Levítico 26

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 God tell dem, “Make una nor make juju for unasef or make image, pila, stone kon dey woship am. Na mi bi di Oga una God.
1 "Não fareis ídolos. Não levantareis estátuas nem estelas, e não poreis em vossa terra pedra alguma adornada de figuras, para vos prostrardes diante dela, porque eu sou o Senhor, vosso Deus.
2 Una must keep di Sabat Day and honor di place where dem for dey woship mi. Na mi bi Oga God.
2 Guardareis os meus sábados e reverenciareis o meu santuário. Eu sou o Senhor.
3 “If una keep my law and obey my kommand,
3 Se seguirdes minhas leis e guardardes os meus preceitos e os praticardes, eu vos darei as chuvas nos seus tempos.
4 I go send una rain for di korrect time, so dat una land go produce food and una trees go bear fruits.
4 A terra dará o seu produto e as árvores da terra se carregarão de frutos.
5 Una harvest go plenty well-well, sotey una go still dey harvest korn until di time to pick grape and una go still dey pick grape for di time to plant korn. Una go get all wetin una won chop and una nor go fear for di land wey una dey stay.
5 A debulha do trigo prolongar-se-á até a vindima, e a vindima até a sementeira; comereis o vosso pão à saciedade, e habitareis em segurança na vossa terra.
6 I go give una peace for una land and fear nor go katch una wen una dey sleep. I go kill all di wild animals for di land and war nor go dey der.
6 Darei paz à vossa terra, e vosso sono não será perturbado. Afastarei da terra os animais nocivos, e a espada não passará pela vossa terra.
7 Una go ovakom una enemies.
7 Quando perseguirdes os vossos inimigos, cairão sob vossa espada.
8 Five of una go fit win hundred pipol and hundred of una go win 10,000 pipol.
8 Cinco dentre vós perseguirão um cento, e cem dos vossos perseguirão dez mil, e os vossos inimigos cairão sob vossa espada.
9 I go bless and give una many shidren; I go keep my own part for di kovenant wey I make with una.
9 Eu me voltarei para vós, e vos farei crescer; multiplicar-vos-ei e ratificarei a minha aliança convosco.
10 Una harvest go remain enter anoda year and una go even trowey wetin remain for di old harvest, so dat una go get space to put di new ones.
10 Comereis as colheitas antigas, bem conservadas, e lançareis fora as velhas, para dar lugar às novas.
11 I go stay with una for inside my holy tent and I nor go ever komot for where una dey.
11 Porei o meu tabernáculo no meio de vós, e a minha alma não vos rejeitará.
12 I go dey with una; I go bi una God and una go bi my pipol.
12 Andarei entre vós: serei o vosso Deus e vós sereis o meu povo.
13 Na mi bi di Oga una God wey take una komot from Egypt, so dat una nor go bi slave again. I skata di pawa wey hold una for groun and I make una waka with pride.”
13 Eu sou o Senhor, vosso Deus, que vos tirei do Egito para livrar-vos da escravidão. Quebrei as cadeias de vosso jugo, e vos fiz andar com a cabeça erguida.
14 God kon tell dem, “If una nor obey my kommand, I go ponish una.
14 Mas se não me escutardes e não guardardes os meus mandamentos,
15 If una nor gri obey my law, kommand or keep di kovenant wey I make with una,
15 se desprezardes os meus preceitos e vossa alma aborrecer as minhas leis, de sorte que não pratiqueis todos os meus mandamentos e violeis minha aliança, eis como vos hei de tratar:
16 I go ponish una. I go bring distroshon to una; diziz wey dem nor go fit cure and fever wey go make una blind, naim I go take waste una life. Una go plant una seed, but e nor go produce good food for una, bikos una enemies go win una kon chop wetin una plant.
16 enviarei terríveis flagelos sobre vós: a tísica e a febre que empanarão vosso olhar e vos farão desfalecer. Debalde semeareis a vossa semente, porque vossos inimigos a comerão.
