Levítico 25

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 God tell Moses for Mount Sinai:
1 Então disse o Senhor a Moisés no monte Sinai:
2 “Make yu go tell Israel pipol sey, ‘Wen una enter di land wey I dey give una, una must nor work for di sevent year, just as God kommand.
2 "Diga o seguinte aos israelitas: Quando vocês entrarem na terra que lhes dou, a própria terra guardará um sábado para o Senhor.
3 For six years, una go plant for una farm kon kut una gardin and gada wetin una harvest,
3 Durante seis anos semeiem as suas lavouras, aparem as suas vinhas e façam a colheita de suas plantações.
4 but for di sevent year, una must let di land rest kon dedikate dat year to God. Una must nor plant or harvest.
4 Mas no sétimo ano a terra terá um sábado de descanso, um sábado dedicado ao Senhor. Não semeiem as suas lavouras, nem aparem as suas vinhas.
5 Make una nor even harvest any korn wey grow on dia own wey nobody plant and make una nor gada di grape from di gardin wey una nor kut; bikos na di year wey di land dey rest.
5 Não colham o que crescer por si, nem colham as uvas das suas vinhas que não serão podadas. A terra terá um ano de descanso.
6 Even doh una nor plant for una land dat year, di land go produce food for una, una slave, di men wey una hire to work for una, di strenjas wey dey stay for una land,
6 Vocês se sustentarão do que a terra produzir no ano de descanso, você, o seu escravo, a sua escrava, o trabalhador contratado e o residente temporário que vive entre vocês,
7 una animals; di big animal wey dey una farm and all di tins wey di land produce, go bi food for una to chop.
7 bem como os seus rebanhos e os animais selvagens de sua terra. Tudo o que a terra produzir poderá ser comido.
8 “ ‘Make una kount seven times seven years and e go bi forty-nine years.
8 "Contem sete semanas de anos, sete vezes sete anos; essas sete semanas de anos totalizam quarenta e nove anos.
9 Den for di tent day for di sevent mont, di day to forgive sins, yu go send somebody go blow di trumpet for di whole land for Israel.
9 Então façam soar a trombeta no décimo dia do sétimo mês; no Dia da Expiação façam soar a trombeta por toda a terra de vocês.
10 Na like dis una go take make di nomba fifty year dey holy and una go free evribody wey dey stay for di land. For dis year, all di propaty wey dem don sell before, dem go gi-am back to di owner or en relashon. And anybody wey dem sell as slave, go-go back to en family.
10 Consagrem o qüinquagésimo ano e proclamem libertação por toda a terra a todos os seus moradores. Este lhes será um ano de jubileu, quando cada um de vocês voltará para a propriedade da sua família e para o seu próprio clã.
11 Una nor go plant for una farm or harvest di korn wey dey grow by ensef or gada di grape wey dey di land wey una nor kut.
11 O quinquagésimo ano lhes será jubileu; não semeiem e não ceifem o que cresce por si mesmo nem colham das vinhas não podadas.
12 Di whole year go dey holy to una; una go chop only di food wey di land produce by ensef.
12 É jubileu, e lhes será santo; comam apenas o que a terra produzir.
13 “ ‘For dis year, all di land wey dem don sell, dem go gi-am back to dia owner.
13 "Nesse ano do jubileu cada um de vocês voltará para a sua propriedade.
14 Wen una sell land to una fellow Israel pipol or buy from dem, make una nor do wayo.
14 "Se vocês venderem alguma propriedade ao seu próximo ou se comprarem alguma propriedade dele, não explore o seu irmão.
15 Una go fix di prize akordin to di nomba for di year wey di land go produce food, before di year wey una go riton am.
15 O que comprarem do seu próximo será avaliado com base no número de anos desde o Jubileu. E fará a venda com base no número de anos que restam de colheitas.
16 If di years many well-well, di prize go inkrease, but if di years small, di prize go low, bikos dem dey sell di food wey di land produce.
16 Quando os anos forem muitos, vocês deverão aumentar o preço, mas quando forem poucos, deverão diminuir o preço, pois o que ele está lhes vendendo é o número de colheitas.
17 Make una nor play una fellow Israel pesin wayo, but make una obey di Oga una God.
17 Não explorem um ao outro, mas temam ao Deus de vocês. Eu sou o Senhor, o Deus de vocês.
18 “ ‘Una must obey my law and my kommandment, so dat una nor go fear for di land.
18 "Pratiquem os meus decretos e obedeçam às minhas ordenanças, e vocês viverão com segurança na terra.
