Lucas 9

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA

Sair da comparação
NAA Nova Almeida Atualizada 2017
1 Afta Jesus don koll di twelf disciples togeda, e give dem pawa and authority to drive demon and to heal pipol wey nor well.
1 Tendo Jesus convocado os doze, deu-lhes poder e autoridade sobre todos os demônios e para curar doenças.
2 Den e kon send dem go prish about God Kingdom and heal pipol wey nor well.
2 Também os enviou a pregar o Reino de Deus e a curar os enfermos.
3 E tell dem, “Make una nor take walkin stik, bag, bread, money or estra klot follow body.
3 E disse-lhes:
4 Make una stay for any house wey una enter until una komot for dat aria.
4 Na casa em que vocês entrarem, fiquem ali até saírem daquele lugar.
5 Anywhere wey dem nor welkom una, make una shake di san from una leg as una dey komot and dis go bi witness against dem.”
5 E onde quer que não receberem vocês, ao saírem daquela cidade sacudam o pó dos pés em testemunho contra eles.
6 Di disciples kon travel go all di village dem, dey prish di Good News and heal pipol for evriwhere.
6 Então, saindo, percorriam todas as aldeias, anunciando o evangelho e fazendo curas por toda parte.
7 Wen Herod wey bi ruler hear about evritin wey dey happen, e konfuse, bikos some pipol sey John don wake-up from deat
7 Ora, o tetrarca Herodes soube de tudo o que se passava e ficou perplexo, porque alguns diziam: “João ressuscitou dentre os mortos.”
8 and odas sey Elijah don appear, some still sey one old profet don wake-up.
8 Outros diziam: “Elias apareceu.” E ainda outros diziam: “Um dos antigos profetas ressuscitou.”
9 Herod kon sey, “I orda make dem kut John head komot, but who bi dis one wey I dey hear all dis tins about so?” Bikos of dat, Herod kon try to find out more about Jesus.
9 Herodes, porém, disse: — Eu mandei decapitar João. Quem, então, é este a respeito do qual tenho ouvido tais coisas? E se esforçava para vê-lo.
10 Wen di apostles kom back, dem tell Jesus evritin wey dem don do. Den Jesus take only dem follow body go Betsaida.
10 Ao regressarem, os apóstolos relataram a Jesus tudo o que tinham feito. Ele, levando-os consigo, retirou-se à parte para uma cidade chamada Betsaida.
11 But wen pipol know, dem kon follow Jesus and en disciples go der. E welkom dem, den tell dem about God Kingdom and e heal doz wey nor well.
11 Mas as multidões souberam disso e o seguiram. Acolhendo-as, Jesus lhes falava a respeito do Reino de Deus e socorria os que tinham necessidade de cura.
12 Wen day don dey dark, di disciples kon tell Jesus, “Tell dis pipol make dem go, so dat dem go-go di village and farm wey near dis aria go fine food chop kon sleep for der, bikos dis place na wildaness.”
12 Mas o dia estava chegando ao fim. Então os doze se aproximaram de Jesus e disseram: — Despeça a multidão, para que, indo às aldeias e campos ao redor, se hospedem e encontrem alimento; pois estamos aqui em lugar deserto.
13 But Jesus ansa, “Make una give dem food chop.”
13 Jesus, porém, lhes disse: Os discípulos responderam: — Não temos mais que cinco pães e dois peixes, a não ser que nós mesmos vamos e compremos comida para todo este povo.
14 (Di men wey dey der alone rish 5,000).
14 Porque estavam ali cerca de cinco mil homens. Então Jesus disse aos seus discípulos:
15 Di disciples do as Jesus tok and all di pipol kon sidan.
15 Eles atenderam, fazendo com que todos se assentassem.
16 Den Jesus take di five bread and two fish, e look heaven, tank God, den e kon divide dem. E give di bread and fish to en disciples, make dem share am for di pipol.
16 E Jesus, pegando os cinco pães e os dois peixes, erguendo os olhos para o céu, os abençoou, partiu e deu aos discípulos para que os distribuíssem entre o povo.
17 Evribody chop beleful and wen dem gada di food wey remain, e full twelf basket.
17 Todos comeram e se fartaram; e dos pedaços que sobraram foram recolhidos doze cestos.
18 As Jesus dey pray alone and en disciples dey near am, e kon ask dem, “Na who pipol dey tok sey I bi?”
18 E aconteceu que, enquanto Jesus estava orando em particular, achavam-se presentes os discípulos, a quem perguntou:
19 Dem ansa, “Some sey yu bi John di Baptist, odas sey yu bi Elijah and odas still sey yu bi one old profet wey wake-up from deat.”
19 Eles responderam: — Uns dizem que é João Batista; outros dizem que é Elias; e ainda outros dizem que um dos antigos profetas ressuscitou.
