Lucas 12
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARC
1 Plenty pipol gada around Jesus kon dey waka jam one anoda, so Jesus kon tell en disciples, “Make una shine una eye well-well, bikos of di Farisee pipol wey dey pritend.
1 Ajuntando-se, entretanto, muitos milhares de pessoas, de sorte que se atropelavam uns aos outros, começou a dizer aos seus discípulos: Acautelai-vos, primeiramente, do fermento dos fariseus, que é a hipocrisia.
2 Anytin wey pipol hide naw, go kom out for publik and anytin wey dey sekret naw, God go bring am out.
2 Mas nada há encoberto que não haja de ser descoberto; nem oculto, que não haja de ser sabido.
3 So anytin wey pesin do for darkness, go kom out for lite and anytin wey pesin tok for sekret, pipol go shaut am from on-top house.
3 Porquanto tudo o que em trevas dissestes à luz será ouvido; e o que falastes ao ouvido no gabinete sobre os telhados será apregoado.
4 “I tell una wey bi my friends, make una nor fear pipol wey fit kill pesin, but dem nor fit do pass dat.
4 E digo-vos, amigos meus: não temais os que matam o corpo e depois não têm mais o que fazer.
5 But make I tell una who una must fear: Make una fear di Pesin wey get pawa to trow una inside hell-fire afta E don kill una. Yes, I tell una true word, na-im una must fear!
5 Mas eu vos mostrarei a quem deveis temer: temei aquele que, depois de matar, tem poder para lançar no inferno; sim, vos digo, a esse temei.
6 Nor bi two koins dem dey sell five sparo bird? But God nor dey forget any one among dem.
6 Não se vendem cinco passarinhos por dois ceitis? E nenhum deles está esquecido diante de Deus.
7 Si, God know di nomba of hair wey dey una head. So make una nor fear, bikos una betta pass many sparo bird.
7 E até os cabelos da vossa cabeça estão todos contados. Não temais, pois; mais valeis vós do que muitos passarinhos.
8 “I tell una true word, anybody wey stand up for publik sey en know mi, mi too go stand up for am for where God angels dey.
8 E digo-vos que todo aquele que me confessar diante dos homens, também o Filho do Homem o confessará diante dos anjos de Deus.
9 But pesin wey rijet mi for where pipol dey, mi too go rijet am for where God angels dey.
9 Mas quem me negar diante dos homens será negado diante dos anjos de Deus.
10 And anybody wey tok bad about Man Pikin, God go fit forgi-am, but pesin wey tok bad about di Holy Spirit, God nor go forgi-am.
10 E a todo aquele que disser uma palavra contra o Filho do Homem ser-lhe-á perdoada, mas ao que blasfemar contra o Espírito Santo não lhe será perdoado.
11 “Wen dem karry una go sinagog or go meet govnors and pipol wey get pawa to judge una kase, make una nor worry about how una go defend unasef or wetin una go tok,
11 E, quando vos conduzirem às sinagogas, aos magistrados e potestades, não estejais solícitos de como ou do que haveis de responder, nem do que haveis de dizer.
12 bikos di Holy Spirit go tell una wetin to tok, wen dat time rish.”
12 Porque na mesma hora vos ensinará o Espírito Santo o que vos convenha falar.
13 Den one pesin among di pipol kon sey, “Tisha, tell my broda make e divide di propaty wey awa papa die leave for us.”
13 E disse-lhe um da multidão: Mestre, dize a meu irmão que reparta comigo a herança.
14 But Jesus ask am, “My friend, na who make mi judge for una two matter?”
14 Mas ele lhe disse: Homem, quem me pôs a mim por juiz ou repartidor entre vós?
15 Den Jesus tell dem, “Make una guide against long-trot, bikos nor bi wetin pesin get for dis life go save am.”
15 E disse-lhes: Acautelai-vos e guardai-vos da avareza, porque a vida de qualquer não consiste na abundância do que possui.
16 So Jesus kon tell dem one parabol: “One rish man plok plenty food from en farm,
16 E propôs-lhes uma parábola, dizendo: a herdade de um homem rico tinha produzido com abundância.
17 so e kon tink for en mind sey, ‘Wetin I go do naw? Bikos I nor get anywhere to keep all dis food wey I plok so.’
17 E arrazoava ele entre si, dizendo: Que farei? Não tenho onde recolher os meus frutos.
18 “Den di man sey, ‘I know wetin I go do: I go skata my stores kon build new big-big one wey I go keep all my food and oda tins wey I plok.
