Lucas 11

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB

Sair da comparação
ARIB Almeida Revisada Imprensa Bíblica
1 One day Jesus dey pray for one place. Wen e pray finish, one of en disciples kon tell am, “Oga God! Make yu tish us how to pray, just as John tish en disciples.”
1 Estava Jesus em certo lugar orando e, quando acabou, disse-lhe um dos seus discípulos: Senhor, ensina-nos a orar, como também João ensinou aos seus discípulos.
2 So Jesus tell dem, “Wen una dey pray, make una sey:
2 Ao que ele lhes disse: Quando orardes, dizei: Pai, santificado seja o teu nome; venha o teu reino;
3 Give us di bread wey wi go chop today,
3 dá-nos cada dia o nosso pão cotidiano;
4 Make yu forgive us awa sins,
4 e perdoa-nos os nossos pecados, pois também nós perdoamos a todo aquele que nos deve; e não nos deixes entrar em tentação, {mas livra-nos do mal.}
5 Den Jesus tell dem, “Like sey one of una go meet en friend for mid-nite sey, ‘My friend, abeg give mi three bread,
5 Disse-lhes também: Se um de vós tiver um amigo, e se for procurá-lo à meia-noite e lhe disser: Amigo, empresta-me três pães,
6 bikos one of my friend wey dey travel stop for my place and I nor get anytin to gi-am chop.’
6 pois que um amigo meu, estando em viagem, chegou a minha casa, e não tenho o que lhe oferecer;
7 “Den yor friend kon ansa from inside house, ‘Make yu nor disturb mi. I don lock my door and mi and my shidren dey sleep. I nor go fit get up give yu anytin naw.’
7 e se ele, de dentro, responder: Não me incomodes; já está a porta fechada, e os meus filhos estão comigo na cama; não posso levantar-me para te atender;
8 I tell yu true word, even if di man inside, nor won get up bikos yu bi en friend, e go get up give yu anytin wey yu wont, bikos yu nor let am rest.
8 digo-vos que, ainda que se levante para lhos dar por ser seu amigo, todavia, por causa da sua importunação, se levantará e lhe dará quantos pães ele precisar.
9 “So, I tell yu true word: Make yu ask and God go give yu, find and yu go si wetin yu dey look for, make yu nok and di door go open for yu.
9 Pelo que eu vos digo: Pedi, e dar-se-vos-á; buscai e achareis; batei, e abrir-se-vos-á;
10 Bikos pesin wey ask, go get, pesin wey find, go si wetin e dey find and di pesin wey nok, di door go open for am.
10 pois todo o que pede, recebe; e quem busca acha; e ao que bate, abrir-se-lhe-á.
11 “Wish of una wey bi papa go give en pikin snake, if e ask for fish?
11 E qual o pai dentre vós que, se o filho lhe pedir pão, lhe dará uma pedra? Ou, se lhe pedir peixe, lhe dará por peixe uma serpente?
12 Or if di pikin ask for egg, una go gi-am skorpion?
12 Ou, se pedir um ovo, lhe dará um escorpião?
13 Since una fit give una pikin good tins as una bad rish, wot of una Papa for Heaven wey go give di Holy Spirit to anybody wey ask am?”
13 Se vós, pois, sendo maus, sabeis dar boas dádivas aos vossos filhos, quanto mais dará o Pai celestial o Espírito Santo àqueles que lho pedirem?
14 One day, Jesus kon drive demon wey dey make pesin nor fit tok komot for one man body. Wen di demon don komot, di man bigin tok and di pipol sopraiz well-well.
14 Estava Jesus expulsando um demônio, que era mudo; e aconteceu que, saindo o demônio, o mudo falou; e as multidões se admiraram.
15 But some among dem sey, “Belzibub wey bi demon oga, na en pawa Jesus dey use take drive demons.”
15 Mas alguns deles disseram: É por Belzebu, o príncipe dos demônios, que ele expulsa os demônios.
16 But oda pipol kon dey ask for sign from heaven, bikos dem won test Jesus.
16 E outros, experimentando-o, lhe pediam um sinal do céu.
17 Jesus know wetin dey dia mind, so e tell dem, “Any kingdom where pipol dey fight each oda nor go last and family wey divide, go fall.
17 Ele, porém, conhecendo-lhes os pensamentos, disse-lhes: Todo reino dividido contra si mesmo será assolado, e casa sobre casa cairá.
18 So, if Satan kingdom divide, how en kingdom go take last? I dey ask una dis tin, bikos una dey sey na Belzibub pawa I take dey drive demons.
18 Ora, pois, se Satanás está dividido contra si mesmo, como subsistirá o seu reino? Pois dizeis que eu expulso dos demônios por Belzebu.
