Levítico 13
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA
1 God tell Moses and Aaron:
1 Disse o Senhor a Moisés e a Arão:
2 “If anybody get sore, boil or spot and e turn to diziz for en skin, dem must karry am go meet Aaron wey bi di priest or en sons.
2 O homem que tiver na sua pele inchação, ou pústula, ou mancha lustrosa, e isto nela se tornar como praga de lepra, será levado a Arão, o sacerdote, ou a um de seus filhos, sacerdotes.
3 Di priest go look di sore and if di hair wey dey en skin don turn white and di sore deep well-well pass di skin, di priest go sey di pesin nor dey klean.
3 O sacerdote lhe examinará a praga na pele; se o pelo na praga se tornou branco, e a praga parecer mais profunda do que a pele da sua carne, é praga de lepra; o sacerdote o examinará e o declarará imundo.
4 “But if di sore dey white and e nor deep pass di skin and di hair neva shange to white, di priest go separate di pesin from oda pipol for seven days.
4 Se a mancha lustrosa na pele for branca e não parecer mais profunda do que a pele, e o pelo não se tornou branco, então, o sacerdote encerrará por sete dias o que tem a praga.
5 Di priest go look am again for di sevent day and if e feel sey di sore still bi as e bi before, e go separate am for anoda seven days.
5 Ao sétimo dia, o sacerdote o examinará; se, na sua opinião, a praga tiver parado e não se estendeu na sua pele, então, o sacerdote o encerrará por outros sete dias.
6 Di priest go look am again for di sevent day and if di sore don dey go, e go kon sey e dey klean; bikos na only sore e get. Di pesin go wosh en klot and e go dey klean.
6 O sacerdote, ao sétimo dia, o examinará outra vez; se a lepra se tornou baça e na pele se não estendeu, então, o sacerdote o declarará limpo; é pústula; o homem lavará as suas vestes e será limpo.
7 But if di sore spread afta di priest don look am sey e klean, e must go meet di priest again.
7 Mas, se a pústula se estende muito na pele, depois de se ter mostrado ao sacerdote para a sua purificação, outra vez se mostrará ao sacerdote.
8 Di priest go look am again and if e si sey e don spread, e go sey e nor dey klean, bikos na diziz e get.
8 Este o examinará, e se a pústula se tiver estendido na pele, o sacerdote o declarará imundo; é lepra.
9 “If anybody get diziz for en skin, dem go take am go meet di priest and
9 Quando no homem houver praga de lepra, será levado ao sacerdote.
10 e go look am. If white sore dey di skin wey turn di hair to white and e get plenty pus,
10 E o sacerdote o examinará; se há inchação branca na pele, a qual tornou o pelo branco, e houver carne viva na inchação,
11 na sirious diziz e get for en skin. Di priest go sey e nor dey klean.
11 é lepra inveterada na pele; portanto, o sacerdote o declarará imundo; não o encerrará, porque é imundo.
12 “If di diziz for di skin spread kover all en body,
12 Se a lepra se espalhar de todo na pele e cobrir a pele do que tem a lepra, desde a cabeça até aos pés, quanto podem ver os olhos do sacerdote,
13 di priest go look am again. If e si sey e don really kover en whole body, e go kon sey di pesin klean. If all en skin turn to white, den e dey klean.
13 então, este o examinará. Se a lepra cobriu toda a sua carne, declarará limpo o que tem a mancha; a lepra tornou-se branca; o homem está limpo.
14 But if new sore bigin show, den e nor dey klean.
14 Mas, no dia em que aparecer nele carne viva, será imundo.
15 Di priest go look am again and if e si new sore wey open for en skin, e go sey e nor dey klean. Sore wey open mean skin diziz wey fit kill pesin. So di pesin nor dey klean at-all.
