Marcos 12
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NTLH
1 Jesus kon tok to dem with parabol: “One man plant grape for en farm. E fence am round, dig where dem go dey press di wine put, den kon build big house wey guide go dey stay. E hire am give tenants wey go dey kare for di farm kon travel go far.
1 Depois Jesus começou a falar por meio de parábolas . Ele disse:
2 Wen harvest time rish, e send one of en savant go meet di tenants make dem gi-am en own share for di harvest.
2 Quando chegou o tempo da colheita, o dono enviou um empregado para receber a sua parte.
3 But di tenants seize di savant, beat am kon send am go back with empty hand.
3 Mas os lavradores agarraram o empregado, bateram nele e o mandaram de volta sem nada.
4 Di man still send anoda savant go meet dem. Dem nak en head kon beat am anyhow.
4 O dono mandou mais um empregado, mas eles bateram na cabeça dele e o trataram de um modo vergonhoso.
5 E send anoda one again, dem kon kill-am. Na so dem beat and kill oda savants wey e send too.
5 E ainda outro foi mandado para lá, mas os lavradores o mataram. E o mesmo aconteceu com muitos mais — uns foram surrados, e outros foram mortos.
6 “Di man get one pikin wey e love well-well and na dis one remain for am to send. At last, e kon send am go meet dem dey tok for en mind sey, ‘As dis one bi my pikin, dem go respet am.’
6 E agora a única pessoa que o dono da plantação tinha para mandar lá era o seu querido filho. Finalmente ele o mandou, pensando assim: “O meu filho eles vão respeitar.”
7 “But wen di tenants si am dey kom, dem kon sey, ‘Na di owner pikin dey kom so. Make wi kill-am, so dat wi go get all di propaty for awasef.’
7 Mas os lavradores disseram uns aos outros: “Este é o filho do dono; ele vai herdar a plantação. Vamos matá-lo, e a plantação será nossa.”
8 So dem seize am, kill-am kon trow en body outside di farm.
8 — Então agarraram o filho, e o mataram, e jogaram o corpo para fora da plantação.
9 “Na wetin una tink sey di farm owner go do? E go distroy doz tenant kon give di farm to oda pipol.
9 Aí Jesus perguntou:
10 Una neva read God word wey sey,
10 Vocês não leram o que as
11 Dis na wetin God do
11 Isso foi feito pelo Senhor
12 Naw, dem won kon arrest am, but dem dey fear di pipol, bikos dem know sey Jesus tok dis parabol against dem. So dem kon waka leave am.
12 Os líderes judeus sabiam que a parábola era contra eles e quiseram prender Jesus, mas tinham medo do povo. Por isso deixaram Jesus em paz e foram embora.
13 Dem send some Farisee and Herod pipol, make dem find way to katch Jesus with wetin e go tok.
13 Depois mandaram que alguns fariseus e alguns membros do partido de Herodes fossem falar com Jesus a fim de conseguirem alguma prova contra ele.
14 Wen dem meet am, dem kon ask am, “Tisha, wi know sey yu dey tok trut, yu nor dey do wayo and yu dey tish di trut about God way. E good make wi dey pay tax give Caesar, abi make wi nor pay?”
14 Eles chegaram e disseram: — Mestre, sabemos que o senhor é honesto e não se importa com a opinião dos outros. O senhor não julga pela aparência, mas ensina a verdade sobre a maneira de viver que Deus exige. Diga: é ou não é contra a nossa
15 But Jesus know dia wayo, so e tell dem, “Why una dey test mi? Make una bring one koin make I si.”
15 Mas Jesus percebeu a malícia deles e respondeu:
16 So dem bring one koin and Jesus ask dem, “Wish pesin face and name dey di money so?”
16 Eles trouxeram, e ele perguntou: Eles responderam: — São do Imperador.
17 Jesus tell dem, “Make una give Caesar di tins wey bi Caesar own and make una give God di tins wey bi God own.” Dem sopraiz well-well for wetin Jesus tok.
17 Então Jesus disse: E eles ficaram admirados com Jesus.
18 Di Sadusi pipol (wey nor bilive sey pipol go wake-up from deat) kom meet Jesus tell am,
18 Alguns saduceus , os quais afirmam que ninguém ressuscita, chegaram perto de Jesus e disseram:
19 “Tisha, Moses rite give us sey: ‘If man broda die and en wife nor born for am, en broda must marry di woman, make dem for born shidren for di broda wey don die.’
19 — Mestre, Moisés escreveu para nós a seguinte lei : “Se um homem morrer e deixar a esposa sem filhos, o irmão dele deve casar com a viúva, para terem filhos, que serão considerados filhos do irmão que morreu.”
20 E get seven brodas. Di first one marry and wen e die, e nor get shidren.
20 Acontece que havia sete irmãos. O mais velho casou e morreu sem deixar filhos.
21 Di sekond one kon marry di woman and e nor still get pikin before e die and na so e happen for di third one.
21 O segundo casou com a viúva e morreu sem deixar filhos. Aconteceu a mesma coisa com o terceiro.
22 No one for di seven brodas wey marry di woman get pikin. At last, di woman too kon die.
22 Afinal, os sete irmãos casaram com a mesma mulher e morreram sem deixar filhos. Depois de todos eles, a mulher também morreu.
23 For di time wey pipol go wake-up from deat, na wish pesin wife di woman go kon bi, as e bi sey all di seven brodas marry am?”
