Juízes 9

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 Naw, Abimelek wey bi Gideon pikin, go Shekem town, where all en mama family dey stay kon tell dem
1 Abimeleque, filho de Jerubaal, foi aos irmãos de sua mãe em Siquém e disse a eles e a todo o clã da família de sua mãe:
2 make dem ask Shekem men sey, “Wetin make una wont make Gideon 70 shidren rule una, wen e bi sey only one man fit rule una? Make una remember sey, Abimelek na una own flesh and blood o-o.”
2 "Perguntem a todos os cidadãos de Siquém: O que é melhor para vocês: ter todos os setenta filhos de Jerubaal governando sobre vocês, ou somente um homem? Lembrem-se de que eu sou sua própria carne".
3 So en mama family kon tok to di men and dem kon agri to follow Abimelek, bikos e bi dia own family pesin.
3 Os irmãos de sua mãe repetiram tudo aos cidadãos de Siquém, e estes se mostraram propensos a seguir Abimeleque, pois disseram: "Ele é nosso irmão".
4 Dem gi-am 70 pieces for silva from Baal temple and e use am take go hire wiked men wey nor dey obey di law.
4 Deram-lhe setenta peças de prata tiradas do templo de Baal-Berite, as quais Abimeleque usou para contratar alguns desocupados e vadios, que se tornaram seus seguidores.
5 Den e go en papa house for Ofrah kon kill en step brodas, di 70 son wey Gideon born. E kill all of dem on-top one stone. But na only Jotam wey bi Gideon last born, run bikos e hide.
5 Foi à casa de seu pai em Ofra e matou seus setenta irmãos, filhos de Jerubaal, sobre uma rocha. Mas Jotão, o filho mais novo de Jerubaal, escondeu-se e escapou.
6 All di leaders for Shekem and Bet-Millo kon make Abimelek king for di oak tree near di pila for Shekem.
6 Então todos os cidadãos de Siquém e de Bete-Milo reuniram-se ao lado do Carvalho, junto à coluna de Siquém, para coroar Abimeleque rei.
7 Wen Jotam hear wetin happen, e go stand on-top Mount Gerizim kon shaut tell di pipol wey dey groun sey, “Shekem leaders, make una hear mi, so dat God go hear una!
7 Quando Jotão soube disso, subiu ao topo do monte Gerizim e gritou para eles: "Ouçam-me, cidadãos de Siquém, para que Deus os ouça.
8 One day, all di tree gada togeda to choose king for demsef. Dem tell di olive tree sey, ‘Kom bi awa king!’
8 Certo dia as árvores saíram para ungir um rei para si. Disseram à oliveira: ‘Seja o nosso rei! ’
9 “But di olive tree ansa, ‘I nor go fit stop to produce my oil wey dem dey use take dey honor gods and human being, just bikos I won bi king!’
9 "A oliveira, porém, respondeu: ‘Deveria eu renunciar ao meu azeite, com o qual se presta honra aos deuses e aos homens, para dominar sobre as árvores? ’
10 “Den all di tree tell di fig sey, ‘Make yu kom bi awa king.’
10 "Então as árvores disseram à figueira: ‘Venha ser o nosso rei! ’
11 “But di fig tree ansa, ‘I nor go fit stop to produce my good sweet fruit, just bikos I won bi una king.’
11 "A figueira, porém, respondeu: ‘Deveria eu renunciar ao meu fruto saboroso e doce, para dominar sobre as árvores? ’
12 “So dem tell di grape vine sey, ‘Make yu kom bi awa king.’
12 "Depois as árvores disseram à videira: ‘Venha ser o nosso rei! ’
13 “But di grape vine ansa, ‘I nor go fit stop to produce my wine wey dey make gods and human being happy, just bikos I won bi una king.’
13 "A videira, porém, respondeu: ‘Deveria eu renunciar ao meu vinho, que alegra os deuses e os homens, para ter domínio sobre as árvores? ’
14 “Den all di tree kon tell shuku-shuku sey, ‘Make yu kom bi awa king.’
