Marcos 10

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA

Sair da comparação
NAA Nova Almeida Atualizada 2017
1 Jesus komot for dat place go Judea and Jordan River aria. Plenty pipol still gada kom meet am. E kon bigin tish dem as e dey do evritime.
1 Saindo dali, Jesus foi para o território da Judeia e para além do Jordão. E outra vez as multidões se reuniram junto a ele, e, de novo, ele as ensinava, segundo o seu costume.
2 Den, some Farisee pipol wey won test am kon ask am, “E bad make man drive en wife at-all?”
2 E, aproximando-se alguns fariseus, o puseram à prova, perguntando: — É lícito ao marido repudiar a sua mulher?
3 Jesus ask dem, “Wetin Moses kommand una?”
3 Jesus respondeu:
4 Dem ansa, “Moses sey make man rite leta to divorce en wife.”
4 Eles disseram: — Moisés permitiu escrever uma carta de divórcio e repudiar.
5 But Jesus tell dem, “E tell una to do so, bikos una heart strong well-well.
5 Mas Jesus lhes disse:
6 But from di time God kreate di world, na man and woman naim E make.
6 Porém, desde o princípio da criação, Deus os fez homem e mulher.
7 Na dis make man dey leave en papa and mama go join en wife
7 “Por isso o homem deixará o seu pai e a sua mãe e se unirá à sua mulher,
8 and di two of dem go bi one. So dem nor go bi two again, but dem go bi one body.
8 tornando-se os dois uma só carne.” De modo que já não são mais dois, porém uma só carne.
9 So, wetin God don join togeda, make nobody separate am.”
9 Portanto, que ninguém separe o que Deus ajuntou.
10 Wen dem enter di house again, en disciples kon ask am about di matter.
10 Em casa, os discípulos voltaram a fazer perguntas sobre esse assunto.
11 Jesus ansa dem, “Anybody wey drive en wife, den e go marry anoda woman, don kommit adultery.
11 E Jesus lhes disse:
12 And any woman wey leave en husband, den e go marry anoda man, don kommit adultery too.”
12 E, se ela repudiar o seu marido e casar com outro, comete adultério.
13 Pipol kon dey bring shidren kom meet Jesus make e tosh dem, but en disciples dey shaut for di pipol wey bring dem kom.
13 Então trouxeram algumas crianças a Jesus para que as abençoasse, mas os discípulos os repreendiam.
14 But wen Jesus si wetin dey happen, e vex kon tell en disciples, “Make una allow small-small shidren kom meet mi, nor stop dem, bikos na pipol like dem, go enter God Kingdom.
14 Jesus, porém, vendo isto, indignou-se e disse-lhes:
15 I tell una true word, anybody wey nor receive God Kingdom like small shidren, nor go ever enter inside.”
15 Em verdade lhes digo: Quem não receber o Reino de Deus como uma criança de maneira nenhuma entrará nele.
16 Afta, Jesus draw di shidren near body kon bless dem.
16 Então, tomando as crianças nos braços e impondo-lhes as mãos, as abençoava.
17 As Jesus dey waka for road, one man run kom meet am sey, “Good Tisha, wetin I go do make I for get life wey nor dey end?”
17 Pondo-se Jesus a caminho, um homem correu ao seu encontro e, ajoelhando-se diante dele, perguntou-lhe: — Bom Mestre, que farei para herdar a vida eterna?
18 Jesus ansa am, “Why yu dey koll mi good? Nobody good espect God.
18 Jesus respondeu:
19 Yu know di kommandment; nor kill pesin, nor sleep with pesin wey yu nor marry, nor tif, nor lie for pesin head, nor shit pesin, respet yor papa and mama.”
19 Você conhece os mandamentos: “Não mate, não cometa adultério, não furte, não dê falso testemunho, não defraude ninguém, honre o seu pai e a sua mãe.”
