Levítico 23

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB

Sair da comparação
ARIB Almeida Revisada Imprensa Bíblica
1 God tell Moses:
1 Depois disse o Senhor a Moisés:
2 “Make yu tell Israel pipol sey, ‘Dis na di day wey God choose for di festival and una go dey do am wen evribody gada to woship.
2 Fala aos filhos de Israel, e dize-lhes: As festas fixas do Senhor, que proclamareis como santas convocações, são estas:
3 “ ‘Una go work for six days, but di sevent day, na di day wey una suppose rest. For dat day, una nor go work, but una go gada woship God.
3 Seis dias se fará trabalho, mas o sétimo dia é o sábado do descanso solene, uma santa convocação; nenhum trabalho fareis; é sábado do Senhor em todas as vossas habitações.
4 “ ‘Make una do all dis festival for di time wen God tok.
4 São estas as festas fixas do Senhor, santas convocações, que proclamareis no seu tempo determinado:
5 For di first mont for di fourteent day for evening, una go celebrate di Passova to honor God.
5 No mês primeiro, aos catorze do mês, à tardinha, é a páscoa do Senhor.
6 Di Fifteent day for di mont go bi di bread wey nor get yist feast and una nor go chop bread wey dem make with yist for eleven days.
6 E aos quinze dias desse mês é a festa dos pães ázimos do Senhor; sete dias comereis pães ázimos.
7 For di first day, una go gada woship and una nor go do any work.
7 No primeiro dia tereis santa convocação; nenhum trabalho servil fareis.
8 Una must offa gift to God for seven days and for di sevent day, una go gada again kon woship God, but una nor go do any work.’ ”
8 Mas por sete dias oferecereis oferta queimada ao Senhor; ao sétimo dia haverá santa convocação; nenhum trabalho servil fareis.
9 God tell Moses:
9 Disse mais o Senhor a Moisés:
10 “Make yu tell Israel pipol sey, ‘Wen dem enter di land wey I won give dem kon harvest dia korn, make dem take di first ones wey dem harvest go give di priest.
10 Fala aos filhos de Israel, e dize-lhes: Quando houverdes entrado na terra que eu vos dou, e segardes a sua sega, então trareis ao sacerdote um molho das primícias da vossa sega;
11 E go offa am as special ofrin to God, so dat I go asept am. Na di day afta Sabat Day, di priest go offa am.
11 e ele moverá o molho perante o Senhor, para que sejais aceitos. No dia seguinte ao sábado o sacerdote o moverá.
12 For di day wey una go offa di korn ofrin, una go sakrifice man lamb wey dey okay as burnt ofrin to God.
12 E no dia em que moverdes o molho, oferecereis um cordeiro sem defeito, de um ano, em holocausto ao Senhor.
13 With di lamb, una go offa two kilogram of flower wey dem mix with olive oil for food ofrin. God like dis ofrin smell. Una go offa am togeda with one lita of wine.
13 Sua oferta de cereais será dois décimos de efa de flor de farinha, amassada com azeite, para oferta queimada em cheiro suave ao Senhor; e a sua oferta de libação será de vinho, um quarto de him.
14 Make una nor chop any new korn, weda raw one or di one wey dem roast or bake to bread, until una don bring di ofrin kom meet God. Una shidren wey una go born go obey dis law forever and ever.
14 E não comereis pão, nem trigo torrado, nem espigas verdes, até aquele mesmo dia, em que trouxerdes a oferta do vosso Deus; é estatuto perpétuo pelas vossas gerações, em todas as vossas habitações.
15 “ ‘Una must kount seven weeks from di day afta di Sabat Day, wen una bring di first korn wey una harvest kom give God.
15 Contareis para vós, desde o dia depois do sábado, isto é, desde o dia em que houverdes trazido o molho da oferta de movimento, sete semanas inteiras;
16 Una must kount fifty days until di day afta seven Sabat Day don pass, den una go give God anoda new korn ofrin.
16 até o dia seguinte ao sétimo sábado, contareis cinqüenta dias; então oferecereis nova oferta de cereais ao Senhor.
17 Each family go bring two bread and dem go offa dem give God as special gift. Dem go make each bread with two kilogram of flower; bake dem with yist kon offa am to God as ofrin from di first korn wey dem harvest.
17 Das vossas habitações trareis, para oferta de movimento, dois pães de dois décimos de efa; serão de flor de farinha, e levedados se cozerão; são primícias ao Senhor.
18 Una must offa seven lamb wey bi one year, one small melu and two rams, join di bread. Dem go bi burnt ofrin to God with dia korn and drink ofrin and God like dis gift.
18 Com os pães oferecereis sete cordeiros sem defeito, de um ano, um novilho e dois carneiros; serão holocausto ao Senhor, com as respectivas ofertas de cereais e de libação, por oferta queimada de cheiro suave ao Senhor.
19 Una go offa man goat for sin ofrin and lamb wey bi two years for peace ofrin.
19 Também oferecereis um bode para oferta pelo pecado, e dois cordeiros de um ano para sacrifício de ofertas pacíficas.
20 Di priest go offa di bread and di two lamb as special gift to God. Dis ofrin dem dey holy.
20 Então o sacerdote os moverá, juntamente com os pães das primícias, por oferta de movimento perante o Senhor, com os dois cordeiros; santos serão ao Senhor para uso do sacerdote.
21 For dat day, una nor go do una evriday work, but una go gada togeda woship mi. Una shidren go dey obey dis law forever.
21 E fareis proclamação nesse mesmo dia, pois tereis santa convocação; nenhum trabalho servil fareis; é estatuto perpétuo em todas as vossas habitações pelas vossas gerações.
