Juízes 4

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NTLH

Sair da comparação
NTLH Nova Tradução na Linguagem de Hoje 2000
1 Afta Ehud die, Israel pipol sin against God again.
1 Depois que Eúde morreu, o povo de Israel pecou novamente contra Deus, o Senhor .
2 So God kon give dem to King Jabin for Hazor for Kanaan make e rule dem. Di kommander for en sojas na Sisera, wey kom from Haroshet-Haggoyim.
2 Por isso o Senhor deixou que eles fossem conquistados por Jabim, rei de Canaã, que governava a cidade de Hazor. O comandante do seu exército era Sísera, que morava em Harosete-Hagojim.
3 Sisera, get 900 iron war horse and e opress and rule Israel pipol with wikedness for twenty years, before Israel pipol kon kry give God make E help dem.
3 Jabim tinha novecentos carros de ferro. Durante vinte anos ele maltratou o povo de Israel sem dó nem piedade. Então o povo de Israel pediu socorro a Deus, o Senhor .
4 Dat time, Deborah wey bi Lappidot wife, na profetes and judge for Israel.
4 Débora, mulher de Lapidote, era profetisa . Era também juíza dos israelitas naquele tempo.
5 E dey always sidan under one palm tree wey dey between Rama and Bethel for Efraim hill kountry and Israel pipol dey go der go meet am, make e judge dem.
5 Havia uma palmeira entre Ramá e Betel, na região montanhosa de Efraim. Débora sentava-se debaixo dela, e os israelitas vinham até ali para que ela julgasse as questões que eles traziam.
6 One day, e send message go koll Barak, Abinoam pikin, wey dey stay for Kedesh for Naftali land kon tell am, “Dis na wetin di Oga wey bi Israel God kommand sey make yu do: Make yu koll 10,000 wariors from Naftali and Zebulun tribe go Mount Tabor.
6 Ela mandou chamar Baraque, filho de Abinoão, que estava na cidade de Quedes, no território da tribo de Naftali, e lhe disse: — O
7 And I go bring Sisera, kommander for Jabin sojas, with en war horse and warrior kom Kishon River and for der, I go give una viktory ova am.”
7 Eu vou trazer Sísera, o comandante do exército de Jabim, até o rio Quisom para lutar contra você. Ele virá com seus carros de ferro e soldados, mas eu farei com que você o vença.”
8 But Barak ansa, “If yu nor follow mi go, I nor go-go anywhere.”
8 Então Baraque disse a Débora: — Só irei se você for comigo. Se você não for, eu também não irei.
9 Den Deborah sey, “Okay! I go follow yu go, but nobody go praiz yu for dis war, bikos God don sey na woman go kill Sisera.” So Deborah kon follow Barak go Kedesh.
9 Ela respondeu: — Está bem! Eu vou com você. Mas você não ficará com as honras da vitória, pois o E Débora foi com Baraque para Quedes.
10 Barak koll Zebulun and Naftali tribe kon gada dem togeda for Kedesh and na 10,000 wariors follow am. Deborah still follow am go too.
10 Baraque convocou as tribos de Zebulom e Naftali para a cidade de Quedes, e dez mil homens o seguiram. E Débora foi com ele.
11 By dis time, Heba, one Kenite man, komot from where en oda tribe pipol dey, go build en tent for near Kedesh, near one oak tree for Zaanannim. Na Moses broda-in-law wey Hobab bi en grand-grand papa.
11 Acontece que Héber, o queneu, havia se separado dos outros queneus, os descendentes de Hobabe, cunhado de Moisés. Ele havia armado as suas barracas perto do carvalho de Zaananim, que não ficava longe de Quedes.
12 Wen dem tell Sisera sey, Barak, Abinoam pikin don go Mount Tabor,
12 Avisaram Sísera que Baraque, filho de Abinoão, havia subido ao monte Tabor.
13 e koll en 900 iron war horse and en men, den dem mash komot from Haroshet-Haggoyim go Kishon River.
13 Então ele mandou vir os seus novecentos carros de ferro e todos os seus homens e os fez ir de Harosete-Hagojim até o rio Quisom.
14 Deborah tell Barak, “Make yu ready, bikos God dey lead yu and today E go give yu viktory ova Sisera.” So Barak kom down from Mount Tabor with en 10,000 men.
14 Então Débora disse a Baraque: — Vá agora porque é hoje que o Então Baraque desceu do monte Tabor com os seus dez mil homens.
15 Wen Barak attack, God kon konfuse Sisera and en men. Sisera kom down from en war horse kon take leg dey run.
15 Quando Baraque apareceu com o seu exército, o Senhor fez com que houvesse uma grande confusão no meio dos soldados e dos carros de Sísera. Aí Sísera desceu do seu carro e fugiu a pé.
16 But Barak porshu di war horse and Sisera men go Haroshet-Haggoyim kon kill all of dem for der.
16 Mas Baraque perseguiu os carros e o exército até Harosete-Hagojim. Todo o exército de Sísera foi destruído; ninguém escapou.
17 By dat time, Sisera run go meet Jael wey bi Herber from Kenite, wife. Bikos King Jabin for Hazor and Herber family na friends.
17 Porém Sísera fugiu para a barraca de Jael, mulher de Héber, o queneu. Ele fez isso porque Jabim, rei de Hazor, estava em paz com a família de Héber.
18 Jael go outside go meet Sisera kon tell am, “My oga! Make yu kom inside my house. Make yu nor fear at-all.” So Sisera go inside, den di woman hide am kon take blanket kover am.
18 Jael saiu da barraca para encontrar Sísera e lhe disse: — Entre, meu senhor. Entre na minha barraca. Não tenha medo. Então ele entrou, e Jael o cobriu com um tapete.
19 Sisera tell am, “Abeg, make yu give mi wota drink, bikos my trot don dry.” So di woman gi-am milk from one leda bag, den kon kover am again.
19 E Sísera pediu a ela: — Por favor, me dê um pouco de água porque estou com muita sede. Ela abriu um
20 Den Sisera tell di woman, “Make yu stand for di door and if anybody kom ask yu weda pesin dey here, make yu sey no.”
20 E ele disse: — Fique na porta da barraca e, se alguma pessoa vier e perguntar se há alguém aqui, diga que não.
21 But as Sisera dey sleep, bikos e don taya well-well, Jael kon take hammer and nail waka small-small go near am kon nail en head from di korna join groun, so Sisera kon die.
21 Sísera estava muito cansado e caiu num sono profundo. Aí Jael pegou um martelo e uma estaca da barraca, entrou de mansinho e fincou a estaca na cabeça dele, na fonte. A estaca atravessou a cabeça e entrou na terra. E ele morreu.
22 Wen Barak find Sisera rish der, Jael tell am, “Make yu kom si di man wey yu dey find.” So Barak follow di woman enter di tent and e kon si sey Sisera don die, bikos di woman nail en head join groun.
22 Quando Baraque chegou, perseguindo Sísera, Jael saiu para encontrá-lo e disse: — Venha cá, e eu lhe mostro o homem que você está procurando. Então Baraque foi com ela e encontrou Sísera no chão, morto, com a estaca atravessada na cabeça.
23 So for dat day, God kon give Israel pipol viktory ova Jabin wey bi Kanaan pipol king.
23 Naquele dia Deus fez com que os israelitas derrotassem Jabim, o rei cananeu.
24 From dat time go, Israel pipol kon get pawa and strong more-more pass King Jabin, until dem distroy am finish.
24 E eles continuaram atacando Jabim cada vez mais, até acabarem com ele.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Juízes 4, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.