20 Di man kon tell Jesus, “Tisha, I dey obey all dis law with all my heart since I bi small pikin.”
20 Então o homem respondeu: — Mestre, tudo isso tenho observado desde a minha juventude.
21 As Jesus look am, e kon feel for am, den e tell am, “E get one tin wey yu neva do. Go sell all wetin yu get, give poor pipol di money and yu go get plenty propaty for heaven. Den make yu kom follow mi.”
21 E Jesus, olhando para ele com amor, disse:
22 Wen di man hear dis word, e vex komot der, bikos e get plenty money.
22 Ele, porém, contrariado com esta palavra, retirou-se triste, porque era dono de muitas propriedades.
23 Den Jesus look round kon tell en disciples, “E go hard well-well for pipol wey get money well-well to enter God Kingdom!”
23 Então Jesus, olhando ao redor, disse aos seus discípulos:
24 Di disciple sopraiz for wetin Jesus tok. But Jesus tell dem again, “My shidren, e go hard well-well to enter God Kingdom o-o!
24 Os discípulos estranharam estas palavras, mas Jesus insistiu em dizer-lhes:
25 E go dey eazy for kamel to pass nidol whole, dan for pipol wey get money well-well to enter God Kingdom.”
25 É mais fácil um camelo passar pelo fundo de uma agulha do que um rico entrar no Reino de Deus.
26 Dem sopraiz more-more kon dey ask each oda, “Den, who God go save?”
26 Eles ficaram muito admirados, dizendo entre si: — Sendo assim, quem pode ser salvo?
27 Jesus look dem kon ansa, “Dis tins hard well-well for human being, but nor bi for God, bikos evritin dey possibol for God.”
27 Jesus, olhando para eles, disse:
28 Pita kon tell am, “Si! Wot of wi wey don leave evritin wey wi get kon follow yu?”
28 Então Pedro começou a dizer-lhe: — Eis que nós deixamos tudo e seguimos o senhor.
29 Jesus ansa, “I tell una true word, e nor get anybody wey leave en house, brodas, sistas, papa, mama, shidren or land bikos of di gospel,
29 Jesus respondeu:
30 wey nor go receive hundred times more dan di house, brodas, sistas, papa, mama, shidren and land wey e leave for dis world. Aldo e nor go eazy for dem, but di life wey nor go end for di world wey dey kom, go bi dia own.
30 que não receba, já no presente, cem vezes mais casas, irmãos, irmãs, mães, filhos e campos, com perseguições; e, no mundo por vir, receberá a vida eterna.
31 But many pipol wey bi first naw, go bi last and pipol wey bi last naw, go bi first.”
31 Porém muitos primeiros serão últimos, e os últimos serão primeiros.
32 Jesus and en disciples kon dey go Jerusalem. As Jesus dey waka for dia front, di disciples konfuse and doz wey dey follow dem kon dey fear, bikos dem nor know wetin go happen for der. Jesus koll en twelf disciples go korna again kon bigin tell dem wetin go happen to am.
32 Estavam a caminho, subindo para Jerusalém, e Jesus ia adiante dos seus discípulos. Estes se admiravam e o seguiam tomados de apreensões. E Jesus, chamando outra vez os doze para um lado, começou a revelar-lhes as coisas que deviam acontecer com ele, dizendo:
33 “Si, wi dey go Jerusalem and dem go sell Man Pikin give di priest oga dem and di law tishas. Dem go kondemn am and dem go gi-am to di Gentile pipol.
33 — Eis que subimos para Jerusalém, e o Filho do Homem será entregue aos principais sacerdotes e aos escribas. Eles vão condená-lo à morte e entregá-lo aos gentios.
34 Dem go laf am, spit for en body, flog am well-well kon kill-am, but afta three days, e go wake-up.”
34 Vão zombar dele, cuspir nele, açoitá-lo e matá-lo; mas, depois de três dias, ressuscitará.
35 Zebedee shidren, James and John, kom meet Jesus sey, “Tisha, wi wont make yu do wetin wi won beg yu.”
35 Então se aproximaram dele Tiago e João, filhos de Zebedeu, dizendo: — Mestre, queremos que o senhor nos conceda o que vamos pedir.
