Juízes 2
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 God angel komot from Gilgal go Bokim kon tell Israel pipol, “Na mi bring una kom out from Egypt kon put una for dis land wey I promise to give una grand-grand papa and I tok sey I nor go break my promise with una.
1 O anjo do Senhor subiu de Gálgala a Boquim e disse: Eu vos fiz subir do Egito e vos conduzi a esta terra que eu tinha prometido com juramento a vossos pais. E vos tinha dito: jamais hei de romper a aliança que fiz convosco;
2 I sey make una nor make kovenant with di pipol wey dey dis land and make una distroy dia altar, but una nor do wetin I tell una. ‘Wetin make una do like dis?’
2 vós, porém, não fareis aliança com os habitantes desta terra e lançareis por terra os seus altares! Ora, vós não obedecestes à minha voz.
3 For dat time, I tell una sey, if una disobey mi, I nor go drive di pipol wey dey stay for una land komot again. Dem go bi wahala to una and dia god go dey sweet una to serve.”
3 Por que fizestes isso? Por essa razão eu disse: não os expulsarei de diante de vós; eles permanecerão ao vosso lado e os seus deuses vos serão um laço.
4 Wen God angel don tok to Israel pipol finish, all of dem kon dey kry.
4 Ao dizer o anjo do Senhor estas palavras aos filhos de Israel, o povo pôs-se a chorar.
5 So dem koll di place Bokim (wey mean “Cry”) kon offa sakrifice give God.
5 Pelo que chamaram àquele lugar Boquim, e ofereceram ali sacrifícios ao Senhor.
6 Afta Joshua don sey make di pipol dey go, each tribe komot go take di land wey dem divide for dem.
6 Josué despediu o povo, e os israelitas foram cada um para a sua herança, a fim de tomar posse da terra.
7 So thru-out Joshua time, Israel pipol serve God and even afta e don die, dem still kontinue to dey serve am, since di leaders wey si all di good-good tins wey God do for dem still dey alive.
7 Durante toda a vida de Josué e dos anciãos que lhe sobreviveram, e que tinham testemunhado a grande obra que o Senhor tinha feito em favor de Israel, o povo serviu o Senhor.
8 Joshua wey bi Nun pikin, God savant, die wen e bi one hundred and ten years.
8 Josué, filho de Nun, servo do Senhor, morreu com a idade de cento e dez anos.
9 Dem beri am for en land wey dey Timnat-Heres, for Efraim hill kountry, near di nort side for Mount Gaash.
9 Sepultaram-no no território de sua possessão, em Tamnat-Heres, na montanha de Efraim, ao norte do monte de Gaas.
10 Afta dat generashon die finish, di next generashon forget God and evritin wey E don do for dem.
10 Toda aquela geração se foi também unir a seus pais, e sucedeu-lhe outra que não conhecia o Senhor, nem o que ele tinha feito em favor de Israel.
11 Israel pipol sin against God and dem kon start to serve one juju wey dem dey koll Baal.
11 Os israelitas fizeram então o mal aos olhos do Senhor e serviram os Baal.
12 Dem forget di Oga wey bi dia grand-grand papa God wey bring dem kom out from Egypt kon bigin follow and woship di pipol wey dey around dem, gods.
12 Abandonaram o Senhor, o Deus de seus pais, que os tinha tirado do Egito, e seguiram outros deuses, os dos povos que habitavam em torno deles; prostraram-se diante deles, excitando assim a cólera do Senhor.
13 Dem forget God kon dey serve Baal and Ashtoret image.
13 Abandonaram o Senhor para servirem Baal e Astarot.
14 Bikos of dis, God vex well-well for dem, so E let tif karry all wetin dem get. E allow dia enemies opress dem and dem nor fit protet demsef again.
14 A cólera do Senhor inflamou-se contra Israel, e ele entregou-os nas mãos de piratas, que os despojaram, e vendeu-os aos inimigos dos arredores, de sorte que não puderam mais resistir-lhes.
15 Anytime wen Israel pipol go fight war, God dey-dey against dem, just as God tok before and dem sofa well-well.
15 Para onde quer que fossem, a mão do Senhor estava contra eles para fazer-lhes mal, como o Senhor lhes tinha dito e jurado, e viram-se em grande aflição.
16 Den God give Israel pipol leaders wey kom save dem from dia enemies hand.
16 {Entretanto} o Senhor suscitava-lhes juízes que os livraram das mãos dos opressores,
17 But dem nor still listin to di leaders, instead dem still dey serve and woship oda gods and dem nor do like dia grand-grand papa wey obey all God kommand.
17 mas nem mesmo os seus juízes ouviam e continuavam prostituindo-se a outros deuses, adorando-os. Abandonaram depressa o caminho que tinham seguido seus pais, na obediência aos mandamentos do Senhor, e não os imitaram.
18 As long as di leaders wey God give di pipol dey alive, E help and diliver dem from dia enemies. God sorry for dem well-well wen dem kry to am with pain, bikos of wetin dia enemies dey do dem.
18 Ora, quando o Senhor suscitava juízes, ele estava com o juiz para livrá-los de seus inimigos enquanto vivesse o juiz: o Senhor compadecia-se dos gemidos que soltavam diante de seus inimigos e de seus opressores.
19 But anytime di leaders die, dem go-go kontinue di bad-bad tins wey dem dey do. Dia own kon even worse pass di ones wey dia grand-grand papa do. Dem follow oda gods; dey serve and woship dem; dem nor gri stop dia sturbones and dem still dey do bad-bad tins.
19 Mas, depois que o juiz morria, corrompiam-se e se tornavam ainda piores do que seus pais, seguindo outros deuses, servindo-os e adorando-os; e não renunciavam aos seus crimes e à sua obstinação.
20 So, God vex well-well for dem kon sey, “Bikos dis pipol don break my kovenant wey I make with dia grand-grand papa and forget my kommand,
20 Inflamou-se, pois, contra Israel a cólera do Senhor: Visto que este povo violou o meu pacto, dizia ele, a aliança que eu tinha feito com seus pais, e não obedeceram à minha voz,
21 I nor go drive any of di nashon wey Joshua nor fit win before e die.
21 também eu não expulsarei de diante deles nenhuma das nações que Josué deixou ao morrer.
22 I go use am take test dem weda dem go follow mi, just as dia grand-grand papa do.”
22 Por elas, queria o Senhor provar os israelitas, e ver se eles seguiriam ou não o caminho do Senhor, como o tinham feito seus pais.
23 Na dis make God leave di nashons for der. E nor drive dem komot or allow Joshua win all of dem.
23 E o Senhor deixou subsistir todas essas nações que não tinha entregue nas mãos de Josué, e não as quis expulsar logo.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Juízes 2, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.