Josué 7

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 Israel pipol disobey wetin dem tell dem about di tins wey dey Jeriko. Akan wey bi Karmi pikin, wey Zabdi born, wey Zera born from Judah tribe, kon tif some tins from Jeriko, so God kon dey vex for Israel pipol.
1 Os israelitas cometeram uma infidelidade a respeito do interdito. Acã, filho de Carmi, filho de Zabdi, filho de Zara, da tribo de Judá, reteve para si algumas coisas condenadas, e a cólera do Senhor inflamou-se contra os israelitas.
2 Joshua send men from Jeriko sey make dem go spy Ai town (Ai town dey near Bet-Aven, di east side for Bethel land) e kon tell dem, “Make una go spy di land.” So di men kon go spy di town.
2 Josué enviou de Jericó homens a Hai, situada junto de Bet-Aven, ao oriente de Betel: Subi, disse-lhes ele, e explorai a terra. Eles subiram e exploraram Hai.
3 Dem kom back kon tell Joshua, “Nor send all di sojas go, about two or 3,000 sojas go distroy di whole Ai town. Nor disturb di whole sojas, bikos Ai na small town.”
3 Voltando para junto de Josué, disseram-lhe: É inútil o povo todo subir, mas vão só dois ou três mil homens e apoderem-se da cidade. Não se fatigue todo o povo, porque a população da cidade é muito reduzida.
4 So about 3,000 men kon go, but dem run from Ai men.
4 Três mil homens aproximadamente se puseram a caminho, mas foram batidos pela gente de Hai,
5 Ai men kill about thirty-six from dem kon porshu di rest of dem from di town gate go rish di low aria. Di pipol pawa fail dem like ice-blok wey dey melt.
5 caindo mortos trinta e seis homens; os inimigos perseguiram-nos desde a porta da cidade até Sabarim, ainda quando fugiam pela encosta. O povo ficou consternado com isso e perdeu toda a coragem.
6 Joshua tear en klot; en and di leaders for Israel fall for groun before di Kovenant Box until evening and dem pak dirty full dia head
6 Josué rasgou suas vestes e prostrou-se com a face por terra até a tarde diante da arca do Senhor, tanto ele como os anciãos de Israel, e cobriram de pó as suas cabeças.
7 Joshua kon pray, “My Oga God! Wetin make Yu take us cross Jordan River kon give us to Amor pipol, so dat dem go distroy us?
7 Ah, Senhor Javé, clamou Josué, por que fizestes este povo passar o Jordão, para nos entregardes nas mãos dos amorreus que nos destruirão? Oxalá tivéssemos ficado do outro lado do rio!
8 “Why wi nor just stay for di oda side for Jordan River! Wetin I go tok naw wey Israel pipol dey run from dia enemies?
8 Que direi eu, Senhor, vendo Israel voltar as costas aos seus inimigos?
9 Wen Kanaan pipol and evribody wey dey stay di land go hear wetin happen so, all of dem go kom distroy us and nobody go remember us. My Oga God, wetin Yu go do to keep yor respet?”
9 Os cananeus e todos os habitantes da terra vão sabê-lo, e nos cercarão e farão desaparecer o nosso nome da face da terra. E que fareis vós ao vosso grande nome?
10 God ansa Joshua, “Make yu get up! Wetin make yu face groun dey mourn?
10 Então o Senhor disse a Josué: Levanta-te. Por que estás assim prostrado com a face por terra?
11 Israel pipol don sin; dem don go against my kommandment! Dem take some tins wey I sey make dem keep for mi from Jeriko; dem tif dem kon put dem join dia own propaty.
11 Israel pecou, a ponto de violar a aliança que eu lhe tinha prescrito, e a ponto de tomar as coisas votadas ao interdito, roubá-las, ocultá-las, escondê-las entre as bagagens.
12 Israel pipol nor fit stand for dia enemies front; dem run bikos disgrace don dey follow dem. I nor go dey with una again, unless una distroy wetin make dis wahala dey happen to una.
12 Eis por que os israelitas não puderam resistir aos seus inimigos, mas voltaram-lhes as costas, pois caíram sob o interdito. Se não tirardes o interdito do meio de vós, não estarei mais convosco de ora em diante.
13 “Make yu get up! Go santify di pipol make yu tell dem: ‘Make una santify unasef before tumoro, bikos Israel God sey, “Israel pipol, una body dey dirty! Una nor go fit fight una enemies until una remove wetin make una dirty.”
