Levítico 14

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NTLH

Sair da comparação
NTLH Nova Tradução na Linguagem de Hoje 2000
1 God tell Moses:
1 O Senhor Deus deu a Moisés
2 “For di day wen di priest won klean di pesin wey bin get diziz, dis na di tins wey e go do.
2 as seguintes leis a respeito da cerimônia de purificação das pessoas que sararam de doenças contagiosas da pele: A pessoa será levada ao sacerdote,
3 Di priest go-go outside di kamp go look di pesin. If di pesin wey get di diziz don dey okay,
3 e este sairá com ela do acampamento e a examinará. Se a pessoa tiver sarado,
4 di priest go orda sey make dem bring two klean bird, part for cedar wood, red rope and some hyssop leaf.
4 o sacerdote mandará trazer duas aves puras , um pedaço de madeira de cedro, lã tingida de vermelho e um galho de hissopo .
5 Di priest go orda sey make dem kill one bird put for klay pot wey dem just fetch wota put.
5 O sacerdote mandará que matem uma das aves em cima de um pote de barro cheio de água tirada de uma fonte.
6 Di bird wey dem kill and put en blood for klean wota, di priest go take di oda bird with di cedar wood part, di red rope and hyssop leaf kon deep dem inside am.
6 Depois ele pegará a outra ave, o pedaço de madeira de cedro, a lã tingida de vermelho e o hissopo e os mergulhará no sangue da ave que foi morta.
7 Den e go sprinkol am seven times for di pesin wey dem dey santify kon sey e dey klean and e go let di bird wey dey alive fly go outside di town for di open field.
7 Em seguida borrifará com o sangue sete vezes a pessoa que está sendo purificada e declarará que ela está pura. Depois disso o sacerdote soltará no campo a ave viva.
8 “Di pesin go wosh e klot, barber en hair kon baf; den e go dey klean. E go fit enter di kamp, but e go stay outside en house for seven days.
8 Aí a pessoa deverá lavar a roupa que estiver vestindo, rapar todos os cabelos e pelos e tomar um banho; então estará pura. Depois entrará no acampamento, mas deverá ficar sete dias fora da sua barraca.
9 For di sevent day, e go barber en hair again, en bear-bear, di hair wey dey en eye and all di hair wey dey en body. E go still wosh en klot kon baf, den e go dey klean.
9 No sétimo dia ela deverá rapar de novo a cabeça, a barba, as sobrancelhas e todos os outros pelos do corpo, lavar a roupa que estiver vestindo e tomar um banho; então estará pura.
10 “For di eight day, e go bring two man lamb and one woman own wey bi one year and dem must dey okay and if dem divide flower bag into ten, e go bring three part wey dem mix with olive oil. If dem divide one lita for olive oil into ten, e go bring three part kom.
10 No dia seguinte a pessoa pegará dois carneirinhos e uma ovelhinha de um ano de idade, todos sem defeito. Para a oferta de cereais ela pegará três quilos de farinha misturada com azeite e mais um quarto de litro de azeite.
11 Di priest go take di pesin and di ofrin go di tent for God present.
11 O sacerdote levará a pessoa e as suas ofertas até a entrada da Tenda Sagrada e ali, na presença de Deus, o Senhor ,
12 Di priest go take one man lamb with di olive oil kon offa am as guilt and sin ofrin to God.
12 pegará um dos carneirinhos e o azeite, e os oferecerá como sacrifício para tirar culpas. É uma oferta especial ao Senhor e pertence ao sacerdote.
13 Den e go kill di man lamb for di place where dem for dey kill lamb for sin and burnt ofrin. E must do dis tin, bikos na di priest get di sin and guilt ofrin and dem dey holy.
13 Depois matará o carneirinho num lugar sagrado, onde são mortos os animais das ofertas para tirar culpas e das ofertas que são completamente queimadas. O sacerdote deverá fazer isso porque a oferta para tirar culpas é como a oferta para tirar pecados: é uma coisa muito sagrada e pertence ao sacerdote.
14 Den di priest go take some blood for di lamb kon put am for di pesin wey dem dey santify rite ear; en big finger for en rite hand and en big toe for en rite leg.
14 O sacerdote pegará um pouco do sangue do animal e com o dedo o passará na ponta da orelha direita, no dedo polegar da mão direita e no dedão do pé direito da pessoa que está sendo purificada.
15 Di priest go take some olive oil pour for en left hand,
15 Depois derramará uma parte do azeite na palma da sua mão esquerda,
16 deep en rite finger inside, den dem go sprinkol am seven times for God present.
16 molhará um dedo da mão direita no azeite e o borrifará sete vezes ali na presença do Senhor .
17 E go take some oil wey dey en hand and some blood for di lamb kon put dem for di pesin wey dem dey santify rite ear; di big finger for en rite hand and di big toe for en rite leg.