19 If na Belzibub pawa I take dey drive demons, den na wish pawa una pikin dem dey use? So, na una pikin go judge una.
19 E, se eu expulso os demônios por Belzebu, por quem os expulsam os vossos filhos? Por isso eles mesmos serão os vossos juizes.
20 But if na God pawa I take dey drive demon komot, den God Kingdom don rish where una dey.
20 Mas, se é pelo dedo de Deus que eu expulso os demônios, logo é chegado a vós o reino de Deus.
21 “Wen pesin wey get pawa ready well-well guide en own house, all en tins go dey save.
21 Quando o valente guarda, armado, a sua casa, em segurança estão os seus bens;
22 But wen pesin wey get pawa pass am attack and win am, di pesin go karry all di tins wey di man take dey protet ensef kon divide di propaty wey remain.
22 mas, sobrevindo outro mais valente do que ele, e vencendo-o, tira-lhe toda a armadura em que confiava, e reparte os seus despojos.
23 “Anybody wey nor dey with mi, dey against mi and anybody wey nor dey work with mi, dey work against mi.
23 Quem não é comigo, é contra mim; e quem comigo não ajunta, espalha.
24 “Wen evil spirit komot for pesin body, e go dey waka anyhow, dey fine where e go rest. But wen e nor si, e go tell ensef, ‘Make I go back to di house wey I from komot.’
24 Ora, havendo o espírito imundo saindo do homem, anda por lugares áridos, buscando repouso; e não o encontrando, diz: Voltarei para minha casa, donde saí.
25 But wen e kom back, kon si sey dem don swip evriwhere klean, arrange am and nobody dey der,
25 E chegando, acha-a varrida e adornada.
26 e go-go bring seven oda spirits wey wiked pass am join ensef and dem go stay for der, so di pesin kondishon go worse pass as e bi before.”
26 Então vai, e leva consigo outros sete espíritos piores do que ele e, entrando, habitam ali; e o último estado desse homem vem a ser pior do que o primeiro.
27 As Jesus tok dis tins, one woman for der kon shaut, “God go bless di belle wey born yu and di breast wey yu sok!”
27 Ora, enquanto ele dizia estas coisas, certa mulher dentre a multidão levantou a voz e lhe disse: Bem-aventurado o ventre que te trouxe e os peitos em que te amamentaste.
28 Den Jesus sey, “Pipol wey hear God word and do wetin e tok, na dem God don bless!”
28 Mas ele respondeu: Antes bem-aventurados os que ouvem a palavra de Deus, e a observam.
29 As pipol dey plenty more-more, Jesus kon sey, “Pipol wey dey dis world naw wiked well-well; dem dey look for sign, but God nor go show dem any sign, escept di tin wey happen for Jonah time.
29 Como afluíssem as multidões, começou ele a dizer: Geração perversa é esta; ela pede um sinal; e nenhum sinal se lhe dará, senão o de Jonas;
30 Just as Jonah bi profet for Nineveh pipol, na so Man Pikin go bi sign for di pipol wey dey dis world naw.
30 porquanto, assim como Jonas foi sinal para os ninivitas, também o Filho do homem o será para esta geração.
31 For Judgement Day, Sheba Kween go bear witness against pipol wey dey dis world naw and God go kondemn dem, bikos di kween travel from far place kom hear di wise tins wey Solomon tish. But naw, pesin wey big pass Solomon dey here!
31 A rainha do sul se levantará no juízo com os homens desta geração, e os condenará; porque veio dos confins da terra para ouvir a sabedoria de Salomão; e eis, aqui quem é maior do que Salomão.
32 For Judgement Day, na so too Nineveh pipol go bear witness against pipol wey dey dis world naw, bikos dem turn from sin kom meet God wen Jonah prish give dem. But naw, pesin wey big pass Jonah dey here.”
32 Os homens de Nínive se levantarão no juízo com esta geração, e a condenarão; porque se arrependeram com a pregação de Jonas; e eis aqui quem é maior do que Jonas.
33 “Nobody dey lite lamp put for under basket or for where pipol nor go fit si am, but dem go put am for where pipol go si am wen dem enter di house.
33 Ninguém, depois de acender uma candeia, a põe em lugar oculto, nem debaixo do alqueire, mas no velador, para que os que entram vejam a luz.
34 Na eye bi di lamp wey body get. If yor eye well, lite go full yor whole body, but wen yor eye nor well, na darkness go full yor body.
34 A candeia do corpo são os olhos. Quando, pois, os teus olhos forem bons, todo o teu corpo será luminoso; mas, quando forem maus, o teu corpo será tenebroso.
35 So make sure sey wetin dey inside yu, na lite, nor bi darkness.
35 Vê, então, que a luz que há em ti não sejam trevas.
36 If lite full yor body and darkness nor dey inside at-all, e go shine well-well like wen lamp dey shine for yor face.”
36 Se, pois, todo o teu corpo estiver iluminado, sem ter parte alguma em trevas, será inteiramente luminoso, como quando a candeia te alumia com o seu resplendor.
