Juízes 11

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVT

Sair da comparação
NVT Nova Versão Transformadora
1 Jeftah na one strong man for Jabesh-Gilead. En mama na ashawo and na en papa bi Gilead.
1 Jefté era um guerreiro corajoso. Era filho de Gileade, mas sua mãe era uma prostituta.
2 Gilead wife for house still born oda sons for am and wen di oda sons don big, dem kon tell Jeftah, “Make yu nor tink sey yu go get any of awa papa propaty, bikos na ashawo born yu. So make yu komot awa house.”
2 A esposa de Gileade teve muitos filhos, e quando esses meios-irmãos cresceram, expulsaram Jefté, dizendo: “Você não receberá parte alguma da herança de nosso pai, pois é filho de outra mulher”.
3 So Jeftah komot from di house kon go stay for Tob town. Na for der e for make sturbon friends kon dey follow dem waka.
3 Então Jefté fugiu de seus irmãos e foi viver na terra de Tobe. Em pouco tempo, passou a chefiar um bando de desocupados que se uniram a ele.
4 E nor too tey, before Ammon pipol kom fight Israel pipol.
4 Por essa época, os amonitas começaram a guerrear contra Israel.
5 Wen di fight start, Gilead leaders kon go tell Jeftah for Tob town
5 Quando os amonitas atacaram, os líderes de Gileade mandaram buscar Jefté na terra de Tobe.
6 sey, “Make yu kom lead us go fight Ammon pipol.”
6 “Venha e seja nosso comandante!”, disseram. “Ajude-nos a lutar contra os amonitas!”
7 But Jeftah ansa, “Nor bi bikos una hate mi well-well, naim make una force mi komot from my papa house. Why una kom meet mi naw wen una dey trobol?”
7 Mas Jefté lhes disse: “Não são vocês os mesmos que me odiavam e que me expulsaram da casa de meu pai? Por que me chamam agora que estão em apuros?”.
8 Dem ansa, “Wi kom meet yu, bikos wi wont make yu lead all of us for Gilead go fight Ammon pipol.”
8 “Porque precisamos de você”, responderam os líderes. “Se você nos comandar na batalha contra os amonitas, nós o proclamaremos governante de todo o povo de Gileade.”
9 Den Jeftah tell dem, “If I follow una go fight Ammon pipol and God give mi viktory, I go bi una ruler?”
9 Jefté lhes disse: “Quer dizer que se eu for com vocês e o S enhor me der a vitória sobre os amonitas, governarei todo o povo?”.
10 Dem ansa, “Yes! Wi agri and na God bi awa witness.”
10 Os líderes de Gileade responderam: “O S enhor é nossa testemunha de que faremos exatamente como você disse”.
11 So, Jeftah follow Gilead leaders go back and di pipol kon make am dia leader and ruler. Jeftah tell dem wetin e wont wen dem dey God present for Mizpa.
11 Então Jefté foi com os líderes de Gileade, e o povo o fez governante e comandante do exército. Em Mispá, na presença do S enhor , Jefté repetiu o que tinha dito aos líderes.
12 Afta, Jeftah send messenjas go meet Ammon king kon ask am, “Wetin make yu won attack awa land?”
12 Jefté enviou mensageiros ao rei de Amom para perguntar: “Por que você saiu para guerrear contra minha terra?”.
13 Ammon king ansa, “Na bikos Israel pipol take my land, wen dem dey kom out from Egypt. Dem take my land wey start from Arnon River for sout go rish Jabbok River for nort and Jordan River for west. So make una give mi back, so dat peace go dey.”
13 O rei de Amom respondeu aos mensageiros de Jefté: “Quando saíram do Egito, os israelitas roubaram minhas terras desde o rio Arnom até o rio Jaboque, e até o Jordão. Agora, devolva-nos pacificamente esse território”.
14 Jeftah kon send messenjas go back go meet Ammon king
14 Jefté enviou a seguinte mensagem em resposta ao rei amonita:
15 sey,
15 “Assim diz Jefté: Israel não roubou terra alguma de Moabe nem de Amom.
