Lucas 8

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 Afta sometaim, Jesus kon travel go all di town and village dey prish di Good News about God Kingdom. Di twelf apostles
1 Depois disso, Jesus andava pelas cidades e aldeias anunciando a boa nova do Reino de Deus.
2 and some wimen wey Jesus drive evil spirit and difren sickness komot for dia body, go with am: Mary (wey dem dey koll Magdalin), wey Jesus drive seven demon komot for en body,
2 Os Doze estavam com ele, como também algumas mulheres que tinham sido livradas de espíritos malignos e curadas de enfermidades: Maria, chamada Madalena, da qual tinham saído sete demônios;
3 Joanna, Shuza wife (wey bi managa for Herod house), Susanna and many oda wimen wey dey use dia own money support Jesus and en disciples.
3 Joana, mulher de Cuza, procurador de Herodes; Susana e muitas outras, que o assistiram com as suas posses.
4 Many pipol gada round Jesus and some still dey kom from difren place, so e kon tell dem dis parabol:
4 Havia se reunido uma grande multidão: eram pessoas vindas de várias cidades para junto dele. Ele lhes disse esta parábola:
5 “One man go plant seed for en farm. As e dey plant, some fall for road, pipol mash dem pass and birds kon chop dem.
5 Saiu o semeador a semear a sua semente. E ao semear, parte da semente caiu à beira do caminho; foi pisada, e as aves do céu a comeram.
6 Some wey fall for where stones dey kon grow and die, bikos wota nor dey dat groun.
6 Outra caiu no pedregulho; e, tendo nascido, secou, por falta de umidade.
7 Odas fall for where shuku-shuku dey and wen dem grow, di shuku-shuku grow too, kon shuk dem die.
7 Outra caiu entre os espinhos; cresceram com ela os espinhos, e sufocaram-na.
8 But di ones wey fall for betta groun, grow kon bear pass hundred seed.”
8 Outra, porém, caiu em terra boa; tendo crescido, produziu fruto cem por um. Dito isto, Jesus acrescentou alteando a voz: Quem tem ouvidos para ouvir, ouça!
9 Den en disciples ask am wetin di parabol mean.
9 Os seus discípulos perguntaram-lhe a significação desta parábola.
10 Jesus ansa dem, “Una get di shance to know God Kingdom sekret, but dis oda pipol, na only parabol dem go take hear am, so dat
10 Ele respondeu: A vós é concedido conhecer os mistérios do Reino de Deus, mas aos outros se lhes fala por parábolas; de forma que vendo não vejam, e ouvindo não entendam.
11 “Na wetin di parabol mean bi dis: Di seed na God word.
11 Eis o que significa esta parábola: a semente é a palavra de Deus.
12 Di ones wey fall for road, na di pipol wey hear God word, but devil kon tif am from dia heart, so dat dem nor go bilive and God nor go save dem.
12 Os que estão à beira do caminho são aqueles que ouvem; mas depois vem o demônio e lhes tira a palavra do coração, para que não creiam nem se salvem.
13 Di ones wey fall for where stones dey, na di pipol wey hear God word kon receive am with happiness, but dem nor get rut. Dem bilive small, but wen wahala kom, dem nor bilive again.
13 Aqueles que a recebem em solo pedregoso são os ouvintes da palavra de Deus que a acolhem com alegria; mas não têm raiz, porque crêem até certo tempo, e na hora da provação a abandonam.
14 Di seeds wey fall for shuku-shuku, na di pipol wey hear God word, but wahala, plenty propaty and jolly-jolly for dis world kon shuk dem, so di fruit nor even ripe.
14 A que caiu entre os espinhos, estes são os que ouvem a palavra, mas prosseguindo o caminho, são sufocados pelos cuidados, riquezas e prazeres da vida, e assim os seus frutos não amadurecem.
15 But di seeds wey fall for betta groun, na di pipol wey hear God word, hold am with betta mind, dey obey God and bear wahala, so dem kon bear plenty fruit.”
15 A que caiu na terra boa são os que ouvem a palavra com coração reto e bom, retêm-na e dão fruto pela perseverança.
16 “Pesin nor go lite kandol kon take bucket kover am or hide am under bed, but e go put am for where pipol go si am wen dem enter di house.
16 Ninguém acende uma lâmpada e a cobre com um vaso ou a põe debaixo da cama; mas a põe sobre um castiçal, para iluminar os que entram.
17 Bikos e nor get wetin pipol hide naw, wey God nor go bring out and wetin dey sekret naw, God go bring am out for where lite dey.
17 Porque não há coisa oculta que não acabe por se manifestar, nem secreta que não venha a ser descoberta.
18 So make una listin well-well, bikos pesin wey get, God go gi-am more, but pesin wey nor get, even di small one wey e tink sey e get, God go take am from en hand.”
18 Vede, pois, como é que ouvis. Porque ao que tiver, lhe será dado; e ao que não tiver, até aquilo que julga ter lhe será tirado.