37 As Jesus dey tok, one Farisee koll am kom en house kon chop, so Jesus go sidan for where dem go for chop.
37 Acabando Jesus de falar, um fariseu o convidou para almoçar com ele; e havendo Jesus entrado, reclinou-se à mesa.
38 Di Farisee sopraiz well-well wen e si sey Jesus nor first wosh-hand, before e bigin chop.
38 O fariseu admirou-se, vendo que ele não se lavara antes de almoçar.
39 But Jesus tell am, “Una wey bi Farisee pipol dey wosh outside cup and plate, but inside una belle, long-trot and wikedness full am.
39 Ao que o Senhor lhe disse: Ora vós, os fariseus, limpais o exterior do corpo e do prato; mas o vosso interior do copo e do prato; mas o vosso interior está cheio de rapina e maldade.
40 Una bi fool! Nor bi God wey make di outside still make inside?
40 Loucos! quem fez o exterior, não fez também o inferior?
41 But make una from una heart give to pipol wey nor get, so dat evritin go dey klean for una.
41 Dai, porém, de esmola o que está dentro do copo e do prato, e eis que todas as coisas vos serão limpas.
42 “Curse dey una head! Una wey bi Farisee pipol! Una dey give God one out of evry ten tins wey una get! But una dey forget pipol wey nor get.
42 Mas ai de vós, fariseus! porque dais o dízimo da hortelã, e da arruda, e de toda hortaliça, e desprezais a justiça e o amor de Deus. Ora, estas coisas importava fazer, sem deixar aquelas.
43 “Curse dey una head! Una wey bi Farisee pipol! Una dey won sidan for betta chair for sinagog and una dey like make pipol dey greet una for market.
43 Ai de vós, fariseus! porque gostais dos primeiros assentos nas sinagogas, e das saudações nas praças.
44 “Curse dey una head! Una bi like grave wey pipol dey mash pass and dem nor know sey na grave.”
44 Ai de vós! porque sois como as sepulturas que não aparecem, sobre as quais andam os homens sem o saberem.
45 One man wey know di law well-well kon ansa, “Tisha, yu dey curse us as yu dey tok like dis so o-o.”
45 Disse-lhe, então, um dos doutores da lei: Mestre, quando dizes isso, também nos afrontas a nós.
46 But Jesus ansa am, “Curse dey una head! Una wey know di law well-well! Una karry heavy load put for pipol back and una nor won even take hand tosh di load!
46 Ele, porém, respondeu: Ai de vós também, doutores da lei! porque carregais os homens com fardos difíceis de suportar, e vós mesmos nem ainda com um dos vossos dedos tocais nesses fardos.
47 “Curse dey una head! Una dey build profets grave, di profets wey una grand-grand papa kill.
47 Ai de vós! porque edificais os túmulos dos profetas, e vossos pais os mataram.
48 Dis show sey una support di tins wey una grand-grand papa dem do, bikos dem kill di profets and una build dia graves!
48 Assim sois testemunhas e aprovais as obras de vossos pais; porquanto eles os mataram, e vós lhes edificais os túmulos.
49 Na dis one make God tok with en wisdom sey, ‘I go send profets and apostles go meet dem and dem go sofa and kill some among dem.’
49 Por isso diz também a sabedoria de Deus: Profetas e apóstolos lhes mandarei; e eles matarão uns, e perseguirão outros;
50 So di profets blood wey dem don kill since di world start, di pipol wey dey dis world naw, go take dia head karry am.
50 para que a esta geração se peçam contas do sangue de todos os profetas que, desde a fundação do mundo, foi derramado;
51 From wen dem kill Abel go rish di time wen dem kill Zekaraya for di altar inside di temple, dia blood dey dis pipol head and God go judge dem.
51 desde o sangue de Abel, até o sangue de Zacarias, que foi morto entre o altar e o santuário; sim, eu vos digo, a esta geração se pedirão contas.
52 “Curse dey una head! Una wey know di law well-well! Una don seize di key wey dey make pipol know di trut! Since una nor gri enter, una nor wont make oda pipol enter too.”
52 Ai de vós, doutores da lei! porque tirastes a chave da ciência; vós mesmos não entrastes, e impedistes aos que entravam.
53 Wen Jesus komot from der, di pipol wey know di law well-well and di Farisee pipol kon dey vex, so from dat time, dem kon bigin ask Jesus yeye kweshon about many tins
53 Ao sair ele dali, começaram os escribas e os fariseus a apertá-lo fortemente, e a interrogá-lo acerca de muitas coisas,
54 and dem kon dey plan, so dat dem go fit find word for en mout, wey dem go take hold am.
54 armando-lhe ciladas, a fim de o apanharem em alguma coisa que dissesse.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Lucas 11, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.