Lucas 7
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 Afta Jesus tish di pipol all dis tins, e kon go Kapanaum.
1 Tendo Jesus concluído todos os seus discursos ao povo que o escutava, entrou em Cafarnaum.
2 For der, one Roman soja get one savant wey e like well-well, but di savant nor well and e nearly die.
2 Havia lá um centurião que tinha um servo a quem muito estimava e que estava à morte.
3 Wen di soja hear about Jesus, e kon send some Jew eldas go meet am sey, make e kom heal en savant.
3 Tendo ouvido falar de Jesus, enviou-lhe alguns anciãos dos judeus, rogando-lhe que o viesse curar.
4 Wen dem si Jesus, dem beg am well-well sey, “E good make yu kom help am,
4 Aproximando-se eles de Jesus, rogavam-lhe encarecidamente: Ele bem merece que lhe faças este favor,
5 bikos e love awa pipol and e even build sinagog for us.”
5 pois é amigo da nossa nação e foi ele mesmo quem nos edificou uma sinagoga.
6 So Jesus follow dem go.
6 Jesus então foi com eles. E já não estava longe da casa, quando o centurião lhe mandou dizer por amigos seus: Senhor, não te incomodes tanto assim, porque não sou digno de que entres em minha casa;
7 Na dis make mi nor waka kom meet yu, instead, make yu just give orda and my savant go well.
7 por isso nem me achei digno de chegar-me a ti, mas dize somente uma palavra e o meu servo será curado.
8 Bikos mi too get pipol wey big pass mi and I get di ones wey I big pass. If I tell one, ‘Go!’ E go-go and anoda one, ‘Kom!’ E go kom and if I tell my savant, ‘Do dis tin!’ E go do am.”
8 Pois também eu, simples subalterno, tenho soldados às minhas ordens; e digo a um: Vai ali! E ele vai; e a outro: Vem cá! E ele vem; e ao meu servo: Faze isto! E ele o faz.
9 Wen Jesus hear dis, e sopraiz and belle sweet am, naim e look di pipol wey dey follow am kon tell dem, “I tell una true word, I neva si dis kind faith before, even for Israel.”
9 Ouvindo estas palavras, Jesus ficou admirado. E, voltando-se para o povo que o ia seguindo, disse: Em verdade vos digo: nem mesmo em Israel encontrei tamanha fé.
10 So, wen doz wey di soja send go back to di house, dem kon si sey di savant don well.
10 Voltando para a casa do centurião os que haviam sido enviados, encontraram o servo curado.
11 Afta, Jesus go one town wey dem dey koll Nain, en disciples with many pipol follow am.
11 No dia seguinte dirigiu-se Jesus a uma cidade chamada Naim. Iam com ele diversos discípulos e muito povo.
12 Near di town gate, dem meet pipol dey karry one dead body go beri. Di man mama na widow and naim bi di woman only pikin, so plenty pipol from di town kon follow am.
12 Ao chegar perto da porta da cidade, eis que levavam um defunto a ser sepultado, filho único de uma viúva; acompanhava-a muita gente da cidade.
13 Wen Jesus si di woman, e sorry for am kon tell am, “Make yu nor kry again.”
13 Vendo-a o Senhor, movido de compaixão para com ela, disse-lhe: Não chores!
14 Den e waka go tosh di koffin and di men wey karry am kon stop. Jesus kon sey, “Yong man, get up!”
14 E aproximando-se, tocou no esquife, e os que o levavam pararam. Disse Jesus: Moço, eu te ordeno, levanta-te.
15 So di man get up kon start to tok. Jesus kon gi-am back to en mama.
15 Sentou-se o que estivera morto e começou a falar, e Jesus entregou-o à sua mãe.
16 Fear katch all of dem and dem kon dey praiz God sey, “Na big profet kom meet us so-o!” and “God don kom help en pipol!”
16 Apoderou-se de todos o temor, e glorificavam a Deus, dizendo: Um grande profeta surgiu entre nós: Deus voltou os olhos para o seu povo.
17 Di news about Jesus spread round Judea and all di place wey near der.
17 A notícia deste fato correu por toda a Judéia e por toda a circunvizinhança.
18 John disciples kon tell John about di tins wey dey happen. So e koll two of en disciples
18 Os discípulos de João referiram-lhe todas estas coisas.
19 kon send dem go ask Jesus sey, “Na yu bi di pesin wey wi dey espect, abi make wi wait for anoda pesin?”
