Juízes 19

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NTLH

Sair da comparação
NTLH Nova Tradução na Linguagem de Hoje 2000
1 For dat time, Israel pipol nor get king. But e get one man from Levi tribe wey dey stay for Efraim hill kountry. One day, e bring one girl kom from Betlehem for Judah as en girl-friend.
1 Naqueles dias em que Israel não tinha rei, um levita foi morar bem longe, na região montanhosa de Efraim. Ele arranjou uma jovem de Belém de Judá para ser a sua concubina .
2 But di girl dey vex for am, so e kon go back to en papa house for Betlehem. Afta four monts don pass,
2 Porém ela brigou com ele e voltou para a casa do seu pai, em Belém. E ficou lá durante quatro meses.
3 en boy-friend kon go Betlehem go tok to am make e kom back. E take en savant and two donkey follow body. Wen e rish di girl papa house, di papa kon welkom am.
3 Então o homem resolveu ir a Belém atrás dela, para tentar convencê-la a voltar. Ele foi com o seu empregado e levou dois jumentos. E a moça o recebeu na casa do seu pai. Quando o pai da moça viu o levita, recebeu-o com alegria
4 Di papa beg am make e stay small, so e stay der; chop, drink and sleep for three days.
4 e insistiu para que ficasse na sua casa. E ele ficou ali três dias. Assim o casal tomou as suas refeições e passou as noites ali.
5 For di fourt day, di man kwik wake-up kon ready to go, but di girl papa tell am, “Make yu chop sometin, before yu go.”
5 No quarto dia eles se levantaram cedo e se aprontaram para ir embora. Mas o pai da moça disse ao levita: — Coma alguma coisa antes de ir e assim você se sentirá melhor. Você pode ir mais tarde.
6 So di two men sidan kon chop and drink, den di papa kon sey, “Abeg stay for just dis nite make yu enjoy yorsef.”
6 Então os dois homens se sentaram, e comeram, e beberam juntos. Aí o pai da moça disse: — Por favor, fique mais uma noite e divirta-se.
7 Di man stand up won kon go, but di papa still dey beg make e stay, so e kon agri to stay for dat nite.
7 O homem se levantou para sair, mas o pai da moça insistiu muito que ele ficasse. E assim o levita passou outra noite ali.
8 For di fift day, e kon kwik wake-up make e dey go. Again, di girl papa kon sey, “Make yu chop sometin; den yu fit go for aftanoon.” So dem sidan kon chop.
8 No quinto dia, bem cedo, ele se levantou para ir, mas o pai da moça pediu: — Por favor, coma alguma coisa. Espere até mais tarde. E os dois homens comeram juntos.
9 Afta, wen di man, en girl-friend and en savant dey ready to go, di papa kon sey, “Look, evening don almost rish. Make una stay and enjoy for dis nite, den tumoro morning, una fit get up early kon go.”
9 Quando o homem, a moça e o empregado iam saindo, o pai disse: — Olhe! Agora já é quase noite. É melhor você ficar para passar a noite aqui. Logo vai ficar escuro. Fique aqui e divirta-se. Amanhã você poderá se levantar cedo e viajar de volta para casa. — Por que não paramos e passamos a noite nesta cidade dos jebuseus ?
10 But dis time, di man don make up en mind to go. So e take en two donkey and en girl-friend kon pass thru Jebus (wey bi Jerusalem).
10 — ausente —
11 Time don go far before dem rish Jebus, so di man savant tell am, make wi stop for Jebus town kon sleep for der.
11 — ausente —
12 But di masta sey, “No! Wi nor go fit stay for dis town wey Israel pipol nor dey, instead wi go-go Gibeah.
12 Mas o patrão respondeu: — Não vamos parar numa cidade onde o povo não é israelita. Vamos continuar até Gibeá.
13 Make wi waka fast, so dat wi go fit rish Gibeah or Rama, den wi go sleep for any of di towns.”
13 É melhor a gente andar mais um pouco e passar a noite em Gibeá ou Ramá.
14 So dem kontinue. Evening don dey rish wen dem rish Gibeah town for Benjamin land,
14 Então passaram pela cidade de Jebus e continuaram a viagem. O sol já se havia escondido quando eles chegaram a Gibeá, cidade da tribo de Benjamim.
15 so dem stop kon sleep for der. Dem sleep for di town hall, bikos nobody allow dem sleep for dia house.
15 Aí saíram da estrada para passar a noite na cidade. O levita chegou e se sentou na praça. Mas ninguém o convidou para dormir na sua casa.
16 Dat evening, one old man just dey kom back from farm where e for go work. E kom from Efraim tribe, but e dey stay for Gibeah, wey all di pipol kom from Benjamin tribe.
16 E aconteceu que passou por ali um velho que estava voltando do seu trabalho na roça. Ele era da região montanhosa de Efraim, mas estava morando em Gibeá. O povo dali era da tribo de Benjamim.