19 Jesus mama and en brodas kom meet am, but dem nor fit go near am, bikos pipol plenty for der.
19 A mãe e os irmãos de Jesus foram procurá-lo, mas não podiam chegar-se a ele por causa da multidão.
20 So pipol tell am, “Yor mama and brodas dey outside, dem won si yu.”
20 Foi-lhe avisado: Tua mãe e teus irmãos estão lá fora e desejam ver-te.
21 Jesus ansa, “My mama and brodas na pipol wey dey hear and obey God word.”
21 Ele lhes disse: Minha mãe e meus irmãos são estes, que ouvem a palavra de Deus e a observam.
22 One day, Jesus and en disciples enter kenu, den e tell dem, “Make wi cross go di oda side for di river.” So dem kon go.
22 Num daqueles dias ele subiu com os seus discípulos a uma barca. Disse ele: Passemos à outra margem do lago. E eles partiram.
23 As dia kenu dey move for di wota, Jesus dey sleep, den strong breeze start to blow and dem kon dey fear, bikos wota dey enter di kenu.
23 Durante a travessia, Jesus adormeceu. Desabou então uma tempestade de vento sobre o lago. A barca enchia-se de água, e eles se achavam em perigo.
24 Dem kon tell Jesus, “Oga God! Oga God! Na die wi dey so!”
24 Aproximaram-se dele então e o despertaram com este grito: Mestre, Mestre! Nós estamos perecendo! Levantou-se ele e ordenou aos ventos e à fúria da água que se acalmassem; e se acalmaram e logo veio a bonança.
25 Den Jesus ask dem, “Where una faith dey?”
25 Perguntou-lhes, então: Onde está a vossa fé? Eles, cheios de respeito e de profunda admiração, diziam uns aos outros: Quem é este, a quem os ventos e o mar obedecem?
26 Dem kon rish Gerasenes aria wey face Galilee.
26 Navegaram para a região dos gerasenos, que está defronte da Galiléia.
27 As Jesus kom down from di kenu, one man wey get demon for di town kom meet am. E don tey wen dis man wear klot or stay inside house, but e dey stay for beri groun.
27 Mal saltou em terra, veio-lhe ao encontro um homem dessa região, possuído de muitos demônios; há muito tempo não se vestia nem parava em casa, mas habitava no cemitério.
28 Wen e si Jesus, e fall for en front kon shaut, “Make yu leave mi! Jesus, God Pikin, Abeg yu, nor ponish mi!”
28 Ao ver Jesus, prostrou-se diante dele e gritou em alta voz: Por que te ocupas de mim, Jesus, Filho do Deus Altíssimo? Rogo-te, não me atormentes!
29 E shaut, bikos Jesus don first kommand di evil spirit make e komot for en body (bikos di evil spirit don disturb di man well-well and dem dey shain and guide am. But e dey break di shain and di demon go drive am go inside wildaness.)
29 Porque Jesus ordenara ao espírito imundo que saísse do homem. Pois há muito tempo que se apoderara dele, e guardavam-no preso em cadeias e com grilhões nos pés, mas ele rompia as cadeias e era impelido pelo demônio para os desertos.
30 Jesus ask am, “Wetin bi yor name?” E ansa, “Na Legion, bikos wi plenty inside am.”
30 Jesus perguntou-lhe: Qual é o teu nome? Ele respondeu: Legião! {Porque eram muitos os demônios que nele se ocultavam.}
31 Di demons kon beg Jesus make e send dem go inside di river.
31 E pediam-lhe que não os mandasse ir para o abismo.
32 Near di river, many pig dey togeda dey chop and di evil spirits beg Jesus make dem enter inside di pigs. So Jesus allow dem.
32 Ora, andava ali pastando no monte uma grande manada de porcos; rogaram-lhe os demônios que lhes permitisse entrar neles. Ele permitiu.
33 Di demons komot for di man body go enter di pigs and all of dem rush enter di river go die.
33 Saíram, pois, os demônios do homem e entraram nos porcos; e a manada de porcos precipitou-se, pelo despenhadeiro, impetuosamente no lago e afogou-se.
34 Wen di pipol wey dey keep di pigs si wetin happen, dem run go inside town bigin spread di news.
34 Quando aqueles que os guardavam viram o acontecido, fugiram e foram contá-lo na cidade e pelo campo.
35 So pipol run kom si wetin dey happen and dem meet Jesus for der. Di man wey Jesus drive demon komot for en body, don well and e wear klot sidan near Jesus leg, so fear kon katch di pipol.
35 Saíram eles, pois, a ver o que havia ocorrido. Chegaram a Jesus e acharam a seus pés, sentado, vestido e calmo, o homem de quem haviam sido expulsos os demônios; e tomados de medo,
36 Pipol wey si wetin happen, tell di town pipol how Jesus heal di man wey get demon before.
36 ouviram das testemunhas a narração desse exorcismo.