19 E João chamou dois dos seus discípulos e enviou-os a Jesus, perguntando: És tu o que há de vir ou devemos esperar por outro?
20 Wen dem si Jesus, dem kon sey, “John di Baptist send us make wi ask sey, ‘Na yu bi di pesin wey wi dey espect, abi make wi wait for anoda pesin?’ ”
20 Chegando estes homens a ele, disseram: João Batista enviou-nos a ti, perguntando: És tu o que há de vir ou devemos esperar por outro?
21 For dat same time, Jesus heal many pipol wey get difren sickness, pipol wey get evil spirit and pipol wey nor fit si, kon dey si.
21 Ora, naquele momento Jesus havia curado muitas pessoas de enfermidades, de doenças e de espíritos malignos, e dado a vista a muitos cegos.
22 So, Jesus ansa dem, make una go tell John wetin una don si and hear: “Blind pipol dey si, pipol wey nor fit waka before, dey waka, pipol wey get leprosy, dia body don klean, pipol wey nor dey hear, don dey hear naw, pipol wey don die, don wake-up and even poor pipol, don hear di Good News.
22 Respondeu-lhes ele: Ide anunciar a João o que tendes visto e ouvido: os cegos vêem, os coxos andam, os leprosos ficam limpos, os surdos ouvem, os mortos ressuscitam, aos pobres é anunciado o Evangelho;
23 God go bless pipol wey nor dey doubt mi.”
23 e bem-aventurado é aquele para quem eu não for ocasião de queda!
24 Wen John messenjas don go, Jesus kon bigin tok to di pipol about John: “Wetin una go find for inside wildaness? Na grass wey breeze dey blow?
24 Depois que se retiraram os mensageiros de João, ele começou a falar de João ao povo: Que fostes ver no deserto? Um caniço agitado pelo vento?
25 Wetin una go out go si? Na man wey wear fine klot? No! Bikos pipol wey dey wear fine klot and dey enjoy life, na king palis dem dey stay.
25 Mas que fostes ver? Um homem vestido de roupas finas? Mas os que vestem roupas preciosas e vivem no luxo estão nos palácios dos reis.
26 Wetin una go out go si? Na profet? Yes! I tell una, e even big pass profet.
26 Mas, enfim, que fostes ver? Um profeta? Sim, digo-vos, e mais do que profeta.
27 Dis na wetin dem rite about am,
27 Este é aquele de quem está escrito: Eis que envio o meu mensageiro ante a tua face; ele preparará o teu caminho diante de ti {Ml 3,1}.
28 I tell una true word, among all di pipol wey woman born, nobody big rish John di Baptist, but di pesin wey small pass for God Kingdom, big pass am.”
28 Pois vos digo: entre os nascidos de mulher não há maior que João. Entretanto, o menor no Reino de Deus é maior do que ele.
29 (Naw, evribody wey hear dis tins, even di tax kollectors, know sey God dey do wetin dey rite, bikos John di Baptist, baptize dem.
29 Ouvindo-o todo o povo, e mesmo os publicanos, deram razão a Deus, fazendo-se batizar com o batismo de João.
30 But di Farisee pipol and di law tishas rijet wetin God plan for dem, bikos John nor baptize dem.)
30 Os fariseus, porém, e os doutores da lei, recusando o seu batismo, frustraram o desígnio de Deus a seu respeito.
31 How I won take tok about pipol wey dey for dis world naw?
31 A quem compararei os homens desta geração? Com quem se assemelham?
32 Dem bi like shidren wey sidan for market dey tell each oda,
32 São semelhantes a meninos que, sentados na praça, falam uns com os outros, dizendo: Tocamos a flauta e não dançastes; entoamos lamentações e não chorastes.
33 Wen John di Baptist kom, e nor chop food or drink wine, but una sey, ‘E get demon!’
33 Pois veio João Batista, que nem comia pão nem bebia vinho, e dizeis: Ele está possuído do demônio.
34 But God Pikin kom, dey chop and drink and una sey, ‘Si am, long-trot, drunkard, na tax kollectors and sinnas bi en friend.’
