Lucas 3
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI
1 Tiberius Caesar don dey rule for fifteen years wen Pontius Pilate bi govnor for Judea and Herod dey rule Galilee, en broda Filip dey rule Iturea and Trakonitis aria and Lysanias dey rule Abilene.
1 No décimo quinto ano do reinado de Tibério César, quando Pôncio Pilatos era governador da Judéia; Herodes, tetrarca da Galiléia; seu irmão Filipe, tetrarca da Ituréia e Traconites; e Lisânias, tetrarca de Abilene;
2 For dat time, na Annas and Kaiafas bi di High Priests. So God kon tok to John, wey bi Zekaraya pikin, for inside wildaness.
2 Anás e Caifás exerciam o sumo sacerdócio. Foi nesse ano que veio a palavra do Senhor a João, filho de Zacarias, no deserto.
3 John kon go all di aria wey dey round Jordan River dey prish sey make pipol turn from dia sin kom meet God and make dem baptize, so dat God go forgive dem.
3 Ele percorreu toda a região próxima ao Jordão, pregando um batismo de arrependimento para o perdão dos pecados.
4 As Profet Isaya tok for di book wey e rite sey,
4 Como está escrito no livro das palavras de Isaías, o profeta: "Voz do que clama no deserto: ‘Preparem o caminho para o Senhor, façam veredas retas para ele.
5 Evry place wey low,
5 Todo vale será aterrado e todas as montanhas e colinas, niveladas. As estradas tortuosas serão endireitadas e os caminhos acidentados, aplanados.
6 and evribody for dis world go si God salvashon.’ ”
6 E toda a humanidade verá a salvação de Deus’".
7 So John tell di pipol wey kom make e for baptize dem sey, “Una wey bi snake shidren! Who warn una make una run komot from God ponishment wey dey kom?
7 João dizia às multidões que saíam para serem batizadas por ele: "Raça de víboras! Quem lhes deu a idéia de fugir da ira que se aproxima?
8 Naw, make una bear fruit wey go show sey una don really turn from sin kom meet God, make una nor start to sey, ‘Abraham na awa papa.’ Bikos God fit take dis stones wey dey for groun take make pikin for Abraham!
8 Dêem frutos que mostrem o arrependimento. E não comecem a dizer a si mesmos: ‘Abraão é nosso pai’. Pois eu lhes digo que destas pedras Deus pode fazer surgir filhos a Abraão.
9 Even naw sef, di axe don ready to kut di tree wey nor dey bear betta fruit, dem go kut am down kon trow am inside fire.”
9 O machado já está posto à raiz das árvores, e toda árvore que não der bom fruto será cortada e lançada ao fogo".
10 So di pipol kon ask am, “Wetin wi go do naw?”
10 "O que devemos fazer então? ", perguntavam as multidões.
11 John ansa dem, “Di pesin wey get two klot must give one to pesin wey nor get at-all and di pesin wey get food must share with pesin wey nor get.”
11 João respondia: "Quem tem duas túnicas reparta-as com quem não tem nenhuma; e quem tem comida faça o mesmo".
12 Tax kollectors too waka kom make John for baptize dem and dem kon ask am, “Tisha, wetin wi go do?”
12 Alguns publicanos também vieram para serem batizados. Eles perguntaram: "Mestre, o que devemos fazer? "
13 John tell dem, “Make una nor kollect money pass di one wey di law tok.”
13 Ele respondeu: "Não cobrem nada além do que lhes foi estipulado".
14 Den some sojas kon still ask am, “Wot of us? Wetin wi go do?”
14 Então alguns soldados lhe perguntaram: "E nós, o que devemos fazer? " Ele respondeu: "Não pratiquem extorsão nem acusem ninguém falsamente; contentem-se com o seu salário".
15 All di pipol kon dey wonder weda John, naim bi di Mezaya wey dem dey wait for.
15 O povo estava em grande expectativa, questionando em seus corações se acaso João não seria o Cristo.
16 John ansa dem, “Na ordinary wota I take dey baptize una, but di pesin wey big pass mi, dey kom, I nor rish who go luz di rope wey dey en shoe. E go baptize una with di Holy Spirit and fire.
16 João respondeu a todos: "Eu os batizo com água. Mas virá alguém mais poderoso do que eu, tanto que não sou digno nem de curvar-me e desamarrar as correias das suas sandálias. Ele os batizará com o Espírito Santo e com fogo.
17 E whole shovel for hand to harvest di korn keep for en store, but e go burn di korn kanda with fire wey nor dey kwensh.”
17 Ele traz a pá em sua mão, a fim de limpar sua eira e juntar o trigo em seu celeiro; mas queimará a palha com fogo que nunca se apaga".
