Lucas 6
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA
1 Jesus dey waka pass where dem plant korn put and en disciples kon plok some korn dey chop.
1 Aconteceu que, num sábado, Jesus passava pelas searas, e os seus discípulos colhiam e comiam espigas, debulhando-as com as mãos.
2 Some of di Farisee pipol kon sey, “Why una dey do wetin awa law tok sey make wi nor do for Sabat Day?”
2 E alguns dos fariseus lhes disseram: — Por que vocês fazem o que não é lícito aos sábados?
3 Jesus ansa dem, “Una neva read wetin David do wen en and en men dey hongry?
3 Jesus tomou a palavra e disse:
4 E enter God house kon take di bread wey holy wey only priests suppose chop and en and en men chop am.”
4 Como entrou na casa de Deus e, pegando os pães da proposição, comeu e deu também aos que estavam com ele, pães que não lhes era lícito comer, mas exclusivamente aos sacerdotes?
5 So Jesus tell dem, “Na Man Pikin bi Sabat Day Oga God.”
5 Então Jesus lhes disse:
6 For anoda Sabat Day, Jesus enter di sinagog dey tish. One man wey en rite hand don die dey der.
6 Aconteceu que, em outro sábado, Jesus entrou na sinagoga e começou a ensinar. Estava ali um homem que tinha a mão direita ressequida.
7 Di law tishas and di Farisee pipol dey look Jesus with korna eye weda e go heal pipol for Sabat Day, so dat dem go si wetin dem go take akuiz am.
7 Os escribas e os fariseus observavam Jesus, procurando ver se ele faria uma cura no sábado, a fim de acharem de que o acusar.
8 But Jesus know wetin dem dey tink, so e kon tell di man wey en hand die, “Get up, make yu kom stand for here”, so di man get up, go stand near am.
8 Mas Jesus, conhecendo os pensamentos deles, disse ao homem da mão ressequida: E ele, levantando-se, ficou em pé.
9 Den Jesus ask dem, “E dey rite to do good for Sabat Day” or “to save or distroy anybody life?”
9 Então Jesus disse a eles:
10 Afta Jesus look dem round, e kon tell di man, “Stresh yor hand out.” So di man stresh en hand and di hand kon well.
10 Então Jesus, olhando para todos que estavam ao seu redor, disse ao homem: Ele assim o fez, e a mão lhe foi restaurada.
11 But di Farisee pipol and di law tishas kon vex sotey dem nor dey si road again, so dem kon bigin ask diasef, “Wetin wi go do Jesus Christ.”
11 Mas eles se encheram de furor e discutiam entre si quanto ao que fariam contra Jesus.
12 Jesus go mountin go pray and e dey der dey pray to God till day break.
12 Naqueles dias, Jesus se retirou para o monte, a fim de orar, e passou a noite orando a Deus.
13 Wen day break, Jesus koll en disciples kon choose twelf among dem wey e koll apostles:
13 E, quando amanheceu, chamou a si os seus discípulos e escolheu doze dentre eles, aos quais deu também o nome de apóstolos:
14 Simon (wey bi Pita) and en broda Andru and James, John, Filip, Bartolomew
14 Simão, a quem acrescentou o nome de Pedro, e André, seu irmão; Tiago e João; Filipe e Bartolomeu;
15 Matiu, Tomas, James (Afaeus pikin) Simon wey bi Zealot, (pesin wey dey fight for en kountry).
15 Mateus e Tomé; Tiago, filho de Alfeu, e Simão, chamado Zelote;
16 Judas (James pikin) and Judas Iskariot wey leta sell Jesus give en enemies.
16 Judas, filho de Tiago, e Judas Iscariotes, que se tornou traidor.
17 Den Jesus kom down with en apostles kon stand for groun wey level. Many disciples from Judea, Jerusalem and all di small towns wey near Tyre and Sidon gada kon hear am dey prish and e heal doz wey nor well
17 E, descendo com eles do monte, Jesus parou num lugar plano onde se encontravam muitos discípulos seus e grande multidão do povo, de toda a Judeia, de Jerusalém e do litoral de Tiro e de Sidom,
18 and odas wey evil spirit dey worry.
