Lucas 14

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVT

Sair da comparação
NVT Nova Versão Transformadora
1 For one Sabat Day, wen Jesus go chop for one Farisee oga house, di pipol kon dey look am,
1 Certo sábado, Jesus foi comer na casa de um líder fariseu, onde o observavam atentamente.
2 bikos one man wey en hand and leg swell-up, stand for en front.
2 Estava ali um homem com o corpo muito inchado.
3 Jesus kon ask di pipol wey sabi di law well-well and di Farisee pipol sey, “E dey rite to heal for Sabat Day?”
3 Jesus perguntou aos fariseus e aos especialistas da lei: “A lei permite ou não curar no sábado?”.
4 Dem nor tok anytin. Naim Jesus hold di man, heal am kon sey make e dey go.
4 Eles nada responderam, e Jesus tocou no homem enfermo, o curou e o mandou embora.
5 Den Jesus tell dem, “If any of una get pikin or melu wey fall inside well for Sabat Day, una nor go kwik-kwik draw am kom out?”
5 Depois, perguntou a eles: “Qual de vocês, se seu filho ou seu boi cair num buraco, não se apressará em tirá-lo de lá, mesmo que seja sábado?”.
6 But dem nor fit ansa.
6 Mais uma vez, não puderam responder.
7 Wen Jesus si how di pipol wey dem invite dey rush to sidan for betta chair, e kon tell dem one parabol:
7 Quando Jesus observou que os convidados para o jantar procuravam ocupar os lugares de honra à mesa, deu-lhes este conselho:
8 “Wen dem invite yu go party, nor rush go sidan for betta chair, bikos di pesin wey dey do di party fit don invite pesin wey big pass yu.
8 “Quando você for convidado para um banquete de casamento, não ocupe o lugar de honra. E se chegar algum convidado mais importante que você?
9 Den di pesin wey invite two of una go tell yu, ‘Get up make dis man sidan.’ Den with shame, yu go-go sidan for back.
9 O anfitrião virá e dirá: ‘Dê o seu lugar a esta pessoa’, e você, envergonhado, terá de sentar-se no último lugar da mesa.
10 But wen dem invite yu, make yu sidan for back chair, so dat wen di pesin wey dey do di party si yu, e go sey, ‘My friend, kom sidan for dis betta place for front.’ Den all di pipol wey dey follow yu chop, go give yu respet.
10 “Em vez disso, ocupe o lugar menos importante à mesa. Assim, quando o anfitrião o vir, dirá: ‘Amigo, temos um lugar melhor para você!’. Então você será honrado diante de todos os convidados.
11 Anybody wey dey karry body up, dem go bring am down and anybody wey put en body for groun, dem go karry am up.”
11 Pois os que se exaltam serão humilhados, e os que se humilham serão exaltados”.
12 Jesus still tell di man wey invite am, “Wen yu dey do party, nor invite yor friends, brodas, rilashons and neighbours wey get money, so dat wen dem dey do dia own party, dem go invite yu too.
12 Então Jesus se voltou para o anfitrião e disse: “Quando oferecer um banquete ou jantar, não convide amigos, irmãos, parentes e vizinhos ricos. Eles poderão retribuir o convite, e essa será sua única recompensa.
13 Instead wen yu dey do big party, make yu invite poor pipol, pipol wey dia leg or hand kut komot, pipol wey nor fit waka and pipol wey nor dey si.
13 Em vez disso, convide os pobres, os aleijados, os mancos e os cegos.
14 Den, God go bless yu, bikos dem nor go fit pay yu back, but na God go pay yu wen E go raiz en pipol from deat; di pipol wey do wetin E like.”
14 Assim, na ressurreição dos justos, você será recompensado por ter convidado aqueles que não podiam lhe retribuir”.
15 Wen one of di pipol for di party hear wetin Jesus tok, e kon tell Jesus, “God don bless evribody wey go chop for di party for en kingdom!”
15 Ao ouvir isso, um homem que estava à mesa com Jesus exclamou: “Feliz será aquele que participar do banquete no reino de Deus!”.
16 But Jesus tell am, “One man do big party kon invite many pipol kom.
16 Jesus respondeu com a seguinte parábola: “Certo homem preparou um grande banquete e enviou muitos convites.
17 Wen di party time rish, e kon tell en savant make dem go tell evribody wey e invite sey, ‘Make una kom, bikos evritin don ready.’
17 Quando estava tudo pronto, mandou seu servo dizer aos convidados: ‘Venham, o banquete está pronto’.
18 “But all of dem kon dey komplain one-by-one. Di first one sey, ‘I just buy land and I won go si am. Abeg, make yu nor vex.’