34 Veio o Filho do Homem, que come e bebe, e dizeis: Eis um comilão e beberrão, amigo dos publicanos e libertinos.
35 But doz wey get wisdom, know sey evritin about am, na trut.”
35 Mas a sabedoria foi justificada por todos os seus filhos.
36 One Farisee kon invite Jesus kom chop for en house, so Jesus enter di Farisee house kon sidan.
36 Um fariseu convidou Jesus a ir comer com ele. Jesus entrou na casa dele e pôs-se à mesa.
37 Den, wen one woman from dat town wey bi sina hear sey Jesus dey chop for di Farisee house, e kon bring one fine oil bottol, wey dey send well-well, kom.
37 Uma mulher pecadora da cidade, quando soube que estava à mesa em casa do fariseu, trouxe um vaso de alabastro cheio de perfume;
38 E knee down for Jesus front dey kry and e kon dey wet Jesus leg with di tears from en eye. E klean Jesus leg with en hair kon kiss dem, den e pour di oil put.
38 e, estando a seus pés, por detrás dele, começou a chorar. Pouco depois suas lágrimas banhavam os pés do Senhor e ela os enxugava com os cabelos, beijava-os e os ungia com o perfume.
39 Wen di Farisee wey invite Jesus si wetin dey happen, e kon tok for en mind sey, “If dis man na profet true-true, e for know sey dis woman wey dey tosh am so, na sina e bi.”
39 Ao presenciar isto, o fariseu, que o tinha convidado, dizia consigo mesmo: Se este homem fosse profeta, bem saberia quem e qual é a mulher que o toca, pois é pecadora.
40 Jesus kon tell di Farisee, “Simon, e get wetin I won tell yu.”
40 Então Jesus lhe disse: Simão, tenho uma coisa a dizer-te. Fala, Mestre, disse ele.
41 “E get one man wey get two savant wey dey owe am money, one dey hold am 5,000 and di oda one, five hundred.
41 Um credor tinha dois devedores: um lhe devia quinhentos denários e o outro, cinqüenta.
42 Wen two of dem nor fit pay di money back, e kon sey make dem forget about di money. Afta dat, wish of dem go like di man pass?”
42 Não tendo eles com que pagar, perdoou a ambos a sua dívida. Qual deles o amará mais?
43 Simon ansa, “Na di one wey en money big pass.”
43 Simão respondeu: A meu ver, aquele a quem ele mais perdoou. Jesus replicou-lhe: Julgaste bem.
44 Den Jesus look di woman kon ask Simon, “Yu dey si dis woman? I enter yor house, yu nor give mi wota wosh leg, but di woman don wosh my leg with en tears kon take en hair klean am.
44 E voltando-se para a mulher, disse a Simão: Vês esta mulher? Entrei em tua casa e não me deste água para lavar os pés; mas esta, com as suas lágrimas, regou-me os pés e enxugou-os com os seus cabelos.
45 Wen I enter yor house, yu nor kiss or greet mi as awa tradishon bi, but since I enter, dis woman neva stop to kiss my leg.
45 Não me deste o ósculo; mas esta, desde que entrou, não cessou de beijar-me os pés.
46 Yu nor pour oil for my head, but dis woman don anoint my leg with oil wey dey send well-well.
46 Não me ungiste a cabeça com óleo; mas esta, com perfume, ungiu-me os pés.
47 Make I tell yu, I don forgive dis woman en many sins, so en love don big well-well, but di pesin wey dem forgive small sin, en love go small.”
47 Por isso te digo: seus numerosos pecados lhe foram perdoados, porque ela tem demonstrado muito amor. Mas ao que pouco se perdoa, pouco ama.
48 Den Jesus tell di woman, “I forgive yu all yor sins.”
48 E disse a ela: Perdoados te são os pecados.
49 But di pipol wey sidan dey chop with Jesus kon dey tell each oda, “Who bi dis man wey dey forgive sin?”
49 Os que estavam com ele à mesa começaram a dizer, então: Quem é este homem que até perdoa pecados?
50 So, Jesus tell di woman, “Yor faith don save yu; make peace follow yu go.”
50 Mas Jesus, dirigindo-se à mulher, disse-lhe: Tua fé te salvou; vai em paz.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Lucas 7, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.