18 E disse: Farei isto: derribarei os meus celeiros, e edificarei outros maiores, e ali recolherei todas as minhas novidades e os meus bens;
19 Den I go tell mysef, “Yu get plenty food wey go last yu for many years, so make yu go sleep, chop and drink, dey enjoy yorsef!” ’
19 e direi à minha alma: alma, tens em depósito muitos bens, para muitos anos; descansa, come, bebe
20 “But God kon tell di man, ‘Yu bi fool! Dis nite, yu go die, den who go kon get all dis tins wey yu don gada for yorsef?’
20 Mas Deus lhe disse: Louco, esta noite te pedirão a tua alma, e o que tens preparado para quem será?
21 “Na so e go bi with pesin wey dey gada money keep for ensef, but en heart nor dey with God.”
21 Assim é aquele que para si ajunta tesouros e não é rico para com Deus.
22 Jesus tell en disciples, “Naw I dey tell una, make una nor worry about una life, wetin una go chop or klot wey una go wear for body.
22 E disse aos seus discípulos: Portanto, vos digo: não estejais apreensivos pela vossa vida, sobre o que comereis, nem pelo corpo, sobre o que vestireis.
23 Bikos life good pass food and awa body betta pass klot.
23 Mais é a vida do que o sustento, e o corpo, mais do que as vestes.
24 Make una tink how birds bi: Dem nor dey plant or plok, dem nor get where dem dey keep food put, but God dey give dem food chop. If God dey kare for dem, wot about una wey betta pass dem?
24 Considerai os corvos, que nem semeiam, nem segam, nem têm despensa nem celeiro, e Deus os alimenta; quanto mais valeis vós do que as aves?
25 Wish of una go fit add one hour join en life, bikos e dey worry?
25 E qual de vós, sendo solícito, pode acrescentar um côvado à sua estatura?
26 So, if una nor fit do dis simpol tin, why una dey worry about di odas?
26 Pois, se nem ainda podeis as coisas mínimas, por que estais ansiosos pelas outras?
27 “Make una tink of how flowers dey grow: Dem nor dey work or make klot for demsef. But I tell una true word, even Solomon for all di glory wey e get, nor dress fine rish flowers!
27 Considerai os lírios, como eles crescem; não trabalham, nem fiam; e digo-vos que nem ainda Salomão, em toda a sua glória, se vestiu como um deles.
28 If God dey dress flowers wey dey today and pipol go kut am trow for fire tumoro, dat God nor go fit kare for una? Una faith small well-well o-o!
28 E, se Deus assim veste a erva, que hoje está no campo e amanhã é lançada no forno, quanto mais a vós,
29 Make una nor dey worry about wetin una go chop or drink.
29 Não pergunteis, pois, que haveis de comer ou que haveis de beber, e não andeis inquietos.
30 Na bikos of all dis tins, pipol wey nor know God dey worry demsef, but una Papa for heaven know sey una nid dem.
30 Porque os gentios do mundo buscam todas essas
31 Instead, make una first struggol to enter God Kingdom and God go give una all di oda tins.
31 Buscai, antes, o Reino de Deus, e todas essas
32 “Make una nor fear, una wey bi small sheep, bikos una Papa go happy to give una di kingdom.
32 Não temas, ó pequeno rebanho, porque a vosso Pai agradou dar-vos o Reino.
33 Make una sell evritin wey una get and give di money to poor pipol. Bag wey nor go tear, make una take am gada betta tins for heaven, where tif nor go fit rish and siti-siti nor go fit spoil dem.
33 Vendei o que tendes, dai esmolas, e fazei para vós bolsas que não se envelheçam, tesouro nos céus que nunca acabe, aonde não chega ladrão, e a traça não rói.
34 Bikos na where yor propaty dey, na der yor heart go dey too.
34 Porque onde estiver o vosso tesouro, ali estará também o vosso coração.
35 “Make una ready to serve God and make una lite dey shine evritime.
35 Estejam cingidos os vossos lombos, e acesas, as vossas candeias.
36 Make una bi like pipol wey dey wait for dia oga to kom back from party, so dat wen e nok, una go kwik open door for am.
36 E sede vós semelhantes aos homens que esperam o seu senhor, quando houver de voltar das bodas, para que, quando vier e bater, logo possam abrir-lhe.
37 Di savant wey en oga go kom back kon meet am dey work, make e happy well-well bikos di oga go prepare ensef make e for serve di savant food for tabol.
37 Bem-aventurados aqueles servos, os quais, quando o Senhor vier, achar vigiando! Em verdade vos digo que se cingirá, e os fará assentar à
38 Make doz savant happy well-well, even if di oga kom for nine or three oklok for nite kon si sey dem neva sleep.
38 E, se vier na segunda vigília, e se vier na terceira vigília, e
39 But make una know sey, if di owner of di house know wen tif dey kom, e nor go let di tif break enter en house.
39 Sabei, porém, isto: se o pai de família soubesse a que hora havia de vir o ladrão, vigiaria e não deixaria minar a sua casa.
