Juízes 6
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NTLH
1 Israel pipol sin against God again, so E allow Midian pipol rule dem for seven years.
1 O povo de Israel pecou contra Deus, o Senhor , e por isso ele deixou que o povo de Midiã os dominasse durante sete anos.
2 Midian pipol get pawa well-well and Israel pipol kon dey hide for rock and oda place wey dey save for di hills.
2 Os israelitas se escondiam dos midianitas em cavernas e em outros lugares seguros nas montanhas porque os midianitas eram mais fortes do que eles.
3 Anytime wen Israel pipol plant, Midian, Amalek pipol and anoda tribe for di desert go kon attack dem.
3 Todas as vezes que os israelitas semeavam, os midianitas vinham com os amalequitas e os povos do deserto e os atacavam.
4 Dem go kamp for di land kon distroy all dia plants from di aria for sout go rish Gaza. Dem go karry all di animals and dem nor go leave anytin make Israel pipol chop.
4 Acampavam na terra e destruíam as suas colheitas até o sul, perto de Gaza. Não deixavam nada para os israelitas viverem — nem ao menos uma ovelha, uma vaca ou um jumento.
5 Dem go kom with dia kattle and tent wey tick like lokust. Dem go use dia kamel take skata di land
5 Chegavam com o seu gado e as suas barracas e eram tão numerosos como gafanhotos. Eles e os seus camelos eram tantos, que nem dava para contar. Vinham para destruir a terra,
6 and Israel pipol nor fit do dem anytin.
6 e o povo de Israel não podia com eles. Então os israelitas pediram socorro a Deus, o Senhor .
7 Den, Israel pipol kon kry give God make E help dem.
7 Quando eles oraram ao Senhor por causa dos midianitas,
8 So God send one profet go meet dem with dis message: “Dis na wetin di Oga wey bi Israel God dey tok: ‘I take una komot Egypt for where una for bi slave.
8 ele mandou um profeta , que lhes disse: — Assim diz o
9 I save una from Egypt pipol and from all di pipol wey opress una. I porshu all una enemies kon give una dia land.
9 Eu os livrei dos egípcios e dos que lutaram contra vocês aqui, nesta terra. Expulsei os seus inimigos e dei a vocês a terra deles.
10 Den I tell una sey, “Na mi bi una Oga and God. Una must nor woship Amor pipol gods; even doh una dey stay dia land naw.” But una nor gri listin to mi.’ ”
10 Eu disse que sou o Senhor , o Deus de vocês, e que vocês não deviam adorar os deuses dos amorreus, que viviam nesta terra. Mas vocês não quiseram me ouvir.”
11 Den God angel kom Ofrah village kon sidan under di oak tree, wey bi Joash wey kom from Abiezer family, own. Den, en pikin Gideon dey hide pick wheat for one wine press, so dat Midian pipol nor go si am.
11 Então o Anjo do Senhor veio e sentou-se debaixo de um carvalho que havia perto do povoado de Ofra. Esse carvalho pertencia a Joás, que era da família de Abiezer. O seu filho, Gideão, estava malhando trigo no tanque de pisar uvas, escondido, para que os midianitas não o encontrassem.
12 Di angel appear to am kon sey, “Strong man, God dey with yu!”
12 Então o Anjo do Senhor apareceu a ele e disse: — Você é corajoso, e o
13 Gideon ansa, “My Oga! If God really dey with us, wetin make all dis tins dey happen to us? And where all di mirakle wey awa grand-grand papa dem tell us? Bikos dem sey, ‘Na God take us komot from Egypt!’ But naw, God don forget us kon allow Midian pipol dey rule us.”
13 Gideão respondeu: — Se o
14 Den God angel turn kon tell am, “Make yu go with di pawa wey yu get kon save Israel pipol from Midian pipol, bikos na mi dey send yu!”
14 Então o Senhor Deus ordenou a Gideão: — Vá com toda a sua força e livre o povo de Israel dos midianitas. Sou eu quem está mandando que você vá.
15 Gideon ansa, “My Oga! Na how I go take save Israel pipol? Na my family weak pass for Manasseh tribe and na mi small pass for di family!”