17 Em seguida porá com o dedo um pouco de azeite na pessoa que está sendo purificada, nos mesmos lugares em que pôs o sangue do animal, isto é, na ponta da orelha direita, no dedo polegar da mão direita e no dedão do pé direito.
18 E go put di remainin oil wey dey en hand for di pesin head. Na like dis di priest go take make di pesin dey holy for God eye.
18 O resto do azeite ele derramará na cabeça da pessoa. Assim, na presença do Senhor , o sacerdote conseguirá o perdão dos pecados daquela pessoa.
19 Di priest go offa di sin ofrin kon beg God for di pesin wey dem dey santify and afta dat one, e go kill di animal for di burnt ofrin
19 Depois o sacerdote oferecerá o sacrifício para tirar pecados, conseguindo com isso o perdão dos pecados da pessoa que está sendo purificada. Em seguida ele matará o animal para a oferta que vai ser completamente queimada
20 kon offa di burnt and korn ofrin for di altar. So di priest go beg God for am and e go dey holy.
20 e o oferecerá no altar, junto com a oferta de cereais. Assim, o sacerdote conseguirá o perdão dos pecados daquela pessoa, e ela estará pura.
21 “If di pesin dey poor and e nor get money, e go bring only one special man lamb as en ofrin to God and na di priest get am. E go bring one kilogram of flower wey dem mix with olive oil as korn ofrin and three lita of olive oil.
21 Se a pessoa for pobre e não puder pagar tudo, ela levará ao sacerdote um carneirinho para a oferta para tirar culpas, que é uma oferta especial dedicada ao Senhor e que pertence ao sacerdote. Levará só um quilo de farinha misturada com azeite e mais um quarto de litro de azeite
22 E go still bring two dove or two pijin, one for di sin ofrin and one for di burnt ofrin.
22 e duas rolinhas ou dois pombinhos, conforme as suas posses. Uma das aves será a oferta para tirar pecados, e a outra será a oferta que vai ser completamente queimada.
23 For di eight days wey e go take klean ensef, e go give di priest all dis tins for di tent gate.
23 No oitavo dia do tempo da sua purificação, a pessoa levará tudo isso até a entrada da Tenda Sagrada e entregará ao sacerdote. Então ali na presença do Senhor
24 Di priest go take di lamb and di olive oil as special gift to God.
24 o sacerdote pegará o carneirinho e o azeite e os oferecerá ao Senhor como uma oferta especial que pertence ao sacerdote.
25 E go kill di lamb kon take some of di blood put for di pesin rite ear, en big finger for en rite hand and di big toe for en rite leg.
25 Em seguida matará o carneirinho, pegará um pouco do sangue do animal e com o dedo o colocará na ponta da orelha direita, no dedo polegar da mão direita e no dedão do pé direito da pessoa que está sendo purificada.
26 “Di priest go pour some oil for en left hand
26 Depois derramará uma parte do azeite na palma da sua mão esquerda
27 and with one finger wey dey en rite hand, e go sprinkol am seven times for God present.
27 e com um dedo da mão direita borrifará o azeite sete vezes ali na presença de Deus, o Senhor .
28 E go put some of di oil for di same place just as e put di blood before for di pesin rite ear, di big finger for en rite hand and for di big toe for en rite leg.
28 Então, com o dedo, porá um pouco do azeite na pessoa que está sendo purificada, nos mesmos lugares em que pôs o sangue do animal, isto é, na ponta da orelha direita, no dedo polegar da mão direita e no dedão do pé direito.
29 E go put di remainin oil wey dey en hand for di pesin head and like dis, e dey make di pesin holy.
29 O resto do azeite ele derramará na cabeça da pessoa e assim na presença do Senhor conseguirá o perdão dos pecados dela.
30 Den e go offa one dove or pijin
30 Depois, conforme as posses dessa pessoa, o sacerdote oferecerá as duas rolinhas ou os dois pombinhos.
31 as sin ofrin and di oda go bi for burnt ofrin with di korn ofrin. Like dis, di priest go beg for di pesin wey e dey santify before God.
31 Uma das aves será a oferta para tirar pecados, e a outra será a oferta que vai ser completamente queimada. Assim, na presença de Deus, o Senhor , o sacerdote conseguirá o perdão dos pecados da pessoa que está sendo purificada.
32 Dis law na for poor pesin wey get diziz, wey nor fit pay or do di normal ofrin.”
32 Esta é a lei para a purificação das pessoas que sararam de uma doença contagiosa da pele, mas que não têm recursos para comprar tudo o que a lei exige.
