Juízes 13

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 Israel pipol sin against God again, so E kon allow Filistia pipol rule dem for forty years.
1 Os israelitas voltaram a fazer o que o Senhor reprova, e por isso o Senhor os entregou nas mãos dos filisteus durante quarenta anos.
2 For dat time, Manoah, one man wey kom from Dan tribe, dey stay for Zorah. E nor get any pikin, bikos en wife neva born.
2 Certo homem de Zorá, chamado Manoá, do clã da tribo de Dã, tinha mulher estéril.
3 God angel appear to Manoah wife kon tell am, “Even doh yu neva fit born pikin, yu go soon get belle and yu go born boy.
3 Certo dia o anjo do Senhor apareceu a ela e lhe disse: "Você é estéril, não tem filhos, mas engravidará e dará à luz um filho.
4 So make yu dey kareful and make yu nor drink wine or any oda strong drink or chop any food wey dem dey forbid.
4 Todavia, tenha cuidado, não beba vinho nem outra bebida fermentada, e não coma nada impuro;
5 Afta yu don born am, make yu nor ever kut en hair, bikos from di day wey dem born am, dem go dedikate am give God as Nazirite. E go save Israel pipol from Filistia pipol hand.”
5 e não se passará navalha na cabeça do filho que você vai ter, porque o menino será nazireu, consagrado a Deus desde o nascimento; ele iniciará a libertação de Israel das mãos dos filisteus".
6 Den di woman run go tell en husband, “One man from God appear to mi! E look like God angel and if yu si am, yu go fear. I nor ask am where e from kom and e nor tell mi en name.
6 Então a mulher foi contar tudo ao seu marido: "Um homem de Deus veio falar comigo. Era como um anjo de Deus, de aparência impressionante. Não lhe perguntei de onde tinha vindo, e ele não me disse o seu nome,
7 But e tell mi sey, ‘I go get belle kon born boy.’ E still sey, ‘Make I nor drink wine or any strong drink or chop food wey dem dey forbid, bikos from di day wen I go born di pikin go rish di day wey e go die, dem go dedikate am give God as Nazirite.’ ”
7 mas ele me assegurou: ‘Você engravidará e dará à luz um filho. Todavia, não beba vinho nem outra bebida fermentada, e não coma nada impuro, porque o menino será nazireu, consagrado a Deus, desde o nascimento até o dia da sua morte’ ".
8 Den Manoah pray give God, “My God! Abeg, make yor angel kom again kon tell us more tins wey wi go do about di pikin, wen dem don born am.”
8 Então Manoá orou ao Senhor: "Senhor, eu te imploro que o homem de Deus que enviaste volte para nos instruir sobre o que fazer com o menino que vai nascer".
9 God do wetin Manoah ask for and en angel kom back kon meet di woman wen e sidan for field. Dat time, en husband Manoah, nor dey with am.
9 Deus ouviu a oração de Manoá, e o anjo de Deus veio novamente falar com a mulher quando ela estava sentada no campo; Manoá, seu marido, não estava com ela.
10 So di woman run go tell en husband kwik-kwik sey, “Di man wey appear to mi dat day, don kom again!”
10 Mas ela foi correndo contar ao marido: "O homem que me apareceu outro dia está aqui! "
11 So Manoah get up kon follow en wife and wen e si di angel, e kon sey, “Na yu bi di man wey tok to my wife dat day?”
11 Manoá levantou-se e seguiu a mulher. Quando se aproximou do homem, perguntou: "És tu o que falaste com a minha mulher? " "Sim", disse ele.
12 Den Manoah sey, “If wetin yu tok so happen, wish kind tins di boy go dey do and wish kind life e go live?”
12 "Quando as suas palavras se cumprirem", Manoá perguntou, "como devemos criar o menino? O que ele deverá fazer? "
13 God angel ansa, “Make sure sey, yor wife do di tins wey I sey make e do.
13 O Anjo do Senhor respondeu: "Sua mulher terá que seguir tudo o que eu lhe ordenei.
14 E must nor chop anytin wey dem make from grape vine; make e nor drink wine or any strong drink or chop food wey dem dey forbid.”
14 Ela não poderá comer nenhum produto da videira, nem vinho ou bebida fermentada, nem comer nada impuro. Terá que obedecer a tudo o que lhe ordenei".
15 Den Manoah tell God angel, “Abeg stay here make wi kill and kook one small goat make yu chop.”
15 Manoá disse ao Anjo do Senhor: "Gostaríamos que ficasses conosco; queremos oferecer-te um cabrito".
16 Di angel ansa, “I go stay, but I nor go chop anytin. Instead, make yu kook and burn am as ofrin give God.” (Manoah tok like dis, bikos e nor know sey na God angel dey with am.)
16 O anjo do Senhor respondeu: "Se eu ficar, não comerei nada. Mas, se você preparar um holocausto, ofereça-o ao Senhor". Manoá não sabia que ele era o anjo do Senhor.
17 Den Manoah ask God angel, “Wetin bi yor name, so dat wi go honor yu wen all dis tins don happen.”
17 Então Manoá perguntou ao anjo do Senhor: "Qual é o teu nome, para que te prestemos homenagem quando se cumprir a tua palavra? "
18 Di angel ansa, “Why yu won know my name? My name too dey wonderful to undastand.”
18 Ele respondeu: "Por que pergunta o meu nome? Meu nome está além do entendimento".
19 Den Manoah take small goat and some korn kon offa dem for di altar on-top rock as ofrin to God wey dey do wonders.
19 Então Manoá apanhou um cabrito e a oferta de cereal, e os ofereceu ao Senhor sobre uma rocha. E o Senhor fez algo estranho enquanto Manoá e sua mulher observavam:
20 As di smoke dey go up for di altar, Manoah and en wife kon si God angel inside di smoke dey go heaven, so dem kon fall face groun.
20 Quando a chama do altar subiu ao céu, o Anjo do Senhor subiu na chama. Vendo isso, Manoá e à sua mulher prostraram-se, rosto em terra.
21 Na den dem kon know sey di man na God angel, so e nor appear to dem again.
21 Como o Anjo do Senhor não voltou a manifestar-se a Manoá e à sua mulher, Manoá percebeu que era o Anjo do Senhor.
22 Manoah tell en wife, “Wi go die, bikos wi don si God!”
22 "Sem dúvida vamos morrer! " disse ele à mulher, "pois vimos a Deus! "
23 But di wife ansa, “If God won kill us, E nor for asept awa burnt ofrin and E nor for appear to us kon tell us all dis wonderful tins or do dis mirakle.”
23 Mas a sua mulher respondeu: "Se o Senhor tivesse a intenção de nos matar, não teria aceitado o holocausto e a oferta de cereal das nossas mãos, nem nos teria mostrado todas essas coisas, nem nos teria revelado o que agora nos revelou".
24 So wen di woman born, e kon koll di pikin, “Samson.” Di pikin grow well and God kon bless am.
24 A mulher deu à luz um menino e pôs-lhe o nome de Sansão. Ele cresceu, e o Senhor o abençoou,
25 God Spirit gi-am pawa and e dey stay for Dan wey dey between Zorah and Eshtaol.
25 e o Espírito do Senhor começou a agir nele quando ele se achava em Maané-Dã, entre Zorá e Estaol.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Juízes 13, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.