Juízes 1
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA
1 Afta Joshua die, Israel pipol kon ask God, “Na wish tribe go first go attack Kanaan pipol?”
1 Depois da morte de Josué, os filhos de Israel consultaram o Senhor , dizendo: Quem dentre nós, primeiro, subirá aos cananeus para pelejar contra eles?
2 God ansa, “Na Judah tribe, bikos I don give dem viktory ova di land.”
2 Respondeu o Senhor : Judá subirá; eis que nas suas mãos entreguei a terra.
3 Den Judah men tell dia relashon from Simeon tribe sey, “Make una join us go fight Kanaan pipol wey dey di aria wey God give us. Den wi go follow una go fight and win una own aria too.” So Simeon men follow Judah pipol.
3 Disse, pois, Judá a Simeão, seu irmão: Sobe comigo à herança que me caiu por sorte, e pelejemos contra os cananeus, e também eu subirei contigo à tua, que te caiu por sorte. E Simeão partiu com ele.
4 Wen Judah men attack, God make dem win Kanaan and Periz pipol and dem kill 10,000 men wey dey fight war for Bezek town.
4 Subiu Judá, e o Senhor lhe entregou nas mãos os cananeus e os ferezeus; e feriram deles, em Bezeque, dez mil homens.
5 As dem dey Bezek, dem meet King Adoni-Bezek kon fight am. Dem win Kanaan and Periz pipol.
5 Em Bezeque, encontraram Adoni-Bezeque e pelejaram contra ele; e feriram aos cananeus e aos ferezeus.
6 King Adoni-Bezek kon dey run, but Israel pipol porshu and katch am, den dem kut en big finger from en hand and en big toe for en leg komot.
6 Adoni-Bezeque, porém, fugiu; mas o perseguiram e, prendendo-o, lhe cortaram os polegares das mãos e dos pés.
7 So Adoni-Bezek sey, “I don kut seventy kings hand and leg komot wons and I make dem chop food from under my tabol. But naw, God don pay mi back for wetin I do to dem.” So, dem karry am go Jerusalem and e die for der.
7 Então, disse Adoni-Bezeque: Setenta reis, a quem haviam sido cortados os polegares das mãos e dos pés, apanhavam migalhas debaixo da minha mesa; assim como eu fiz, assim Deus me pagou. E o levaram a Jerusalém, e morreu ali.
8 Den Judah men attack and seize Jerusalem; dem kill all di pipol kon burn di town rish groun.
8 Os filhos de Judá pelejaram contra Jerusalém e, tomando-a, passaram-na a fio de espada, pondo fogo à cidade.
9 Afta, dem go fight Kanaan pipol wey dey stay for di hill kountry; Negev and for di hill bottom wey dey for di west side.
9 Depois, os filhos de Judá desceram a pelejar contra os cananeus que habitavam nas montanhas, no Neguebe e nas planícies.
10 Dem mash against Kanaan pipol for Hebron (wey dem dey koll Kiriat-Arba before), dem stay der kon fight and win Sheshai, Ahiman and Talmai pipol.
10 Partiu Judá contra os cananeus que habitavam em Hebrom, cujo nome, outrora, era Quiriate-Arba, e Judá feriu a Sesai, a Aimã e a Talmai.
11 From der, dem go fight doz wey dey Debir town (wey dem dey koll Kiriat-Sefer before).
11 Dali partiu contra os moradores de Debir; e era, dantes, o nome de Debir Quiriate-Sefer.
12 Den Kaleb sey, “I go give my dota Aksah as wife to anybody wey go attack and seize Kiriat-Sefer.”
12 Disse Calebe: A quem derrotar Quiriate-Sefer e a tomar, darei minha filha Acsa por mulher.
13 Kenaz wey bi Kaleb yonga broda, na-im pikin Otniel attack and seize Kiriat-Sefer. So Kaleb pikin, Aksah kon bi Otniel wife.
13 Tomou-a, pois, Otniel, filho de Quenaz, o irmão de Calebe, mais novo do que ele; e Calebe lhe deu sua filha Acsa por mulher.
14 Di day wen Otniel dey marry Aksah, e kon tell di girl sey make e ask en papa for land. So as di girl kom down from en donkey, Kaleb kon ask am, “Na wetin yu wont?”
14 Esta, quando se foi a ele, insistiu com ele para que pedisse um campo ao pai dela; e ela apeou do jumento; então, Calebe lhe perguntou: Que desejas?
15 E ansa, “Abeg make yu give mi anoda gift. Yu don already give mi land for Negev, but naw, I wont make yu give mi place where wota dey.” Den Kaleb kon gi-am di spring for up-and-down.
15 Respondeu ela: Dá-me um presente; deste-me terra seca, dá-me também fontes de água. Então, Calebe lhe deu as fontes superiores e as fontes inferiores.
16 Moses fada-in-law shidren-shidren, wey bi Ken pipol, follow Judah pipol komot from Jeriko, di palm trees town, till dem rish di wildaness for Judah. Dem go stay with doz wey dey der, near Arad town for Negev.
16 Os filhos do queneu, sogro de Moisés, subiram, com os filhos de Judá, da cidade das Palmeiras ao deserto de Judá, que está ao sul de Arade; foram e habitaram com este povo.
17 Afta, Judah pipol join Simeon pipol go fight Kanaan pipol for Zefat and dem skata di town finish. Leta, dem kon koll di town, Hormah.