22 Wen una gada di harvest from una land, make una nor harvest evritin for di land finish and una must nor gada evritin for una harvest. Make una leave some for poor pipol and strenjas. Na mi bi di Oga una God.’ ”
22 Quando fizeres a sega da tua terra, não segarás totalmente os cantos do teu campo, nem colherás as espigas caídas da tua sega; para o pobre e para o estrangeiro as deixarás. Eu sou o Senhor vosso Deus.
23 God tell Moses:
23 Disse mais o Senhor a Moisés:
24 “Make yu tell Israel pipol sey, ‘For di first day for di sevent mont, una go rest well-well and una must kom togeda kon woship mi wen una hear di trumpet sound.
24 Fala aos filhos de Israel: No sétimo mês, no primeiro dia do mês, haverá para vós descanso solene, em memorial, com sonido de trombetas, uma santa convocação.
25 Make una nor do any work, but una must give special ofrin to God.’ ”
25 Nenhum trabalho servil fareis, e oferecereis oferta queimada ao Senhor.
26 God tell Moses:
26 Disse mais o Senhor a Moisés:
27 “Di tent day for di sevent mont go bi di day to pray make God forgive una. Una go gada woship and una nor go chop anytin, but una go give ofrin to God.
27 Ora, o décimo dia desse sétimo mês será o dia da expiação; tereis santa convocação, e afligireis as vossas almas; e oferecereis oferta queimada ao Senhor.
28 Una nor go do any work for dat day, bikos na di day to pray make di Oga una God forgive una.
28 Nesse dia não fareis trabalho algum; porque é o dia da expiação, para nele fazer-se expiação por vós perante o Senhor vosso Deus.
29 Anybody wey chop anytin for dat day, nor go dey among God pipol again.
29 Pois toda alma que não se afligir nesse dia, será extirpada do seu povo.
30 And if anybody do any work for dat day, God go use en own hand kill-am.
30 Também toda alma que nesse dia fizer algum trabalho, eu a destruirei do meio do seu povo.
31 Dis na di law wey all una pikin must obey, no matter where dem dey.
31 Não fareis nele trabalho algum; isso será estatuto perpétuo pelas vossas gerações em todas as vossas habitações.
32 Dat day na Sabat Day, so una must rest and una must honbol unasef for di ninet day for di mont for evening and from dat evening still di next morning, una must respet di Sabat Day.”
32 Sábado de descanso vos será, e afligireis as vossas almas; desde a tardinha do dia nono do mês até a outra tarde, guardareis o vosso sábado.
33 God tell Moses:
33 Disse mais o Senhor a Moisés:
34 “Make yu tell Israel pipol sey, ‘For di Fifteent day for di sevent mont, dem must use seven days take do di house feast for God.
34 Fala aos filhos de Israel, dizendo: Desde o dia quinze desse sétimo mês haverá a festa dos tabernáculos ao Senhor por sete dias.
35 Di first day na to woship am; den una nor go do any work.
35 No primeiro dia haverá santa convocação; nenhum trabalho servil fareis.
36 For seven days, una must offa gift to God. For di eight day, una go gada woship kon give ofrin to God. Na di day for woship and una nor go do any work.
36 Por sete dias oferecereis ofertas queimadas ao Senhor; ao oitavo dia tereis santa convocação, e oferecereis oferta queimada ao Senhor; será uma assembléia solene; nenhum trabalho servil fareis.
37 (Dis na di holy festival wey una go use take honor God as una gada dey woship and give ofrin to am. Dis ofrin na burnt and korn ofrin; sakrifice and drink ofrin for each day akordin to wetin God tok.
37 Estas são as festas fixas do Senhor, que proclamareis como santas convocações, para oferecer-se ao Senhor oferta queimada, holocausto e oferta de cereais, sacrifícios e ofertas de libação, cada qual em seu dia próprio;
38 Dis festival join di normal Sabat Day and dis ofrin dem join di normal gift ofrin. Dis na ofrin to take do una vow and di ones wey una give God from una mind.)
38 além dos sábados do Senhor, e além dos vossos dons, e além de todos os vossos votos, e além de todas as vossas ofertas voluntárias que derdes ao Senhor.
39 “ ‘Wen una don harvest wetin una plant for una land, make una celebrate dis festival for seven days and e go start for di Fifteent day for di sevent mont. Di first day go dey special, so una go rest.
39 Desde o dia quinze do sétimo mês, quando tiverdes colhido os frutos da terra, celebrareis a festa do Senhor por sete dias; no primeiro dia haverá descanso solene, e no oitavo dia haverá descanso solene.
40 For dat day, una go take some of di good fruit from una tree, palm tree branches wey get leaf well-well kon celebrate to honor God.
40 No primeiro dia tomareis para vós o fruto de árvores formosas, folhas de palmeiras, ramos de árvores frondosas e salgueiros de ribeiras; e vos alegrareis perante o Senhor vosso Deus por sete dias.
41 Una must celebrate for seven days. Una shidren-shidren must keep dis law forever.
41 E celebrá-la-eis como festa ao Senhor por sete dias cada ano; estatuto perpétuo será pelas vossas gerações; no mês sétimo a celebrareis.
42 Make una stay for anoda place for seven days; all of una wey kom from Israel must stay der,
42 Por sete dias habitareis em tendas de ramos; todos os naturais em Israel habitarão em tendas de ramos,
43 so dat una shidren-shidren go know sey na mi give una house afta I take una komot from Egypt. Na mi bi di Oga una God.’ ”
43 para que as vossas gerações saibam que eu fiz habitar em tendas de ramos os filhos de Israel, quando os tirei da terra do Egito. Eu sou o Senhor vosso Deus.
44 So Moses tell Israel pipol evritin wey God tok.
44 Assim declarou Moisés aos filhos de Israel as festas fixas do Senhor.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Levítico 23, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.