20 Den Jesus ask dem, “But who una tok sey I bi?”
20 Então Jesus perguntou: Respondendo, Pedro disse: — O Cristo de Deus.
21 But Jesus warn dem well-well sey make dem nor tell anybody about am.
21 Jesus, porém, advertindo-os, mandou que a ninguém declarassem tal coisa,
22 Den Jesus tell dem, “God Pikin go sofa many tins: di eldas, di priest oga dem and di law tishas go rijet am, dem go kill-am and afta three days, God go wake am up.”
22 dizendo:
23 So Jesus tell all of dem, “If pesin won follow mi, e must forget ensef, karry en cross evriday, dey follow mi.
23 Jesus dizia a todos:
24 Bikos anybody wey won save en life, go luz am and anybody wey luz en life bikos of mi, go save am.
24 Pois quem quiser salvar a sua vida a perderá; e quem perder a vida por minha causa, esse a salvará.
25 Wetin pesin go gain if e get di whole world, but e luz en soul?
25 De que adianta uma pessoa ganhar o mundo inteiro, se vier a perder-se ou causar dano a si mesma?
26 Anybody wey dey shame for mi and my word, Man Pikin go shame for am wen e go kom back for en glory and di glory wey en Papa and di angels get.
26 Pois quem se envergonhar de mim e das minhas palavras, dele se envergonhará o Filho do Homem, quando vier na sua glória e na glória do Pai e dos santos anjos.
27 But I tell una true word, some pipol wey stand for here nor go die, before dem go si God Kingdom.”
27 Em verdade lhes digo que alguns dos que aqui se encontram não passarão pela morte até que vejam o Reino de Deus.
28 One week afta Jesus tok all dis tins, e kon take Pita, John and James go on-top one mountin go pray.
28 Cerca de oito dias depois de proferidas estas palavras, Jesus levou consigo Pedro, João e Tiago e subiu ao monte com o propósito de orar.
29 As e dey pray, en face shange and en klot kon dey shine like lite.
29 E aconteceu que, enquanto ele orava, a aparência do seu rosto se transfigurou e a roupa dele ficou de um branco brilhante.
30 At wons, Moses and Elijah kon dey tok with am.
30 E eis que dois homens falavam com ele: eram Moisés e Elias,
31 As dem appear with glory, dem kon tell Jesus how e go sofa and die for Jerusalem, as dem rite for God word.
31 que apareceram em glória e falavam da morte de Jesus, que ele estava para cumprir em Jerusalém.
32 Pita and di odas wey dey with am dey sleep before, but at wons sleep komot from dia eye and dem si Jesus glory and di two men wey stand with am.
32 Pedro e seus companheiros estavam caindo de sono; mas, conservando-se acordados, viram a glória de Jesus e os dois homens que estavam com ele.
33 Den as Moses and Elijah won go, Pita kon tell Jesus, “Oga God, e good make wi stay here. Make wi build three tent, one for yu, one for Moses and one for Elijah.” (Pita nor even know wetin e dey tok.)
33 Quando estes começaram a se afastar de Jesus, Pedro lhe disse: — Mestre, bom é estarmos aqui. Façamos três tendas: uma para o senhor, outra para Moisés e outra para Elias. Porém, Pedro não sabia o que estava dizendo.
34 As e still dey tok, one kind kloud surround dem, fear kon katch di disciples, as Moses and Elijah enter di kloud.
34 Enquanto assim falava, veio uma nuvem e os envolveu. E ficaram com medo ao entrar na nuvem.
35 One vois from di kloud kon sey, “Dis na my pikin wey I choose. Make una listin to am!”
35 E dela veio uma voz que dizia: — Este é o meu Filho, o meu eleito; escutem o que ele diz!
36 Afta di vois don tok finish, Jesus kon dey alone for di place, but di disciples kwayet and dem nor tell anybody wetin dem si.
36 Depois daquela voz, perceberam que Jesus estava sozinho. Eles ficaram calados e, naqueles dias, não contaram nada a ninguém a respeito do que tinham visto.
37 Di next day wen dem kom down from di mountin, many pipol kom meet Jesus.
37 No dia seguinte, quando eles desceram do monte, uma grande multidão veio ao encontro de Jesus.
38 Den one man among di pipol kry kom, “Tisha, Abeg yu, si my pikin, na-im bi di only boy wey I get!
38 E eis que, do meio da multidão, surgiu um homem, dizendo em alta voz: — Mestre, peço que o senhor olhe o meu filho, porque é o único que tenho.
39 Evil spirit dey worry am and e dey make am shaut. Di spirit dey shake am and foam dey komot for en mout. Di spirit nor gri leave am and e dey trobol am well-well.
39 Um espírito se apodera dele, e, de repente, o menino grita, e o espírito o convulsiona até espumar; e dificilmente o deixa, depois de o ter maltratado.
40 Abeg yor disciples make dem drive di demon komot, but dem nor fit.”
40 Pedi aos seus discípulos que o expulsassem, mas eles não puderam.
41 Jesus kon tell dem, “Una wey dey do bad tins and nor gri bilive, how long I go stay with una?” Den e tell di man, “Bring yor pikin kom here.”