16 Wen dem komot from Egypt, dem travel pass di desert from di Red Sea till dem rish Kadesh.
16 Quando o povo de Israel veio do Egito e chegou a Cades, depois de atravessar o mar Vermelho,
17 Israel pipol send messenjas go meet Edom king sey, ‘Abeg make yu allow us pass yor land.’ But Edom king nor gri. Dem still tell Moab king di same tin, but e nor gri too. Den Israel pipol kon stay for Kadesh.
17 enviou mensageiros ao rei de Edom e pediu: ‘Deixe-nos passar por sua terra’. Contudo, seu pedido foi negado. Então fizeram o mesmo pedido ao rei de Moabe, mas ele também não os deixou passar. Por isso, o povo de Israel ficou em Cades.
18 Israel pipol pass thru di desert and dem nor tosh Edom or Moab pipol with dia land. Dem travel go east for Moab land kon go kamp for di oda side for Arnon River, but dem nor cross Arnon, bikos Arnon divide Moab kountry.
18 “Depois, passaram pelo deserto, contornando Edom e Moabe. Acompanharam a divisa de Moabe a leste e acamparam do outro lado do rio Arnom. Em momento algum atravessaram o Arnom para entrar em Moabe, pois o Arnom era a divisa de Moabe.
19 Israel pipol send messenjas go meet King Sihon for Amor wey dey rule from Heshbon sey, ‘Abeg make yu allow us pass yor land go awa land.’
19 “Então Israel enviou mensageiros a Seom, rei dos amorreus, que governava em Hesbom, e pediu: ‘Deixe-nos passar por sua terra, para chegarmos ao nosso destino’.
20 But King Sihon nor gri, instead, e gada all en sojas, go kamp for Jahza kon attack dem.
20 O rei Seom, porém, não confiava em Israel o suficiente para deixar o povo passar por seu território. Em vez disso, mobilizou seu exército em Jaza e atacou Israel.
21 But di Oga wey bi Israel pipol God, make dem win King Sihon and en sojas. So dem kon take di land wey bi Amor pipol own.
21 Mas o S enhor , o Deus de Israel, entregou o rei Seom nas mãos de seu povo, que derrotou os amorreus. Israel tomou posse de toda a terra dos amorreus que viviam naquela região,
22 Dem take Amor land, from Arnon River for sout go rish Jabbok River for nort and from di desert wey dey for east go rish Jordan River for west.
22 desde o Arnom até o Jaboque, e desde o deserto até o Jordão.
23 Since di Oga wey bi Israel pipol God don drive Amor pipol komot bikos of en pipol, yu tink sey yu go fit just kom take am from dem?
23 “Como você vê, foi o S enhor , o Deus de Israel, que tirou a terra dos amorreus e a entregou a Israel. Por que, então, haveríamos de devolvê-la?
24 Yu fit take anytin wey Kemosh yor god give yu, but wi go take all di land wey di Oga awa God give us.
24 Fique com o que seu deus Camos lhe der, e nós ficaremos com o que o S enhor , nosso Deus, nos der.
25 Yu tink sey yu betta pass Balak, Zippor pikin wey bi Moab king? E try to shalenge Israel pipol, abi e nor do am? E nor ever fit fight us.
25 Acaso você é melhor que Balaque, filho de Zipor, rei de Moabe? Ele tentou disputar esses territórios com Israel? Entrou em guerra contra os israelitas?
26 For three hundred years naw, Israel pipol dey stay for Heshbon and di towns wey dey near am; Aroer and di towns wey dey near am and di oda town wey dey Arnon! Why yu nor kom klaim di land, dat time?
26 “Israel vive aqui há trezentos anos. Habita em Hesbom e nos povoados ao redor, até Aroer e seus povoados, e todas as cidades às margens do rio Arnom. Por que, até agora, vocês não fizeram esforço algum para reaver esse território?
27 I neva do yu any bad tin, but naw, yu dey do mi bad as yu kom attack mi. Make God wey dey judge, judge today between Israel and Ammon pipol!”