23 Portanto, no dia da ressurreição, quando todos os mortos tornarem a viver, de qual dos sete a mulher vai ser esposa? Pois todos eles casaram com ela!
24 Jesus ansa dem, “Una nor know sey una dey deceive unasef, bikos una nor know God word and en pawa.
24 Jesus respondeu:
25 Wen pipol wake-up from deat, dem nor go marry again, instead dem go bi like angels for heaven.
25 Pois, quando os mortos ressuscitarem, serão como os anjos do céu, e ninguém casará.
26 Naw, for di matter about pipol wey go wake-up, una neva read for di book wey Moses rite about di bush wey fire dey burn and how God tell Moses, ‘Na Mi bi Abraham, Isaak and Jakob God?’
26 Vocês nunca leram no
27 God nor bi God for di pipol wey don die, but na for di pipol wey dey alive. Na big mistake una dey make so!”
27 E Deus não é Deus dos mortos e sim dos vivos. Vocês estão completamente errados!
28 So, one man wey sabi di law kon dey hear dem dey argue. Wen e si sey Jesus dey ansa dem well, e kon ask am, “Wish kommandment big pass?”
28 Um mestre da Lei que estava ali ouviu a discussão. Viu que Jesus tinha dado uma boa resposta e por isso perguntou: — Qual é o mais importante de todos os mandamentos da
29 Jesus ansa am, “Na dis bi di kommandment wey big pass: ‘Make una listin, Israel pipol, di Oga God, awa God na one e bi.
29 Jesus respondeu:
30 Make una love God una Oga God with all una heart, soul and all una pawa.’
30 Ame o Senhor, seu Deus, com todo o coração, com toda a alma, com toda a mente e com todas as forças.”
31 Di sekond one na, ‘Make una love una neighbour as una love unasef.’ E nor get any kommandment wey big pass dis two.”
31 E o segundo mais importante é este: “Ame os outros como você ama a você mesmo.” Não existe outro mandamento mais importante do que esses dois.
32 Di man wey dey tish di law kon tell Jesus, “Na thru, Tisha. Yu dey korrect for wetin yu tok, na only God bi Oga God and know oda god dey apart from am.
32 Então o mestre da Lei disse a Jesus: — Muito bem, Mestre! O senhor disse a verdade. Ele é o único Deus, e não existe outro além dele.
33 To love God with all awa heart, mind and pawa and to love awa neighbour as awasef big pass all di sakrifice and ofrins wey pesin fit give God.”
33 Devemos amar a Deus com todo o nosso coração, com toda a nossa mente e com todas as nossas forças e também devemos amar os outros como amamos a nós mesmos. Pois é melhor obedecer a estes dois mandamentos do que trazer animais para serem queimados no altar e oferecer outros sacrifícios a Deus.
34 Wen Jesus si sey di man tink well before e ansa, e kon tell di man, “Yu nor dey far from God Kingdom.” From dat time, nobody get di mind to ask am any kweshon again.
34 Jesus viu que o mestre da Lei tinha respondido com sabedoria e disse: Depois disso ninguém tinha coragem de fazer mais perguntas a Jesus.
35 As Jesus dey tish for di temple varanda, e kon sey, “Why e bi sey di law tishas dey sey Christ na David pikin?
35 Quando Jesus estava ensinando no pátio do Templo, perguntou:
36 Di Holy Spirit pawa make David tok sey,
36 Pois Davi, inspirado pelo Espírito Santo, escreveu:
37 If David ensef koll Christ, ‘Oga God,’ how Christ go kon take bi en pikin again?”
37 O próprio Davi chama o Messias de Senhor. Portanto, como é que o Messias pode ser descendente de Davi? Uma grande multidão escutava com prazer o que Jesus ensinava.
38 Wen Jesus dey tish, e kon sey, “Make una dey kareful about di pipol wey sabi di law. Dem like to waka about with long klot and dem like loud greetin for market,
38 Ele dizia ao povo:
39 di chair wey betta pass for sinagog and high tabol for party, na der dem dey like sidan put.
39 preferem os lugares de honra nas
40 Woman wey en husband don die, dem dey kollect en propaty and dem dey pray long prayer make pipol for si dem. Na dia ponishment go worse pass.”
40 Exploram as viúvas e roubam os seus bens; e, para disfarçarem, fazem orações compridas. Portanto, o castigo que eles vão sofrer será pior ainda!
41 Den, Jesus sidan face di ofrin box, dey look as pipol dey put money inside. Many rish pipol kon dey put plenty money inside.
41 Jesus estava no pátio do Templo, sentado perto da caixa das ofertas, olhando com atenção as pessoas que punham dinheiro ali. Muitos ricos davam muito dinheiro.
42 One poor woman wey e husband don die kon kom, put two koins wey nor rish one penny for inside di box.
42 Então chegou uma viúva pobre e pôs na caixa duas moedinhas de pouco valor.
43 Jesus kon koll en disciples sey, “I tell una true word, dis poor woman wey e husband don die put money wey pass di oda pipol own.
43 Aí Jesus chamou os discípulos e disse:
44 Bikos di oda pipol give dia ofrin from di plenty money wey dem get, but dis woman, as e poor rish, put evritin wey e get for life.”
44 Porque os outros deram do que estava sobrando. Porém ela, que é tão pobre, deu tudo o que tinha para viver.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Marcos 12, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.