Lucas 4

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 Di Holy Spirit enter Jesus body kon karry am from Jordan River go inside wildaness.
1 Jesus, cheio do Espírito Santo, voltou do Jordão e foi levado pelo Espírito ao deserto,
2 For der, devil kon tempt am for forty days. Dat time, Jesus dey fast, so e nor chop food, but afta e fast finish, e kon dey hongry.
2 onde, durante quarenta dias, foi tentado pelo diabo. Não comeu nada durante esses dias e, ao fim deles, teve fome.
3 Devil kon tell am, “If na true sey yu bi God Pikin, make yu kommand dis stone make e turn to food.”
3 O diabo lhe disse: "Se você é o Filho de Deus, mande a esta pedra que se transforme em pão".
4 Den Jesus ansa, “God word sey, ‘Nor bi only food man suppose to chop for dis world, but na evry word wey God tok.’ ”
4 Jesus respondeu: "Está escrito: ‘Nem só de pão viverá o homem’ ".
5 Den devil take Jesus go on-top one mountin kon show am all di kingdom wey dey dis world.
5 O diabo o levou a um lugar alto e mostrou-lhe num relance todos os reinos do mundo.
6 Den e tell am, “I go give yu all dis place and all di honor wey follow am as yor kingdom, bikos dem don gi-am to mi and I fit gi-am to anybody wey I wont.
6 E lhe disse: "Eu lhe darei toda a autoridade sobre eles e todo o seu esplendor, porque me foram dados e posso dá-los a quem eu quiser.
7 So, if yu bow down woship mi, I go give yu evritin.”
7 Então, se você me adorar, tudo será seu".
8 Jesus ansa, “God word sey, ‘Na only God yu must woship and serve.’ ”
8 Jesus respondeu: "Está escrito: ‘Adore o Senhor, o seu Deus e só a ele preste culto’".
9 Den devil take Jesus go Jerusalem kon make am stand on-top di place where high pass for di temple kon tell am, “If yu really bi God Pikin, make yu jump go down,
9 O diabo o levou a Jerusalém, colocou-o na parte mais alta do templo e lhe disse: "Se você é o Filho de Deus, jogue-se daqui para baixo.
10 bikos God word sey,
10 Pois está escrito: ‘Ele dará ordens a seus anjos a seu respeito, para lhe guardarem;
11 and,
11 com as mãos eles os segurarão, para que você não tropece em alguma pedra’".
12 Jesus ansa am, “God word sey, ‘Make yu nor test God wey bi yor Oga God.’ ”
12 Jesus respondeu: "Dito está: ‘Não ponha à prova o Senhor, o seu Deus’".
13 So wen devil don tempt Jesus finish, e kon leave am until anoda time.
13 Tendo terminado todas essas tentações, o diabo o deixou até ocasião oportuna.
14 As di Holy Spirit pawa full Jesus body, e kon go back to Galilee and en story bigin spread for di whole aria.
14 Jesus voltou para a Galiléia no poder do Espírito, e por toda aquela região se espalhou a sua fama.
15 E bigin tish for dia sinagog and evribody kon dey praiz God.
15 Ensinava nas sinagogas, e todos o elogiavam.
16 Afta, Jesus go Nazaret where e for grow up, e enter di sinagog for Sabat Day as e dey always do and e kon get up make e read.
16 Ele foi a Nazaré, onde havia sido criado, e no dia de sábado entrou na sinagoga, como era seu costume. E levantou-se para ler.
17 Dem gi-am di book wey Profet Isaya rite. Jesus kon open am rish di place wey dem rite sey,
17 Foi-lhe entregue o livro do profeta Isaías. Abriu-o e encontrou o lugar onde está escrito:
18 “God Spirit dey my body,
18 "O Espírito do Senhor está sobre mim, porque ele me ungiu para pregar boas novas aos pobres. Ele me enviou para proclamar liberdade aos presos e recuperação da vista aos cegos, para libertar os oprimidos
19 and make I announce sey
19 e proclamar o ano da graça do Senhor".
20 Jesus klose di book kon gi-am back to di pesin wey dey hold am, den e go sidan. So evribody wey dey di sinagog kon dey look am.
20 Então ele fechou o livro, devolveu-o ao assistente e assentou-se. Na sinagoga todos tinham os olhos fitos nele;
21 Den Jesus tell dem, “Today, di tins wey dem rite for God word for where I read, don happen, just as una hear am wen I dey read am.”
21 e ele começou a dizer-lhes: "Hoje se cumpriu a Escritura que vocês acabaram de ouvir".
22 Evribody dey tok good about Jesus, dem sopraiz for di sweet-sweet word wey dey kom out from en mout. So dem kon ask, “Dis nor bi Josef pikin?”
22 Todos falavam bem dele, e estavam admirados com as palavras de graça que saíam de seus lábios. Mas perguntavam: "Não é este o filho de José? "
23 Jesus tell dem, “I know sey una go kwote proverb for mi sey, ‘Doctor, make yu cure yorsef!’ And una go sey, ‘For here wey bi yor home-town, wi won make yu do wetin wi hear sey yu do for Kapanaum.’ ”
23 Jesus lhes disse: "É claro que vocês me citarão este provérbio: ‘Médico, cura-te a ti mesmo! ’ Faze aqui em tua terra o que ouvimos que fizeste em Cafarnaum".