37 Den all di pipol for Gerasenes and di aria wey near der, kon tell Jesus make e leave dem, bikos dem dey fear well-well. So Jesus and en disciples enter kenu kon komot for der.
37 Então todo o povo da região dos gerasenos rogou a Jesus que se retirasse deles, pois estavam possuídos de grande temor. Jesus subiu à barca, para regressar.
38 Di man wey demon komot for en body beg Jesus make e follow am, but Jesus tell am,
38 Nesse momento, pedia-lhe o homem, de quem tinham saído os demônios, para ficar com ele. Mas Jesus despediu-o, dizendo:
39 “Make yu go yor house go tell dem wetin God don do for yu.” So di man kon go, dey tell pipol for di town wetin Jesus do for am.
39 Volta para casa, e conta quanto Deus te fez. E ele se foi, publicando por toda a cidade essas grandes coisas...
40 Wen Jesus go back for di oda side for di river, pipol welkom am for der, bikos e don tey wey dem dey wait for am.
40 À sua volta, Jesus foi recebido por uma multidão que o esperava.
41 Den Jairus wey bi oga for di sinagog waka kom. E fall for groun near Jesus leg, dey beg am make e kom en house,
41 O chefe da sinagoga, chamado Jairo, foi ao seu encontro. Lançou-se a seus pés e rogou-lhe que fosse à sua casa,
42 bikos e only dota wey don rish twelf years, dey die.
42 porque tinha uma filha única, de uns doze anos, que estava para morrer. Jesus dirigiu-se para lá, comprimido pelo povo.
43 One woman dey among dem wey don dey mestrate for twelf years naw, bikos nobody fit heal am.
43 Ora, uma mulher que padecia dum fluxo de sangue havia doze anos, e tinha gasto com médicos todos os seus bens, sem que nenhum a pudesse curar,
44 E waka kom Jesus back kon tosh Jesus klot korna and at wons, di blood kon stop.
44 aproximou-se dele por detrás e tocou-lhe a orla do manto; e no mesmo instante lhe parou o fluxo de sangue.
45 Den Jesus ask, “Na who tosh mi?”
45 Jesus perguntou: Quem foi que me tocou? Como todos negassem, Pedro e os que com ele estavam disseram: Mestre, a multidão te aperta de todos os lados...
46 But Jesus sey, “Somebody tosh mi, bikos pawa komot for my body.”
46 Jesus replicou: Alguém me tocou, porque percebi sair de mim uma força.
47 Wen di woman si sey e nor go fit hide again, e kom out dey shake kon fall for Jesus front. For evribody present, e tok wetin make am tosh Jesus and how e kon well at wons.
47 A mulher viu-se descoberta e foi tremendo e prostrou-se aos seus pés; e declarou diante de todo o povo o motivo por que o havia tocado, e como logo ficara curada.
48 Jesus kon tell di woman, “My pikin, yor faith don heal yu. Make peace follow yu.”
48 Jesus disse-lhe: Minha filha, tua fé te salvou; vai em paz.
49 As Jesus still dey tok, somebody run kom from Jairus house kon tell Jairus sey, “Yor pikin don die, so make yu nor worry di tisha again.”
49 Enquanto ainda falava, veio alguém e disse ao chefe da sinagoga: Tua filha acaba de morrer; não incomodes mais o Mestre.
50 But wen Jesus hear am, e tell Jairus, “Make yu nor fear, just bilive and yor pikin go well.”
50 Mas Jesus o ouviu e disse a Jairo: Não temas; crê somente e ela será salva.
51 Wen dem rish di house, Jesus nor let anybody follow am enter, escept Pita, John and James with di pikin papa and mama.
51 Quando Jesus chegou à casa, não deixou ninguém entrar com ele, senão Pedro, Tiago, João com o pai e a mãe da menina.
52 Evribody for der dey kry take body nak groun, but Jesus tell dem, “Make una nor kry, bikos di girl neva die, na sleep e dey sleep.”
52 Todos, entretanto, choravam e se lamentavam. Mas Jesus disse: Não choreis; a menina não morreu, mas dorme.
53 Dem kon bigin laf am, bikos dem know sey di girl don die.
53 Zombavam dele, pois sabiam bem que estava morta.
54 But Jesus whole di girl hand kon sey, “My pikin, get up.”
54 Mas segurando ele a mão dela, disse em alta voz: Menina, levanta-te!
55 Naim di girl spirit enter di body back and e kon get up at wons. Den Jesus tell dem make dem give di pikin food chop.
55 Voltou-lhe a vida e ela levantou-se imediatamente. Jesus mandou que lhe dessem de comer.
56 Di papa and mama sopraiz well-well, but Jesus kommand dem make dem nor tell anybody wetin happen.
56 Seus pais ficaram tomados de pasmo; Jesus ordenou-lhes que não contassem a pessoa alguma o que se tinha passado.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Lucas 8, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.