18 Mas todos eles deram desculpas. Um disse: ‘Acabei de comprar um campo e preciso inspecioná-lo. Peço que me desculpe’.
19 “Anoda one sey, ‘I just buy ten melu and I dey go look how dem bi. Abeg, make yu nor vex.’ Melu|alt="Oxen" src="LB00018B.TIF" size="col" loc="14:19" copy="LB" ref="14:19"
19 Outro disse: ‘Acabei de comprar cinco juntas de bois e quero experimentá-las. Sinto muito’.
20 “Di last one kon sey, ‘I nor go fit kom, bikos I just marry new wife.’
20 Ainda outro disse: ‘Acabei de me casar e não posso ir’.
21 “So di savant kom back kon tell en oga evritin wey dem tok. Di oga vex well-well kon tell di savant, ‘Make yu go all di street and korna-korna wey dey dis town, go bring poor pipol: pipol wey dia leg or hand kut komot and pipol wey nor fit waka kon di party.’
21 “O servo voltou e informou a seu senhor o que tinham dito. Ele ficou furioso e ordenou: ‘Vá depressa pelas ruas e becos da cidade e convide os pobres, os aleijados, os cegos e os mancos’.
22 “Afta, di savant sey, ‘Oga God, I don do wetin yu tok and di party neva still full.’
22 Depois de cumprir essa ordem, o servo informou: ‘Ainda há lugar para mais gente’.
23 “So di oga tell di savant, ‘Make yu go main road and enter evriwhere for di aria, tell pipol make dem kom, so dat my house go full.’
23 Então o senhor disse: ‘Vá pelas estradas do campo e junto às cercas entre as videiras e insista com todos que encontrar para que venham, de modo que minha casa fique cheia.
24 Bikos I tell yu, nobody among doz pipol wey I first invite, go taste my food!”
24 Pois nenhum dos que antes foram convidados provará do meu banquete’”.
25 Plenty pipol dey waka follow Jesus for road, so e turn look dem kon sey:
25 Uma grande multidão seguia Jesus, que se voltou para ela e disse:
26 “If anybody kom meet mi and e nor love mi pass en papa, mama, wife, pikin, brodas and sistas, even en ownsef, e nor go fit bi my disciple.
26 “Se alguém que me segue amar pai e mãe, esposa e filhos, irmãos e irmãs, e até mesmo a própria vida, mais que a mim, não pode ser meu discípulo.
27 Anybody wey nor gri karry en cross follow mi, nor fit bi my disciple.
27 E, se não tomar sua cruz e me seguir, não pode ser meu discípulo.
28 “Wish of una wey won build big house, nor go first kakulate weda di money wey e get go rish to finish am?
28 “Quem começa a construir uma torre sem antes calcular o custo e ver se possui dinheiro suficiente para terminá-la?
29 If e nor do so, wen e don lay di foundashon and e nor fit finish di house, evribody wey si wetin happen, go kon dey laf am.
29 Pois, se completar apenas os alicerces e ficar sem dinheiro, todos rirão dele,
30 Dem go sey, ‘Dis man start to build house and e nor fit finish am!’
30 dizendo: ‘Esse aí começou a construir, mas não conseguiu terminar!’.
31 “Abi wish king wey won go fight anoda king, nor go first sidan tink weda di 10,000 men wey e get go fit fight di 20,000 wey di oda king get?
31 “Ou que rei iria à guerra sem antes avaliar se seu exército de dez mil poderia derrotar os vinte mil que vêm contra ele?
32 If e si sey e nor go fit win, e go send messenja wen di oda king still dey far, go ask am how dem go take setol.
32 E, se concluir que não, o rei enviará uma delegação para negociar um acordo de paz enquanto o inimigo está longe.
33 Like dis too, nobody fit bi my disciple if e nor komot en mind from evritin wey e get.
33 Da mesma forma, ninguém pode se tornar meu discípulo sem abrir mão de tudo que possui.
34 “Salt good, but if e nor get taste, how dem go fit make am sweet again?
34 “O sal é bom para temperar, mas, se perder o sabor, como torná-lo salgado outra vez?
35 Pipol nor go fit use am do anytin, na trowey dem go trowey am. Anybody wey get ear, make e hear wetin I dey tok!”
35 O sal sem sabor não serve nem para o solo nem para adubo; é jogado fora. Quem é capaz de ouvir, ouça com atenção!”.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Lucas 14, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.