Lucas 15
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ACF
1 Anytime Jesus dey prish, tax kollectors and sinnas dey kom listin to am.
1 E Chegavam-se a ele todos os publicanos e pecadores para o ouvir.
2 But di Farisee pipol and di law tishas dey komplain sey, “Dis man dey follow sinnas chop.”
2 E os fariseus e os escribas murmuravam, dizendo: Este recebe pecadores, e come com eles.
3 So, Jesus kon tell dem dis parabol:
3 E ele lhes propôs esta parábola, dizendo:
4 “If yu get hundred sheep and one lost, yu nor go leave di ninty-nine wey remain go find dat one till yu si am?
4 Que homem dentre vós, tendo cem ovelhas, e perdendo uma delas, não deixa no deserto as noventa e nove, e vai após a perdida até que venha a achá-la?
5 Den wen yu si am, yu go karry am for shoulder, dey happy.
5 E achando-a, a põe sobre os seus ombros, jubiloso;
6 Wen yu rish house, yu go koll yor friends and neighbours sey, ‘Make una kom follow mi happy, bikos I don si my sheep wey lost before.’
6 E, chegando a casa, convoca os amigos e vizinhos, dizendo-lhes: Alegrai-vos comigo, porque já achei a minha ovelha perdida.
7 I tell una true word, na so happiness dey for heaven wen one sina turn from sin kom meet God, pass ninty-nine good pipol wey don already dey with God.
7 Digo-vos que assim haverá alegria no céu por um pecador que se arrepende, mais do que por noventa e nove justos que não necessitam de arrependimento.
8 “Or, if one woman get ten koins and one lost, wetin e go do? E nor go lite lamp, swip di whole house until e si am?
8 Ou qual a mulher que, tendo dez dracmas, se perder uma dracma, não acende a candeia, e varre a casa, e busca com diligência até a achar?
9 Wen e don si am, e go koll en friends and neighbours gada kon sey, ‘Make una kom follow mi happy, bikos I don si my money wey lost before.’
9 E achando-a, convoca as amigas e vizinhas, dizendo: Alegrai-vos comigo, porque já achei a dracma perdida.
10 I tell una true word, na so God angels dey happy, wen one sina turn from sin kom meet God.”
10 Assim vos digo que há alegria diante dos anjos de Deus por um pecador que se arrepende.
11 Den Jesus sey, “One man dey wey get two sons.
11 E disse: Um certo homem tinha dois filhos;
12 Di yonga one kon tell en papa, ‘Give mi my own share for awa propaty.’ So en papa kon gi-am.
12 E o mais moço deles disse ao pai: Pai, dá-me a parte dos bens que me pertence. E ele repartiu por eles a fazenda.
13 “Afta sometaim, di yong boy karry evritin wey e get travel go one far kountry kon waste all en money for yeye life.
13 E, poucos dias depois, o filho mais novo, ajuntando tudo, partiu para uma terra longínqua, e ali desperdiçou os seus bens, vivendo dissolutamente.
14 Wen e don finish all wetin e get, e nor si anytin to chop, bikos honga dey for dat kountry, so e kon dey sofa.
14 E, havendo ele gastado tudo, houve naquela terra uma grande fome, e começou a padecer necessidades.
15 E kon dey work for one man for der, di man dey send am go en farm go give pig food.
15 E foi, e chegou-se a um dos cidadãos daquela terra, o qual o mandou para os seus campos, a apascentar porcos.
16 Di honga kon make am dey won chop di food wey di pig dem dey chop, bikos nobody gi-am food.
16 E desejava encher o seu estômago com as bolotas que os porcos comiam, e ninguém lhe dava nada.
17 “But wen en eye klear, e kon sey, ‘All my papa workers get food wey dem nor fit chop finish, but hongry don nearly kill mi for here!
17 E, tornando em si, disse: Quantos jornaleiros de meu pai têm abundância de pão, e eu aqui pereço de fome!
18 I go get up go meet my papa tell am, “Papa I don sin against heaven and against yu.
18 Levantar-me-ei, e irei ter com meu pai, e dir-lhe-ei: Pai, pequei contra o céu e perante ti;
19 I nor rish make dem koll mi yor pikin again. Make yu take mi as yor worker.” ’
19 Já não sou digno de ser chamado teu filho; faze-me como um dos teus jornaleiros.
20 So e get up kon go meet en papa.
20 E, levantando-se, foi para seu pai; e, quando ainda estava longe, viu-o seu pai, e se moveu de íntima compaixão e, correndo, lançou-se-lhe ao pescoço e o beijou.
21 “Den di pikin tell am, ‘Papa, I don sin against heaven and yu. I nor rish make dem koll mi yor pikin again. Make yu take mi as yor worker.’
21 E o filho lhe disse: Pai, pequei contra o céu e perante ti, e já não sou digno de ser chamado teu filho.
22 “But di papa koll en savants kon tell dem, ‘Make una bring di best klot, ring and shoe and make una wear dem for my pikin.
22 Mas o pai disse aos seus servos: Trazei depressa a melhor roupa; e vesti-lho, e ponde-lhe um anel na mão, e alparcas nos pés;
23 Den, make una go take di melu wey fat pass, kill-am make wi do party,
23 E trazei o bezerro cevado, e matai-o; e comamos, e alegremo-nos;
24 bikos dis my pikin die before, but naw, e don kom back to life, e lost before, but naw, I don si am!’ So di party kon start.
24 Porque este meu filho estava morto, e reviveu, tinha-se perdido, e foi achado. E começaram a alegrar-se.
25 “By dat time, di senior son dey kom from farm where e go work. Wen e don near house, e kon dey hear music and si pipol dey dance.
25 E o seu filho mais velho estava no campo; e quando veio, e chegou perto de casa, ouviu a música e as danças.
26 So e koll one savant kon ask am, ‘Wetin dey happen?’
26 E, chamando um dos servos, perguntou-lhe que era aquilo.
27 Di savant ansa, ‘Yor broda don kom back and yor papa don kill di melu wey fat pass, bikos e kom back well and nor-tin bad happen to am.’
27 E ele lhe disse: Veio teu irmão; e teu pai matou o bezerro cevado, porque o recebeu são e salvo.
28 “Di senior broda kon dey vex and e nor gri enter house, so en papa kon beg am make e enter.
28 Mas ele se indignou, e não queria entrar.
29 So, e tell en papa, ‘Si, all dis many years I dey work like slave for yu and e nor get anytime wey I disobey yu, but yu neva give mi even one small goat make I do party with my friends.
29 E saindo o pai, instava com ele. Mas, respondendo ele, disse ao pai: Eis que te sirvo há tantos anos, sem nunca transgredir o teu mandamento, e nunca me deste um cabrito para alegrar-me com os meus amigos;
30 But wen dis yor pikin kom back afta e don waste all yor money with ashawo, yu kon kill di melu wey fat pass for am!’
30 Vindo, porém, este teu filho, que desperdiçou os teus bens com as meretrizes, mataste-lhe o bezerro cevado.
31 “Den di papa tell am, ‘My pikin, yu always dey here with mi and evritin wey I get na yor own.
31 E ele lhe disse: Filho, tu sempre estás comigo, e todas as minhas coisas são tuas;
32 But e good make I do party, bikos yor broda die before, but naw, e don kom back to life, e lost before, but naw, wi don si am.’ ”
32 Mas era justo alegrarmo-nos e folgarmos, porque este teu irmão estava morto, e reviveu; e tinha-se perdido, e achou-se.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Lucas 15, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.