14 "Finalmente todas as árvores disseram ao espinheiro: ‘Venha ser o nosso rei! ’
15 “Di shuku-shuku ansa, ‘If una really wont make I bi una king, den make una kom stay under mi. If not, fire go from my shuku-shuku branches burn Lebanon cedars.’ ”
15 "O espinheiro disse às árvores: ‘Se querem realmente ungir-me rei sobre vocês, venham abrigar-se à minha sombra; do contrário, sairá fogo do espinheiro e consumirá até os cedros do Líbano! ’
16 Naw Jotam kon sey, “Wen una make Abimelek una king, una really dey honest and sincere? Una respet Gideon kon trit en family well since e deserve am?
16 "Será que vocês agiram de fato com sinceridade quando fizeram Abimeleque rei? Foram justos com Jerubaal e sua família, como ele merecia?
17 Make una remember sey, my papa fight and risk en life take save una from Midian pipol hand.
17 Meu pai lutou por vocês e arriscou a vida para livrá-los das mãos de Midiã,
18 But today, una don turn una back against my papa family. Una kill en 70 son on-top one stone. Abimelek na en pikin wey di savant woman born for am and na una family, so una kon make am king for Shekem.
18 hoje, porém, vocês se revoltaram contra a família de meu pai, mataram seus setenta filhos sobre a mesma rocha, e proclamaram Abimeleque, o filho de sua escrava, rei sobre os cidadãos de Siquém pelo fato de ser irmão de vocês.
19 So, if wetin una do to Gideon and en family, dey good and honest, den make una happy with Abimelek and e go happy with una too.
19 Se hoje vocês de fato agiram com sinceridade para com Jerubaal e sua família, alegrem-se com Abimeleque, e alegre-se ele com vocês!
20 But if e nor dey good for una eye, make Abimelek burn Shekem and Bet-Millo men with fire. Den fire go kom out from Shekem and Bet-Millo kon burn and kill Abimelek too.”
20 Entretanto, se não foi assim, que saia fogo de Abimeleque e consuma os cidadãos de Siquém e de Bete-Milo, e que saia fogo dos cidadãos de Siquém e de Bete-Milo, e consuma Abimeleque! "
21 Bikos Jotam dey fear Abimelek en broda, e kon run go stay for Beer.
21 Depois Jotão fugiu para Beer, e foi morar ali, longe de seu irmão Abimeleque.
22 Abimelek rule Israel pipol for three years.
22 Fazia três anos que Abimeleque governava Israel,
23 Den God kon make Abimelek and Shekem men bigin fight demsef and dem kon go against am.
23 quando Deus enviou um espírito maligno entre Abimeleque e os cidadãos de Siquém, e estes agiram traiçoeiramente contra Abimeleque.
24 Dis tin happen so dat, Abimelek and di men for Shekem wey enkourage am to kill Gideon 70 shidren, go sofa for wetin dem do.
24 Isso aconteceu para que o crime contra os setenta filhos de Jerubaal, o derramamento do sangue deles, fosse vingado em seu irmão Abimeleque e nos cidadãos de Siquém que o ajudaram a assassinar os seus irmãos.
25 Shekem leaders hide some men for bush dey wait Abimelek and to rob anybody wey pass der. But Abimelek kon know about dia plan.
25 Os cidadãos de Siquém enviaram homens para o alto das colinas para emboscarem os que passassem por ali, e Abimeleque foi informado disso.
26 So wen Gaal, Ebed pikin kom Shekem with en brodas, di men for Shekem kon put dia hope on am.
26 Nesse meio tempo Gaal, filho de Ebede, mudou-se com seus parentes para Siquém, cujos cidadãos confiavam nele.
27 All of dem go dia vineyard go pick grape kon make wine take do party. Dem go dia god temple dey drink, chop and curse Abimelek.
27 Sucedeu que foram ao campo, colheram uvas, pisaram-nas, e fizeram uma festa no templo do seu deus. Comendo e bebendo, amaldiçoaram Abimeleque.
28 So Gaal sey, “Who bi dis Abimelek wey wi Shekem men dey serve? Nor bi Gideon pikin e bi? Zebul dey take orda from am, but why wi go serve am sef? Make una serve Hamor shidren, wey bi Shekem papa.
