Lucas 16

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NTLH

Sair da comparação
NTLH Nova Tradução na Linguagem de Hoje 2000
1 Jesus tell en disciples, “E get one rish man wey hear sey en manaja dey waste en money.
1 Jesus disse aos seus discípulos:
2 So e koll di manaja kon tell am, ‘I nor like wetin I dey hear about yu. Make yu go rite how yu take dey spend all my money, bikos yu nor go bi my manaja again.’
2 Por isso ele o chamou e disse: “Eu andei ouvindo umas coisas a respeito de você. Agora preste contas da sua administração porque você não pode mais continuar como meu administrador.”
3 “Den di manaja tell ensef, ‘Wetin I go do naw? My oga won sak mi and I nor strong rish to dig and na shame for mi to go beg.
3 — Aí o administrador pensou: “O patrão está me despedindo. E, agora, o que é que eu vou fazer? Não tenho forças para cavar a terra e tenho vergonha de pedir esmola.
4 I know wetin I go do, so dat wen my oga sak mi, I go get friends wey go welkom mi for dia house.’
4 Ah! Já sei o que vou fazer… Assim, quando for mandado embora, terei amigos que me receberão nas suas casas.”
5 “So e gada all di pipol wey dey hold en oga money. E kon ask di first one, ‘How mush yu dey whole my oga?’
5 — Então ele chamou todos os devedores do patrão e perguntou para o primeiro: “Quanto é que você está devendo para o meu patrão?”
6 “Di man ansa, ‘One hundred gallon olive oil.’ Di manaja kon sey, ‘Take dis paper, sidan kwik-kwik make yu rite fifty.’
6 — “Cem barris de azeite!” — respondeu ele.
7 “Den e ask anoda one, ‘How mush yu dey whole?’
7 — Para o outro ele perguntou: “E você, quanto está devendo?”
8 “Di oga praiz di wayo manaja, bikos of di wayo sense wey e use. Bikos dis world pipol sabi use dia wayo sense for business pass pipol wey dey for lite.
8 — E o patrão desse administrador desonesto o elogiou pela sua esperteza. E Jesus continuou:
9 So I tell una true word, make una use una money well, so dat una go make friends for unasef and wen di money finish, God go welkom una for en kingdom wey go dey forever.
9 Por isso eu digo a vocês: usem as riquezas deste mundo para conseguir amigos a fim de que, quando as riquezas faltarem, eles recebam vocês no lar eterno.
10 “Anybody wey fit handle small tins, go fit handle big tins too and anybody wey do wayo for small tins, go still do wayo for big ones too.
10 Quem é fiel nas coisas pequenas também será nas grandes; e quem é desonesto nas coisas pequenas também será nas grandes.
11 If pipol nor trust yu with money for dis world, God nor go fit give yu en rishis for heaven.
11 Pois, se vocês não forem honestos com as riquezas deste mundo, quem vai pôr vocês para tomar conta das riquezas verdadeiras?
12 And if pipol nor fit trust yu with dia propaty, na who go give yu yor own?
12 E, se não forem honestos com o que é dos outros, quem lhes dará o que é de vocês?
13 “No savant go fit serve two oga, bikos e must hate one kon love di oda one, or e go serve one with all en body dan di oda one. So, yu nor go fit serve God and money for di same time.”
13 — Um escravo não pode servir a dois donos ao mesmo tempo, pois vai rejeitar um e preferir o outro; ou será fiel a um e desprezará o outro. Vocês não podem servir a Deus e também servir ao dinheiro.
14 Wen di Farisee pipol (wey like money) hear dis one, dem kon dey take Jesus make yeye.
14 Os fariseus ouviram isso e zombaram de Jesus porque amavam o dinheiro.
15 But Jesus tell dem, “Na una dey make unasef good for pipol eye, but God know una heart. Bikos wetin human being value well-well, naim God nor like.
15 Então Jesus disse a eles:
16 “Moses Law and di tins wey di profets rite, naim pipol dey follow, before John di Baptist kom. But since e kom, dem don dey prish di Good News about God Kingdom and evribody won force ensef enter.