18 que vieram para o ouvir e para ser curados de suas doenças. Também os atormentados por espíritos imundos eram curados.
19 Evribody dey try to tosh am, bikos pawa wey dey komot from en body, dey heal pipol.
19 E todos da multidão procuravam tocar em Jesus, porque dele saía poder; e curava todos.
20 Den Jesus look en disciples, tell dem,
20 Então, olhando para os seus discípulos, Jesus lhes disse:
21 Make una happy, una wey dey hongry,
21 — Bem-aventurados são vocês
22 Una wey pipol hate, rijet, curse and dey koll bad pipol
22 — Bem-aventurados são vocês quando as pessoas os odiarem, expulsarem da sua companhia, insultarem e rejeitarem o nome de vocês como indigno, por causa do Filho do Homem.
23 and una go dey happy for dat day.
23 Alegrem-se naquele dia e exultem, porque grande é a recompensa de vocês no céu; porque os pais dessas pessoas fizeram o mesmo com os profetas.
24 “But curse dey una head, una wey get money well-well naw,
24 — Mas ai de vocês, os ricos,
25 Curse dey una head, una wey don ova beleful,
25 — Ai de vocês
26 Curse dey una head,
26 — Ai de vocês, quando todos os elogiarem, porque os pais dessas pessoas fizeram o mesmo com os falsos profetas!
27 “But I dey tell una wey dey listin, ‘Make una love una enemy and do good to pipol wey hate una.’
27 — Digo, porém, a vocês que me ouvem: amem os seus inimigos, façam o bem aos que odeiam vocês.
28 Make una bless doz wey curse una and pray for doz wey dey trit una anyhow.
28 Abençoem aqueles que os amaldiçoam, orem pelos que maltratam vocês.
29 If anybody slap una for face, make una turn di oda side gi-am too. If anybody use force kollect una koat, make una gi-am una shirt join too.
29 Ao que lhe bate numa face, ofereça também a outra; e, ao que lhe tirar a capa, deixe que leve também a túnica.
30 Make una give evribody wey ask una for sometin and if anybody take wetin bi una own, make una nor ask for am back.
30 Dê a todo o que lhe pedir alguma coisa; e, se alguém levar o que é seu, não exija que seja devolvido.
31 Make una do for pipol as una wont make dem do for una.
31 Façam aos outros o mesmo que vocês querem que eles façam a vocês.
32 “If una love only di pipol wey love una, wetin go make God bless una? Even sinnas sef love doz wey love dem.
32 — Se vocês amam aqueles que os amam, que recompensa terão? Porque até os pecadores amam aqueles que os amam.
33 And if una do good for only doz wey dey do good for una, wetin go make God bless una? Even sinnas dey do di same tin too.
33 Se fizerem o bem aos que lhes fazem o bem, que recompensa terão? Até os pecadores fazem isso.
34 If una borrow pesin money wen una know sey e go fit pay una back, wetin go make God bless una? Sinnas sef dey borrow money give sinnas, so dat dem go pay dem back dia korrect money.
34 E, se emprestam àqueles de quem esperam receber, que recompensa terão? Também os pecadores emprestam aos pecadores, para receberem outro tanto.
35 But make una love una enemies kon do good and make una nor espect anytin back wen una borrow anybody sometin. Na dis go make God pay una back and una go bi en shidren, bikos God ensef dey do good for wiked pipol and doz wey nor dey sey tank yu.
35 Vocês, porém, amem os seus inimigos, façam o bem e emprestem, sem esperar nada em troca; vocês terão uma grande recompensa e serão filhos do Altíssimo. Pois ele é bondoso até para os ingratos e maus.
36 So, make una dey show mesi, just as una Papa dey show mesi.”
36 Sejam misericordiosos, como também é misericordioso o Pai de vocês.
37 “Make una nor judge oda pipol, so dat God nor go judge una. Make una nor kondemn odas, so dat God nor go kondemn una. Make una forgive odas and God go forgive una.
