Lucas 5
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NTLH
1 Jesus stand near Gennesaret and pipol gada make dem for hear God word.
1 Certo dia Jesus estava na praia do lago da Galileia, e a multidão se apertava em volta dele para ouvir a mensagem de Deus.
2 E si two kenu for di wotaside, but di Fisha men wey get dem, don kom down dey wosh dia net.
2 Ele viu dois barcos no lago, perto da praia. Os pescadores tinham saído deles e estavam lavando as redes.
3 E enter inside one kenu wey bi Simon Pita own kon tell am make e push di kenu enter wota small. Den Jesus kon sidan dey tish di pipol from di kenu.
3 Jesus entrou num dos barcos, o de Simão, e pediu que ele o afastasse um pouco da praia. Então sentou-se e começou a ensinar a multidão.
4 Wen e don tok finish, e kon tell Simon, “Push di kenu go where deep pass for di wota, make una for fit katch fish.”
4 Quando acabou de falar, Jesus disse a Simão:
5 Simon ansa, “Oga God, wi dey here from nite till day break and wi nor katch anytin. But as yu tok, wi go trow awa net inside wota.”
5 Simão respondeu: — Mestre, nós trabalhamos a noite toda e não pescamos nada. Mas, já que o senhor está mandando jogar as redes, eu vou obedecer.
6 So, dem trow dia net inside wota and dem katch many fish sotey dia net kon start to tear.
6 Quando eles jogaram as redes na água, pescaram tanto peixe, que as redes estavam se rebentando.
7 So, dem kon do sign give di oda pipol wey dey follow dem work, make dem kom help dem. Wen dem put all di fish inside di two kenu, di kenu dem kon dey won sink.
7 Então fizeram um sinal para os companheiros que estavam no outro barco a fim de que viessem ajudá-los. Eles foram e encheram os dois barcos com tanto peixe, que os barcos quase afundaram.
8 Wen Simon si wetin happen, e kon knee down for Jesus front dey sey, “Abeg, nor near mi Oga God, bikos I bi sina.”
8 Quando Simão Pedro viu o que havia acontecido, ajoelhou-se diante de Jesus e disse: — Senhor, afaste-se de mim, pois eu sou um pecador!
9 Pita and all di pipol wey dey with am sopraiz well-well wen dem si all di fish wey dem katch.
9 Simão e os outros que estavam com ele ficaram admirados com a quantidade de peixes que haviam apanhado.
10 James and John wey bi Zebedee shidren, wey dey follow Pita work, sopraiz too.
10 Tiago e João, filhos de Zebedeu, que eram companheiros de Simão, também ficaram muito admirados. Então Jesus disse a Simão:
11 So wen dem don push dia kenu rish groun for di wotaside, dem leave evritin kon follow Jesus.
11 Eles arrastaram os barcos para a praia, deixaram tudo e seguiram Jesus.
12 Wen Jesus dey for one town, one man wey get leprosy kom meet am. Wen di man si Jesus, e fall face groun kon beg am sey, “Oga God, if yu like to do am, yu go fit heal mi.”
12 Certa vez Jesus estava numa cidade onde havia um homem que tinha o corpo todo coberto de lepra. Quando viu Jesus, o leproso se ajoelhou diante dele, encostou o rosto no chão e pediu: — Senhor, eu sei que o senhor pode me curar se quiser!
13 So Jesus tosh di man kon sey, “I like to do am. ‘Oya! Make yor body klean naw!’ ” At wons, di leprosy komot for di man body.
13 Jesus estendeu a mão, tocou nele e disse: No mesmo instante a lepra desapareceu.
14 Jesus tell di man, “Make yu nor tell anybody, but go show yorsef to di priest and pay di ofrin wey Moses kommand sey, pipol wey dia leprosy don komot for dia body go bring, so dat di priest go know sey yu don really well.”
14 Então Jesus lhe deu esta ordem:
15 But di news about Jesus kon spread pass before and many pipol kom meet am make dem for fit hear en word and make e for heal dem.
15 Mas as notícias a respeito de Jesus se espalhavam ainda mais, e muita gente vinha para ouvi-lo e para ser curada das suas doenças.
16 But Jesus komot go pray for wildaness, where pipol nor dey.
16 Porém Jesus ia para lugares desertos e orava.
17 One day, wen Jesus dey tish, some Farisee pipol and di law tishas kon kom from all di village wey dey Galilee, Judea and Jerusalem, dem sidan near Jesus and God pawa dey with am to heal pipol.
17 Um dia Jesus estava ensinando, e alguns fariseus e alguns mestres da Lei estavam sentados perto dele. Eles tinham vindo de todas as cidades da Galileia e da Judeia e também de Jerusalém. O poder do Senhor estava com Jesus para que ele curasse os doentes.
18 Some men karry one man for bed wey nor fit waka, kom. Dem kon dey try to karry am enter di house kom meet Jesus,
18 Alguns homens trouxeram um paralítico deitado numa cama e estavam querendo entrar na casa e colocá-lo diante de Jesus.