16 — A
17 E betta make heaven and eart vanish, dan make even di small-small laws dey yuzles.
17 — É mais fácil o céu e a terra desaparecerem do que ser tirado um simples acento de qualquer palavra da Lei.
18 “Any man wey drive en wife, den marry anoda woman, don kommit adultery and di man wey marry woman wey leave en husband, don kommit adultery too.”
18 — Se um homem se divorciar e casar com outra mulher, comete adultério. E quem casar com a mulher divorciada também comete adultério.
19 “E get one rish man wey dey wear dear-dear klot and e dey enjoy life evriday.
19 Jesus continuou:
20 But for en gate, one poor man wey en name bi Lazarus and sore full en body, liedan for der,
20 Havia também um homem pobre, chamado Lázaro, que tinha o corpo coberto de feridas, e que costumavam largar perto da casa do rico.
21 e dey wait to chop wetin fall from di rish man tabol. Dogs sef dey kom lick di sore for en body.
21 Lázaro ficava ali, procurando matar a fome com as migalhas que caíam da mesa do homem rico. E até os cachorros vinham lamber as suas feridas.
22 “Di poor man kon die and angels karry am go where Abraham dey. Di rish man still die too and dem beri am.
22 O pobre morreu e foi levado pelos anjos para junto de Abraão, na festa do céu. O rico também morreu e foi sepultado.
23 As di rish man dey for hell-fire dey sofa, e kon look up si Abraham for far with Lazarus for en korna.
23 Ele sofria muito no
24 Naim e shaut, ‘Papa Abraham, make yu sorry for mi, abeg send Lazarus make e put en finger for wota kon tosh my mout, bikos I dey sofa inside dis fire.’
24 Então gritou: “Pai Abraão, tenha pena de mim! Mande que Lázaro molhe o dedo na água e venha refrescar a minha língua porque estou sofrendo muito neste fogo!”
25 “But Abraham ansa, ‘My pikin, remember sey wen yu dey alive, yu dey enjoy good tins, but Lazarus nor enjoy at-all. But naw, e dey enjoy for here and yu dey sofa for der.
25 — Mas Abraão respondeu: “Meu filho, lembre que você recebeu na sua vida todas as coisas boas, porém Lázaro só recebeu o que era mau. E agora ele está feliz aqui, enquanto você está sofrendo.
26 Nor bi only dat one sef, but dem block di centre, so dat pipol wey won cross from here go meet una, nor go fit and nobody go fit from una side cross kom meet us.’
26 Além disso, há um grande abismo entre nós, de modo que os que querem atravessar daqui até vocês não podem, como também os daí não podem passar para cá.”
27 “So di rish man kon sey, ‘Abeg yu papa, make yu send Lazarus go my papa house for di world,
27 — O rico disse: “Nesse caso, Pai Abraão, peço que mande Lázaro até a casa do meu pai
28 (bikos I get five brodas), so dat e go warn dem, make dem nor for kom sofa for dis place.’
28 porque eu tenho cinco irmãos. Deixe que ele vá e os avise para que assim não venham para este lugar de sofrimento.”
29 “But Abraham ansa, ‘Moses and di profets dey with yor brodas for di world, so make dem listin to dia word.’
29 — Mas Abraão respondeu: “Os seus irmãos têm a
30 “Di rish man kon sey, ‘No, sir! But if pesin wey don die go meet dem, dem go turn from sin kom meet God.’
30 — “Só isso não basta, Pai Abraão!”, respondeu o rico. “Porém, se alguém ressuscitar e for falar com eles, aí eles se arrependerão dos seus pecados.”
31 “Abraham ansa am, ‘If dem nor gri listin to Moses and di profets, dem nor go still listin, even if pesin wey don die go back go meet dem.’ ”
31 — Mas Abraão respondeu: “Se eles não escutarem Moisés nem os profetas, não crerão, mesmo que alguém ressuscite.”

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Lucas 16, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.