Juízes 7
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NTLH
1 One day, Gideon and en men get up for early morning kon go stay near Harod where wota dey flow pass. Midian pipol kamp dey for di valley near di nort side wey divide dem from Moreh hill.
1 Jerubaal, isto é, Gideão, e todos os homens que estavam com ele se levantaram de madrugada e foram acampar perto da fonte de Harode. O acampamento dos midianitas ficava no vale, no lado norte, perto do monte Moré.
2 God kon tell Gideon, “Di men wey yu get too many for mi to give una viktory ova Midian pipol. Dem go tink sey na dem win by demsef and bikos of dat, dem nor go kon tank mi.
2 O Senhor Deus disse a Gideão: — Você tem gente demais, e por isso não posso deixar que vocês derrotem os midianitas. Se eu deixasse, vocês poderiam pensar que venceram sem a minha ajuda.
3 So make yu tell dem, ‘Anybody wey dey fear, make e go back to en house and wi go stay here for Mount Gilead.’ ” So 22,000 pipol kon go house back, but 10,000 pipol still remain.
3 Anuncie ao povo o seguinte: “Quem estiver com medo, que saia do monte Gilboa e volte para casa.” Gideão anunciou, e vinte e dois mil homens voltaram. Mas dez mil ficaram.
4 But God still tell Gideon, “Di men wey yu get still too many, make yu take dem go di wota and I go choose di ones wey I wont, for der. If I tell yu sey, ‘Make dis man follow yu,’ e go follow and if I sey, ‘Make dis man nor follow,’ e nor go follow yu.”
4 E o Senhor disse a Gideão: — Ainda é gente demais. Leve todos até as águas, e ali eu separarei os que irão com você. Se eu disser que um homem deve ir com você, ele irá. Se disser que outro não deve ir, ele não irá.
5 So Gideon take di men go di wota, den God tell am, “Make yu take doz wey drink di wota like dog and nor bi doz wey go knee down drink am.”
5 Aí Gideão fez com que os homens descessem até as águas. E o Senhor Deus lhe disse: — Todos os homens que lamberem a água com a língua, como fazem os cachorros, devem ser separados dos que se ajoelharem para beber.
6 And na only three hundred men drink di wota like dog, but di rest knee down drink am.
6 Trezentos homens juntaram água nas mãos e lamberam. Todos os outros se ajoelharam para beber.
7 God tell Gideon, “I go use dis three hundred men wey drink di wota like dog, take save and give yu viktory ova Midian pipol. So, make yu tell di remainin pipol make dem dey go dia house back.”
7 Aí o Senhor disse a Gideão: — Com estes trezentos homens que lamberam a água, eu libertarei vocês e lhes darei a vitória sobre os midianitas. Diga aos outros que voltem para casa.
8 So Gideon send di men go dia house, escept di three hundred men wey follow di rules and na dem dey keep di trumpets. Midian pipol kamp dey under Israel pipol own for di valley.
8 Então Gideão mandou todos os outros israelitas para casa, menos aqueles trezentos. Mas estes ficaram com toda a comida e todas as cornetas. O acampamento dos midianitas estava abaixo deles, no vale.
9 Dat nite, God tell Gideon, “Get up make yu go attack Midian pipol, bikos I don give yu viktory.
9 Naquela noite o Senhor Deus disse a Gideão: — Levante-se e ataque o acampamento dos midianitas. Eu já dei a vitória a você.
10 But if yu dey fear to attack, make yu and yor savant Purah, go di kamp
10 Mas, se você estiver com medo de atacar, desça até o acampamento deles. Leve junto Purá, o seu ajudante.
11 and una go hear wetin dem dey tok, den from der, yu go get di mind to attack.” So Gideon and en savant Purah kon go near dia enemy kamp.
11 Você vai ouvir o que eles estão dizendo e então terá coragem para atacar o acampamento. Gideão e Purá desceram até bem perto do acampamento inimigo.
12 Midian and Amalek pipol and di men wey dey stay di desert, many for di valley like worm and dia kamel many like san-san for wotaside.
12 Os midianitas, os amalequitas e os povos do deserto estavam espalhados no vale, como uma nuvem de gafanhotos. Eles e os seus camelos eram tantos como os grãos de areia da praia do mar.
13 Wen Gideon rish der, e hear one man dey tell en friend about di dream wey e dream kon sey, “I dream sey, bread wey nor get yist roll enter awa kamp kon nak and skata awa tents for groun.”
