Juízes 8

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 Den Efraim men tell Gideon, “Why yu do us like dis? Wen yu dey go fight Midian pipol, why yu nor koll us?” Dem kon dey komplain about am.
1 Os homens de Efraim disseram a Gedeão: Por que nos trataste assim, não nos chamando a pelejar contigo contra Madiã? E houve entre eles uma violenta discussão.
2 But e tell dem, “Make una nor vex! Even doh una nor kwik kom, wetin una do still big pass di ones wey mi and my men do. E just bi like wen dem harvest grape: di grape wey Efraim tribe waka leave for groun, betta pass all di ones wey Abiezer harvest!
2 Gedeão respondeu-lhes: Que fiz eu, ao lado do que vós fizestes? Porventura não valem mais os cachos de Efraim que as vindimas de Abieser?
3 Si, na una use God pawa take kill Midian pipol two shief, wey bi Oreb and Zeeb. Wetin I do wey rish dat one?” Wen e tok like dis finish, di pipol kon stop to vex.
3 Foi nas vossas mãos que o Senhor entregou os príncipes de Madiã, Oreb e Zeb. Que pude eu, pois, fazer em comparação do que vós fizestes? E com estas palavras aquietaram-se.
4 For dis time, Gideon and en three hundred men don cross Jordan River. Dem don taya, but dem still dey porshu dia enemies.
4 Gedeão chegou ao Jordão e passou-o com seus trezentos homens, continuando a perseguir o inimigo, apesar de sua fadiga.
5 Wen dem rish Sukkot, Gideon tell di men for di town sey, “Abeg, make una give my men some bread make dem chop, dem don taya and I dey porshu Zebah and Zalmunna wey bi Midian pipol kings.”
5 Chegando a Socot, disse aos seus moradores: Dai, peço-vos, pão aos homens que me acompanham, porque estão muito cansados; estou perseguindo Zebéia e Salmana, reis de Madiã.
6 But Sukkot leaders ansa, “Why yu wont make wi give yor men food wen una neva katch Zebah and Zalmunna.”
6 Os chefes de Socot responderam-lhe: Tens já talvez em teu poder o punho de Zebéia e de Salmana para que possamos dar pão à tua tropa?
7 So Gideon ansa, “Okay no problem! By di time wey God go put dem for my hand, I go flog una with kane and shuku-shuku wey I plok from desert!”
7 Pois bem, replicou Gedeão, quando o Senhor me houver entregue nas mãos Zebéia e Salmana, eu vos rasgarei a pele com espinhos e abrolhos do deserto!
8 So Gideon go Penuel go meet di pipol wey dey der kon beg dem for di same tin, but dem ansa am, just like Sukkot leaders.
8 Dali subiu a Fanuel, onde fez o mesmo pedido, mas obteve a mesma resposta que em Socot.
9 E tell dem, make una nor worry, “I dey go, I go kom back alive and nor-tin go do mi. And by di time wey I kom back, I go distroy una towa!”
9 Gedeão disse-lhes: Quando eu voltar vitorioso, destruirei esta torre.
10 By dat time, Zebah and Zalmunna and dia soja, dey Karkor. Dem bi only 15,000 wey remain from all di men wey dey di desert tribe and dem don kill 120,000 of dia soja.
10 Zebéia e Salmana estavam então em Carcor com o seu forte exército, cerca de quinze mil homens, que eram o restante de todo o exército dos filhos do oriente, pois haviam já perecido cento e vinte mil combatentes que manejavam a espada.
11 Gideon pass di road wey dey di desert korna for di east side for Nobah and Jogbehah kon go attack di sojas for der.
11 Gedeão subiu pelo caminho dos nômades, a oriente de Nobe e de Jegba, e feriu o acampamento dos inimigos que se julgavam perfeitamente seguros.
12 Di two Midian king wey bi Zebah and Zalmunna run komot, but e porshu and katch dem and dis tin kon make all di sojas sopraiz.
12 Zebéia e Salmana, reis de Madiã, fugiram, mas foram perseguidos e presos por Gedeão, depois de ter derrotado toda a sua guarnição.
13 Wen Gideon dey kom back from di war, e kon pass thru Heres Pass and
13 Gedeão, filho de Joás, voltou da batalha pela subida de Hares.
14 e katch one man from Sukkot kon ask am kweshon, den di man rite di 77 leaders name for Sukkot, give Gideon.
14 Deteve um jovem entre os habitantes de Socot e fez-lhe perguntas. Este escreveu-lhe uma lista com setenta e sete nomes dos chefes de Socot e dos anciãos.
15 Den Gideon go meet Sukkot men kon tell dem, “Una remember di time wen una sey una nor go fit help mi? Una sey una nor go fit give my sojas wey don taya food to chop, bikos I neva katch Zebah and Zalmunna. Naw, make una si dem!”
15 Gedeão veio ter com os habitantes de Socot e disse-lhes: Eis aqui Zebéia e Salmana a respeito dos quais me insultastes, dizendo: tens já talvez em teu poder o punho de Zebéia e de Salmana, para que possamos dar pão aos teus homens fatigados?
16 So e take kane and shuku-shuku from di desert kon flog Sukkot leaders.
16 Tomou então os anciãos da cidade e açoitou-os com espinhos e abrolhos do deserto.
17 E still distroy Penuel towa kon kill di men wey dey di town.
17 Destruiu também a torre de Fanuel e matou os habitantes da cidade.
18 Den, Gideon ask Zebah and Zalmunna, “Di men wey una kill for Tabor, make una tell mi how dem bi!” Dem ansa, “Dem bi like yu, all of dem bi like king pikin.”