17 I go turn against una kon make una enemies win and di pipol wey hate una, go rule una. Fear go katch una sotey una go dey run wen nobody dey porshu una.
17 Voltarei minha face contra vós e sereis vencidos pelos vossos inimigos: eles vos dominarão, e fugireis sem que ninguém vos persiga.
18 “If afta all dis tins happen and una nor still obey mi, I go inkrease una ponishment seven times.
18 Se nem ainda assim me ouvirdes, castigar-vos-ei sete vezes mais pelos vossos pecados.
19 I go break una strong pride; una nor go get rain; una land go dry kon strong like iron.
19 Quebrarei o orgulho de vosso poder, tornarei o vosso céu como ferro e a vossa terra como bronze.
20 All una hard work nor go do una good, bikos una land nor go produce food and di trees nor go bear fruit.
20 Inutilmente se gastará a vossa força, pois vossa terra não dará os seus produtos, e as árvores da terra não produzirão os seus frutos.
21 “If una kontinue to rijet mi and una nor gri obey mi, I go inkrease una ponishment seven times again.
21 Se me puserdes obstáculos e não quiserdes ouvir-me, ferir-vos-ei sete vezes mais, conforme os vossos pecados.
22 I go send wild animals among una and dem go kill una shidren; distroy una animal kon kill una pipol and di road go dey dry.
22 Mandarei contra vós as feras do campo, que devorarão vossos filhos, matarão vossos animais e vos reduzirão a um pequeno número, de modo que os vossos caminhos se tornarão desertos.
23 “If afta all dis ponishment una still nor listin to mi, but kontinue to rijet mi,
23 Se apesar desses castigos não vos quiserdes corrigir, e vos obstinardes em resistir-me,
24 I go turn kon ponish una seven times and e go worse pass di ones wey I ponish una before.
24 eu vos resistirei por minha vez e vos ferirei sete vezes mais, por causa dos vossos pecados.
25 I go ponish una with war, bikos una nor keep di kovenant wey I make with una and if una gada for una towns make una for dey save, I go send diziz wey dem nor dey fit cure among una and una enemies go win una.
25 Farei cair sobre vós a espada para vingar a minha aliança. Se vos ajuntardes em vossas cidades, lançarei a peste no meio de vós e sereis entregues nas mãos de vossos inimigos.
26 Una nor go get food to chop and ten wimen go dey bake all dia bread wey dem get for only one oven. Dem go share am and afta una don chop finish, una go still dey hongry.
26 Tirar-vos-ei o pão, vosso sustentáculo, de tal sorte que dez mulheres o cozerão em um só forno e vo-lo entregarão por peso; comereis e não ficareis saciados.
27 “If afta all dis tins happen, una still dey rijet or disobey mi,
27 Se, apesar disso, não me ouvirdes, e me resistirdes ainda,
28 I go turn against una. Bikos I dey vex, di ponishment wey I go give una go bad seven times pass di ones wey I give una before.
28 marcharei contra vós em meu furor e vos castigarei sete vezes mais, por causa dos vossos pecados.
29 Una go dey hongry sotey una go dey chop una own shidren.
29 Comereis a carne de vossos filhos e de vossas filhas.
30 I go distroy di place where una for dey woship on-top di hills kon skata una incense altars, den kill and trowey una dead body near una juju wey don fall. I go rijet una finish.
30 Destruirei vossos lugares altos e quebrarei vossas estelas solares; amontoarei vossos cadáveres sobre os de vossos ídolos, e minha alma vos abominará.
31 I go distroy una towns kon skata di place where una for dey woship and I nor go asept una sakrifice.
31 Reduzirei a deserto as vossas cidades, devastarei vossos santuários e não aspirarei mais o suave odor de vossos perfumes.
32 I go distroy una land finish and una enemies wey dey stay der before, go shok for di kind distroshon.
32 Desolarei vossa terra e vossos inimigos ficarão estupefatos com ela quando a habitarem.
33 I go make war happen to una and I go skata una go strenj land. Nobody go dey di land and I go distroy una towns.
33 Eu vos dispersarei entre as nações, e desembainharei a espada atrás de vós; vossa terra será devastada e vossas cidades se tornarão desertas.