19 Di land go produce food and una go chop until una beleful and una nor go fear for di land.
19 Então a terra dará o seu fruto, e vocês comerão até fartar-se e ali viverão em segurança.
20 If una sey, “Wetin wi go chop for di sevent year if wi nor plant or gada awa harvest?”
20 Vocês poderão perguntar: ‘Que iremos comer no sétimo ano, se não plantarmos nem fizermos a colheita? ’
21 I go kommand my blessing for una for di sixt year, so dat di land go produce food wey una go chop for three years.
21 Saibam que eu lhes enviarei a minha bênção no sexto ano, e a terra produzirá o suficiente para três anos.
22 Even wen una plant for una farm for di eight year, una go still dey chop wetin una harvest for di sixt year and una go get plenty food to chop. Even wen una harvest for di ninet year, di ones wey una harvest for di sixt year, go still remain.
22 Quando vocês estiverem plantando no oitavo ano, comerão ainda da colheita anterior e dela continuarão a comer até a colheita do nono ano.
23 “ ‘Una nor go sell una land forever, bikos di land na God own and una bi strenja wey God allow to use di land.
23 "A terra não poderá ser vendida definitivamente, porque ela é minha, e vocês são apenas estrangeiros e imigrantes.
24 Wen dem sell di land, una go sell back to di owner wen e won buy am back.
24 Em toda terra em que tiverem propriedade, concedam o direito de resgate da terra.
25 If any Israel pesin dey poor and una kon force am sell en land, e relashon wey dey klose to am go must buy am back.
25 "Se alguém do seu povo empobrecer e vender parte da sua propriedade, seu parente mais próximo virá e resgatará aquilo que o seu compatriota vendeu.
26 If pesin nor get money to buy di land back den, but leta e kon get,
26 Se, contudo, um homem não tiver quem lhe resgate a terra, mas ele mesmo prosperar e adquirir recursos para resgatá-la,
27 e go pay di man wey buy di land di money wey go rish to kover di remainin years, before di year wey dem go riton di land.
27 calculará os anos desde que a vendeu e devolverá a diferença àquele a quem a vendeu; então poderá voltar para a sua propriedade.
28 But if di pesin nor get plenty money to buy di land back, di land go dey with di man wey buy am till di year wey dem go riton di land. For dat year, e go riton di land give di owner.
28 Mas, se não adquirir recursos para devolver-lhe o valor, a propriedade que vendeu permanecerá em posse do comprador até o ano do jubileu. Será devolvida no Jubileu, e ele então poderá voltar para a sua propriedade.
29 “ ‘If anybody sell house for town wey get wall, e get di rite to buy am back for di first year wey e sell am.
29 "Se um homem vender uma casa numa cidade murada, terá o direito de resgate até que se complete um ano após a venda. Nesse período poderá resgatá-la.
30 But if e nor buy am back for dat year, e nor go fit buy am back again and di house go bi di pesin and en sons own; dem nor go riton am for di year wey dem dey riton propaty.
30 Se não for resgatada antes de se completar um ano, a casa da cidade murada pertencerá definitivamente ao comprador e aos seus descendentes; não será devolvida no Jubileu.
31 But house wey dey for di village wey nor get wall, dem go trit dem like field; di first owner for di house get di rite to buy di house back and dem go riton am for di year wey dem dey riton propaty.
31 Mas as casas dos povoados sem muros ao redor serão consideradas campo aberto. Poderão ser resgatadas e serão devolvidas no Jubileu.
32 Levi pipol get di rite to buy dia propaty back anytime for di town wey dem share give dem.
32 "No caso das cidades dos levitas, eles sempre terão direito de resgatar suas casas nas cidades que lhes pertencem.
33 If Levi pesin sell one among di house for di town and dem nor buy am back, dem must riton am for di year wey dem dey riton propaty, bikos di house wey Levi pipol get for dia town, na dia permanent propaty among Israel pipol.
33 Assim, a propriedade dos levitas, isto é, uma casa vendida em qualquer cidade deles, é resgatável e deverá ser devolvida no Jubileu, porque as casas das cidades dos levitas são propriedade deles entre os israelitas.
34 But di land wey dia animal dey stay, dem nor go sell am at-all; bikos na dia propaty e bi forever.
34 Mas as pastagens pertencentes às suas cidades não serão vendidas; são propriedade permanente deles.
35 “ ‘If una fellow Israel pesin dey poor and e nor fit support ensef, una must gi-am evritin as una dey give di pipol wey una hire, so dat dem go kontinue to stay with una.
35 "Se alguém do seu povo empobrecer e não puder sustentar-se, ajudem-no como se faz ao estrangeiro e ao residente temporário, para que possa continuar a viver entre vocês.
36 Make una nor add intrest join, but make una obey God, so dat una fellow Israel pipol go fit stay near una.
36 Não cobrem dele juro algum, mas temam o seu Deus, para que o seu próximo continue a viver entre vocês.
37 Make una nor add intrest for di money wey una borrow dem or gain for di food wey una sell give dem.
37 Vocês não poderão exigir dele juros nem emprestar-lhe mantimento visando lucro.
38 Na mi bi di Oga una God wey karry una komot from Egypt kon give una Kanaan land. Na mi bi una God.
38 Eu sou o Senhor, o Deus de vocês, que os tirou da terra do Egito para dar-lhes a terra de Canaã e para ser o seu Deus.