18 E disse a Zebéia e a Salmana: Como eram aqueles homens que matastes no Tabor? Eram, responderam-lhe, semelhantes a ti; cada um deles parecia um filho de rei
19 So Gideon sey, “Dem bi my brodas, my mama shidren. If to sey una nor kill dem, I swear I nor for kill una.”
19 Eram meus irmãos, filhos de minha mãe! Juro pelo Senhor, se os tivésseis deixado com vida, eu não vos mataria.
20 Den e tell en senior pikin Jeta, “I kommand yu make yu kill dem!” But di pikin nor gri bring out en swod, e dey fear, bikos e still bi small boy.
20 E disse a Jeter, seu filho primogênito: Levanta-te e mata-os! Mas o jovem não ousou tirar a espada, porque, sendo ainda muito novo, tinha medo.
21 So Zebah and Zalmunna kon tell Gideon, “Make yu kill us yorsef, bikos yu nid to get heart like man first, before yu go fit do wetin man dey do.” So Gideon kill dem kon take di gold wey dey dia kamel neck.
21 Vem tu mesmo, disseram-lhe Zebéia e Salmana, e mata-nos; porque, tal o homem, tal a sua força. Gedeão matou Zebéia e Salmana, e tomou os colares que os camelos traziam ao pescoço.
22 Leta, Israel pipol tell Gideon, “Make yu bi awa ruler, yu and yor shidren-shidren, bikos yu don save us from Midian pipol hand.”
22 Os israelitas disseram a Gedeão: Sê o nosso rei, tu e teu filho, e o filho de teu filho, porque tu nos livraste das mãos dos madianitas.
23 But Gideon ansa, “I nor go fit bi una ruler, even my pikin nor fit. Na God go bi una ruler.”
23 Não, respondeu ele, não reinarei sobre vós, nem meu filho tampouco; é o Senhor quem será o vosso rei.
24 And e still sey, “Make I beg una for one tin. Make all of una give mi di ear-ring wey una take from Midian pipol.” (dis na bikos, Midian pipol and oda desert pipol, dey wear gold ear-ring.)
24 E ajuntou: Tenho um pedido a vos fazer: que cada um de vós me dê as argolas de vosso despojo. Os inimigos, que eram os ismaelitas, usavam argolas de ouro.
25 Di pipol ansa, “Wi go dey happy to give yu.” So dem put klot for groun and evribody kon put di ear-ring wey dem take.
25 Eles responderam: Nós tas daremos de muito boa vontade. E, estendendo no chão um manto, lançaram nele as argolas de sua presa.
26 Di gold ear-ring wey Gideon kollect, heavy rish 20 kilogram and dis ones nor join di fine-fine gold, necklaces and di purpol klot wey Midian king dem dey wear and di kollar wey dey round dia kamel neck.
26 O peso das argolas de ouro que ele tinha pedido era de mil e setecentos siclos de ouro, sem contar os colares, brincos e ornamentos de púrpura que costumavam usar os reis de Madiã, afora ainda os colares que traziam seus camelos no pescoço.
27 So Gideon make image with di gold kon put am for Ofrah wey bi en own town. Israel pipol forget God kon go der dey go woship di image. And e kon turn wahala for Gideon and en family.
27 Gedeão fez de tudo isso um efod e o expôs em sua cidade de Efra. Mas todos os israelitas se prostituíram ante esse efod que se tornou, assim, um laço para Gedeão e sua casa.
28 So Israel pipol win Midian pipol and dem nor kon dey fear dem again. Di land kon get peace for forty years until Gideon die.
28 Os madianitas foram humilhados diante dos israelitas e não puderam mais levantar a cabeça, de sorte que a terra pôde gozar um repouso de quarenta anos no tempo de Gedeão.
29 Gideon go back to en own town kon stay der.
29 Jerobaal, filho de Joás, retirou-se e foi habitar em sua casa.
30 E get 70 sons, bikos e marry many wife.
30 Teve setenta filhos, saídos todos dele, porque tinha numerosas mulheres.
31 E still get one girl-friend for Shekem wey born one pikin for am and e kon koll am, Abimelek.
31 Sua concubina, que estava em Siquém, deu-lhe também um filho, que foi chamado Abimelec.
32 Gideon, Joash pikin, old well-well before e die and dem beri am for en papa Joash grave, for Ofrah wey dey Abiezer town.
32 Morreu Gedeão, filho de Joás, numa ditosa velhice, e foi sepultado no túmulo de Joás, seu pai, em Efra de Abieser.
33 Afta Gideon don die, Israel pipol kon dey sin against God, bikos dem dey woship Baal.
33 Depois de sua morte, os filhos de Israel prostituíram-se de novo com os baal, e tomaram Baal-Berit por seu deus.
34 So dem nor kon dey serve and woship di Oga God wey save dem from all dia enemies wey dey around dem.
34 Não se lembraram os israelitas do Senhor, seu Deus, que os tinha livrado das mãos de todos os inimigos que os cercavam,
35 Even with all di good tins wey Gideon do for Israel pipol, dem still dey trit en family anyhow.
35 nem testemunharam gratidão alguma pela casa de Jerobaal-Gedeão por todos os benefícios que ele tinha feito a Israel.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Juízes 8, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.