18 Na so John prish di Good News for di pipol.
18 E com muitas outras palavras João exortava o povo e lhe pregava as boas novas.
19 But wen John tell Herod wey bi govnor sey, God dey vex with am, bikos of en broda wife, Herodias, wey e marry and all di bad-bad tins wey e do,
19 Todavia, quando João repreendeu Herodes, o tetrarca, por causa de Herodias, mulher do próprio irmão de Herodes, e por todas as outras coisas más que ele tinha feito,
20 Herod take all dis join di vexnashon wey e get for John, so e kon lock am for prison.
20 Herodes acrescentou a todas elas a de colocar João na prisão.
21 So wen all di pipol don baptize, Jesus ensef kon baptize too. Wen e dey pray, heaven open,
21 Quando todo o povo estava sendo batizado, também Jesus o foi. E, enquanto ele estava orando, o céu se abriu
22 di Holy Spirit kom down for en head like dove. Den one vois tok from heaven sey, “Yu bi my Pikin wey I love well-well and yu dey make belle sweet mi.”
22 e o Espírito Santo desceu sobre ele em forma corpórea, como pomba. Então veio do céu uma voz: "Tu és o meu Filho amado; em ti me agrado".
23 Jesus start en ministry wen e bi thirty years.
23 Jesus tinha cerca de trinta anos de idade quando começou seu ministério. Ele era, como se pensava, filho de José, filho de Eli,
24 Heli na Mattat pikin, wey Levi born.
24 filho de Matate, filho de Levi, filho de Melqui, filho de Janai, filho de José,
25 Josef na Mattatias pikin wey bi Amos pikin, wey bi Nahum pikin, wey bi Esli pikin, wey bi Naggai pikin.
25 filho de Matatias, filho de Amós, filho de Naum, filho de Esli, filho de Nagai,
26 Naggai na Maat pikin, wey bi Mattatias pikin, wey bi Semein pikin, wey bi Josek pikin, wey bi Joda pikin.
26 filho de Maate, filho de Matatias, filho de Semei, filho de Joseque, filho de Jodá,
27 Joda na Joanan pikin, wey bi Rhesa pikin, wey bi Zerubabel pikin, wey bi Shealtiel pikin, wey bi Neri pikin.
27 filho de Joanã, filho de Ressa, filho de Zorobabel, filho de Salatiel, filho de Neri,
28 Neri na Melchi pikin, wey bi Addi pikin, wey bi Kosam pikin, wey bi Elmadam pikin, wey bi Er pikin.
28 filho de Melqui, filho de Adi, filho de Cosã, filho de Elmadã, filho de Er,
29 Er na Joshua pikin, wey bi Elieza pikin, wey bi Jorim pikin, wey bi Mattat pikin, wey bi Levi pikin.
29 filho de Josué, filho de Eliézer, filho de Jorim, filho de Matate, filho de Levi,
30 Levi na Simeon pikin, wey bi Judah pikin, wey bi Josef pikin, wey bi Jonam pikin, wey Eliakim born.
30 filho de Simeão, filho de Judá, filho de José, filho de Jonã, filho de Eliaquim,
31 Eliakim na Melea pikin, wey bi Menna pikin, wey bi Mattata pikin, wey bi Natan pikin, wey bi David pikin.
31 filho de Meleá, filho de Mená, filho de Matatá, filho de Natã, filho de Davi,
32 Jesse wey Obed born, naim bi David papa. Obed papa na Boaz, wey bi Salmon pikin, wey bi Nashon pikin.
32 filho de Jessé, filho de Obede, filho de Boaz, filho de Salmom, filho de Naassom,
33 Amminadab wey bi Admin pikin, naim born Nashon. Admin papa na Arni, wey bi Hezron pikin, wey bi Perez pikin wey Judah born.
33 filho de Aminadabe, filho de Ram, filho de Esrom, filho de Perez, filho de Judá,
34 Jakob wey Isaak born, naim bi Judah papa. Abraham born Isaak and na Terah wey Nahor born, bi Abraham papa.
34 filho de Jacó, filho de Isaque, filho de Abraão, filho de Terá, filho de Naor,
35 Nahor na Serug pikin, wey bi Reu pikin, wey bi Peleg pikin, wey bi Eber pikin, wey bi Shela pikin.
35 filho de Serugue, filho de Ragaú, filho de Faleque, filho de Éber, filho de Salá,
36 Kainan wey Arfaxad born, naim bi Shela papa. Arfaxad na Shem pikin, and Noah wey Lamek born, naim bi Shem papa.
36 filho de Cainã, filho de Arfaxade, filho de Sem, filho de Noé, filho de Lameque,
37 Lamek na Metuselah pikin, wey bi Enoch pikin, wey bi Jared pikin and Mahalalel wey Kenan born, naim bi Jared papa.
37 filho de Matusalém, filho de Enoque, filho de Jarede, filho de Maalaleel, filho de Cainã,
38 Kenan na Enosh pikin, wey bi Seth pikin, wey bi Adam pikin and na God kreate Adam.
38 filho de Enos, filho de Sete, filho de Adão, filho de Deus.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Lucas 3, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.