41 Jesus exclamou:
42 As di boy dey kom, di demon trow am for groun, e start to dey shake and foam kon dey komot from en mout. Den Jesus kommand di demon make e komot and e heal di boy, kon gi-am to en papa.
42 Quando o menino estava se aproximando, o demônio o atirou no chão e o convulsionou; mas Jesus repreendeu o espírito imundo, curou o menino e o entregou ao pai.
43 Den evribody wey dey der kon sopraiz as dem si God pawa.
43 E todos ficaram maravilhados com a majestade de Deus. Como todos estavam admirados com tudo o que Jesus fazia, ele disse aos seus discípulos:
44 “Make una nor forget wetin I won tell una, dem go sell God Pikin give human being.”
44 — Prestem bem atenção nas seguintes palavras: o Filho do Homem está para ser entregue nas mãos dos homens.
45 But dem nor undastand dis word, bikos God hide am from dem make dem for nor know wetin di word mean. Di disciples demsef dey fear to ask Jesus about di matter.
45 Eles, porém, não entendiam isso, e lhes foi encoberto para que não o compreendessem. E temiam fazer perguntas a Jesus a respeito deste assunto.
46 Di disciples kon dey ask demsef, “Who big pass among us for God Kingdom?”
46 Surgiu entre os discípulos uma discussão sobre qual deles seria o maior.
47 Wen Jesus know wetin dem dey tok, e bring one small pikin near am
47 Mas Jesus, sabendo o que se passava no coração deles, pegou uma criança, colocou-a junto de si
48 kon tell dem, “Anybody wey welkom dis small pikin bikos of mi, don welkom mi and anybody wey welkom mi, don welkom God wey send mi, bikos di pesin wey small pass among una, na-im big pass for God Kingdom.”
48 e lhes disse:
49 John tell Jesus, “Oga God, wi si one man dey drive demon with yor name and wi tell am make e stop, bikos e nor dey with us.”
49 João tomou a palavra e disse: — Mestre, vimos certo homem que expulsava demônios em seu nome, mas nós o proibimos de fazer isso, porque não segue conosco.
50 Jesus kon ansa am, “Nor stop am, bikos anybody wey nor dey against us, dey awa side.”
50 Mas Jesus lhe disse:
51 Wen di time wey God go take Jesus go heaven don near, Jesus tink for en mind sey, e go-go Jerusalem.
51 E aconteceu que, ao se completarem os dias em que seria elevado ao céu, Jesus manifestou, no semblante, a firme resolução de ir para Jerusalém.
52 E kon send messenjas go for front and dem enter one village for Samaria go prepare evritin before e go rish der,
52 E enviou mensageiros que fossem na frente. Indo eles, entraram numa aldeia de samaritanos para lhe preparar pousada.
53 but di villagers nor gri welkom am, bikos dem si sey, e won go Jerusalem.
53 Mas não o receberam, porque o aspecto dele era de quem, decisivamente, ia para Jerusalém.
54 Wen James and John si wetin happen, dem kon sey, “Oga God, yu wont make wi koll fire down from heaven kon kill dis pipol?”
54 Vendo isto, os discípulos Tiago e João perguntaram: — Senhor, quer que mandemos descer fogo do céu para os consumir?
55 But Jesus turn warn dem,
55 Mas Jesus, voltando-se, os repreendeu.
56 den en and dem kon go anoda village. Farmer wey dey farm with en melu|alt="Man ploughing with his ox" src="cn02081b.tif" size="col" loc="LOOK 9:56" copy="Cook" ref="9:56"
56 E seguiram para outra aldeia.
57 As Jesus dey go for road, one man kon tell am, “I won follow yu go anywhere wey yu dey go.”
57 Enquanto seguiam pelo caminho, alguém disse a Jesus: — Vou segui-lo para onde quer que o senhor for.
58 Jesus kon tell am, “Rabbits get whole, birds get nest, but Man Pikin nor get anywhere to put en head!”
58 Mas Jesus lhe respondeu:
59 Jesus kon tell anoda man, “Make yu follow mi,” but dat one sey, “Oga God, make I first go beri my papa.”
59 A outro Jesus disse: Mas ele respondeu: — Senhor, deixe-me ir primeiro sepultar o meu pai.
60 Jesus kon tell am, “Make doz wey don die, beri who don die. But make yu go prish about God Kingdom.”
60 Mas Jesus insistiu:
61 Anoda pesin kon sey, “Oga God! I go like to follow yu, but make I first go tell my family bye-bye.”
61 Outro lhe disse: — Senhor, quero segui-lo, mas permita que antes disso eu me despeça das pessoas da minha casa.
62 Jesus tell am, “Pesin wey put hand for dis work, den e kon dey look back, nor get part for God Kingdom.”
62 Mas Jesus lhe respondeu:

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Lucas 9, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.