13 Quando Gideão chegou, ouviu um homem contando o seu sonho a um amigo. Ele dizia: — Eu sonhei que um pão de
14 So di friend ansa, “True-true, Gideon, Joash pikin wey kom from Israel, na en swod bi dat o-o! Na wetin di dream mean bi dat! God don gi-am viktory ova Midian pipol and all awa sojas.”
14 O amigo respondeu: — É a espada de Gideão, o israelita, o filho de Joás! Isso quer dizer que Deus entregou a ele o nosso povo e todo o nosso exército!
15 Wen Gideon hear di dream and wetin e mean, e knee down kon woship God. Den e go back to en kamp kon sey, “Make una get up! Bikos God don give us viktory ova Midian sojas.”
15 Quando Gideão ouviu esse sonho e entendeu o que ele queria dizer, ajoelhou-se e adorou a Deus. Então voltou para o acampamento israelita e disse: — Levantem-se! O
16 E divide en three hundred men into three groups kon give each pesin trumpet and cup wey tosh dey inside.
16 Gideão separou os trezentos em três grupos e deu a cada homem uma corneta de chifre de carneiro e um jarro com uma tocha dentro.
17 E tell dem, “Wen wi rish di kamp korna, make una do anytin wey I do.
17 E disse: — Olhem para mim! E, quando eu chegar perto do acampamento inimigo, façam o que eu fizer.
18 And as mi and my group blow awa trumpet, make una blow una own round di kamp kon shaut, ‘Dis one na for God and for Gideon!’ ”
18 Quando eu e o meu grupo tocarmos as cornetas, então vocês, que estarão cercando o acampamento, toquem as cornetas e gritem: “Pelo Senhor e por Gideão!”
19 As dem just shange doz wey dey guide before mid-nite, Gideon and en hundred men kom di kamp korna kon blow dia trumpet and break di cup wey dey dia hand,
19 Um pouco antes da meia-noite, na hora de ser trocada a guarda, Gideão e os seus cem homens chegaram bem perto do acampamento. Então tocaram as cornetas e quebraram os jarros que levavam.
20 den di oda group, do di same tin too. All of dem hold dia tosh for dia left hand, while di trumpet dey dia rite hand and dem kon shaut, “One swod for God and for Gideon!”
20 Os três grupos tocaram as cornetas e quebraram os jarros. Eles seguravam a tocha na mão esquerda e a corneta na direita e gritavam: “Uma espada pelo Senhor e por Gideão!”
21 Each man stand for one place round di kamp and dia enemies sojas kon dey shaut run komot from di place wey dem dey.
21 E cada um ficou parado no seu lugar em volta do acampamento. Então todo o exército inimigo fugiu, gritando.
22 Wen Gideon men dey blow dia trumpet, God make di enemies bigin fight demsef with dia swod. So dem run go Zaretan, wey far rish Bet-Shittah and Abel-Meholah town, near Tabbat.
22 Enquanto os trezentos homens tocavam as cornetas, o Senhor Deus fez com que os homens do acampamento atacassem uns aos outros com as suas espadas. Eles fugiram na direção de Zererá e foram a Bete-Sita e até a divisa de Abel-Meolá, perto de Tabate.
23 Israel pipol from Naftali Asher and Manasseh tribes kom out kon porshu Midian pipol.
23 Então os homens das tribos de Naftali, de Aser e das duas metades da tribo de Manassés foram chamados e perseguiram os midianitas.
24 Gideon send messenjas go all di hill kountry for Efraim sey, “Make una kom join mi fight Midian pipol and make una guide Jordan River and di small rivers go rish Bet-Barah, so dat Midian pipol nor go cross go der.” So Efraim men kon go guide di river.
24 Gideão enviou mensageiros para dizerem a todos os que moravam na região montanhosa de Efraim: — Desçam e lutem contra os midianitas. Defendam o rio Jordão e os seus riachos até Bete-Bara e não deixem os midianitas atravessarem. Então os homens de Efraim foram e defenderam o rio Jordão e os seus riachos até Bete-Bara.
25 Dem katch two Midian shief wey bi, Oreb and Zeeb. Dem kill Oreb for Oreb rock and Zeeb for where dem for dey press wine and di place name na Zeeb. Israel pipol still porshu Midian pipol, but dem bring Oreb and Zeeb head kom give Gideon for Jordan River east.
25 Eles prenderam Orebe e Zeebe, os dois chefes midianitas. Mataram Orebe na pedra de Orebe e mataram Zeebe no seu tanque de pisar uvas. Continuaram a perseguir os midianitas e levaram a cabeça de Orebe e a de Zeebe para Gideão, que estava a leste do rio Jordão.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Juízes 7, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.