Josué 9

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVT

Sair da comparação
NVT Nova Versão Transformadora
1 Wen all di kings for Jordan River west; di kountries for hill; di ones for di valley go rish Mediterranean wotaside; plus di whole Lebanon (plus Hit, Amor, Kanaan, Periz, Hiv and Jebus pipol) hear about Israel pipol and wetin dem do,
1 Todos os reis a oeste do rio Jordão souberam do que havia acontecido. Eram os reis dos hititas, dos amorreus, dos cananeus, dos ferezeus, dos heveus e dos jebuseus que viviam nas montanhas, nas colinas do oeste, ao longo do litoral do mar Mediterrâneo, até as montanhas do Líbano, ao norte.
2 dem kon join togeda won go fight against Joshua and Israel pipol.
2 Esses reis juntaram suas tropas para lutar como um só exército contra Josué e os israelitas.
3 Wen di pipol for Gibeon hear wetin Joshua do to Jeriko and Ai,
3 Contudo, quando os habitantes de Gibeom souberam do que Josué tinha feito com Jericó e Ai,
4 dem kon tink and do wetin dey wise. Dem kollect some food kon put tear-tear klot on-top dia donkey with wine bag wey don tear wey dem pash.
4 usaram de astúcia para se salvar. Enviaram mensageiros a Josué e carregaram seus jumentos com sacos gastos e vasilhas de couro velhas e rachadas.
5 Dem wear sandal wey dem don pash kon wear tear-tear klot. All dia bread dry and strong.
5 Os mensageiros calçavam sandálias gastas e remendadas e vestiam roupas esfarrapadas, e também levavam pães secos e esfarelados.
6 Dem kom meet Joshua for di kamp for Gilgal kon tell en and di men for Israel sey, “Where wi from kom dey far well-well. Make una promise us sey una nor go kill us.”
6 Quando chegaram ao acampamento em Gilgal, disseram a Josué e aos líderes de Israel: “Viemos de uma terra distante para pedir que vocês façam um tratado de paz conosco”.
7 Israel men kon tell Hiv men sey, “E fit bi sey una dey stay near us. So how wi go fit make promise with una?”
7 Os israelitas disseram a esses heveus: “Como podemos ter certeza de que não vivem aqui por perto? Pois, se for o caso, não podemos fazer tratado algum com vocês”.
8 But dem kon tell Joshua, “Wi won bi yor savant.”
8 Eles responderam: “Somos seus servos”. “Mas quem são vocês?”, insistiu Josué. “De onde vieram?”
9 Dem ansa, “Where yor savants from kom, far well-well and wi dey respet God, bikos wi don hear of all di tins wey E do for una for Egypt
9 Eles disseram: “Seus servos vieram de uma terra muito distante. Ouvimos falar do poder do S enhor , seu Deus, e de tudo que ele fez no Egito.
10 and di ones wey E do to di two Amor pipol king for di oda side for Jordan River and dem bi King Sihon for Heshbon and King Og for Bashan wey dey Ashtarot.
10 Também soubemos do que ele fez aos dois reis amorreus a leste do Jordão: Seom, rei de Hesbom, e Ogue, rei de Basã, que vivia em Astarote.
11 Na awa leaders and pipol sey, ‘Make una take food for una journey go meet dem. Tell dem sey wi dey ready to bi dia savant. So make dem promise us sey dem nor go kill us.’
11 Por isso, nossos líderes e todo o nosso povo nos instruíram: ‘Levem provisões para uma viagem longa. Vão encontrar-se com os israelitas e digam-lhes: Somos seus servos; por favor, façam um tratado conosco’.
12 Awa bread dey warm wen wi start dis journey, but naw, e don dry kon strong.
12 “Estes pães haviam acabado de sair do forno quando partimos. Agora, como podem ver, estão secos e esfarelados.
13 Di wine bag get betta wine wen wi start di journey, but make una si how dem don skata finish. Awa klot and sandals don skata, bikos di journey long well-well.”
13 Estas vasilhas de couro estavam novas quando as enchemos, mas agora estão rachadas. E nossas roupas e sandálias estão gastas da viagem extremamente longa”.