17 Wen e si dem sidan for di town hall, e kon ask dem, “Where una from kom and where una dey go.”
17 O velho viu o viajante na praça e perguntou: — De onde você é? Para onde vai?
18 Di Levi man ansa, “Wi dey kom from Betlehem for Judah and wi dey go di oda side for Efraim hill kountry, bikos na der wi dey stay. I travel go Betlehem before and naw I dey go back to my house. But nobody gri make wi sleep for dia house dis nite,
18 O levita respondeu: — Eu estou viajando de Belém de Judá para bem longe, para a região montanhosa de Efraim, onde moro. Fui a Belém e agora estou voltando para casa, mas ninguém me ofereceu hospedagem para esta noite.
19 even doh sey wi get evritin wey wi wont. Wi get food for awa donkey, plenty bread and wine for awasef.”
19 Nós temos alimento e palha para os jumentos, e pão e vinho para mim, para a minha concubina e para o meu empregado. Temos tudo o que precisamos.
20 Den di old man sey, “Make una kom my house, I go give una anytin wey una wont. Una nor nid to stay for di town hall.”
20 O velho disse: — Venham comigo; vocês serão bem-recebidos na minha casa. Eu cuidarei de vocês. Por favor, não passem a noite na praça.
21 So e take dem go en house kon feed dia donkey. Afta dem don wosh dia leg, dem kon chop and drink togeda.
21 Então ele os levou para a sua casa e deu de comer aos jumentos. Os seus hóspedes lavaram os pés, comeram e beberam.
22 As dem dey chop and drink, some pipol wey dey kause trobol for di town kon surround di house. Dem bigin nok di door dey shaut for di old man, “Make yu bring di man wey dey stay with yu, so dat wi go sleep with am.”
22 Enquanto eles conversavam alegremente, alguns homens imorais daquela cidade cercaram a casa e começaram a bater na porta. E disseram ao velho: — Traga para fora o homem que está na sua casa! Nós queremos ter relações com ele.
23 But di old man go outside go meet dem kon tell dem, “No! My brodas, abeg make una nor do dis kind evil tin! Dis man na my visitor and dis kind tin na shame.
23 Aí o velho saiu e disse: — Não, meus amigos! Por favor, não façam essa coisa tão má e tão imoral! Este homem é meu hóspede.
24 Look, make una take my dota wey bi virgin and di man girl-friend. I go bring dem kom out for una, make una take dem do wetin una like, but make una nor do dis kind bad tin to di man.”
24 Olhem! Estão aqui a minha filha virgem e a concubina dele. Eu vou pôr as duas para fora, e vocês poderão fazer com elas o que quiserem. Mas não façam essa coisa horrível com este homem!
25 But dem nor gri listin to di man. So di Levi kon push en girl-friend go outside for dem. So dem rape am, do am anyhow till day break.
25 Mas eles não quiseram ouvi-lo. Então o levita pegou a sua concubina, a pôs para fora e a entregou a eles. E eles a forçaram, e abusaram dela a noite toda, e só a deixaram de manhã.
26 Wen day break, di woman kom di old man house where en boy-friend dey kon fall for di gate, e stay der until sun kom out for morning.
26 Ao amanhecer a mulher veio e caiu na frente da casa onde o seu marido estava. E ficou ali até clarear o dia.
27 Wen di boy-friend open door for morning make e dey go, e si en girl-friend liedan for der and e hand dey di door-mot.
27 De manhã o marido se levantou para continuar a viagem. Quando abriu a porta, achou a sua concubina caída em frente da casa, com as mãos na soleira da porta.
28 So e tell am, “Make yu get up make wi dey go!” But di woman nor ansa. So e karry am put for en donkey kon take am go house.
28 Aí lhe disse: — Levante-se! Vamos embora! Porém não teve resposta. Então pôs o corpo dela atravessado sobre o jumento e seguiu viagem para casa.
29 Wen e rish house, e take knife kon kut en girl-friend body into twelf part, den e send one part go each of di twelf tribe for Israel.
29 Quando chegou lá, entrou, pegou uma faca e cortou o corpo da concubina em doze pedaços. Depois mandou um pedaço para cada uma das doze tribos de Israel.
30 Evribody wey si am kon sey, “Wi neva hear dis kind tin before! Dis kind tin neva happen wons since Israel pipol komot from Egypt! Wi nid to do sometin about am! So dem kon dey tok among demsef dey ask, ‘Na wetin wi go do naw?’ ”
30 E todos os que viam isso diziam: — Nunca vimos uma coisa assim! Nunca houve uma coisa igual a essa, desde o tempo em que os israelitas saíram do Egito! Pensem! O que vamos fazer agora?

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Juízes 19, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.