mundo e pregai o Evangelho a toda criatura.
16 Anybody wey bilive and dem baptize am, God go save am, but anybody wey nor bilive, God go kondemn am.
16 Quem crer e for batizado será salvo, mas quem não crer será condenado.
17 Dis signs go follow pipol wey bilive: With my name, dem go drive demon komot from pipol body; dem go speak new language wey dem nor learn;
17 Estes milagres acompanharão os que crerem: expulsarão os demônios em meu nome, falarão novas línguas,
18 dem go fit whole snake and if dem drink poizin, e nor go do dem anytin; dem go put dia hand for pipol wey nor well body and di pipol go well.”
18 manusearão serpentes e, se beberem algum veneno mortal, não lhes fará mal; imporão as mãos aos enfermos e eles ficarão curados.
19 Afta Jesus don tok to dem finish, God kon karry am go heaven and e sidan for God rite side.
19 Depois que o Senhor Jesus lhes falou, foi levado ao céu e está sentado à direita de Deus.
20 Den, di disciples go evriwhere for di aria dey prish di gospel and Jesus dey do many mirakles thru dem, so dat pipol go know sey, wetin dem dey prish, na true.]
20 Os discípulos partiram e pregaram por toda parte. O Senhor cooperava com eles e confirmava a sua palavra com os milagres que a acompanhavam.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Marcos 16, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.