27 Portanto, não pequei contra você. Pelo contrário, você fez mal ao me atacar. Que o S enhor , o Juiz, decida hoje qual de nós está certo: Israel ou Amom”.
28 But Ammon king, nor listin to Jeftah message.
28 Mas o rei de Amom não deu atenção à mensagem de Jefté.
29 Dat time, God Spirit dey with Jeftah and e kon go Gilead and Manasseh town. E lead en sojas from Mizpa wey dey Jabesh-Gilead, go fight Ammon pipol.
29 Então o Espírito do S enhor veio sobre Jefté. Ele atravessou o território de Gileade e Manassés, incluindo Mispá em Gileade, e dali avançou contra os amonitas.
30 Jeftah make vow give God sey, “If Yu make mi win Ammon pipol,
30 Jefté fez um voto ao S enhor : “Se entregares os amonitas em minhas mãos,
31 anytin wey go first kom out from my house kom welkom mi, I go sakrifice am as burn ofrin give Yu.”
31 darei ao S enhor o que sair primeiro de minha casa quando eu regressar vitorioso. Eu o oferecerei como holocausto”.
32 So, Jeftah lead en sojas go fight Ammon pipol and God gi-am viktory.
32 Jefté saiu com seu exército para combater os amonitas, e o S enhor os entregou em suas mãos.
33 E kill Ammon pipol kon distroy about twenty towns, from Aroer go rish one aria wey near Minnit till e distroy rish Abel-Keramin. Na like dis Israel pipol take win Ammon pipol.
33 Ele aniquilou os amonitas e destruiu vinte cidades, desde Aroer até os arredores de Minite, chegando até Abel-Queramim. Assim, os israelitas derrotaram os amonitas.
34 Wen Jeftah rish en house for Mizpa, en only pikin wey e get for en life, run kom out kon meet am, dey dance and play tamborin with happiness.
34 Quando Jefté voltou para casa em Mispá, sua filha saiu ao seu encontro, tocando tamborim e dançando. Era sua única filha; ele não tinha nenhum outro filho nem filha.
35 Wen e si am, e vex kon tear en klot. E kry kon shaut, “Oh my dota! Yu don distroy mi! Yu don kause wahala for mi! I don make vow give God and I nor go fit take am back.”
35 Quando Jefté a viu, rasgou as próprias roupas e gritou. “Ah, minha filha! Você acabou comigo! Trouxe desgraça sobre mim! Fiz um voto ao S enhor e não posso voltar atrás!”.
36 Naim di girl sey, “Papa, if yu make vow give God, den yu must do wetin yu vow, bikos na God give yu viktory ova yor enemies, Ammon pipol.
36 Ela disse: “Pai, se fez um voto ao S enhor , faça comigo o que prometeu, pois o S enhor lhe deu grande vitória sobre seus inimigos, os amonitas.
37 But first allow mi go do dis one tin: Allow mi go on-top di hill go roll and kry with my friends for two mont first, bikos I go die as virgin.”
37 Mas, primeiro, permita que eu ande pelos montes e chore com minhas amigas por dois meses, pois morrerei virgem”.
38 Jeftah tell am, “Yu fit go.” So Jeftah allow am go for two monts. Di pikin and en friends kon go di hill for two monts dey kry, bikos e nor go ever born shidren.
38 “Pode ir”, disse Jefté, e deixou que ela se ausentasse por dois meses. Ela e suas amigas foram para os montes e lamentaram, pois ela jamais teria filhos.
39 Wen e rish house, di papa do di vow wey e make give God kon kill di girl as virgin.
39 Quando ela voltou para casa, seu pai cumpriu o voto que havia feito, e ela morreu sem ter tido relações com homem algum. Por isso, tornou-se costume em Israel
40 So Israel yong wimen, dey komot for four days evry year go mourn, bikos of wetin happen to Jeftah pikin.
40 as moças israelitas saírem por quatro dias todos os anos para lamentar o destino da filha de Jefté, de Gileade.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Juízes 11, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.