Lucas 10

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NTLH

Sair da comparação
NTLH Nova Tradução na Linguagem de Hoje 2000
1 Afta, Jesus choose seventy-two men kon send dem two-by-two go all di town and oda place where e won go leta.
1 Depois disso o Senhor escolheu mais setenta e dois dos seus seguidores e os enviou de dois em dois a fim de que fossem adiante dele para cada cidade e lugar aonde ele tinha de ir.
2 E tell dem, “Di fruit wey dem won plok, plenty, but pipol wey go plok dem, nor plenty rish. Make una pray make di Oga God wey get di farm send workers kon gada en fruit.
2 Antes de os enviar, ele disse:
3 Make una go! I dey send una like small-small sheep go meet wiked animal.
3 Vão! Eu estou mandando vocês como ovelhas para o meio de lobos.
4 Make una nor take bag or shoe and nor greet anybody for road.
4 Não levem bolsa, nem sacola, nem sandálias. E não parem no caminho para cumprimentar ninguém.
5 “Wen una enter any house, make una first sey, ‘Make peace dey dis house!’
5 Quando entrarem numa casa, façam primeiro esta saudação: “Que a paz esteja nesta casa!”
6 If anybody wey wont peace dey der, una peace go stay with am, but if e nor dey, una peace go kom back to una.
6 Se um homem de paz morar ali, deixem a saudação com ele; mas, se o homem não for de paz, retirem a saudação.
7 Make una stay for dat house, chop and drink anytin wey dem give una, bikos anybody wey dey work, suppose to get en pay. Make una nor dey waka from one house go anoda.
7 Fiquem na mesma casa e comam e bebam o que lhes oferecerem, pois o trabalhador merece o seu salário. Não fiquem mudando de uma casa para outra.
8 “Wen una enter any town and dem welkom una, make una chop di food wey dem give una
8 — Quando entrarem numa cidade e forem bem-recebidos, comam a comida que derem a vocês.
9 and heal di pipol wey nor well for dat town, den tell di pipol wey dey der sey, ‘God Kingdom don kom meet una.’
9 Curem os doentes daquela cidade e digam ao povo dali: “O
10 But wen una enter any town and dem nor welkom una, make una go road kon sey,
10 Porém, quando entrarem numa cidade e não forem bem-recebidos, vão pelas ruas, dizendo:
11 ‘Even di san for una town wey dey awa leg, wi shake am komot make e bi witness against una. But make una know sey: God Kingdom don kom meet una.’
11 “Até a poeira desta cidade que grudou nos nossos pés nós sacudimos contra vocês! Mas lembrem disto: o Reino de Deus chegou até vocês.”
12 I tell una true word, e go betta for Sodom for judgement day pass dat town!
12 E Jesus disse mais isto:
13 “Korazin and Betsaida pipol, curse dey una head! Bikos if to sey na for Tyre and Sidon dem for do di mirakles wey dem do for una town, di pipol der for don turn from sin kom meet God since, dem for don sidan, wear sack-klot and put ashes for dia head kon dey beg God make E forgive dem.
13 Jesus continuou:
14 But e go betta for Tyre and Sidon pipol pass una for judgement day!
14 No Dia do Juízo, Deus terá mais pena de Tiro e de Sidom do que de vocês, Corazim e Betsaida!
15 Una Kapanaum pipol, una tink sey God go just karry una go heaven? No, E go trow una for hell-fire.”
15 E você, cidade de Cafarnaum, acha que vai subir até o céu? Pois será jogada no
16 Jesus tell en disciples, “Anybody wey listin to una, don listin to mi and anybody wey rijet una, don rijet mi and God wey send mi.”
16 Então disse aos discípulos:
17 Di seventy-two men kon kom back with happiness, dey sey, “Oga God, even demons dey obey us wen wi kommand dem with yor name!”
17 Os setenta e dois voltaram muito alegres e disseram a Jesus: — Até os demônios nos obedeciam quando, pelo poder do nome do senhor, nós mandávamos que saíssem das pessoas!
18 Jesus tell dem, “I si Satan wen e fall like tunda-lite from heaven.
18 Jesus respondeu:
19 Make una listin, I don give una pawa to waka on-top snake and skorpion and to ovakom all di enemy pawa, so nor-tin go fit wound una.
19 Escutem! Eu dei a vocês poder para pisar cobras e escorpiões e para, sem sofrer nenhum mal, vencer a força do inimigo.
20 Make una nor only dey happy sey evil spirit dey obey una, instead make una happy sey God rite una name for heaven.”
20 Porém não fiquem alegres porque os espíritos maus lhes obedecem, mas sim porque o nome de cada um de vocês está escrito no céu.
21 For dat time, di Holy Spirit kon make Jesus dey happy, so e kon sey, “I praiz yu, Papa wey bi Oga God for heaven and eart, bikos yu don hide dis tins from pipol wey get sense and wise, but yu show dem to yor shidren. Yes, Papa, na so yu wont make e bi.
