Lucas 13
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA
1 Some pipol wey dey der wen Jesus dey tok kon tell am how Pilate kill some Galilee pipol kon mix dia blood with dia sakrifice.
1 Naquela mesma ocasião, chegando alguns, falavam a Jesus a respeito dos galileus cujo sangue Pilatos misturara com os sacrifícios que os mesmos realizavam.
2 Jesus ansa dem, “Una tink sey na doz Galilee pipol sin pass evribody, bikos dem sofa all dis tins?
2 Ele, porém, lhes disse: Pensais que esses galileus eram mais pecadores do que todos os outros galileus, por terem padecido estas coisas?
3 I tell una true word, nor bi so e bi! Unless una turn from sin kom meet God, all of una go die too!
3 Não eram, eu vo-lo afirmo; se, porém, não vos arrependerdes, todos igualmente perecereis.
4 Doz eighteen pipol wey die wen towa fall for dia head for Siloam, una tink sey na dia sin big pass for Jerusalem?
4 Ou cuidais que aqueles dezoito sobre os quais desabou a torre de Siloé e os matou eram mais culpados que todos os outros habitantes de Jerusalém?
5 I tell una true word, nor bi so e bi! Unless una turn from sin kom meet God, all of una go die too!”
5 Não eram, eu vo-lo afirmo; mas, se não vos arrependerdes, todos igualmente perecereis.
6 Jesus tell dem dis parabol, “One man plant fig tree for en farm, so e kon dey look for fruit from di tree, but e nor si.
6 Então, Jesus proferiu a seguinte parábola: Certo homem tinha uma figueira plantada na sua vinha e, vindo procurar fruto nela, não achou.
7 Naim e kon tell doz wey dey wosh di farm sey, ‘Since three years naw, I dey fine fruit for dis tree, but wen I look, I nor dey si. So, make una kut am down! Why wi still let am dey take space?’
7 Pelo que disse ao viticultor: Há três anos venho procurar fruto nesta figueira e não acho; podes cortá-la; para que está ela ainda ocupando inutilmente a terra?
8 But di farmer ansa, ‘Oga God, still leave am for dis year make I put fertaliza,
8 Ele, porém, respondeu: Senhor, deixa-a ainda este ano, até que eu escave ao redor dela e lhe ponha estrume.
9 Den if e bear fruit next year, wi go leave am, but if e nor bear, yu fit kut am trowey.’ ”
9 Se vier a dar fruto, bem está; se não, mandarás cortá-la.
10 Wen Jesus dey tish for one sinagog for Sabat Day,
10 Ora, ensinava Jesus no sábado numa das sinagogas.
11 one woman wey evil spirit bend en body for eighteen years dey der.
11 E veio ali uma mulher possessa de um espírito de enfermidade, havia já dezoito anos; andava ela encurvada, sem de modo algum poder endireitar-se.
12 Wen Jesus si am, e koll di woman kon tell am, “Woman, yu don free from yor trobol.”
12 Vendo-a Jesus, chamou-a e disse-lhe: Mulher, estás livre da tua enfermidade;
13 Jesus tosh di woman and at wons, en body kon strait and e start to praiz God.
13 e, impondo-lhe as mãos, ela imediatamente se endireitou e dava glória a Deus.
14 But di oga for di sinagog vex sey Jesus heal pesin for Sabat Day, so e kon tell di pipol, “Wi get six days wen pipol suppose work, so make una kom make dem heal una for doz six days, but nor bi for Sabat Day.”
14 O chefe da sinagoga, indignado de ver que Jesus curava no sábado, disse à multidão: Seis dias há em que se deve trabalhar; vinde, pois, nesses dias para serdes curados e não no sábado.
15 Den Jesus ansa am, “Yu wey dey pritend! Una nor dey luz una melu or donkey from rope go drink wota for Sabat Day?
15 Disse-lhe, porém, o Senhor: Hipócritas, cada um de vós não desprende da manjedoura, no sábado, o seu boi ou o seu jumento, para levá-lo a beber?
16 So make I nor free dis woman wey bi Abraham pikin, wey dey Satan prison for eighteen years, bikos today na Sabat Day?”
16 Por que motivo não se devia livrar deste cativeiro, em dia de sábado, esta filha de Abraão, a quem Satanás trazia presa há dezoito anos?
17 Wen Jesus tok dis tin, shame katch all en enemies, so di pipol kon dey happy, bikos of wetin Jesus dey do.
17 Tendo ele dito estas palavras, todos os seus adversários se envergonharam. Entretanto, o povo se alegrava por todos os gloriosos feitos que Jesus realizava.