36 Jesus kon ask dem, “Wetin una wont make I do for una?”
36 E Jesus lhes perguntou:
37 Dem ansa, “Make yu allow us sidan with yu for yor kingdom, one for yor rite and di oda for yor left hand.”
37 Eles responderam: — Permite-nos que, na sua glória, nos assentemos um à sua direita e o outro à sua esquerda.
38 Jesus ask dem, “Una know wetin una dey ask for so? Una go fit drink from di cup wey I go drink from? Abi una go fit bear di baptizim wey dem go baptize mi?”
38 Mas Jesus lhes disse:
39 Dem ansa, “Wi go fit.” Den Jesus tell dem, “Una go really drink from di cup wey I go drink from and una go fit bear di baptizim wey dem go baptize mi,
39 Eles responderam: — Podemos. Então Jesus lhes disse:
40 but nor bi mi go tok who go sidan for my left or rite side, bikos e get di pipol wey God prepare am for.”
40 Quanto a sentar à minha direita ou à minha esquerda, não me compete concedê-lo, pois é para aqueles a quem está preparado.
41 Wen di oda ten disciples hear wetin Zebedee shidren tell Jesus, dem kon dey vex for dem.
41 Quando os outros dez discípulos ouviram isso, começaram a ficar indignados com Tiago e João.
42 Jesus koll and tell dem, “Una know sey pipol wey dey rule di Gentile pipol dey do oga for dem and pipol wey dey high place dey use dia pozishon dey opress pipol.
42 Mas Jesus, chamando todos para junto de si, disse:
43 But nor bi so e suppose bi among una. Anybody wey won bi oga among una, must bi una savant
43 Mas entre vocês não é assim; pelo contrário, quem quiser tornar-se grande entre vocês, que se coloque a serviço dos outros;
44 and anybody wey won bi first among una, must bi evribody savant.
44 e quem quiser ser o primeiro entre vocês, que seja servo de todos.
45 Bikos even Man Pikin nor kom make dem serve am, but e kom to serve pipol and to give en life make many pipol for dey save.”
45 Pois o próprio Filho do Homem não veio para ser servido, mas para servir e dar a sua vida em resgate por muitos.
46 Dem kon go Jeriko. As Jesus and en disciples with plenty pipol dey komot for der, Bartimaeus wey bi Timaeus pikin, one beggar wey blind, sidan for road dey beg.
46 E foram para Jericó. Quando Jesus saía de Jericó, juntamente com os discípulos e numerosa multidão, Bartimeu, um cego mendigo, filho de Timeu, estava sentado à beira do caminho
47 Wen e hear sey na Jesus wey kom from Nazaret dey pass, e kon bigin shaut, “Jesus Christ, David pikin, make yu sorry for mi o-o!”
47 e, ouvindo que era Jesus, o Nazareno, começou a gritar: — Jesus, Filho de Davi, tenha compaixão de mim!
48 Many pipol kon dey shaut for am make e kwayet, but e kon dey shaut more-more sey, “David pikin, sorry for mi o-o!”
48 E muitos o repreendiam para que se calasse, mas ele gritava cada vez mais: — Filho de Davi, tenha compaixão de mim!
49 Jesus stop kon sey, “Make una koll am kom.” So, dem tell di blind man, “Make yu happy! Get up bikos Jesus dey koll yu.”
49 Jesus parou e disse: Chamaram, então, o cego, dizendo-lhe: — Coragem! Levante-se, porque ele está chamando você.
50 Bartimaeus trowey di klot wey e take kover body kon jump up go meet Jesus.
50 Atirando a capa para o lado, o cego levantou-se de um salto e foi até onde estava Jesus,
51 Den Jesus ask am, “Wetin yu wont make I do for yu?”
51 que lhe perguntou: O cego respondeu: — Mestre, que eu possa ver de novo.
52 So, Jesus tell am, “Go, yor faith don heal yu.” At wons, di man kon dey si and e kon follow Jesus.
52 Então Jesus lhe disse: E imediatamente passou a ver e foi seguindo Jesus estrada afora.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Marcos 10, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.