15 Vendo, pois, o sacerdote a carne viva, declará-lo-á imundo; a carne viva é imunda; é lepra.
16 But wen di sore don heal and e don turn white back, di pesin go-go meet di priest,
16 Se a carne viva mudar e ficar de novo branca, então, virá ao sacerdote,
17 wey go look am again. If di sore don turn white, den di priest go sey e don klean.
17 e este o examinará. Se a lepra se tornou branca, então, o sacerdote declarará limpo o que tem a praga; está limpo.
18 “If anybody get boil wey don heal,
18 Quando sarar a carne em cuja pele houver uma úlcera,
19 den di boil kon swell-up and white or red-white spot kon appear for where di boil dey before, e go-go meet di priest.
19 e no lugar da úlcera aparecer uma inchação branca ou mancha lustrosa, branca que tira a vermelho, mostrar-se-á ao sacerdote.
20 Di priest go look am and if di spot deep pass di skin wey near where di boil dey and di hair dem wey dey der kon turn white, e go sey di pesin nor dey klean. Na skin diziz wey dem dey fear well-well.
20 O sacerdote a examinará; se ela parece mais funda do que a pele, e o seu pelo se tornou branco, o sacerdote o declarará imundo; praga de lepra é, que brotou da úlcera.
21 If di priest look am kon si sey di hair wey dey der neva turn white and e nor deep pass di skin, but e get lite kolour, di priest go separate di pesin from oda pipol for seven days.
21 Porém, se o sacerdote a examinar, e nela não houver pelo branco, e não estiver ela mais funda do que a pele, porém baça, então, o sacerdote o encerrará por sete dias.
22 If di spot spread, di priest go sey di pesin nor dey klean; e get diziz.
22 Se ela se estender na pele, o sacerdote declarará imundo o homem; é lepra.
23 But if e nor shange or spread and na only di mark dey show, di priest go sey e dey klean.
23 Mas, se a mancha lustrosa parar no seu lugar, não se estendendo, é cicatriz da úlcera; o sacerdote, pois, o declarará limpo.
24 “Wen sometin like fire burn pesin, if di flesh shange to white or red-white,
24 Quando, na pele, houver queimadura de fogo, e a carne viva da queimadura se tornar em mancha lustrosa, branca que tira a vermelho ou branco,
25 di priest go look am. If di hair for di spot don turn white and e deep pass di skin wey dey near am, den dat na skin diziz wey pipol dey fear well-well and di priest go sey e nor dey klean.
25 o sacerdote a examinará. Se o pelo da mancha lustrosa se tornou branco, e ela parece mais funda do que a pele, é lepra que brotou na queimadura. O sacerdote declarará imundo o homem; é a praga de lepra.
26 But if di hair for where di spot dey turn white and e nor deep pass di skin wey dey near am, but e get lite kolour, di priest go separate am from oda pipol for seven days.
26 Porém, se o sacerdote a examinar, e não houver pelo branco na mancha lustrosa, e ela não estiver mais funda que a pele, mas for de cor baça, o sacerdote encerrará por sete dias o homem.
27 Di priest go look am again for di sevent day and if e dey spread, di priest go sey e nor dey klean.
27 Depois, o sacerdote o examinará ao sétimo dia; se ela se tiver estendido na pele, o sacerdote o declarará imundo; é praga de lepra.
28 But if di spot nor shange, spread and e get lite kolour, den nor bi skin diziz. Di priest go sey e dey klean, bikos na just mark from di fire wey burn am.
28 Mas, se a mancha lustrosa parar no seu lugar e na pele não se estender, mas se tornou baça, é inchação da queimadura; portanto, o sacerdote o declarará limpo, porque é cicatriz da queimadura.
29 “Wen man or woman get sore for head or for di bear-bear side,
29 Quando o homem (ou a mulher) tiver praga na cabeça ou na barba,
30 di priest go look am. If e deep pass di skin wey dey near am and di hair dem dey yellow and tin, den dat na skin diziz wey pipol dey fear well-well, so di priest go sey di pesin nor dey klean.