21 Naquele momento, pelo poder do Espírito Santo, Jesus ficou muito alegre e disse:
22 “My Papa don give mi evritin. Nobody know who di pikin bi escept di Papa and nobody know who di Papa bi escept di pikin and pipol wey di pikin choose to show.”
22 — O meu Pai me deu todas as coisas. Ninguém sabe quem é o Filho, a não ser o Pai; e ninguém sabe quem é o Pai, a não ser o Filho e também aqueles a quem o Filho quiser mostrar quem o Pai é.
23 Den Jesus kon face en disciples tell dem small-small, “God don bless di pesin wey en eye si wetin una dey si so-o-o!
23 Então Jesus virou-se para os discípulos e disse só para eles:
24 I tell una true word, ‘Many profets and kings don try to si wetin una dey si so, but dem nor fit si am and dem don won hear wetin una dey hear so, but dem nor fit hear am.’ ”
24 Eu afirmo a vocês que muitos
25 One man wey sabi di law well-well kon get up test Jesus, “Tisha, wetin I go do to take get life wey nor dey end?”
25 Um mestre da Lei se levantou e, querendo encontrar alguma prova contra Jesus, perguntou: — Mestre, o que devo fazer para conseguir a vida eterna?
26 Jesus kon ask am, “Wetin yu undastand about Moses Law?”
26 Jesus respondeu:
27 Di man ansa, “Make yu love God yor Oga God with all yor heart, yor soul, yor pawa and mind, den love yor neighbour as yu love yorsef.”
27 O homem respondeu: — “Ame o Senhor, seu Deus, com todo o coração, com toda a alma, com todas as forças e com toda a mente. E ame o seu próximo como você ama a você mesmo.”
28 Jesus kon tell am, “Yor ansa korrect, make yu do dem and yu go get korrect life.”
28 — A sua resposta está certa! — disse Jesus. — Faça isso e você viverá.
29 But di man won show sey en know well-well, so e kon ask Jesus, “Who bi my neighbour?”
29 Porém o mestre da Lei, querendo se desculpar, perguntou: — Mas quem é o meu próximo?
30 Jesus tell am dis story, “One man dey travel from Jerusalem go Jeriko and tif kon attack am for road, dem naked am, beat am till e nearly die, den kon waka leave am.
30 Jesus respondeu assim:
31 Afta, one priest dey pass der, wen e si di man, e waka pass for di oda side for di road.
31 Acontece que um sacerdote estava descendo por aquele mesmo caminho. Quando viu o homem, tratou de passar pelo outro lado da estrada.
32 Na so too, one worker for di temple still waka rish where di man dey, but e waka pass di oda side for di road.
32 Também um
33 But one Samaria man wey dey travel for dat road kon rish where di man dey, as e si di man, e sorry for am.
33 Mas um
34 E waka go meet di man kon rob wine and olive oil for en sore and bandage am. Den e put di man on-top en horse kon karry am go one hotel and e kare for am dat nite.
34 Então chegou perto dele, limpou os seus ferimentos com azeite e vinho e em seguida os enfaixou. Depois disso, o samaritano colocou-o no seu próprio animal e o levou para uma pensão, onde cuidou dele.
35 Di next day, di Samaria man give di hotel manaja two silva koins kon tell am, ‘Make yu kare for dis man, wen I kom back, I go pay yu any estra money wey yu spend.’ ”
35 No dia seguinte, entregou duas moedas de prata ao dono da pensão, dizendo:
36 Jesus kon ask di man wey e dey follow tok sey, “Among dis three men, wish one yu tink sey bi neighbour to di man wey tif attack?”
36 Então Jesus perguntou ao mestre da Lei:
37 Di man wey sabi di law well-well kon ansa, “Na di one wey kare for di man.”
37 — Aquele que o socorreu! — respondeu o mestre da Lei. E Jesus disse:
38 As Jesus and en disciples still dey travel, dem rish one village and one woman wey en name bi Marta kon welkom dem for en house.
38 Jesus e os seus discípulos continuaram a sua viagem e chegaram a um povoado. Ali uma mulher chamada Marta o recebeu na casa dela.
39 Mary, wey bi Marta sista, sidan near Jesus leg dey listin to wetin e dey tish.
39 Maria, a sua irmã, sentou-se aos pés do Senhor e ficou ouvindo o que ele ensinava.
40 But Marta nor happy, bikos of all di work wey e dey do, so e meet Jesus kon sey, “Oga God! Si, my sista don leave all di work for mi. Abeg, tell am make e kom help mi.”
40 Marta estava ocupada com todo o trabalho da casa. Então chegou perto de Jesus e perguntou: — O senhor não se importa que a minha irmã me deixe sozinha com todo este trabalho? Mande que ela venha me ajudar.
41 Jesus ansa am, “Marta! Marta! Yu dey too wahala yorsef about many tins,
41 Aí o Senhor respondeu:
42 na only one tin dey important and Mary don choose di korrect tin and nobody go fit take am from am.”
42 mas apenas uma é necessária! Maria escolheu a melhor de todas, e esta ninguém vai tomar dela.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Lucas 10, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.