33 God tell Moses and Aaron:
33 O Senhor Deus deu a Moisés e a Arão
34 “Wen una don enter di land wey dey Kanaan wey I go give una to stay and I kon put diziz for di house wey una won stay,
34 as seguintes leis a respeito de mofo nas casas. Essas leis deviam ser obedecidas depois que o povo de Israel tivesse entrado na terra de Canaã, que Deus lhes daria para ser deles. Quando Deus fizer aparecer mofo na casa de alguém,
35 den who get di house go kom show ensef to di priest sey, ‘I si sometin wey bi like diziz for my house.’
35 o dono irá falar com o sacerdote e dirá que descobriu mofo na sua casa.
36 Den di priest go orda sey make dem santify di house before di priest go enter go look am.
36 Antes de ir examiná-la, o sacerdote mandará que tirem tudo da casa; se não, tudo o que estiver lá dentro será considerado impuro . Depois o sacerdote irá até a casa
37 E go look di diziz and if di diziz wey dey di wall for di house dey yellow, green or red,
37 e examinará o mofo. Se houver manchas esverdeadas ou avermelhadas nas paredes, e, se parecer que entraram nas paredes,
38 e go leave di house kon lock am for seven days.
38 então o sacerdote sairá da casa e a deixará fechada sete dias.
39 For di sevent day, e go-go back go look am again. If di diziz don spread,
39 No sétimo dia ele voltará e examinará a casa de novo. Se descobrir que as manchas se espalharam pelas paredes,
40 e go orda make dem remove di stones wey di diziz dey and dem go trow am for outside di town.
40 mandará que tirem as pedras em que está o mofo e as joguem fora da cidade, num lugar impuro.
41 Afta dat, e go klean di wall kon trow di dirty outside di town.
41 Mandará raspar as paredes de dentro da casa, e o reboco raspado será levado para um lugar impuro fora da cidade.
42 Dem go use anoda stone take shange di stones wey dem remove, den dem go plasta di wall.
42 Depois colocarão pedras novas no lugar das que foram tiradas e rebocarão de novo a casa.
43 “If di diziz kom out again afta dem don remove di stone kon plasta am,
43 Se, depois de se fazer tudo isso, aparecer mofo na casa outra vez,
44 di priest go-go look am, if di diziz don spread, den di house nor dey klean bi dat.
44 o sacerdote a examinará. Se as manchas se tiverem espalhado pelas paredes, é mofo contagioso, e a casa está impura.
45 Dem must distroy di house, en stones and wood kon trow dem outside di town.
45 Ela será derrubada, e as pedras, a madeira e o reboco serão levados para um lugar impuro fora da cidade.
46 Anybody wey enter di house for di time wey dem lock am go dey unklean till evening.
46 Quem entrar na casa durante os sete dias em que estiver fechada ficará impuro até o pôr do sol.
47 Anybody wey liedan or chop for di house must go wosh en klot.
47 E, se nesse tempo alguém se deitar na casa ou comer ali dentro, deverá lavar a roupa que estiver vestindo.
48 If di priest kom look and di diziz nor kom back again afta dem don plasta di wall, e go sey di house dey klean, bikos di diziz don go.
48 Mas, se o sacerdote voltar, e examinar a casa depois de rebocada, e não encontrar mofo nas paredes, ele declarará que ela está pura , pois o mofo desapareceu completamente.
49 To santify di house, e go take two birds, cedar wood, red rope and hyssop leaf
49 A fim de purificar a casa, o sacerdote pegará duas aves, um pedaço de madeira de cedro, lã tingida de vermelho e um galho de hissopo
50 kon kill one of di bird put inside klay pot wey dem just fetch wota put.
50 e matará uma das aves em cima de um pote de barro cheio de água tirada de uma fonte.
51 E go take di cedar wood, di red rope, di hyssop leaf and di bird wey dey alive, deep dem inside di blood kon sprinkol am for di house seven times.
51 Depois pegará a outra ave, o pedaço de madeira de cedro, a lã tingida de vermelho e o hissopo, e os mergulhará primeiro no sangue da ave que foi morta e depois na água fresca, e borrifará a casa sete vezes.
52 Like dis, e go santify di house from di diziz with di bird blood; di klean wota; di bird wey dey alive, di cedar wood, di hyssop leaf and di red rope.
52 Assim, ele purificará a casa com o sangue da ave, a água fresca, a ave viva, o pedaço de madeira de cedro, o hissopo e a lã tingida de vermelho.
53 E go let di bird wey dey alive fly go outside di town for di open field. Na like dis di priest go take santify di house and e go dey klean.
53 Depois levará a ave viva para fora da cidade e a soltará no campo. Assim, o sacerdote fará a cerimônia de purificação, e a casa ficará pura.
54 “Dis na di law for skin diziz;
54 — ausente —
55 diziz for klot and house;
55 — ausente —
56 di ones wey swell-up for body and di spot wey dem dey si.
56 — ausente —
57 Dis law na to know wetin dey klean or not.”
57 Elas servem para se saber quando alguma coisa é impura ou é pura. São essas as leis para todos esses casos.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Levítico 14, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.