30 o sacerdote examinará a praga; se ela parece mais funda do que a pele, e pelo amarelo fino nela houver, o sacerdote o declarará imundo; é tinha, é lepra da cabeça ou da barba.
31 If di priest look am kon si sey di sore nor deep pass di skin wey dey near am and e nor get black hair, di priest go separate am from oda pipol for seven days.
31 Mas, se o sacerdote, havendo examinado a praga da tinha, achar que ela não parece mais funda do que a pele, e, se nela não houver pelo preto, então, o sacerdote encerrará o que tem a praga da tinha por sete dias.
32 Di priest go look di sore again for di sevent day, if e neva spread or yellow and e nor deep pass di skin wey dey near am,
32 Ao sétimo dia, o sacerdote examinará a praga; se a tinha não se tiver espalhado, e nela não houver pelo amarelo, e a tinha não parecer mais funda do que a pele,
33 den di pesin go barb en hair kon leave only di place where di sore dey. Di priest go separate am from oda pipol for anoda seven days.
33 então, o homem será rapado; mas não se rapará a tinha. O sacerdote, por mais sete dias, encerrará o que tem a tinha.
34 For di sevent day, di priest go look di sore again and if e neva spread and e nor deep pass di skin wey dey near am, di priest go sey di pesin dey klean. So e go wosh en klot kon dey klean.
34 Ao sétimo dia, o sacerdote examinará a tinha; se ela não se houver estendido na pele e não parecer mais funda do que a pele, o sacerdote declarará limpo o homem; este lavará as suas vestes e será limpo.
35 But if di sore spread afta di priest don sey e dey klean,
35 Mas, se a tinha, depois da sua purificação, se tiver espalhado muito na pele,
36 di priest go look am again. If di sore don spread, e nor nid to look for hair wey yellow; di pesin nor dey klean bi dat.
36 então, o sacerdote o examinará; se a tinha se tiver espalhado na pele, o sacerdote não procurará pelo amarelo; está imundo.
37 But if di priest feel sey di sore neva spread and black hair dey grow for inside, dat mean sey di sore don heal, den di pesin don klean.
37 Mas, se a tinha, a seu ver, parou, e pelo preto cresceu nela, a tinha está sarada; ele está limpo, e o sacerdote o declarará limpo.
38 “Wen man or woman get white spot for en skin,
38 E, quando o homem (ou a mulher) tiver manchas lustrosas na pele,
39 di priest go look di pesin. If di white spot wey dem get for body na white wey don fade, den na rashes from di pesin skin and e dey klean.
39 então, o sacerdote o examinará; se na pele aparecerem manchas baças, brancas, é impigem branca que brotou na pele; está limpo.
40 “If man nor get hair for back of en head, e dey klean.
40 Quando os cabelos do homem lhe caírem da cabeça, é calva; contudo, está limpo.
41 If man nor get hair for front of en head, e dey klean.
41 Se lhe caírem na frente da cabeça, é antecalva; contudo, está limpo.
42 But if rashes wey dey red dey for di back or di front wey hair nor dey, den dat na diziz.
42 Porém, se, na calva ou na antecalva, houver praga branca, que tira a vermelho, é lepra, brotando na calva ou na antecalva.
43 Di priest go look am, if di diziz na di one wey dey red and white for di back or for di front where hair nor dey,
43 Havendo, pois, o sacerdote examinado, se a inchação da praga, na sua calva ou antecalva, está branca, que tira a vermelho, como parece a lepra na pele,
44 den di man don get strong diziz bi dat. E nor dey klean. Di priest must sey di man nor dey klean, bikos of di diziz wey dey en back head.
44 é leproso aquele homem, está imundo; o sacerdote o declarará imundo; a sua praga está na cabeça.
45 “As for di pesin wey get di diziz, dem must tear e klot; nor komb en hair and e go kover en face dey shaut sey, ‘I nor dey klean! My body dirty well-well!’
