Levítico 20

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 God tell Moses:
1 Disse o Senhor a Moisés:
2 “Go tell Israel pipol sey, ‘Anybody among una wey give en girl pikin to Molek juju, dem must kill-am; di pipol wey dey di land must stone am die.
2 "Diga aos israelitas: Qualquer israelita ou estrangeiro residente em Israel que entregar um dos seus filhos a Moloque, terá que ser executado. O povo da terra o apedrejará.
3 Mi mysef go turn my face against dat pesin kon remove am from my pipol, bikos e don give en pikin to Molek juju and like dat, e don spoil my temple kon disgrace my name.
3 Voltarei o meu rosto contra ele e o eliminarei do meio do seu povo; pois deu os seus filhos a Moloque, contaminando assim o meu santuário e profanando o meu santo nome.
4 If di pipol for di land nor do anytin or kill doz wey dey give dia pikin to Molek,
4 Se o povo deliberadamente fechar os olhos quando alguém entregar um dos seus filhos a Moloque, e deixar de executá-lo,
5 mi mysef go turn against dat man and en family. I go remove am from my pipol, both en and all di pipol wey follow am woship dat juju wey dem dey koll Molek.
5 voltarei o meu rosto contra aquele homem e contra o seu clã e eliminarei do meio do seu povo tanto ele quanto todos os que o seguem, prostituindo-se com Moloque.
6 “ ‘Di pesin wey dey go meet dead body spirit for advise, I go turn against am kon remove am from my pipol.
6 "Voltarei o meu rosto contra aquele que procurar médiuns e espíritas para segui-los, prostituindo-se com eles. Eu o eliminarei do meio do seu povo.
7 “ ‘Make una keep unasef holy, bikos na mi bi di Oga una God.
7 "Consagrem-se, porém, e sejam santos, porque eu sou o Senhor, o Deus de vocês.
8 Make una obey my laws, bikos na mi bi God wey make una dey holy.
8 Obedeçam aos meus decretos e pratiquem-nos. Eu sou o Senhor que os santifica.
9 “ ‘If anybody curse en papa and mama, dem must kill-am and en blood go dey en own head, bikos e curse en papa and mama.
9 "Se alguém amaldiçoar seu pai ou sua mãe, terá que ser executado. Por ter amaldiçoado o seu pai ou a sua mãe, merece a morte.
10 If anybody sleep with en neighbour wife, dem must kill both di man and di woman.
10 "Se um homem cometer adultério com a mulher de outro homem, com a mulher do seu próximo, tanto o adúltero quanto a adúltera terão que ser executados.
11 If anybody sleep with en papa wife, e don disgrace en papa bi dat. So dem must kill both of dem and dia blood go dey for dia own head.
11 "Se um homem se deitar com a mulher do seu pai, desonrou seu pai. Tanto o homem quanto a mulher terão que ser executados, pois merecem a morte.
12 If anybody sleep with en pikin wife, dem must kill both en and di woman wey e sleep with. Dem don kommit evil and dia blood go dey for dia own head.
12 "Se um homem se deitar com a sua nora, ambos terão que ser executados. O que fizeram é depravação; merecem a morte.
13 If man sleep with man like sey e dey sleep with woman, both of dem don kommit bad sin. So dem must kill two of dem and dia blood go dey for dia own head.
13 "Se um homem se deitar com outro homem como quem se deita com uma mulher, ambos praticaram um ato repugnante. Terão que ser executados, pois merecem a morte.
14 If anybody sleep with woman and en dota, dat kind tin bad well-well. So dem go burn di man, di woman and en dota with fire. So make una nor allow dis kind tin happen.
14 "Se um homem tomar uma mulher e a mãe dela, comete perversidade. Tanto ele quanto elas serão queimados com fogo, para que não haja perversidade entre vocês.
15 If any man sleep with animal, dem must kill di man and di animal.
15 "Se um homem tiver relações sexuais com um animal, terá que ser executado, e vocês matarão também o animal.