39 “ ‘If una fellow Israel pipol wey dey stay near una dey poor kon sell ensef for una to bi slave, una nor go make am do di work wey oda slaves dey do.
39 "Se alguém do seu povo empobrecer e se vender a algum de vocês, não o façam trabalhar como escravo.
40 E go stay with una as slave wey una hire and e go serve una until di year wey dem dey riton propaty.
40 Ele deverá ser tratado como trabalhador contratado ou como residente temporário; trabalhará para quem o comprou até o ano do jubileu.
41 For dat time, en and en sons go leave una kon go back to dia family and to dia propaty wey dia grand-grand papa get.
41 Então ele e os seus filhos estarão livres, e ele poderá voltar para o seu próprio clã e para a propriedade dos seus antepassados.
42 Israel pipol na God savants and E karry dem komot from Egypt; so una must nor sell dem as slave.
42 Pois os israelitas são meus servos, a quem tirei da terra do Egito; não poderão ser vendidos como escravos.
43 Make una nor trit dem anyhow, but make una obey di Oga wey bi una God.
43 Não dominem impiedosamente sobre eles, mas temam o seu Deus.
44 But for una own slaves, una fit buy dem from di kountry wey dey near una.
44 "Os seus escravos e as suas escravas deverão vir dos povos que vivem ao redor de vocês; deles vocês poderão comprar escravos e escravas.
45 Una fit still buy from di pikin wey di strenjas among una born. Doz pikin wey dem born for una land go fit bi una propaty.
45 Também poderão comprá-los entre os filhos dos residentes temporários que vivem entre vocês e entre os que pertencem aos clãs deles, ainda que nascidos na terra de vocês; eles se tornarão propriedade de vocês.
46 Una fit give dem to una sons and dem go serve una shidren-shidren forever. But make una nor trit any Israel pesin anyhow.
46 Vocês poderão deixá-los como herança para os seus filhos e poderão fazê-los escravos para sempre, mas sobre os seus irmãos israelitas vocês não poderão dominar impiedosamente.
47 “ ‘If di strenja wey dey stay with una kon get money and en fellow Israel pesin dey poor and e sell ensef give dat strenja to bi slave or anybody from en family,
47 "Se um estrangeiro ou um residente temporário entre vocês enriquecer e alguém do seu povo empobrecer e se vender a esse estrangeiro ou a alguém que pertence ao clã desse estrangeiro,
48 afta dem don sell am, e still get di rite to buy ensef back. One pesin among en brodas fit buy am back,
48 manterá o direito de resgate mesmo depois de vender a si mesmo. Um dos seus parentes poderá resgatá-lo:
49 or en uncle, kousin or family memba; or if en ensef get plenty money, e fit buy ensef back.
49 ou tio, ou primo, ou qualquer parente próximo poderá resgatá-lo. Se, todavia, prosperar, poderá resgatar a si mesmo.
50 E go meet di pesin wey buy am and dem go kount di year wey e take sell ensef until di year wey dem dey riton propaty, den dem must tok di prize for am to dey free. Dis prize na as dem take dey pay di savant wey dem hire to work.
50 Ele e o seu comprador contarão o tempo desde o ano em que vendeu a si mesmo até o ano do jubileu. O preço do resgate se baseará no salário de um empregado contratado por aquele número de anos.
51 If many years still remain wey e go stay with dem, e go riton part of di money wey dem take buy am, so dat e go dey free.
51 Se restarem muitos anos, pagará o seu resgate proporcionalmente ao preço de compra.
52 But if di year wey remain dey small before di year wey dem go riton propaty, e go kakulate di money wey remain and e go pay am, so dat e go dey free.
52 Se restarem apenas poucos anos até o ano do jubileu, fará o cálculo, e pagará o seu resgate proporcionalmente aos anos.
53 If dem hire am for evry year, en oga nor go trit am anyhow.
53 Ele deverá ser tratado como um empregado contratado anualmente; não permitam que o seu senhor domine impiedosamente sobre ele.
54 If dem nor let am go like dat, en and en sons go dey free for di year wey dem dey riton propaty,
54 "Se não for resgatado por nenhuma dessas maneiras, ele e os seus filhos estarão livres no ano do jubileu,
55 bikos Israel pesin nor fit bi slave forever, bikos dem bi my savant wey I karry komot from Egypt; Na mi bi di Oga wey bi dia God.’ ”
55 porque os israelitas são meus servos, os quais tirei da terra do Egito. Eu sou o Senhor, o Deus de vocês".

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Levítico 25, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.