14 Di men for Israel look some of dia tins well-well, but dem forget to ask God sey wetin dem go do.
14 Os israelitas examinaram as provisões deles, mas não consultaram o S enhor a respeito.
15 Joshua promise dem peace kon sey e nor go kill dem. Israel leaders sef agri wetin Joshua tok.
15 Josué fez um tratado de paz com aqueles homens e garantiu que pouparia a vida deles, e os líderes da comunidade confirmaram o acordo com um juramento.
16 Three days afta dem agri with Gibeon pipol, Israel pipol kon know sey dem dey stay near dem.
16 Três dias depois de fazerem esse tratado, os israelitas descobriram que, na verdade, os gibeonitas viviam ali perto.
17 So Israel pipol go and afta three days dem kon rish di town wey Gibeon, Kefirah, Beerot and Kiriat-Jearim pipol dey stay.
17 Partiram de imediato naquela direção e, em três dias, chegaram às cidades dos gibeonitas, chamadas Gibeom, Quefira, Beerote e Quiriate-Jearim.
18 Israel pipol nor attack dem, bikos dia leaders don use Israel God name take swear sey dem nor go kill dem.
18 Contudo, não atacaram as cidades, pois os líderes da comunidade haviam feito um juramento em nome do S enhor , o Deus de Israel. Toda a comunidade se queixou contra seus líderes por causa do tratado,
19 but di leaders kon tell di pipol sey, “Wi use Israel God take swear sey wi nor go kill dem. So naw, wi nor go fit kill dem!
19 mas eles responderam: “Uma vez que fizemos um juramento na presença do S enhor , o Deus de Israel, não podemos tocar neles.
20 Wi must let dem live, so dat wi nor go put curse for awa head.”
20 Temos de deixá-los viver, pois se quebrássemos o juramento a ira divina cairia sobre nós.
21 Di leaders still sey, “Make dem live.” So Gibeon pipol kon dey kut wood and karry wota for di whole kommunity, just as di leaders wont am.
21 Que eles vivam!”. Assim, os israelitas os colocaram para cortar lenha e carregar água para toda a comunidade, de acordo com a decisão dos líderes.
22 Joshua koll Gibeon pipol kon tell dem, “Wetin make una deceive us wen una sey, ‘Where wi der stay, far from una,’ wen una really dey stay near us?
22 Josué reuniu os gibeonitas e lhes disse: “Por que vocês mentiram para nós? Por que disseram que viviam numa terra distante da nossa quando, na verdade, vivem aqui perto?
23 Naw, una go bi awa savants forever and una go dey kut wood and karry wota go awa God house.”
23 Sejam amaldiçoados! De agora em diante, vocês serão sempre servos, encarregados de cortar lenha e carregar água para a casa do meu Deus”.
24 Dem kon tell Joshua, “Wi do like dis, bikos wi hear sey na really true sey di Oga una God don kommand Moses make e give una di whole land kon kill all di pipol wey dey stay der as una rish der. Wi do like dis, bikos wi dey fear una and wi nor won die.
24 Eles responderam: “Agimos desse modo porque foi anunciado a nós, seus servos, que o S enhor , seu Deus, havia ordenado a seu servo Moisés que desse a vocês toda esta terra e que destruísse todos os seus habitantes. Tememos muito por nossa vida por causa de vocês.
25 So naw, wi dey under una. Make una do us wetin una tink sey dey good to do.”
25 Agora, estamos em suas mãos. Façam conosco o que lhes parecer correto”.
26 Joshua kon do as dem tok; E nor let Israel pipol kill dem
26 Assim, Josué livrou os gibeonitas e não permitiu que os israelitas os matassem.
27 and from dat day go, e kon make dem dey kut wood and karry wota for di kommunity and for God altar. Till today, dem still dey do dis work for where God choose sey, make dem dey woship am.
27 Naquele dia, porém, encarregou-os de cortar lenha e carregar água para toda a comunidade de Israel e para o altar do S enhor , no lugar que o S enhor escolhesse construí-lo. Isso é o que fazem até hoje.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Josué 9, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.