34 Den di years for komplete rest wey una nor gri give di land, go kon happen;
34 Então gozará a terra os seus sábados enquanto durar a sua solidão, quando estiverdes na terra de vossos inimigos; então a terra gozará os seus sábados e repousará.
35 nobody go dey der and e go kon get en rest wen una enemies don karry una go dia land.
35 Nos dias em que for devastada, ela terá o repouso que não gozou nos sábados do tempo em que a habitáveis.
36 “I go make some among una wey una enemies karry go dia land dey fear well-well, sotey if una hear leaf sound wey breeze blow, una go dey run. Una go run like sey dem dey porshu una for war and una go fall wen no enemy dey near una.
36 Naqueles dentre vós que sobreviverem, porei tal espanto em seus corações na terra de seus inimigos, que o ruído de uma folha agitada pelo vento os porá em fuga: fugirão como se foge diante da espada e cairão sem que ninguém os persiga.
37 Una go dey shake as if pesin dey porshu una and una nor go fit fight with una enemies.
37 Sem que ninguém os persiga, tropeçarão uns sobre os outros, como diante da espada. Não podereis resistir aos vossos inimigos.
38 Una go die for una enemies land and di land go swallow una.
38 Perecereis entre as nações e a terra inimiga vos consumirá.
39 “Doz of una wey nor go die for una enemy land go waste trowey, bikos of una and una grand-grand papa sin.
39 Os que sobreviverem consumir-se-ão por causa de suas iniqüidades na terra de seus inimigos, e serão também consumidos por causa das iniqüidades de seus pais, que levarão sobre si.
40 Una shidren-shidren go konfess both dia sin and dia grand-grand papa own, wey rijet and dey sturbon to mi,
40 Eles confessarão, então, as suas iniqüidades e as de seus pais, as transgressões cometidas contra mim, porque me resistiram;
41 kon make mi turn against and give dem as slave to dia enemies. But wen una shidren-shidren honbol demsef and dem pay for dia sins and sturbones,
41 e, por isso, eu também lhes resisti e os levei para a terra de seus inimigos. Se, então, humilharem o seu coração incircunciso e sofrerem a pena de sua iniqüidade,
42 I go remember di kovenant wey I make with Abraham, Isaak and Jakob kon fulfil my promise, den give my pipol di land.
42 eu me lembrarei de minha aliança com Jacó, de minha aliança com Isaac e com Abraão, e lembrar-me-ei dessa terra.
43 All di pipol wey dey di land must komot first, make e for get komplete rest and dem must pay di prize, bikos dem rijet my law and kommand.
43 E, depois que eles a tiverem deixado, esta terra gozará os seus sábados enquanto for devastada longe deles; eles sofrerão a pena de suas iniqüidades, porque desprezaram os meus mandamentos e a sua alma feriu as minhas leis.
44 “But even wen dem still dey dia enemy land, I nor go leave and distroy dem finish. Bikos dat one go make my kovenant with dem end, na mi bi di Oga dia God.
44 Apesar de tudo isso, quando estiverem na terra de seus inimigos, não os rejeitarei, nem os abominarei a ponto de exterminá-los e de romper minha aliança com eles; porque eu sou o Senhor, seu Deus.
45 I go renew di kovenant wey I make with dia papa wen I show all di kountries my pawa wey I take karry dem komot from Egypt, so dat mi wey bi di Oga God, go bi dia God.”
45 Lembrar-me-ei de minha aliança com seus pais, quando os tirei do Egito à vista das nações, para ser o seu Deus. Eu sou o Senhor."
46 All dis na di law and kommand wey God give Moses for Mount Sinai about Israel pipol.
46 Tais são as ordenações, os mandamentos e as leis que o Senhor estabeleceu entre ele e os israelitas, por intermédio de Moisés, no monte Sinai.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Levítico 26, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.