Juízes 18
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 Dat time, Israel pipol nor get king.
1 Naquele tempo não havia rei em Israel. Por essa mesma época a tribo de Dá buscava uma possessão para habitar nela, porque até então nada tinha recebido entre as tribos de Israel.
2 So Dan pipol choose five strong warrior from Zorah and Eshtaol town, so dat dem go find land where dem go stay.
2 Os danitas enviaram cinco dos seus, cinco homens valorosos escolhidos dentre todas as suas famílias de Sorea e de Estaol, para explorarem cuidadosamente a terra: Ide, disseram-lhes, e examinai bem a terra. Foram e chegaram à montanha de Efraim, e entraram na casa de Micas, onde passaram a noite.
3 As dem dey Mikah house, dem notis di Levi priest for der, so dem kon ask am, “Na who bring yu kom here? Na wetin yu dey do for here and wetin make yu dey here?”
3 Perto da casa de Micas ouviram a voz do jovem levita e, aproximando-se dele, disseram-lhe: Quem te trouxe aqui? Que fazes aqui? Por que te encontras neste lugar?
4 E ansa dem, “I get agriment with Mikah, to bi en pesinal priest and e dey pay mi.”
4 Respondeu-lhes o jovem: Micas fez-me isto e isso; deu-me um salário e eu sirvo-lhe, de sacerdote.
5 Den dem tell am, “Ask God for us weda awa journey go get head.”
5 Consulta então, replicaram-lhe, o teu deus a fim de saber se nossa viagem será bem sucedida.
6 Di priest tell dem, “Make una go in peace, bikos God dey with una for di journey.”
6 O sacerdote respondeu: Ide em paz: vossa viagem está sob o olhar de Deus.
7 So di five men kon go Laish town and dem si sey, di pipol for der dey live dia life well like Sidon pipol; dem dey peaceful and save. Di pipol get money well-well, bikos di land dey produce betta food. Dem dey stay far from Sidon pipol and dem nor dey fight with anybody.
7 Os cinco homens puseram-se a caminho e foram até Lais. Viram ali um povo que habitava seguro, pacífico e tranqüilo, segundo o costume dos sidônios. Não havia naquele terra nenhum rei que dominasse sobre os seus habitantes, ou que os molestasse em coisa alguma. Viviam longe dos sidônios e não tinham relações com ninguém.
8 Wen di men kom back to Zorah and Eshtaol, dia pipol kon ask dem, “Wetin una find?”
8 Voltando para seus irmãos em Sorea e Estaol, estes disseram: Que pudestes fazer?
9 Dem ansa, “Make una kom, make wi attack dem! Wi don si di land and e dey very good. Wetin una dey wait for? Make wi nor waste time, make wi go take am.
9 Eles responderam: Vamos, subamos contra eles. Vimos a sua terra que é excelente. Por que ficais aí sem nada dizer? Não demoreis a pôr-vos em marcha para tomar posse dessa terra.
10 Wen wi rish der, una go si sey di pipol dey leave eazy life. Di land big well-well and e get evritin wey pesin wont. God don gi-am to us.”
10 Quando ali entrardes, encontrareis um povo que vive em segurança e uma terra espaçosa que Deus vos entregará nas mãos, uma região onde nada falta daquilo que a terra produz.
11 So six hundred men from Dan tribe wey ready for war kon komot go Zorah and Eshtaol.
11 Seiscentos homens da família de Dá partiram, pois, de Sorea e de Estaol, munidos com armas de guerra
12 Dem kamp for Kiriat-Jearim west for Judah and na dis make dem dey koll di place Dan till today.
12 e acamparam em Cariatiarim, em Judá. Por isso deu-se àquele lugar o nome de Mahanê-Dã, o qual assim se chama ainda hoje, e está situado ao ocidente de Cariatiarim.
13 Dem from der pass go Mikah house for Efraim hill kountry.
13 Dali passaram às montanhas de Efraim e chegaram à casa de Micas.
14 Den di five men wey go spy Laish land kon tell di oda pipol, “Dis house wey una dey si so, get holy garment and some oda juju wey dem karve, dey der too. Wetin una wont make wi do?”
14 E os cinco homens que tinham sido enviados a explorar a terra de Lais disseram aos seus irmãos: Sabeis que há nessa casa um efod, uns terafim e um ídolo fundido? Considerai agora o que tendes a fazer.
15 So dem enter Mikah house where di yong priest dey stay kon greet am well.
15 Dirigiram-se para lá e entraram na casa do jovem levita, em casa de Micas, para saudá-lo e informar-se de como ia passando.