37 — Não julguem e vocês não serão julgados; não condenem e vocês não serão condenados; perdoem e serão perdoados;
38 Make una give pipol wey nor get and God go give una wetin really big, E go pak am well-well and di tins go ova full. God go pour all dis tins for una life. But na as una take give odas, na so God go take give una too.”
38 deem e lhes será dado; boa medida, prensada, sacudida e transbordante será dada a vocês; porque com a medida com que tiverem medido vocês serão medidos também.
39 Jesus still tell dem anoda parabol, “Pesin wey blind nor dey fit show anoda blind man road, abi e go fit? No! If na so, dem two go fall inside gutta.
39 Jesus lhes contou também uma parábola:
40 No student go fit big pass en tisha, but wen e don learn finish, e go bi like en tisha.
40 — O discípulo não está acima do seu mestre; todo aquele, porém, que for bem-instruído será como o seu mestre.
41 “Why yu dey look di small dirty wey dey yor broda eye, but yu nor dey si di big wood wey dey yor own eye.
41 — Por que você vê o cisco no olho do seu irmão, mas não repara na trave que está no seu próprio olho?
42 How yu go take tell yor broda sey, ‘Broda, make I remove di dirty wey dey yor eye, but yu nor dey si di wood wey dey yor own eye? Yu wey dey pritend, make yu first komot di wood for yor eye, den yu go si well to fit remove yor broda own.’
42 Como você poderá dizer a seu irmão: “Deixe, irmão, que eu tire o cisco que está no seu olho”, se você não repara na trave que está no seu próprio olho? Hipócrita! Tire primeiro a trave do seu olho e então você verá claramente para tirar o cisco que está no olho do seu irmão.
43 “Bikos betta tree nor dey bear bad fruit and know bad tree dey bear good fruit,
43 — Não há árvore boa que dê mau fruto, nem árvore má que dê bom fruto.
44 bikos na fruit wey tree bear, naim pipol dey take know di kind tree wey e bi. Pipol nor dey plok fig or grape from shuku-shuku tree.
44 Porque cada árvore é conhecida pelos frutos que produz. Porque não se colhem figos de ervas daninhas, nem se apanham uvas dos espinheiros.
45 Wen pesin dey good, na di good tins wey dey inside am, dey make am bear good fruits, but bad pesin, na di bad tins wey dey inside am, dey am make bear bad fruits, bikos na from wetin full inside pesin mind, naim en mout dey tok.
45 A pessoa boa tira o bem do bom tesouro do coração, e a pessoa má tira o mal do mau tesouro; porque a boca fala do que está cheio o coração.
46 “Why una dey koll mi, ‘Oga God’ and una nor dey do wetin I tell una?
46 — Por que vocês me chamam “Senhor, Senhor!”, e não fazem o que eu mando?
47 Anybody wey kom meet mi and listin to my word kon do am; I go show una wetin di pesin bi like.
47 Eu vou mostrar a vocês a quem é semelhante todo aquele que vem a mim, ouve as minhas palavras e as pratica.
48 E bi like man wey dey build house, wey dig groun kon lay di foundashon on-top strong rock. Wen big wota rush kom, e nor go fit shake di house, bikos dem build am for betta rock.
48 Esse é semelhante a um homem que, ao construir uma casa, cavou, abriu profunda vala e lançou o alicerce sobre a rocha. Quando veio a enchente, as águas bateram contra aquela casa e não a puderam abalar, por ter sido bem-construída.
49 But di pesin wey hear my word and e nor do am, e bi like man wey build house wey nor get strong foundashon. Wen big wota kom, di house go fall skata.”
49 Mas o que ouve e não pratica é semelhante a um homem que construiu uma casa sobre a terra, sem alicerces, e, quando as águas bateram contra ela, logo desabou; e aconteceu que foi grande a ruína daquela casa.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Lucas 6, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.