19 but bikos pipol many, dem nor fit karry am pass, so dem kon open di zink for di housetop, drop di man with di bed small-small, till e rish Jesus front for di pipol centre.
19 Porém, por causa da multidão, não conseguiram entrar com o paralítico. Então o carregaram para cima do telhado. Fizeram uma abertura nas telhas e o desceram na sua cama em frente de Jesus, no meio das pessoas que estavam ali.
20 Wen Jesus si how dia faith big rish, e kon tell di man, “My friend, I forgive yu all yor sins.”
20 Jesus viu que eles tinham fé e disse ao paralítico:
21 So di law tishas and di Farisee pipol kon dey tell diasef sey, “Who bi dis man wey dey shalenge God like dis? Who fit forgive sin escept God?”
21 Os mestres da Lei e os fariseus começaram a pensar: — Quem é este homem que
22 Jesus know wetin dem dey tink, so e ask dem, “Why una dey tink like dis sef?
22 Porém Jesus sabia o que eles estavam pensando e disse:
23 Wish one eazy to tok? ‘I forgive yu yor sin?’ or ‘Get up make yu waka?’
23 O que é mais fácil dizer ao paralítico: “Os seus pecados estão perdoados” ou “Levante-se e ande”?
24 But make una for know sey Man Pikin get pawa for dis world to forgive sin, e kon tell di man wey nor fit waka, ‘I tell yu, get up, karry yor bed make yu dey go house.’ ”
24 Pois vou mostrar a vocês que eu, o Então disse ao paralítico:
25 At wons, di man kon get up for dia present, karry di bed wey e liedan put before kon dey praiz God as e dey go house.
25 No mesmo instante o homem se levantou diante de todos, pegou a cama e foi para casa, louvando a Deus.
26 Evribody for der sopraiz well-well. Fear katch dem and dem kon dey wonder dey sey, “Na wonderful tin awa eye si today so o-o!”
26 Todos ficaram muito admirados; e, cheios de medo, louvaram a Deus, dizendo: — Que coisa maravilhosa nós vimos hoje!
27 Afta dis one, Jesus go out and e kon si one tax kollector sidan for where e for dey kollect tax, en name na Levi. Jesus kon tell am, “Make yu follow mi.”
27 Depois disso Jesus saiu e viu um cobrador de impostos, chamado Levi , sentado no lugar onde os impostos eram pagos. Jesus lhe disse:
28 Levi get up, leave evritin kon follow am.
28 Levi se levantou, deixou tudo e seguiu Jesus.
29 Den Levi do party for en house bikos of Jesus, so many tax kollectors and oda pipol kom chop with dem for di party.
29 Então Levi fez para Jesus uma grande festa na sua casa. Havia ali muitos cobradores de impostos, e outras pessoas estavam sentadas com eles.
30 But di Farisee pipol and some law tishas kon dey vex for Jesus disciples sey, “Why una dey chop and drink with tax kollectors and sinnas?”
30 Os fariseus e os mestres da Lei, que eram do partido dos fariseus, ficaram zangados com os discípulos de Jesus e perguntaram: — Por que vocês comem e bebem com os cobradores de impostos e com outras pessoas de má fama?
31 Jesus ansa dem, “Pipol wey well nor nid doctor, na only doz wey nor well, nid am.
31 Jesus respondeu:
32 I nor kom koll good pipol to turn from sin kom meet God, but na sinnas, I kom koll.”
32 Eu não vim para
33 Den some pipol tell Jesus, “John disciples dey fast and pray and di Farisee disciples dey do di same tin too, but yor disciples just dey chop and drink anyhow.”
33 Algumas pessoas disseram a Jesus: — Os discípulos de João Batista jejuam muitas vezes e fazem orações, e os discípulos dos
34 So Jesus ansa dem, “Yu go fit sey make pipol wey kom marriage dey fast wen di man wey dey marry dey der?
34 Jesus respondeu:
35 But time dey kom wen di man wey dey marry nor go dey with dem, dat time, dem go fast.”
35 Mas chegará o tempo em que o noivo será tirado do meio deles; então sim eles vão jejuar!
36 E still tell dem one parabol sey: “Nobody dey tear new klot take pash old one. If e do like dat, e go fit spoil di new klot and di new klot piece nor go mash di old one.
36 Jesus fez também esta comparação:
37 And nobody dey pour new wine inside old wine bag. If e do like dat, di new wine go tear di bag, di wine go trowey and di bag go skata.
37 Ninguém põe vinho novo em
38 Instead, pipol suppose pour new wine inside new wine bag.
38 Não. Vinho novo deve ser posto em odres novos.
39 Nobody go like to drink new wine afta e don drink old wine. Bikos e go sey, ‘Na di old wine betta pass.’ ”
39 E ninguém quer vinho novo depois de beber vinho velho, pois diz: “O vinho velho é melhor.”
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Lucas 5, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.