Juízes 21

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 Wen Israel pipol gada for Mizpa, dem kon vow sey, “Wi nor go ever marry awa dotas give Benjamin tribe.”
1 Os homens de Israel tinham feito este juramento em Mispá: "Nenhum de nós dará sua filha em casamento a um benjamita".
2 So dem go Bethel, sidan for God present till evening kon dey kry well-well.
2 O povo foi a Betel, onde esteve sentado perante o Senhor até à tarde, chorando bem alto e amargamente.
3 Dem sey, “Awa Oga wey bi Israel God! Wetin make dis kind tin happen for Israel? Naw one of awa tribe don dey miss from Israel!”
3 "Ó Senhor, Deus de Israel", lamentaram, "por que aconteceu isso em Israel? Por que teria que faltar hoje uma tribo em Israel? "
4 Di next day for early morning, di pipol build altar kon bring dia burnt and peace ofrin kom.
4 Na manhã do dia seguinte o povo se levantou cedo, construiu um altar e apresentou holocaustos e ofertas de comunhão.
5 Den dem sey, “Wish tribe for Israel nor dey with us wen wi gada for God present for Mizpa?” By dat time, dem don swear before God sey, anybody wey nor gri kom, dem go kill-am.
5 Os israelitas perguntaram: "Quem dentre todas as tribos de Israel deixou de vir à assembléia perante o Senhor? " Pois tinham feito um juramento solene de que qualquer que deixasse de se reunir perante o Senhor em Mispá seria morto.
6 So Israel pipol kon dey sorry for dia broda, Benjamin tribe den dem kon sey, “Today, Israel don lost one of en tribe.
6 Os israelitas prantearam pelos seus irmãos benjamitas. "Hoje uma tribo foi eliminada de Israel", diziam.
7 How wi go fit take find wife for di pipol wey remain, since wi don swear with God sey, wi nor go give dem awa dotas marry?
7 "Como poderemos conseguir mulheres para os sobreviventes, visto que juramos pelo Senhor não lhes dar em casamento nenhuma de nossas filhas? "
8 Na dis make us ask sey, ‘Wish tribe for Israel nor dey with us wen wi gada for God present for Mizpa?’ ” Den dem kon notis sey, Jabesh nor follow dem gada for Mizpa.
8 Então perguntaram: "Qual das tribos de Israel deixou de reunir-se perante o Senhor em Mispá? " Descobriu-se então que ninguém de Jabes-Gileade tinha vindo ao acampamento para a assembléia.
9 Bikos wen dem kount all di pipol finish, dem si sey nobody for Jabesh dey der.
9 Quando contaram o povo, verificaram que ninguém do povo de Jabes-Gileade estava ali.
10 So di pipol kon send anoda 12,000 for dia best sojas go Jabesh town for Gilead sey, make dem kill evribody, even di wimen and shidren.
10 Então a comunidade enviou doze mil homens de guerra com instruções para irem a Jabes-Gileade e matarem à espada todos os que viviam lá, inclusive mulheres e crianças.
11 Dem sey, dis na wetin una go do, “Kill all di sons and any woman wey nor bi virgin.”
11 "É isto o que vocês deverão fazer", disseram, "matem todos os homens e todas as mulheres que não forem virgens".
12 For all di pipol wey dey Jabesh, dem si 400 yong virgin wey neva sleep with man before kon bring dem kom di kamp for Shiloh wey dey Kanaan land.
12 Entre o povo que vivia em Jabes-Gileade encontraram quatrocentas moças virgens e as levaram para o acampamento de Siló, em Canaã.
13 Den di pipol send message go give di pipol wey remain for Benjamin tribe, wey dey stay for Rimon Rock.
13 Depois a comunidade toda enviou uma oferta de comunhão aos benjamitas que estavam na rocha de Rimom.
14 So Benjamin men go back to dia house and Israel pipol kon give dem di girls from Jabesh wey dem nor kill make dem marry. But dem nor many rish.
14 Os benjamitas voltaram naquela ocasião e receberam as mulheres de Jabes-Gileade que tinham sido poupadas. Mas não havia suficientes mulheres para todos eles.
15 Di pipol sorry for Benjamin pipol, bikos God don separate dem from di oda Israel tribes.
15 O povo pranteou Benjamim, pois o Senhor tinha aberto uma lacuna nas tribos de Israel.
16 So di leaders kon ask, “How wi fit take find wife for di pipol wey remain, since all Benjamin wimen don die finish?
16 E os líderes da comunidade disseram: "Mortas as mulheres de Benjamim, como conseguiremos mulheres para os homens que restaram?
17 Bikos doz wey survive for Benjamin tribe must get shidren, so dat one tribe for Israel nor go die finish.
17 Os benjamitas sobreviventes precisam ter herdeiros, para que uma tribo de Israel não seja destruída.
18 But wi nor go fit marry awa dotas give dem, bikos wi don swear sey anybody wey do am go dey under God curse.”
18 Não podemos dar-lhes nossas filhas em casamento, pois nós israelitas fizemos este juramento: Maldito seja todo aquele que der mulher a um benjamita.
19 Den, dem tink of di sakrifice wey dem dey do for God and na evry year for Shiloh, wey dey sout for Lebonah and nort for Bethel, dem for dey do am. E still dey east for di road wey dey between Bethel and Shekem.
19 Há, porém, a festa anual do Senhor em Siló, ao norte de Betel, a leste da estrada que vai de Betel a Siquém, e ao sul de Lebona".
20 So dem tell Benjamin men wey still nid wife sey, “Make una go hide for di vineyards.
20 Então mandaram para lá os benjamitas, dizendo: "Vão, escondam-se nas vinhas
21 Anytime una si di yong wimen for Shiloh kom out kon dance for di festival, una go rush kom out kon katch dem one-by-one go house for Benjamin town as una wife!
21 e fiquem observando. Quando as moças de Siló forem para as danças, saiam correndo das vinhas e cada um de vocês apodere-se de uma das moças de Siló e vá para a terra de Benjamim.
22 Den wen dia papa and brodas kom meet us with vexnashon, wi go tell dem sey, ‘Abeg make una sorry for us. Make una allow dem marry una dotas, bikos wi nor fit find wife for all of dem wen wi distroy Ramot. And nor-tin go do una if una break di vow, bikos una nor really marry una dotas give dem from una mind.’ ”
22 Quando os pais ou irmãos delas se queixarem a nós diremos: Tenham misericórdia deles, pois não conseguimos mulheres para eles durante a guerra, e vocês são inocentes, visto que não lhes deram suas filhas".
23 So Benjamin men do as dem tell dem. Each man katch one woman as dem dey dance for di festival kon karry am go as en wife. Dem go back to dia own land kon build house and stay der again.
23 Foi o que os benjamitas fizeram. Quando as moças estavam dançando, cada homem tomou uma para fazer dela sua mulher. Depois voltaram para a sua herança, reconstruíram as cidades e se estabeleceram nelas.
24 Den Israel pipol komot from der. Evry man go back to en tribe, family and evritin wey e get.
24 Na mesma ocasião os israelitas saíram daquele local e voltaram para as suas tribos e para os seus clãs, cada um para a sua própria herança.
25 For dat time, Israel nor get king; so evribody dey do wetin dem tink sey dey good for dia eye.
25 Naquela época não havia rei em Israel; cada um fazia o que lhe parecia certo.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Juízes 21, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.