28 Então Gaal, filho de Ebede, disse: "Quem é Abimeleque para que o sirvamos? E quem é Siquém? Não é ele o filho de Jerubaal, e não é Zebul o seu representante? Sirvam aos homens de Hamor, o pai de Siquém! Por que servir a Abimeleque?
29 I wish sey, I dey lead dis pipol, I go kill Abimelek! I for tell am sey, ‘Make yu gada all yor soja kom out kon fight!’ ”
29 Ah! Se eu tivesse esse povo sob o meu comando! Eu me livraria dele. E diria a Abimeleque: ‘Mobilize o seu exército e venha! ’"
30 Wen Zebul wey dey rule di town, hear wetin Gaal tok, e kon dey vex.
30 Quando Zebul, o governante da cidade, ouviu o que dizia Gaal, filho de Ebede, ficou indignado.
31 E send messenjas go meet Abimelek for Arumah sey, “Gaal, Ebed pikin and en brodas kom Shekem and dem sey, dem nor go allow yu enter di town.
31 Secretamente enviou mensageiros a Abimeleque dizendo: "Gaal, filho de Ebede, e seus parentes vieram a Siquém e estão agitando a cidade contra você.
32 So naw, make yu and yor men kom out for nite kon hide for di town bush.
32 Venha de noite, você e seus homens, e fiquem à espera no campo.
33 For morning, before sun kom out, make una attack di town, wen Gaal and en men kom out kon fight una, make una distroy dem finish!”
33 De manhã, ao nascer do sol, avance contra a cidade. Quando Gaal e sua tropa atacarem, faça com eles o que achar melhor".
34 So Abimelek and en men kom out for nite; divide demsef kon hide for di bush outside Shekem.
34 E assim Abimeleque e todas as suas tropas partiram de noite e prepararam emboscadas perto de Siquém, em quatro companhias.
35 Wen Abimelek and en men si sey, Gaal kom out kon stand for di town gate, dem stand up from where dem hide put.
35 Ora, Gaal, filho de Ebede, tinha saído e estava à porta da cidade quando Abimeleque e seus homens saíram da sua emboscada.
36 Gaal si dem, so e kon tell Zebul sey, “Look! Some men dey kom down from di mountin!”
36 Quando Gaal os viu, disse a Zebul: "Veja, vem gente descendo do alto das colinas! " Zebul, porém, respondeu: "Você está confundindo as sombras dos montes com homens".
37 But Gaal tell am again, “Look! Some men dey kom from di mountin centre and one group dey kom from di tree where pipol wey dey si vishon dey stay!”
37 Mas Gaal tornou a falar: "Veja, vem gente descendo da parte central do território, e uma companhia está vindo pelo caminho do carvalho dos Adivinhadores".
38 Den Zebul tell am, “Nor bi yu sey, who bi Abimelek wey wi won serve? Dis nor bi di men wey yu curse? Go na! Make yu go fight dem!”
38 Disse-lhe Zebul: "Onde está toda aquela sua conversa? Você dizia: ‘Quem é Abimeleque, para que o sirvamos? ’ Não são estes os homens que você ridicularizou? Saia e lute contra eles! "
39 So Gaal lead Shekem men go fight Abimelek.
39 Então Gaal conduziu para fora os cidadãos de Siquém e lutou contra Abimeleque.
40 Gaal run and Abimelek kon porshu am. Many pipol wound go rish di town gate.
40 Abimeleque o perseguiu, e ele fugiu. Muitos dos homens de Siquém caíram mortos ao longo de todo o caminho, até à porta da cidade.
41 Abimelek go back to Arumah and Zebul kon drive Gaal and en brodas komot for Shekem.
41 Abimeleque permaneceu em Arumá. E Zebul expulsou Gaal e os seus parentes de Siquém.
42 For di next day, Shekem pipol kon go di field and wen Abimelek hear am,
42 No dia seguinte o povo de Siquém saiu aos campos, e Abimeleque ficou sabendo disso.
43 e take en men, divide dem into three group kon hide for di bush around di field. Wen e si di pipol dey kom out from di town, en and en men kom out kon attack dem.