45 As vestes do leproso, em quem está a praga, serão rasgadas, e os seus cabelos serão desgrenhados; cobrirá o bigode e clamará: Imundo! Imundo!
46 As long as e get dis diziz, e go dey unklean and una go keep am for where pipol nor dey-dey for outside di kamp.
46 Será imundo durante os dias em que a praga estiver nele; é imundo, habitará só; a sua habitação será fora do arraial.
47 “Wen klot get diziz, weda na wool or linen klot,
47 Quando também em alguma veste houver praga de lepra, veste de lã ou de linho,
48 or any pieces of linen or wool, or di leda or anytin wey dem take leda make,
48 seja na urdidura, seja na trama, de linho ou de lã, em pele ou em qualquer obra de peles,
49 if di diziz wey dey di klot or leda na yellow wey dey green or red, den dem must show di priest.
49 se a praga for esverdinhada ou avermelhada na veste, ou na pele, ou na urdidura, ou na trama, em qualquer coisa feita de pele, é a praga de lepra, e mostrar-se-á ao sacerdote.
50 Di priest go look di tins well-well kon keep am for outside for seven days.
50 O sacerdote examinará a praga e encerrará, por sete dias, aquilo que tem a praga.
51 E go shek am again for di sevent day. If di diziz don spread for di klot, wrapa or leda, den di klot nor dey klean bi dat.
51 Então, examinará a praga ao sétimo dia; se ela se houver estendido na veste, na urdidura ou na trama, seja na pele, seja qual for a obra em que se empregue, é lepra maligna; isso é imundo.
52 Di priest go burn am with fire, bikos of di diziz wey spread for di klot.
52 Pelo que se queimará aquela veste, seja a urdidura, seja a trama, de lã, ou de linho, ou qualquer coisa feita de pele, em que se acha a praga, pois é lepra maligna; tudo se queimará.
53 “But wen di priest shek and di diziz neva spread for di klot,
53 Mas, examinando o sacerdote, se a praga não se tiver espalhado na veste, nem na urdidura, nem na trama, nem em qualquer coisa feita de pele,
54 e go sey make dem wosh and keep am for anoda seven days.
54 então, o sacerdote ordenará que se lave aquilo em que havia a praga e o encerrará por mais sete dias;
55 Den e go look am again, if di diziz neva shange kolour, even if e nor spread e go still dey unklean; den una must burn di klot, weda di stain dey for back or front.
55 o sacerdote, examinando a coisa em que havia praga, depois de lavada aquela, se a praga não mudou a sua cor, nem se espalhou, está imunda; com fogo a queimarás; é lepra roedora, seja no avesso ou no direito.
56 But if di priest look kon si sey di diziz don fade, e go tear dat part komot for di klot or di leda.
56 Mas, se o sacerdote examinar a mancha, e esta se tornou baça depois de lavada, então, a rasgará da veste, ou da pele, ou da urdidura, ou da trama.
57 Den if di diziz kom back kon spread again, di pesin wey get di klot go burn am.
57 Se a praga ainda aparecer na veste, quer na urdidura, quer na trama, ou em qualquer coisa feita de pele, é lepra que se espalha; com fogo queimarás aquilo em que está a praga.
58 If e wosh di klot and di spot dem komot, e go wosh am again and e go dey klean.”
58 Mas a veste, quer na urdidura, quer na trama, ou qualquer coisa de peles, que lavares e de que a praga se retirar, se lavará segunda vez e será limpa.
59 Dis na di law about diziz wey dey inside klot, weda na wool, linen or leda and na like dis dem go take know weda e dey klean or not.
59 Esta é a lei da praga da lepra da veste de lã ou de linho, quer na urdidura, quer na trama; ou de qualquer coisa de peles, para se poder declará-las limpas ou imundas.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Levítico 13, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.