40 Una must dey ready too, bikos Man Pikin go kom wen nobody dey espect am.”
40 Portanto, estai vós também apercebidos; porque virá o Filho do Homem à hora que não imaginais.
41 Den Pita ask am, “Oga God, na only wi yu dey tell dis parabol, abi na evribody?”
41 E disse-lhe Pedro: Senhor, dizes essa parábola a nós ou também a todos?
42 Jesus ansa, “Who bi di manaja wey get sense and nor dey do wayo? Na pesin wey di oga put make e kare and give di oda savants dia food for di rite time?
42 E disse o Senhor: Qual é, pois, o mordomo fiel e prudente, a quem o senhor pôs sobre os seus servos, para
43 Di savant wey en oga kom back kon meet am dey do en work, make e happy well-well.
43 Bem-aventurado aquele servo a quem o senhor, quando vier, achar fazendo assim.
44 I tell una true word, di oga go sey make e kare for all en propaty.
44 Em verdade vos digo que sobre todos os seus bens o porá.
45 But if dat savant tink for en mind sey, ‘My oga go tey small and e bigin beat di oda savants, weda na man or woman; e kon dey chop, dey drink anyhow,
45 Mas, se aquele servo disser em seu coração: O meu senhor tarda em vir, e começar a espancar os criados e criadas, e a comer, e a beber, e a embriagar-se,
46 den di oga kon kom back for di day wen di savant nor tink sey e go kom. Di oga go ponish di savant kon lock am for where dem dey keep wiked pipol.’
46 virá o Senhor daquele servo no dia em que
47 “Di savant wey know wetin en oga wont and e nor do am, dem go flog am well-well.
47 E o servo que soube a vontade do seu senhor e não se aprontou, nem fez conforme a sua vontade, será castigado com muitos açoites.
48 But di savant wey nor know wetin en oga wont and e do tins wey go make dem flog am, dem go flog am small. Pesin wey God give plenty tins to, E go ask plenty tins from am and di ones wey God give plenty, E go ask doubol from dem.”
48 Mas o que
49 “I bring fire kom dis world and I wish sey di fire don dey katch!
49 Vim lançar fogo na terra e que mais quero, se já está aceso?
50 E get one baptizim wey dem go baptize mi and my mind nor go fit rest until e happen!
50 Importa, porém, que eu seja batizado com um certo batismo, e como me angustio até que venha a cumprir-se!
51 Una tink sey na peace I bring kom dis world? No, I kom divide una!
51 Cuidais vós que vim trazer paz à terra? Não, vos digo, mas, antes, dissensão.
52 From naw go, family wey bi five go divide, three go dey against two, two go dey against three.
52 Porque, daqui em diante, estarão cinco divididos numa casa: três contra dois, e dois contra três.
53 Papa go dey against en son and son go dey against en papa, mama go dey against en dota and dota go dey against en mama, husband mama go dey against en pikin wife and wife go dey against en husband mama.”
53 O pai estará dividido contra o filho, e o filho, contra o pai, a mãe, contra a filha, e a filha, contra a mãe, a sogra, contra sua nora, e a nora, contra sua sogra.
54 Jesus tell di pipol, “Anytime una si sey di kloud dey go west, una dey know sey, heavy rain won fall and true-true, e go fall.
54 E dizia também à multidão: Quando vedes a nuvem que vem do ocidente, logo dizeis: Lá vem chuva; e assim sucede.
55 And wen una si breeze dey blow from east, una go sey, ‘Heat go dey today’ and na so e go bi.
55 E, quando assopra o vento sul, dizeis: Haverá calma; e
56 Una wey dey pritend! Una fit tok how di weda go bi, but why una nor fit tok wetin dey happen so?”
56 Hipócritas, sabeis discernir a face da terra e do céu; como não sabeis, então, discernir este tempo?
57 “Why una nor dey tok wetin dey good for pipol to do?
57 E por que não julgais também por vós mesmos o que é justo?
58 If yu and pesin get kase and una dey go kourt, make yu try setol with am for road, so dat e nor go drag yu go meet di judge, wey go give yu to sojas and dem go trow yu inside prison.
58 Quando, pois, vais com o teu adversário ao magistrado, procura livrar-te dele no caminho; para que não suceda que te conduza ao juiz, e o juiz te entregue ao meirinho, e o meirinho te encerre na prisão.
59 I tell una true word, yu nor go komot for der until yu pay all di money wey yu dey whole!”
59 Digo-te que não sairás dali enquanto não pagares o derradeiro ceitil.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Lucas 12, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.