13 Vai santificar o povo; dize-lhe: purificai-vos para amanhã, porque eis o que diz o Senhor, Deus de Israel: o interdito está no meio de ti, Israel. Não poderás resistir aos teus inimigos, enquanto não tiveres tirado o interdito que está no meio de vós.
14 “ ‘Wen day break, una must kom akordin to tribe. Di tribe wen God go choose go kom akordin to village. Di village wey God go choose go kom akordin to family. Di family wey God go choose must kom man by man.
14 Vireis amanhã, tribo por tribo; a tribo que for designada pelo Senhor apresentar-se-á família por família; e a família marcada se apresentará por suas casas; e a casa indicada pelo Senhor se apresentará por pessoas.
15 Di pesin wey dem katch with di propaty, dem must burn am with evribody wey bi en own, bikos e nor do wetin God tok and e don disgrace Israel pipol.’ ”
15 Aquele que for designado como possuidor do interdito será queimado, ele e tudo o que lhe pertence, porque violou o pacto do Senhor e cometeu uma infâmia em Israel.
16 Di next day for early morning, Joshua kon tell Israel pipol make dem kom tribe by tribe and God kon choose Judah tribe.
16 No dia seguinte pela manhã, Josué mandou vir o povo, tribo por tribo, e a sorte caiu sobre a tribo de Judá.
17 Joshua sey make di pipol for Judah kom village by village and God kon choose Zera village. Joshua sey make Zera pipol kom family by family and God kon choose Zabdi family.
17 Em seguida, aproximando-se as famílias de Judá, a sorte indicou a família de Zara. Mandou que se aproximasse a família de Zara por casas, e a sorte caiu sobre a de Zabdi,
18 Joshua sey make Zabdi Family kom man by man and God kon choose Akan wey en papa na Karmi and Karmi papa na Zabdi wey bi Zera pikin and Zera kom from Judah tribe wey God choose.
18 a qual se apresentou por pessoas; a sorte caiu sobre Acã, filho de Carmi, filho de Zabdi, filho de Zara, da tribo de Judá.
19 So Joshua kon tell Akan, “My pikin, respet Israel God make yu praiz am! Tell mi wetin yu do; nor deceive mi at-all!”
19 Josué disse-lhe: Meu filho, dá glória e homenagem ao Senhor, Deus de Israel; confessa-me o que fizeste, sem nada ocultar.
20 Akan kon tell Joshua, “Na trut. I don sin against Israel God:
20 Acã respondeu a Josué: Sim, fui eu que pequei contra o Senhor, Deus de Israel. Eis o que fiz:
21 From di tins wey wi karry from Jeriko, I si one fine klot from Babilon, with two silva koin and one gold wey heavy rish fifty fit. I like dem, so I take dem. I hide dem under di groun for my tent centre.”
21 vi no meio dos despojos um belo manto de Senaar, duzentos siclos de prata e uma barra de ouro de cinqüenta siclos e, cobiçando, tomei-os. Tudo isso se acha escondido na terra no meio de minha tenda e a prata debaixo {do manto}.
22 So Joshua send pipol go di tent. Di tins dey for di tent and di silva dey under dem.
22 Josué mandou alguns homens que investigassem a tenda, e estes viram que os objetos estavam lá ocultos, e a prata debaixo.
23 Dem take all of dem from di tent centre kon go give Joshua and Israel pipol kon put am for where God go for si am.
23 Tomaram-nos e trouxeram-nos a Josué e a todos os israelitas e puseram-nos diante do Senhor.
24 Den Joshua and Israel pipol take Akan, Zera pikin with di klot, di silva, di gold, en shidren, melu, donkey, sheep, tent and evritin wey bi en own go Akor Valley (wey mean Wahala Valley).
24 Então Josué, em presença de todo o Israel, pegando em Acã, filho de Zara, com a prata, o manto, a barra de ouro, os filhos e as filhas de Acã, seus bois, seus jumentos, suas ovelhas, sua tenda e tudo o que lhe pertencia, levou-os ao vale de Acor.
25 Joshua kon sey, “Wetin make yu bring wahala for awa head? God go put wahala for yor head today!”
25 Chegando ali, Josué disse: Por que nos confundiste? O Senhor te confunda hoje! Todos os israelitas o apedrejaram. E foram queimados no fogo depois de terem sido apedrejados.
26 Dem pak many stones on-top dem (di stones dey der till today) and God vexnashon kon stop. So till today, na Akor Valley dem dey koll dat place.
26 E juntaram sobre Acã um grande monte de pedras, o qual subsiste ainda hoje. Com isso aplacou-se o furor do Senhor. É por esse motivo que o lugar traz ainda agora o nome de vale de Acor.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Josué 7, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.