16 As di six hundred men from Dan tribe wey ready to fight war, stand for di gate to enter di kompond,
16 Entretanto, os seiscentos danitas, armados como estavam, ficaram à porta.
17 di five men wey go spy, enter di shrine karry di image wey dem karve, di efod and di juju dem. While di priest stand for di gate with di six hundred men.
17 Os cinco exploradores penetraram {sozinhos} na capela e tomaram o ídolo com o efod e os terafim, enquanto o sacerdote se achava com os seiscentos homens armados à entrada da porta.
18 Wen di priest si sey di men dey karry di holy tins dey komot from di shrine, e kon ask dem, “Wetin una dey do so?”
18 Tiraram, pois, da casa de Micas, o ídolo, o efod e os terafim. O sacerdote disse-lhes: Que fazeis vós?
19 Dem ansa am, “Kwayet and make yu follow us kon bi awa papa and priest. E nor good sey make yu bi priest for Israel tribe and family, down for one man?”
19 Cala-te, responderam-lhe, põe a mão na boca e vem conosco; tu nos servirás de pai e de sacerdote. O que é melhor para ti: ser sacerdote na casa de um particular, ou numa tribo e numa família de Israel?
20 So di priest happy kon follow dem and e karry all di holy tins.
20 Alegrou-se o coração do sacerdote, e ele, tomando o efod, os terafim e o ídolo, foi com a tropa.
21 Dem kon dey go with dia shidren, animals and all wetin dem get.
21 Puseram-se de novo a caminho, precedidos das crianças, do gado e das bagagens.
22 Wen Dan pipol don go far from Mikah house, Mikah kon koll all en neighbours make dem follow am porshu Dan pipol.
22 Estando eles já longe da casa de Micas, os vizinhos deste ajuntaram-se e perseguiram os danitas.
23 Dem porshu Dan pipol katch. Den, Dan men turn back kon ask Mikah, “Wetin happen? Why yu koll all dis men make dem porshu us like dis?”
23 Interrogados, os filhos de Dã voltaram-se e disseram a Micas: Que queres tu, e por que trazes toda essa gente?
24 Mikah ansa, “Wetin una mean by, ‘Wetin happen?’ Una don take all di gods wey I make and my priest dey go, wetin remain for mi naw!”
24 Ele respondeu: Tirastes os meus deuses que fiz para mim, tomastes o sacerdote e partistes. Que me resta agora? E como podeis perguntar o que quero?
25 So Dan men tell am, “Mind wetin yu dey tok! Unless yu wont make all dis men attack kon kill yu and yor family.”
25 Os danitas replicaram: Nem mais uma palavra diante de nós! Não suceda que alguns se impacientem contra vós e percais a vida, tu e tua família!
26 Den, Dan pipol kon waka dey go. Wen Mikah si sey di pipol too many for am to attack, e kon leave dem go back to en house.
26 E os danitas continuaram o seu caminho. Micas, vendo que aqueles homens eram mais fortes que ele, voltou para a sua casa.
27 Afta Dan pipol don take Mikah holy tins and priest, dem kon rish Laish land where di pipol dey kwayet well-well. Dem attack dem with swod kon burn di town rish groun.
27 Desse modo, tomaram os danitas a obra que Micas tinha feito, juntamente com o seu sacerdote. Atacaram então Lais, um povo pacífico e seguro, passaram-no ao fio da espada e queimaram a cidade.
28 Nobody dey to save dem, bikos dem dey stay far from Sidon pipol and dem nor get any business with oda pipol.
28 Não houve quem a salvasse, porque estava longe de Sidon e não tinham relações com ninguém. Essa cidade estava situada no vale pertencente a Bet-Roob. Os danitas reedificaram a cidade e habitaram-na,
29 Dem shange di town name from Laish to Dan, bikos of dia grand-grand papa wey bi Jakob pikin.
29 chamando-a cidade de Dã, nome de seu pai, que tinha nascido de Israel; a cidade chamava-se primitivamente Lais.
30 Den, dem arrange di juju kon make Jonatan wey bi Gershom pikin, dia priest and na Moses born Gershom. So na dat family bi priest until dem go Babilon.
30 E erigiram em seguida o ídolo. Jonatã, filho de Gersã filho de Moisés, e seus descendentes foram sacerdotes na tribo de Dã até o dia de sua deportação.
31 So Mikah juju dey der, as long as God Tabanako dey for Shiloh.
31 O ídolo de Micas foi conservado entre eles durante todo o tempo que o santuário de Deus ficou em Silo.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Juízes 18, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.