16 If any woman sleep with animal, una must kill di woman and di animal and dia blood go dey for dia own head.
16 "Se uma mulher se aproximar de algum animal para ajuntar-se com ele, vocês matarão a mulher e o animal. Ambos terão que ser executados, pois merecem a morte.
17 If anybody sleep with en own sista, weda na en papa or mama pikin and dem si each oda nakednes, na big disgrace e bi. Una must komot dem from where dia pipol dey. E don disgrace en sista, so e go bear di ponishment for en sin.
17 "Se um homem tomar por mulher sua irmã, filha de seu pai ou de sua mãe, e se envolver sexualmente com ela, pratica um ato vergonhoso. Serão eliminados à vista de todo o povo. Desonrou sua irmã e sofrerá as conseqüências da sua iniqüidade.
18 If any man sleep with woman wey dey si en mestrateshon kon naked am, e don break di law wey tok about holiness.
18 "Se um homem se deitar com uma mulher durante a menstruação e com ela se envolver sexualmente, ambos serão eliminados do meio do seu povo, pois expuseram o sangramento dela.
19 Make una nor naked una mama or papa sista, bikos anybody wey do like dat, go sofa di ponishment.
19 "Não se envolva sexualmente com a irmã de sua mãe, nem com a irmã de seu pai; pois quem se envolver sexualmente com uma parenta próxima sofrerá as conseqüências da sua iniqüidade.
20 If anybody sleep with en uncle wife, e don disgrace en uncle, so e go sofa for en sin and e nor go born before e die.
20 "Se um homem se deitar com a mulher do seu tio, desonrou seu tio. Eles sofrerão as conseqüências do seu pecado; morrerão sem filhos.
21 E dey bad for man to sleep with en broda wife, bikos e don disgrace en broda; so e nor go born before e die.
21 "Se um homem tomar por mulher a mulher do seu irmão, comete impureza; desonrou seu irmão. Ficarão sem filhos.
22 “ ‘Make una make sure sey una obey all my law and kommand, so dat di land wey I won give una nor go rijet una.
22 "Obedeçam a todos os meus decretos e leis e pratiquem-nos, para que a terra para onde os estou levando para habitarem não os vomite.
23 Di pipol wey I dey porshu komot from di land for una, make una nor follow dia laws, bikos I nor like all di tins wey dem dey do.
23 Não sigam os costumes dos povos que vou expulsar de diante de vocês. Por terem feito todas essas coisas, causam-me repugnância.
24 So I tell una: una go stay di land and mi mysef go gi-am to una as una own; bikos milk and honey full am. Na mi bi di Oga una God and I don separate una from di odas.
24 Mas a vocês prometi que herdarão a terra deles; eu a darei a vocês como herança, terra que mana leite e mel. Eu sou o Senhor, o Deus de vocês, que os separou dentre os povos.
25 So una must separate di animal wey dey klean from di ones wey nor klean; di bird wey klean from di ones wey nor dey klean. Make una nor chop dem, bikos I don make una holy.
25 "Portanto, façam separação entre animais puros e impuros e entre aves puras e impuras. Não se contaminem com animal, ou ave, ou com qualquer criatura que se move rente ao chão, os quais separei de vocês por serem eles impuros.
26 Una must dey holy to mi, bikos mi wey bi God dey holy and I don separate una as my own.
26 Vocês serão santos para mim, porque eu, o Senhor, sou santo, e os separei dentre os povos para serem meus.
27 “ ‘Man or woman wey dey woship dead body spirit, dem must kill dem. Dem must stone dem die and anybody wey do dis tin go sofa di ponishment for en sin.’ ”
27 "Os homens ou mulheres que, entre vocês, forem médiuns ou espíritas, terão que ser executados. Serão apedrejados, pois merecem a morte".

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Levítico 20, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.