15 Gideão respondeu: — Senhor, como posso libertar Israel? A minha família é a mais pobre da
16 Den di angel tell am, “Yu go fit do am, bikos I go dey with yu and yu go distroy Midian pipol like sey yu dey fight one pesin.”
16 Mas o Senhor disse: — Você pode fazer isso porque eu o ajudarei. Você esmagará todos os midianitas como se eles fossem um só homem.
17 Gideon sey, “If yu go really help mi, den make yu show mi sign, so dat I go know sey na di Oga God really dey tok to mi.
17 Gideão respondeu: — Se tu estás contente comigo, então dá-me uma prova de que és tu mesmo que estás falando.
18 Abeg, make yu nor komot until I bring food kon offa give yu.”
18 E, por favor, não vás embora até que eu te traga uma oferta. — Eu ficarei aqui até você voltar! — disse Deus.
19 Den Gideon rush go house go kook one yong goat den e use flower bake bread wey nor get yist. E put di meat for basket kon put di bread for pot, den e karry am go give di angel wey dey under di oak tree.
19 Então Gideão entrou, cozinhou um cabrito e fez pão sem fermento com mais ou menos dez quilos de farinha. Pôs a comida numa cesta e pôs o caldo numa panela. Levou tudo e entregou ao Anjo do Senhor , que estava debaixo do carvalho.
20 Di angel tell am, “Make yu put di meat and di bread for dis rock, den pour di oil on-top.” So Gideon do as e tok.
20 Então o Anjo ordenou: — Ponha a carne e o pão nesta pedra e derrame o caldo em cima. Gideão fez o que ele mandou.
21 God angel tosh di meat and bread with di stik wey e hold and fire kom out from di rock kon burn di food finish. Den di angel disappear.
21 Em seguida o Anjo estendeu o bastão que tinha na mão e tocou com a sua ponta a carne e o pão. Então saiu fogo da pedra e queimou a carne e o pão. E o Anjo desapareceu.
22 Gideon bigin kry, wen e kon know sey na God angel bi dat, den e sey, “My Oga God wey get pawa, I don si yor angel face-to-face!”
22 Aí Gideão compreendeu que era mesmo o Anjo do Senhor que ele tinha visto. E disse, apavorado: — Ai de mim,
23 But God tell am, “Nor worry or fear, bikos yu nor go die.”
23 Mas o Senhor respondeu: — Não fique com medo. Tudo está bem. Você não morrerá.
24 So Gideon build one altar for der give God kon koll am, “Yahweh Shalom wey mean, ‘Na Oga God bi peace.’ ” Till today, di altar still dey for Ofrah wey bi Abiezer family land.
24 Gideão construiu ali um altar para Deus, o Senhor , e o chamou de “O Senhor é paz”. E até hoje esse altar está em Ofra, cidade que pertence às famílias de Abiezer.
25 Dat nite, God tell Gideon, “Make yu take yor papa melu and anoda seven years melu, den distroy and skata yor papa Baal altar and di Asherah juju wey dey near am.
25 Naquela noite o Senhor disse a Gideão: — Leve o touro que pertence a seu pai e outro touro de sete anos e derrube o altar do deus
26 Den, yu go build betta altar for di Oga yor God on-top dis hill. Afta yu don build di altar, yu go take di sekond melu kon burn am as ofrin for di altar and yu go use di Asherah juju pole wey yu skata, take do firewood.”
26 Nesse lugar alto e seguro, faça para o Senhor , seu Deus, um altar de pedras bem-arrumadas. Depois pegue o segundo touro e a madeira do poste de Aserá arrancado e queime tudo no altar como sacrifício .
27 So Gideon take ten among en savant follow body go do wetin God tok. But e do am for nite, bikos e dey fear en family and di pipol for di town.
27 Gideão levou dez dos seus empregados e fez o que o Senhor tinha dito. Porém, como estava com medo da sua família e do povo da cidade, em vez de fazer isso de dia, fez de noite.
28 Wen di pipol wake-up di next day, dem si sey dem don distroy di juju altar kon skata di Asherah juju wey dey near am. Dem kon si di sekond melu wey dem burn as ofrin on-top di new altar wey dem build for der.