17 Foi-se, pois, Judá com Simeão, seu irmão, e feriram aos cananeus que habitavam em Zefate e totalmente a destruíram; por isso, lhe chamaram Horma.
18 Dem still attack Gaza, Ashkelon and Ekron town and di oda towns wey dey near der.
18 Tomou ainda Judá a Gaza, a Asquelom e a Ecrom com os seus respectivos territórios.
19 God dey with Judah pipol, so dem take di hill kountry. But dem nor fit drive di pipol wey dey di koast aria komot, bikos di pipol shariot, bi like iron.
19 Esteve o Senhor com Judá, e este despovoou as montanhas; porém não expulsou os moradores do vale, porquanto tinham carros de ferro.
20 So dem give Kaleb, Hebron town just as Moses promise. So Kaleb porshu Anak generashon komot der.
20 E, como Moisés o dissera, deram Hebrom a Calebe, e este expulsou dali os três filhos de Anaque.
21 Benjamin tribe nor fit porshu Jebus pipol komot Jerusalem finish, so till today, Jebus pipol still dey stay for Jerusalem with Benjamin pipol.
21 Porém os filhos de Benjamim não expulsaram os jebuseus que habitavam em Jerusalém; antes, os jebuseus habitam com os filhos de Benjamim em Jerusalém, até ao dia de hoje.
22 Josef shidren-shidren, attack Bethel town and God help dem.
22 Subiu também a casa de José contra Betel, e o Senhor era com eles.
23 Dem send men go spy Bethel (wey dem dey koll Luz before).
23 A casa de José enviou homens a espiar Betel, cujo nome, dantes, era Luz.
24 Dem meet one man dey kom out from di town kon ask am, “Make yu show us how to enter dis town and wi nor go kill yu.”
24 Vendo os espias um homem que saía da cidade, lhe disseram: Mostra-nos a entrada da cidade, e usaremos de misericórdia para contigo.
25 So e show dem and dem kill evribody wey dey di town, escept di man and en family.
25 Mostrando-lhes ele a entrada da cidade, feriram a cidade a fio de espada; porém, àquele homem e a toda a sua família, deixaram ir.
26 Leta, di man komot from der kon go Hit pipol land and e build en own town wey e koll, Luz for der. Naim dem still dey koll am till today.
26 Então, se foi ele à terra dos heteus, e edificou uma cidade, e lhe chamou Luz; este é o seu nome até ao dia de hoje.
27 Manasseh pipol nor fit drive di pipol for Bet-Shean, Taanak, Dor, Ibleam, Megiddo and doz wey dey near der. So doz pipol still dey stay der.
27 Manassés não expulsou os habitantes de Bete-Seã, nem os de Taanaque, nem os de Dor, nem os de Ibleão, nem os de Megido, todas com suas respectivas aldeias; pelo que os cananeus lograram permanecer na mesma terra.
28 Israel pipol kon get pawa well-well and dem force and turn Kanaan pipol to dia slave, but dem nor drive all of dem komot from di land.
28 Quando, porém, Israel se tornou mais forte, sujeitou os cananeus a trabalhos forçados e não os expulsou de todo.
29 Efraim tribe nor fit drive Kanaan pipol wey dey Geza, so Kanaan pipol still dey stay der with dem.
29 Efraim não expulsou os cananeus, habitantes de Gezer; antes, continuaram com ele em Gezer.
30 Zebulun tribe nor fit drive di pipol wey dey Kitron and Nahalol, so Kanaan pipol still dey stay among dem. But dem force and turn Kanaan pipol to dia slave.
30 Zebulom não expulsou os habitantes de Quitrom, nem os de Naalol; porém os cananeus continuaram com ele, sujeitos a trabalhos forçados.
31 Asher tribe nor fit drive di pipol wey dey Akko, Sidon, Ahlab, Akzib, Helbah, Afek and Rehob, komot.
31 Aser não expulsou os habitantes de Aco, nem os de Sidom, os de Alabe, os de Aczibe, os de Helba, os de Afeca e os de Reobe;
32 Instead, Asher pipol dey stay and kontrol Kanaan pipol wey dey di land, bikos dem nor fit porshu dem komot.
32 porém os aseritas continuaram no meio dos cananeus que habitavam na terra, porquanto os não expulsaram.
33 Na so too, Naftali tribe nor fit drive Bet-Shemesh and Bet-Anat pipol komot, instead, dem dey stay and kontrol Kanaan pipol wey dey di land. Dem force di pipol to work for dem as dia slave.
33 Naftali não expulsou os habitantes de Bete-Semes, nem os de Bete-Anate; mas continuou no meio dos cananeus que habitavam na terra; porém os de Bete-Semes e Bete-Anate lhe foram sujeitos a trabalhos forçados.
34 Amor pipol force Dan tribe go stay for di kountries wey dey di hill and dem nor let dem kom down again.
34 Os amorreus arredaram os filhos de Dã até às montanhas e não os deixavam descer ao vale.
35 Amor pipol still dey stay for Mount Heres, Aijalon and Shaalbim, but wen Josef shidren-shidren don strong well-well, dem kon force Amor pipol to work as dia slave.
35 Porém os amorreus lograram habitar nas montanhas de Heres, em Aijalom e em Saalabim; contudo, a mão da casa de José prevaleceu, e foram sujeitos a trabalhos forçados.
36 Amor pipol borda start from Skorpion Pass go rish Sela and e still kontinue from der go.
36 O limite dos amorreus foi desde a subida de Acrabim e desde Sela para cima.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Juízes 1, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.