18 Jesus ask di pipol, “Wetin God Kingdom bi like? How I won take diskribe am?
18 E dizia: A que é semelhante o reino de Deus, e a que o compararei?
19 E bi like mustard seed wey pesin plant for en farm. Di seed grow kon turn to big tree and birds build dia house for di tree.”
19 É semelhante a um grão de mostarda que um homem plantou na sua horta; e cresceu e fez-se árvore; e as aves do céu aninharam-se nos seus ramos.
20 Jesus tok again sey, “Wetin I go tok sey God Kingdom bi like?
20 Disse mais: A que compararei o reino de Deus?
21 E bi like yist wey woman mix with three basket of flower so dat di bread go raiz.”
21 É semelhante ao fermento que uma mulher tomou e escondeu em três medidas de farinha, até ficar tudo levedado.
22 Jesus travel pass some town and village kon dey tish as e dey go Jerusalem.
22 Passava Jesus por cidades e aldeias, ensinando e caminhando para Jerusalém.
23 Somebody kon ask am, “Oga God, na only few pipol God go save?”
23 E alguém lhe perguntou: Senhor, são poucos os que são salvos?
24 “Make una struggol well-well so dat una go fit pass di small door, bikos many pipol go try to enter God Kingdom, but dem nor go fit.
24 Respondeu-lhes: Esforçai-vos por entrar pela porta estreita, pois eu vos digo que muitos procurarão entrar e não poderão.
25 If di Oga God wey get di house go lock di door, una go stand for outside dey nok and beg sey, ‘Oga God, make yu let us enter!’
25 Quando o dono da casa se tiver levantado e fechado a porta, e vós, do lado de fora, começardes a bater, dizendo: Senhor, abre-nos a porta, ele vos responderá: Não sei donde sois.
26 “Den una go sey, ‘Wi chop and drink with yu and yu tish for awa town too.’
26 Então, direis: Comíamos e bebíamos na tua presença, e ensinavas em nossas ruas.
27 “But e go sey, ‘I nor know where una from kom! Make una nor near mi, una bi wiked pipol!’
27 Mas ele vos dirá: Não sei donde vós sois; apartai-vos de mim, vós todos os que praticais iniquidades.
28 “Una go kry dey grind tit wen una si Abraham, Isaak, Jakob and all di profets inside God Kingdom, but God go trow una for outside.
28 Ali haverá choro e ranger de dentes, quando virdes, no reino de Deus, Abraão, Isaque, Jacó e todos os profetas, mas vós, lançados fora.
29 Pipol go from east, west, nort and sout kon sidan for di party for God Kingdom.
29 Muitos virão do Oriente e do Ocidente, do Norte e do Sul e tomarão lugares à mesa no reino de Deus.
30 Den doz wey bi last, go bi first and doz wey bi first, go bi last.”
30 Contudo, há últimos que virão a ser primeiros, e primeiros que serão últimos.
31 Dat time, some Farisee pipol kom meet Jesus tok sey, “Run komot for here, bikos Herod won kill yu.”
31 Naquela mesma hora, alguns fariseus vieram para dizer-lhe: Retira-te e vai-te daqui, porque Herodes quer matar-te.
32 But Jesus tell dem, “Make una go meet dat yeye man tell am, ‘Si, for today, tumoro and next tumoro, I go still dey drive demons dey heal pipol, until my work go finish.’
32 Ele, porém, lhes respondeu: Ide dizer a essa raposa que, hoje e amanhã, expulso demônios e curo enfermos e, no terceiro dia, terminarei.
33 But for today, tumoro and next tumoro, I go-go my way, bikos e nor fit happen sey dem go kill profet outside Jerusalem.
33 Importa, contudo, caminhar hoje, amanhã e depois, porque não se espera que um profeta morra fora de Jerusalém.
34 “Jerusalem pipol! Jerusalem pipol! Una wey kill profets and stone pipol wey God send kom meet una! E don tey wey I won gada una shidren as fawol dey gada en pikin under en feada, but una nor gri!
34 Jerusalém, Jerusalém, que matas os profetas e apedrejas os que te foram enviados! Quantas vezes quis eu reunir teus filhos como a galinha ajunta os do seu próprio ninho debaixo das asas, e vós não o quisestes!
35 Make una look, una shidren don skata! And I tell una true word, una nor go si mi again until una go sey, ‘God don bless di pesin wey kom with en name!’ ”
35 Eis que a vossa casa vos ficará deserta. E em verdade vos digo que não mais me vereis até que venhais a dizer:
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Lucas 13, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.