28 De madrugada, quando os homens da cidade se levantaram, acharam o altar de Baal e o poste da deusa Aserá derrubados e o segundo touro queimado no altar que tinha sido construído ali.
29 So dem ask demsef, “Na who do dis tin?” Afta dem don ask evribody, dem kon know sey na Gideon wey bi Joash pikin, do am.
29 E perguntavam: — Quem será que fez isso? Procuraram saber e descobriram que tinha sido Gideão, filho de Joás.
30 So di pipol tell Joash, “Make yu bring yor pikin kom out, bikos e must die for wetin e do so.”
30 Então disseram a Joás: — Traga o seu filho aqui para ser morto, porque ele derrubou o altar de Baal e o poste da deusa Aserá.
31 But Joash tell di pipol wey kom meet am, “Why una dey fight for di juju? Una dey defend am? Anybody wey won fight or defend di juju, dem go kill-am before morning! If Baal really bi god, den make e defend ensef kon distroy and kill di pesin wey skata en altar!”
31 Mas Joás disse a todos os que estavam ali reunidos contra ele: — Vocês estão defendendo Baal? Quem o defender será morto antes do amanhecer. Se Baal é deus, que ele mesmo se defenda. O altar dele é que foi derrubado.
32 From dat time go, dem kon dey koll Gideon, “Jerub-Baal,” bikos Joash sey, “Make Baal defend ensef, bikos na en altar dem distroy.”
32 Daquele dia em diante, Gideão passou a ser chamado de Jerubaal , pois Joás tinha dito: “Que Baal mesmo se defenda. O altar dele é que foi derrubado.”
33 Leta, Midian, Amalek pipol and anoda tribe for di desert gada togeda kon cross Jordan River go kamp for Jezrel Valley.
33 Então todos os midianitas, os amalequitas e os povos do deserto se juntaram, e atravessaram o rio Jordão, e acamparam no vale de Jezreel.
34 Na wons God Spirit enter Gideon body, so e blow trumpet take koll all Abiezer family kom out make dem follow am.
34 E o Espírito do Senhor dominou Gideão. Ele tocou uma corneta feita de chifre de carneiro, e os homens do grupo de famílias de Abiezer foram juntar-se a ele.
35 E send messenjas go Manasseh, Asher, Zebulun and Naftali sey make all dia sojas kom and dem kon follow am.
35 Gideão enviou também mensageiros para chamar os homens das tribos de Manassés, de Aser, de Zebulom e de Naftali. E eles também foram se juntar a ele.
36 Den Gideon tell God, “If Yu won really use mi take save Israel, just as Yu promise,
36 Então Gideão disse: — Ó Deus, tu disseste que queres me usar para libertar o povo de Israel.
37 den make Yu show mi with di sign wey I go ask for: Dis nite, I go put wool for where wi for dey pick wheat, but wen day break and I si sey dew wet di wool and di groun dey dry, den I go know sey Yu go help mi save Israel pipol, just as Yu promise.”
37 Pois bem. Vou pôr um pouco de lã no lugar onde malhamos o trigo. Se de manhã o orvalho tiver molhado somente a lã, e o chão em volta dela estiver seco, então poderei ficar certo de que tu realmente me usarás para libertar Israel.
38 And evritin happen as Gideon tok am. Wen Gideon wake-up for morning, e skwiz di wool and di wota wey kom out, full one bowl.
38 O que ele disse aconteceu. Na manhã seguinte Gideão se levantou, espremeu a lã, e dela saiu água que deu para encher uma tigela.
39 Den Gideon tell God, “Abeg! Make Yu nor vex for mi sey I still won tok, bikos I still like do one test with di wool and dis time, I like make di wool dey dry, while di groun go soak with wota.”
39 Então ele pediu a Deus: — Não fiques zangado comigo. Mas deixa que eu fale só mais uma vez. Deixa, por favor, que eu faça mais uma prova com a lã. Que desta vez a lã fique seca, e que haja orvalho somente no chão em volta dela!
40 So dat nite, God do wetin Gideon ask for. Di next day, di wool dry well-well, but dew soak di groun.
40 E Deus fez isso naquela noite. A lã ficou seca, e o chão em volta ficou coberto de orvalho.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Juízes 6, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.