24 Jesus still sey, “Make I tell una true word, profet nor dey get respet for en home-town.
24 Continuou ele: "Digo-lhes a verdade: Nenhum profeta é aceito em sua terra.
25 But I tell una di trut, wimen wey dia husband don die many for Israel for Elijah time, wen God stop rain for three and half years and betta honga kon dey evriwhere.
25 Asseguro-lhes que havia muitas viúvas em Israel no tempo de Elias, quando o céu foi fechado por três anos e meio, e houve uma grande fome em toda a terra.
26 But God nor send Elijah go meet any of doz wimen, escept one woman wey en husband die for Zarefat inside Sidon.
26 Contudo, Elias não foi enviado a nenhuma delas, senão a uma viúva de Sarepta, na região de Sidom.
27 Pipol wey get leprosy many for Israel for profet Elisha time, but God nor heal any one escept Naaman, wey kom from Siria.”
27 Também havia muitos leprosos em Israel no tempo de Eliseu, o profeta; todavia, nenhum deles foi purificado: somente Naamã, o sírio".
28 Wen dem hear dis tins, all di pipol for di sinagog kon dey vex.
28 Todos os que estavam na sinagoga ficaram furiosos quando ouviram isso.
29 Dem push Jesus komot from di town kon take am go di hill wey dia town dey on-top, make dem for trow am down.
29 Levantaram-se, expulsaram-no da cidade e o levaram até ao topo da colina sobre a qual fora construída a cidade, a fim de atirá-lo precipício abaixo.
30 But Jesus pass dia centre, waka komot.
30 Mas Jesus passou por entre eles e retirou-se.
31 So Jesus kon go Kapanaum, wey dey Galilee and e bigin tish pipol for Sabat Day.
31 Então ele desceu a Cafarnaum, cidade da Galiléia, e, no sábado, começou a ensinar o povo.
32 Dem sopraiz well-well for en tishing, bikos e dey tok with authority.
32 Todos ficavam maravilhados com o seu ensino, porque falava com autoridade.
33 Inside di sinagog, one man wey evil spirit dey en body kon dey shaut,
33 Na sinagoga havia um homem possesso de um demônio, de um espírito imundo. Ele gritou com toda a força:
34 “Abeg, make yu leave us alone, Jesus wey kom from Nazaret! Yu don kom distroy us? I know who yu bi, yu bi God savant wey holy.”
34 "Ah! que queres conosco, Jesus de Nazaré? Vieste para nos destruir? Sei quem tu és: o Santo de Deus! "
35 But Jesus tell am: “Make yu shut up! Yu demon, komot for en body.” Di demon trow di man for groun for dia front kon komot for en body, but di man nor wound.
35 Jesus o repreendeu, e disse: "Cale-se e saia dele! " Então o demônio jogou o homem no chão diante de todos, e saiu dele sem o ferir.
36 Di pipol sopraiz kon dey ask each oda, “Wetin dey happen so? Dis man dey use God pawa take kommand demon and dem dey obey am!”
36 Todos ficaram admirados, e diziam uns aos outros: "Que palavra é esta? Até aos espíritos imundos ele dá ordens com autoridade e poder, e eles saem! "
37 So di news about Jesus kon spread enter di whole aria for Galilee.
37 E a sua fama se espalhava por toda a região circunvizinha.
38 Afta Jesus komot for di sinagog, e enter Simon house. Simon wife mama get fever and dem kon beg Jesus make e heal am.
38 Jesus saiu da sinagoga e foi à casa de Simão. A sogra de Simão estava com febre alta, e pediram a Jesus que fizesse algo por ela.
39 So Jesus stand near di woman kon kommand di fever komot for en body. Kwik-kwik, di woman get up, bigin kare for Jesus and di odas wey dey di house.
39 Estando ele em pé junto dela, inclinou-se e repreendeu a febre, que a deixou. Ela se levantou imediatamente e passou a servi-los.
40 As day dey dark, evribody wey get pipol wey nor well kon bring dem kom meet Jesus. E tosh dem for head and dem kon well.
40 Ao pôr-do-sol, o povo trouxe a Jesus todos os que tinham vários tipos de doenças; e ele os curou, impondo as mãos sobre cada um deles.
41 Demons dey shaut dey komot from many pipol body, dey sey, “Yu bi God Pikin!” But Jesus warn dem make dem nor tok, bikos dem know sey, naim bi di Mezaya.
41 Além disso, de muitas pessoas saíam demônios gritando: "Tu és o Filho de Deus! " Ele, porém, os repreendia e não permitia que falassem, porque sabiam que ele era o Cristo.
42 Wen day break, Jesus komot go one place where nobody dey. But pipol find am rish der and dem kon dey try to hold am make e nor for leave dem.
42 Ao romper do dia, Jesus foi para um lugar solitário. As multidões o procuravam, e, quando chegaram até onde ele estava, insistiam que não as deixasse.
43 But Jesus tell dem, “I must prish dis Good News about God Kingdom give pipol wey dey oda towns, bikos na wetin God send mi kom do, bi dat.”
43 Mas ele disse: "É necessário que eu pregue as boas novas do Reino de Deus noutras cidades também, porque para isso fui enviado".
44 So e kontinue to prish for di sinagogs wey dey Judea.
44 E continuava pregando nas sinagogas da Judéia.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Lucas 4, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.