43 Então dividiu os seus homens em três companhias e armou emboscadas no campo. Quando viu o povo saindo da cidade, levantou-se contra ele e atacou-o.
44 Abimelek and en group, attack kon block di road wey dem dey pass enter di town. Den di remainin two group kon attack and kill di pipol wey dey for di field.
44 Abimeleque e as tropas que estavam com ele avançaram até à porta da cidade. Então duas companhias avançaram sobre os que estavam nos campos e os mataram.
45 Thru-out dat day, Abimelek fight for di town. E kill all di pipol for di town kon seize am. Den e skata di town kon pour salt full di groun.
45 E Abimeleque atacou a cidade o dia todo, até conquistá-la e matar o seu povo. Depois destruiu a cidade e espalhou sal sobre ela.
46 Wen all di leaders for Shekem Towa hear wetin happen, dem kon run go hide for El-Berit temple.
46 Ao saberem disso, os cidadãos que estavam na torre de Siquém entraram na fortaleza do templo de El-Berite.
47 Abimelek hear sey, all di leaders for Shekem Towa, gada for one place,
47 Quando Abimeleque soube que se haviam reunido lá,
48 so en and en men go on-top Mount Zalmon. E take axe for en hand kon kut one branch from one tree. E put am for en shoulder kon tell en men, “Make una kwik-kwik do wetin una si mi dey do!”
48 ele e todos os seus homens subiram o monte Zalmom. Ele apanhou um machado e cortou um galho de árvore e o pôs nos ombros. Então deu esta ordem aos homens que estavam com ele: "Rápido! Façam o que eu fizer! "
49 So en men kut one-one branch kon follow am. Dem put di branches near di place where dem dey hide put kon lite fire der. All di pipol wey dey inside, die and dem bi like 1,000 men and wimen.
49 Todos os homens cortaram galhos e seguiram Abimeleque. Empilharam os galhos junto à fortaleza e a incendiaram. Assim morreu também o povo que estava na torre de Siquém, cerca de mil homens e mulheres.
50 Den Abimelek go Tebez and e kom surround and seize am.
50 A seguir Abimeleque foi a Tebes, sitiou-a e conquistou-a.
51 E get one strong towa for di town centre, so all di men, wimen and di leaders, run go der, lock di door kon go hide for di roof.
51 Mas dentro da cidade havia uma torre bastante forte, para a qual fugiram todos os homens e mulheres, todo o povo da cidade. Trancaram-se por dentro e subiram para o telhado da torre.
52 Wen Abimelek kom attack di towa, e go di door won kon lite fire put,
52 Abimeleque foi para a torre e atacou-a. E, quando se aproximava da entrada da torre para incendiá-la,
53 but one woman trow grindin stone from up kon land for en head and en brain kon krack.
53 uma mulher jogou-lhe uma pedra de moinho na cabeça, que lhe rachou o crânio.
54 E kwik-kwik koll di pesin wey karry en weapon kon tell am, “Make yu kill mi with yor swod, so dat dem nor go sey, ‘Na woman kill mi.’ ” So di pesin use en swod take shuk am and e kon die.
54 Imediatamente ele chamou seu escudeiro e lhe ordenou: "Tire a espada e mate-me, para que não digam que uma mulher me matou". Então o jovem o atravessou, e ele morreu.
55 Wen Israel pipol si sey, Abimelek don die, dem kon go back to dia house.
55 Quando os israelitas viram que Abimeleque estava morto, voltaram para casa.
56 God pay Abimelek back for di bad tins wey e do to en papa, bikos e kill en 70 brodas.
56 Assim Deus retribuiu a maldade que Abimeleque praticara contra o seu pai, matando os seus setenta irmãos.
57 God still pay Shekem pipol back for di bad-bad tins wey dem do. And di curse wey Jotam, Jerub-Baal (wey bi Gideon) pikin curse dem, really follow dem.
57 Deus fez também os homens de Siquém pagarem por toda a sua maldade. A maldição de Jotão, filho de Jerubaal, caiu sobre eles.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Juízes 9, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.